Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 97. (Read 1021761 times)

newbie
Activity: 44
Merit: 0
Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
Welcome bro, the matter no too they difficult to understand, all the rules wey you suppose know they for meta section, you go see am for the pinned/sticky threads there, go there, take your time read am for better understanding. Well to summarize am ehn, you earn merits when you make constructive posts wey other people like, them go fit give you merits for it, carry for mind say no be merit be the koko here, na your contribution, the better it is, the more likely wey merit go fit show for your side, as for the rules, one wey they most important na im be say make you no plagiarize, no copy person work, come paste am as your own without giving credit. Go check the rules for where i tell you say you go find am, anything wey you no still understand you go use the search button find am, or you drop am here, people they on ground to respond to you.

I don check your posts like this, i see say na bounty reports full for there, no be say e bad oh, but make i tell you truth, e they counter-productive, time don go when bounty they productive, better things they plenty other parts of the forum in the long run, if you fit calm down and learn; na your decision sha.

Senior men dem make una still show me how I go fit dey more productive than just bounty alone. I see a lot of active members, activities and so on, I hope with time o get to be on that list, but in the mean time I no go mind to dey educated from una, learn new things and better way to run matas for this forum.
newbie
Activity: 44
Merit: 0
Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
Welcome bro, the matter no too they difficult to understand, all the rules wey you suppose know they for meta section, you go see am for the pinned/sticky threads there, go there, take your time read am for better understanding. Well to summarize am ehn, you earn merits when you make constructive posts wey other people like, them go fit give you merits for it, carry for mind say no be merit be the koko here, na your contribution, the better it is, the more likely wey merit go fit show for your side, as for the rules, one wey they most important na im be say make you no plagiarize, no copy person work, come paste am as your own without giving credit. Go check the rules for where i tell you say you go find am, anything wey you no still understand you go use the search button find am, or you drop am here, people they on ground to respond to you.

I don check your posts like this, i see say na bounty reports full for there, no be say e bad oh, but make i tell you truth, e they counter-productive, time don go when bounty they productive, better things they plenty other parts of the forum in the long run, if you fit calm down and learn; na your decision sha.

Thanks bro I really appreciate you valid boss. Na una go still help this smalar wey I be for this place so. Make I dey learn from una make una dey show me way. I go dey follow the group small small take dey learn, anywhere wey e be like e hook I no go hesitate to ask questions. Na who ask questions no dey lost
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.

I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
Chairmo, I welcome you specially come this place. You go like am here if you nor dey do gragra. One tin wey I dey try advise new comers be say make you waka go the meta section go look threads wey dem olopka wey dey the forum dey burst users wey dey plagiarize, scam, or break the forum rules. Make you take am easy with the merit matter... see eh if you do better post you go see as merit go follow you like water. If you nor believe as Agbe. If you get any serious question you fit PM any of we brodas here, dem go help you out.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
Welcome bro, the matter no too they difficult to understand, all the rules wey you suppose know they for meta section, you go see am for the pinned/sticky threads there, go there, take your time read am for better understanding. Well to summarize am ehn, you earn merits when you make constructive posts wey other people like, them go fit give you merits for it, carry for mind say no be merit be the koko here, na your contribution, the better it is, the more likely wey merit go fit show for your side, as for the rules, one wey they most important na im be say make you no plagiarize, no copy person work, come paste am as your own without giving credit. Go check the rules for where i tell you say you go find am, anything wey you no still understand you go use the search button find am, or you drop am here, people they on ground to respond to you.

I don check your posts like this, i see say na bounty reports full for there, no be say e bad oh, but make i tell you truth, e they counter-productive, time don go when bounty they productive, better things they plenty other parts of the forum in the long run, if you fit calm down and learn; na your decision sha.
newbie
Activity: 44
Merit: 0
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.

I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
Baba I welcome you specially for this Naija Board. Na here wey you go feel the brotherly love wey they flow for Naija blood. Hope say you don read some of the rules of the forum so that you no go make any mistake wey go knack you for cassala. Some other rules dem no right am one place, na as you dey get experience you go dey learn more about the unwritten rules. My advice bi say make you no rush things, abeg take am jeje. You go first learn many things before your leg go strong wela for the forum. Even me sef my leg and hand still dey shake like one of Naija presidential aspirants because I still dey learn. Sometimes I dey look the kind merit and rank wey some people get for the forum and the thing go dey hungry me but when I look for their date of registration I come understand say no bi today dem begin work hard for the forum. My brother, welicome.

Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.

I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
Baba I welcome you specially for this Naija Board. Na here wey you go feel the brotherly love wey they flow for Naija blood. Hope say you don read some of the rules of the forum so that you no go make any mistake wey go knack you for cassala. Some other rules dem no right am one place, na as you dey get experience you go dey learn more about the unwritten rules. My advice bi say make you no rush things, abeg take am jeje. You go first learn many things before your leg go strong wela for the forum. Even me sef my leg and hand still dey shake like one of Naija presidential aspirants because I still dey learn. Sometimes I dey look the kind merit and rank wey some people get for the forum and the thing go dey hungry me but when I look for their date of registration I come understand say no bi today dem begin work hard for the forum. My brother, welicome.
newbie
Activity: 44
Merit: 0
EFCC don forget politicians, them forget those way dey spend foreign currency for them country dey focus on these men them... e no soft at all. The just dey common these days for street and e dey drop there rep. Na so SARS been stat o, soon the street go cable cable for them.

Senior man the mata worst pass as you talk sef. The issue of this efcc things na just drama for this naija. All government agencies dey function under the directive of the sitting president and friends wey dey in power. E no get any agency we dey act independently of its own.

If na for oyinbo land now all this agencies like efcc and ndla abi na ndle them go get their power to act right from. Their own boss without minding say them dey fear suspension or replacement. If na for oyinbo land them go don impeach the president from day one but for here them no born them well to even say Mr president you are doing the wrong thing or Mr governor you are not working.

No worry bro wait make buhari comot for that seat then you go dey hear efcc everywhere say them catch one politician, them dey find one politician them recover money wey one politician hide, how them take know all this if no be say them dey work together for that aso rock so when another president come now who he favor go come begin expose the others to save their own head. Efcc no fit do anything until the president comot another one come enter come dey give order say the past administration them chop money make efcc find them.

See wetin buhari do the format efcc president, he just scak am for no reason come replace am with this 40yrs old man wey I no fit even remember him name now. Just like that president comot efcc leader without reason. He no dey happen like that for another place. Let's wait till buhari leave aso rock then you go see how active efcc go dey.
member
Activity: 756
Merit: 30
2morow na Tuesday. I been dey wait 4 d weekly list 2 be published yesterday or 2day, because i promised 2 reward di 1st - 3rd positions of di week but i never see am till now. I dont know how it is done.
Frankolala you are welcome to the forum. This is where the real knowledge of bitcoin and other crypto currencies are shared. So you have to lie low to acquire the knowledge in the forum so you can also teach other. We want 9ja 2 legalize bitcoin and before then, we need a large number of users in the country so that when it starts the transaction will be very easy smooth both online and offline. Make sure be active here and other boards.
For di efcc mata. nigeria is a lawless contri, how come police, ndela, efcc come dey aras pipo like in we contri. 4 weti I see with mi corocoro eye yestaday, i no fit believ till. ndela just go arrest 2 innocent boys in mi area b4 they arrest them eh. see beating. dem come say any person wey come closer go enta 2. oboy na so i go mi way
I never come across weekly updates sha na monthly updates I dey see which I Don manage see myself two times for the list. Twale for our senior men dem @igehhh @uchegod-21 and our oga boss brainboss wey get brain.
Concerning the legalization of crypto in our country ehh no be new thing to us say our leaders no dey like to see average man dey make am so dey no wan legalize am since dey know say we go make am and the thing dey pain dem. Our God go soon intervene sha
The issue of EFCC and NDLEA and the rest just tire me but me I dey think say na set up and avenue to cash out for them. Although na for news I dey always hear the story cux e no too common for my side wey be remote area.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
2morow na Tuesday. I been dey wait 4 d weekly list 2 be published yesterday or 2day, because i promised 2 reward di 1st - 3rd positions of di week but i never see am till now. I dont know how it is done.
Baba I no think there is a weekly user update on this thread, what we have is monthly user update and that is always publish by the beginning of every new month and the thread is managed by @igehhh here is the link: https://bitcointalksearch.org/topic/charts-monthly-overview-of-nigeria-local-board-monthly-merit-reward-5357434
And we are given an analysis based of the chart on users performance and commentaries by my boss @ uchegod-21 and this has been an entertaining schedule every month as it serves as a wake-up call to all of us most especially those who may be sleeping on duty and lacking in they activeness in this thread.
So you have to wait till then, I may be wrong on that if another weekly update exist without my knowledge.
newbie
Activity: 44
Merit: 0
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.

I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
2morow na Tuesday. I been dey wait 4 d weekly list 2 be published yesterday or 2day, because i promised 2 reward di 1st - 3rd positions of di week but i never see am till now. I dont know how it is done.
Frankolala you are welcome to the forum. This is where the real knowledge of bitcoin and other crypto currencies are shared. So you have to lie low to acquire the knowledge in the forum so you can also teach other. We want 9ja 2 legalize bitcoin and before then, we need a large number of users in the country so that when it starts the transaction will be very easy smooth both online and offline. Make sure be active here and other boards.
For di efcc mata. nigeria is a lawless contri, how come police, ndela, efcc come dey aras pipo like in we contri. 4 weti I see with mi corocoro eye yestaday, i no fit believ till. ndela just go arrest 2 innocent boys in mi area b4 they arrest them eh. see beating. dem come say any person wey come closer go enta 2. oboy na so i go mi way
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
  User name : Frankolala
  Genre : male
  State : Yenagoa, Bayelsa
   Skill : Mathematics teacher,Electrian.
   
  I greet all my brothers for the house o,I join this forum May this year but be cos of work I no com fit dey active. The suffer for this country too much, so I say make I com try hustle for this site. I just serious with the forum last 3 weeks, I thank baba God say I don b jnr member now but bros I no go lie for u e no easy here for person like me we no get Idea on bit coin but I dey learn sha

  I bin no know say naija get their own local board until my man Agbe com tell me everything. Na e introduce me to this forum so na my sure Boss.

You are welcome and congratulation. The forum no be 4 bobo juice, Mi 2 i no come kno which drink I go come call am. weti i go tell u bi say, make you no post like dat. read more and comment more on other pipo threads. if u dont know bitcoin as u talk am. make u dey read well well nd ask question.
once again u r welcome on board.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
 User name : Frankolala
  Genre : male
  State : Yenagoa, Bayelsa
   Skill : Mathematics teacher,Electrian.
    
  I greet all my brothers for the house o,I join this forum May this year but be cos of work I no com fit dey active. The suffer for this country too much, so I say make I com try hustle for this site. I just serious with the forum last 3 weeks, I thank baba God say I don b jnr member now but bros I no go lie for u e no easy here for person like me we no get Idea on bit coin but I dey learn sha

  I bin no know say naija get their own local board until my man Agbe com tell me everything. Na e introduce me to this forum so na my sure Boss.
Welcome to we 9ja local thread soon to be local board, but your intro get k leg small were you need to correct ammmm, that place were you put your skill, you come mention mathematics as part of your skills which to me seem to be a profession rather than a skill, the only skills I see there is the electricians, but that one again no go too sell for this side sake of say an digital skills dey marketable for this place. But all in all my ultimate advice be say e no easy bit if you give your best everything go fall into place and before you know it, yourself face go show for this our 9ja corna.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
  User name : Frankolala
  Genre : male
  State : Yenagoa, Bayelsa
  
  I greet all my brothers for the house o,I join this forum May this year but be cos of work I no com fit dey active. The suffer for this country too much, so I say make I com try hustle for this site. I just serious with the forum last 3 weeks, I thank baba God say I don b jnr member now but bros I no go lie for u e no easy here for person like me we no get Idea on bit coin but I dey learn sha

  I bin no know say naija get their own local board until my man Agbe com tell me everything. Na e introduce me to this forum so na my sure Boss.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
The country eh, life hard and to survive cef con hard join. People just believe say, as a young guy, you no suppose get money, you no suppose dey drive. Something way oyibo cef dey drive enter college, na watin dem dey outlaw for we naija, e no dey okay na. Dem just make people way dey try utilise opportunities way dem see online dey difficult. Anyhow way you wan try explain am, na so dem go believe say, na fraud you dey do. Once e no be something way be say, the office dey visible and you dey live okay, them don tag am fraud. The matter just cast.
EFCC don forget politicians, them forget those way dey spend foreign currency for them country dey focus on these men them... e no soft at all. The just dey common these days for street and e dey drop there rep. Na so SARS been stat o, soon the street go cable cable for them.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
and con mistakenly dey on generator for afternoon.. they don tag you Yahoo boy straight oh.
I just dey compelled to chook mouth put for dis particular comment. I read oda nice suggestions by oda members too but dis wan need make I emphasize am. Na true you talk here. At all cost, make una avoid anything wey go make una put gen on for afternoon on work days or leave am on into midnight. E dey follow make people think sey someone na yahoo guy. Get a strong power bank wey go serve your phone wella. You nor even too need laptop to stay for dis forum sef, except you be bounty manager. Me na phone I dey use since I enta dis forum.

@Agbe, congratulobia my guy! You deserve your new rank. Continue to dey keep your head low.

Yeye people. No mind dem any body wey put gen say make even relax as light no dey dey don become yahoo person, na so dem go dey look you dey poke nose to find something wey dem go see. Some go even want look inside your phone screen to know wetin you dey do with am, the whole thing tire person. I believe this power bank suggestion make sense and that one go reduce the burning of generator during the day and maybe weekend go better.

Congrats @Agbe, you don really try because e no easy and brainboss na really encouragement. Make God show him brainboss more love

At all e no easy but big congratulations to our brother @Agbe him really try.
About the power something me for even like buy am too to reduce suspicion from others in compound wey be say for day time person go feel like run Gen chil small make pesin brain calm down base on things around us and matter wey ground na so them go label names.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Discussion: EFCC massive arrest ongoing in Port Harcourt, what's your take on this and any solution to stop this abuse?

So if u never hear, for the past 4-5 weeks PH dey on fire oh massive arrest of young guys between 16 to 30 yrs dey ongoing and no how you go tell me say all of them dey guilty, personally self I fit count how many nights I dun sleep for my house since July. No be say I dey guilty but if them get information come your house see you and you be young guy with expensive lifestyle na money matta before you come out even though you no dey guilty and I dey avoid careless expenses this days. I understand say na Intel dem dey carry move and we know how this business be, e require you to spend enough time for house as na your hustle be this and people wey no understand go think say you dey press since you no dey comot house go work and you dey very alright I come be young guy too (double wahala) 😂😂😂
 
Baba na correct information be this and if we no put mouth for dis matter well tins like dis go continue dey happen for our pitakwa here. De matter dom tire me like dis because you no go tell me say every young boy wey dey live for better house dey dress well dey do Yahoo as efcc dey claim. Baba, I go advice make everybody dey mind people wey dem dey bring come dia house ooo as dis men dey work with boys and girls wey dey give them Intel about person wey dey live large especially if dem no no wetin you dey work.  Me and dem dom battle for 2016 and my only offense be say dem see land document wey bear my name for that reason dem arrest me almost killed me because dem been dey force me to accept say I dey press. No go sleep for hotel because na dia bad pass as some staff dey give dem intel. Just dey your house dey do your work un kum kum no too dey allow unknown faces around you and no too dey overspend if you go out so that eyes no go too dey on you. Finally, carry all the important documents wey dey your house keep for another place because as dem see something wey you buy with big money hmmm you dom dey guilty be that. Did matter no dey get ending as dem go suck anybody wey dem catch till the person dry.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Una Dooo!!! Happy Sunday. First of all. Make una thank you. I bin dey hustled 2 hv 100 merits 2 enta full member. Di mata tired me at dat time, I nearly leave am 4 d hustle. But our boss nd odas encouraged me. So I come dey do am. 2di I don get hero member merit while in full member. I dey speechless. All glory to God nd CryptopreneurBrainboss and dose who helped me 2 achieve dis great achievement. I am still ur boy.
Thanks 2 all. Dose wey dey talk 4 dis thread nd come  1st 2 3 go collect reward. Every week I go give if I get reward 2 encourage ourselves here.
Congratulations broda, na good thing to come back to where u been start in order to appreciate bosses, them they really try to see us grow by given us proper guidance and advices. Weting remain now to to do back and support Ida's with ur experiences, advice and others. I like your courage because you strive to get wetting you want, your dedication was the main caurage, ride on @Agbe, this is just the beginning.
member
Activity: 756
Merit: 30
WAY FORWARD: 103 GET ALL YOUR CRYPTO APPS INTO ONE PHONE AND MAKE THE PHONE YOUR HOME PHONE INFACT HIDE AMMMM WELLA, THEN COME GET SMALL TOUCH LIGHT PHONE FOR OUTING ONCE YOU ENTER YOUR HOUSE YOU FIT DO YOUR WORK ON A LOW KEY.
Na better advice be this ooo but e make me laugh sortey I nack my head for wall. To be honest with you guys ehh people Don dey call me yahoo boy for street base on say I dey always press phone nawao and e dey pain me cuz I no get shishi for my account. I no just understand this country sef again. Wetin person go do wey people no go suspect you ehhh e dey hard. I sha no go dey comot with my phone again 😂 make everybody rest!
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
You nor even too need laptop to stay for dis forum sef, except you be bounty manager. Me na phone I dey use since I enta dis forum.
Baba na true talk be this and very nice suggestion, the matter done tough for young struggling 9ja youths oooo. I done give out my laptop since sake of say I no need lapi as a regular poster on the forum, but I know say at some point and due to work demand, some of us here still need laptops to work. The way things dey go very soon lapi no go get use again since very soon apps go dey for phone were managers go fit use do their work. As I done talk mmmm before the area were person dey stay you need to observe you environment and the people were you dey relate with, in fact the forum sweet for lone walker, make I no lie una apart from my wife, no body know as e dey go with me and I never introduced any body put for the forum why because two is already a crowd I no know who they friends be and even they friends -friends so maintain your lane jeje.
WE ARE FACED WITH TWO PROBLEM IS THIS PART OF THE WORLD.
1:  BAD LEADERSHIP/GOVERNMENT AGENCIES
2:  LAZY YOUTHS WHO ALWAYS DISCREDIT THEY MATE WERE MAKE AMMM BY TAGGING THEM YAHOO SAKE OF SAY THEM DEY DO THINGS WERE THEM THE DREAM TO DO.

Jump to: