Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 95. (Read 1021315 times)

member
Activity: 756
Merit: 30

Boss you too much for this AMA... Person just dey learn new new things every day for this forum. E don tey wey I dey wonder how to make the long quotes short but I no Sabi am. The person wey introduced me to the forum na newbie wey concentrate on bounty and e no even know anything for the forum apart from posting bounty reports 😢 even how to quote a reply e no know until I teach am. Me I dey try adapt to Forum but e dey difficult since I no get better tutor wey go dey guide me. Everything wey I dey do for this forum na with una help and my own efforts.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
My boss CryptopreneurBrainboss, you fit do anything to help make the thread they very clean?

Bitcointallk get very limited features, if na telegram now we fit restrict how many minutes person need to wait before him make post. The only feature wey dey available and I dun take advantage of am na Self moderated thread and the spams are getting deleted when seen if you see post wey no go wey instead of reporting to moderator, just hit me up make I delete am. We want the best idea ourselves as such we no go alone people wey dey find activities spoil am.

How una see deleting of reply that just quoted the whole posts and just drop one or two line reply?. I understand say many newbie never know how the forum dey be and make una no worry, men dey active wey go drop guidelines immediately we get our local baord to help you understand how to fit into the system wey the forum dey use. To grow here na just mindset/smartness nobi say you get to oveesabi wetin dey the industry.

Reminder: EFCC still dey active, dem raid yesterday again, some dem dey update for website others na backyard something.
legendary
Activity: 2044
Merit: 1055
Bitcoin will break $25,000 today. Cool

What do you think?
hero member
Activity: 952
Merit: 742

The rule be say;
  • If you post, wait make 1 or 2 people post too before you go drop another post
  • Another rule be say, some posts wey long, if you wan quote the post, e no necessary say you go quote the whole post, you go need to delete some part wey no too make meaning for wetin you wan comment, so that the whole thing no go too long. Na wetin make for some posts you go see something like
Code:
before dem go comment.
  • If na image you wan post, for the image opening tag, make you try put width property to like 200 and below, so that the image no go cover the whole page

Make una thank you very much.

Weldone uchegod-21 and thank you for d correction. Na beta tin u talk and e go really help us make them no go they cast us if we they make dat kind mistake for big places wey de this forum. Make we try use here for learning, make we drop all weting we they think say e de right for hear so that them go correct us b4 we intend posting for other boards so that our mistakes no go they plenty.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@Agbe once again congratulations to Sir member rank I no know say you don already lap us like this. Same way you carry enter the rank na so you go take enter another rank, mostly Believe in your self and play safe. Here if pesin too do over sabi e dey hard them to push more further and I like the way you carry learn fast without any delay.
One love, together we move!
I no say 9ja no dey carry last and very soon power go enter our hands.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
_na June 2023 you go enter Hero rank proper  Grin the growth here is massive. Keep supporting.
I no see am dat way. He go enta Hero Member by December dis Year. Though I no kno how u calculate ur own. U bi Senior man 4 d forum so u know beta dan...
@Agbe congratulation on ur great achievement. No 4get us carry us along...
Lol. I could be wrong though, well I.dont know how you come up with your own numbers, but bear in mine that every month carries 28 max( 14 2weeks) Activity points excluding this month for example from September -December  =112 Activity points. Snr man nodey for calculations ooo I would like to see how you calculated your own.
Na April di thing go bi ooo. No bi Bobo juice o. Dis wan na India movie 8 episodes, dat is na 8 months 4rom September dis year. Make I dey wrote my articles nd do my thing dey go small small. Mate2237 ur calculation e no correct. 14+2= 28. Dat is 14 activities 4 2 weeks go give u 28 activities den di 28 which is 4 wan month go bi multiply by 8 months starting 4rom September dis year 2 April next year go give you 224 activities. U come plus 2 dis present wans of 252, u go come get 476. 224+252=476 den dis August I go I go still get 14 u come plus di 14 2 di 476 dat is 490. 476+14=490. So na April no be June or December.

New pipo we dey come, make una try follow di rules. Make una dey read more 4 now so una go do well later. Experience is always a best teacher. Read more.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Una Wehdone my people. Concerning wetin Oga Coyster and Igehhh talk, which some people don chuck mouth into. This one na only thread wey we get and we go want make e dey clean for all of us.
I just notice say new new people dey try long quote or reply consecutively for the thread. People wey their hands don strong no dey do am.

Again, new people e no mean say make una no post again, make una post, any mistake wey una wan make, make una make am here and get correction than to go make am for the larger forum. Some local boards wet no dey understand English, some people dey only post for local board till dem even reach Sr member or Hero rank. So, make una no feel anyhow but important thing be say, if person give correction, make we try learn fast so that that particular mistake no go repeat again.

The rule be say;
  • If you post, wait make 1 or 2 people post too before you go drop another post
  • Another rule be say, some posts wey long, if you wan quote the post, e no necessary say you go quote the whole post, you go need to delete some part wey no too make meaning for wetin you wan comment, so that the whole thing no go too long. Na wetin make for some posts you go see something like
Code:
before dem go comment.
  • If na image you wan post, for the image opening tag, make you try put width property to like 200 and below, so that the image no go cover the whole page

Make una thank you very much.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Sr. Member Rank

Ah! Agbe, Sr. Member!! E shock me 4 d most sweet way! Congrats my bro. Omo, u don try nd I dey see d work way u dey cari dis ur user archive so tay, ur face don show 4 men dem eye. E goes well my broda, ur packaging nd grace no b here.

4 d talk way u talk 4 up dere, e sweet me say, u cari 4 mind d tins way don sup wth u 4 forum nd hw u tak push tru nd u use all does tins cari motivate ur self say, e no go hard u ascend again nd na so e con b kwa. Dat show say, hardwork pay. Mak u dey do well mak ur futur fine o. I greet u.

ahahahh... That is why when pipo dey asked me to show them the way (di secret 2 succeed) I dey laf. my brodas nd sisters there is no secret in dis forum, yes u fit say i dey motivate pipo bt na di true story bi dat. Smartvirus know weti i dey i talk. What is bitcoin sef i bin no kno. Na di reading wey I do 4 di forum come dey help me. Di pesen wey motivate me in di forum was SatoPrincess Two milestones achieved [Amazing journey to Legendary] . She enta Sr. Member within 5 months interval from di day of registration. And I said won day I go bi like her nd even more dan. nd 2day here I am. My merits r not only Sr. Member bt Hero Member. I no dey compare myself with her, she dey beta pass me by far. I am only say where I got di motivation. Smartvirus go happy whenever place he dey. 4 him encouragements nd i no fail am.

2day na my day. let me jubilate.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis. I Kno how I take start am. U know how mani threads date I don create wey mods don delete? U kno how mani threads mods don locked or I don locked? U kno how I take disturb Brainboss, Igehhh, Kenny, Smartvirus (my pioneer boss), Davidvictorson, Zlantann, etc. U kno d thread I created dat I received the highest attacked 4rom d forum? It was Igehhh date helped me out on dat issue. All dis things happen from May dis year and I was a Member Rank. I really struggled 2 enta full member nd Brainboss, Davidvictorson and Zlantann pushed me enta full member nd I say I no go struggle 2 enta Sr Member + and I thank God say I don enta full member make I do my thing small small dey go bt surprisely I come become merit Rascal not only Sr. Member Hero Member merit. Merit dat I was struggling with now I no dey struggle again. Na activities I need. What a blessing from God.

God give u d grace as well.
Congratulations broda, I de very happy for u, na this kind achievement I they expect make we they get all times. As u enter Sr Member, ihope u go soon enter other ranks soon as ur merits don already reach Hearo own, I wish u all the best.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Sr. Member Rank

Ah! Agbe, Sr. Member!! E shock me 4 d most sweet way! Congrats my bro. Omo, u don try nd I dey see d work way u dey cari dis ur user archive so tay, ur face don show 4 men dem eye. E goes well my broda, ur packaging nd grace no b here.

4 d talk way u talk 4 up dere, e sweet me say, u cari 4 mind d tins way don sup wth u 4 forum nd hw u tak push tru nd u use all does tins cari motivate ur self say, e no go hard u ascend again nd na so e con b kwa. Dat show say, hardwork pay. Mak u dey do well mak ur futur fine o. I greet u.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
The country eh, life hard and to survive cef con hard join. People just believe say, as a young guy, you no suppose get money, you no suppose dey drive. Something way oyibo cef dey drive enter college, na watin dem dey outlaw for we naija, e no dey okay na. Dem just make people way dey try utilise opportunities way dem see online dey difficult. Anyhow way you wan try explain am, na so dem go believe say, na fraud you dey do. Once e no be something way be say, the office dey visible and you dey live okay, them don tag am fraud. The matter just cast.
EFCC don forget politicians, them forget those way dey spend foreign currency for them country dey focus on these men them... e no soft at all. The just dey common these days for street and e dey drop there rep. Na so SARS been stat o, soon the street go cable cable for them.
We the youths don supposed understand by naw say these policies them wey we politicians the make for the country nah to make sure say it keep us under lock and key under poverty so that anytime Dem put calls to us for election mata we youths go ball out based on say nothing dey pocket so if them ball out for them something go enter their pocket at the end of the day.

No be say d politicians Dem no know wetin to do but the coco be say if them do am every youths go dey independent and no go dey answer their calls to d go do the uglies.
  Smartvirus  just imagine say as u get something u dey use hold ur side wey weigh u at all at all, if any politicians com call u make u go do uglies for am make him lap u 5k u no go gree go do am, bcos u get something wey the bread RBS but for those wey no get anything source Dem go rush that offer say na opportunity for them to get money.

So na just the game those men d use us play dey block block our channels Dem, but baba God pass Dem.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
_na June 2023 you go enter Hero rank proper  Grin the growth here is massive. Keep supporting.
I no see am dat way. He go enta Hero Member by December dis Year. Though I no kno how u calculate ur own. U bi Senior man 4 d forum so u know beta dan...
@Agbe congratulation on ur great achievement. No 4get us carry us along...
Lol. I could be wrong though, well I.dont know how you come up with your own numbers, but bear in mine that every month carries 28 max( 14 2weeks) Activity points excluding this month for example from September -December  =112 Activity points. Snr man nodey for calculations ooo I would like to see how you calculated your own.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
_na June 2023 you go enter Hero rank proper  Grin the growth here is massive. Keep supporting.
I no see am dat way. He go enta Hero Member by December dis Year. Though I no kno how u calculate ur own. U bi Senior man 4 d forum so u know beta dan...
@Agbe congratulation on ur great achievement. No 4get us carry us along...
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis. I Kno how I take start am. 

Congratulations brotherly on your new rank. I no dey here when you start to know how tins been dey for you but wetin I no go forget to tell you be say kolanut dey last long for the mouth of person wey value am and in all things hard work and patience dey pay, bless up na man you be.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Wetin I wan add be say, make you guys try get goods dem dey sell or you get services you dey render. Na the two ways to secure your future and if God wan bless you, him go see genuine ways to place hand bless you.

I no go lie na true talk be dis and your advice make sense well well. OP, I belive say the only sure way wey you fit dey naija here wey hunger no go wire you or small small boys no go dey oppress you na to get things wey you go dey buy dey resale as our brother@ uchegod-21 dom talk or you get one better hand work wey you fit take dey solve people problem and dem go dey pay you. Even God self talk say em dey bless em children through the work of dia hands.


These suggestions wey dey come from una two side concerning how we go take help our self concerning the fallen economy and how e dey affect our pucket and the dollar problem, na so e suppose relate to government.  Government never do anything to help Naira and dem want make miracle just com happen on top am, no be juju be that?

• During the time of Jonathan if we go start from there, power generation been dey want dey go 6k mw and sometimes e go still drop back to 4k mw but today wetin be the generation strength ?

• During Jonathan, fuel price dey around #87 or so.

• During Jonathan, how many borders them close
• etc. I no wan bore una with all the economic indices wey we know wey fit help grow the system and increase GDP.
Refinery nko, for where.

We no produce anything and can't export anything to at least get some foreign reserve but na borrow this government take kill the system finish.  I watch one video wey peter Obi say during Jonathan, Nigeria dey own just 3 trillion but now the thing don waka enter 26 trillion. How dem want make dollar no kill Naira, politicians now dey spray dollar. Make dem rest.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis. I Kno how I take start am. U know how mani threads date I don create wey mods don delete? U kno how mani threads mods don locked or I don locked? U kno how I take disturb Brainboss, Igehhh, Kenny, Smartvirus (my pioneer boss), Davidvictorson, Zlantann, etc. U kno d thread I created dat I received the highest attacked 4rom d forum? It was Igehhh date helped me out on dat issue.
Congratulations it makes sense just few days ago I looked up at your profile while making some local board stats about and I was surprised to see your merits score, I'm impressed with your growth, you are already a Hero member just lacking Activity points. I went through the same process and I'm still going through it. Don't look at your Activity points just enjoy the forum because cause na June 2023 you go enter Hero rank proper  Grin the growth here is massive. Keep supporting.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis.
Pinch yoursef small, e go remind you sey na reality. My broda, na so d thing dey be. Things we struggle to get often become easy to get once we take the pressure of getting it off our mind and enjoy doing it. Congratulobia on being an unofficial Hero Member.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis.

God give u d grace as well.
First of all, congratulations @Agbe on your sr member rank and also congratulations to all those who reached their activities and merit requirements for the next rank.
Congratulations brother man @Agbe note this, no be how you start matter, an how you end ammmmm, thank God say you no give up on your struggle even though it was hard at the beginning. We all experienced the same thing on this forum, just as I been talk mmmm b4 we 9ja no dey give and also remember the provide I dropt a couple of days back that.
A: Smooth sea does not make a good sailors.
B: What God do for one person, he can do it for all


More grace brother man
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis. I Kno how I take start am. U know how mani threads date I don create wey mods don delete? U kno how mani threads mods don locked or I don locked? U kno how I take disturb Brainboss, Igehhh, Kenny, Smartvirus (my pioneer boss), Davidvictorson, Zlantann, etc. U kno d thread I created dat I received the highest attacked 4rom d forum? It was Igehhh date helped me out on dat issue. All dis things happen from May dis year and I was a Member Rank. I really struggled 2 enta full member nd Brainboss, Davidvictorson and Zlantann pushed me enta full member nd I say I no go struggle 2 enta Sr Member + and I thank God say I don enta full member make I do my thing small small dey go bt surprisely I come become merit Rascal not only Sr. Member Hero Member merit. Merit dat I was struggling with now I no dey struggle again. Na activities I need. What a blessing from God.

God give u d grace as well.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na true talk way does oga dem yarn so o. D fact say, we dey try meet up our osusu nd to say we wan dey mak here face show or our own face show for here cef nor mean say, we go do am anyhow. To see 1 persn name lik 3 tyms dey peper me for eye bt stil, I no go say mak dem stp shah jst dat, mak e reali b discussion. Make plenty pple talk b4 u talk, mak e no con b lik say, na 1 persn nd en crew gt d place. Una dey try shah bt, mak we keep am clean as those oga dem don talk, we go arriv las las.

E get anode tin I 4 lik talk shah, althogh, I sabi say, na Brainboss create dis corner, mak we no too dey duty am. Moderation no easy lik dat o nd en hand kwa stil dey 4 orda tins lik, campaign, bounty nd en life. I no knw hw e dey be am as e nevr talk bt if na me, e go wayh me smal o. Again, if e delete pple post, complain nd accusation of biase go b wahala. E fit cef discourage ordas.

So d mata nw jst fall 2 us way dey use here to behav well. Persn way get house suppose knw say, na en work to keep am clean.
Pages:
Jump to: