Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 98. (Read 1021761 times)

hero member
Activity: 2520
Merit: 624
and con mistakenly dey on generator for afternoon.. they don tag you Yahoo boy straight oh.
I just dey compelled to chook mouth put for dis particular comment. I read oda nice suggestions by oda members too but dis wan need make I emphasize am. Na true you talk here. At all cost, make una avoid anything wey go make una put gen on for afternoon on work days or leave am on into midnight. E dey follow make people think sey someone na yahoo guy. Get a strong power bank wey go serve your phone wella. You nor even too need laptop to stay for dis forum sef, except you be bounty manager. Me na phone I dey use since I enta dis forum.

@Agbe, congratulobia my guy! You deserve your new rank. Continue to dey keep your head low.

Yeye people. No mind dem any body wey put gen say make even relax as light no dey dey don become yahoo person, na so dem go dey look you dey poke nose to find something wey dem go see. Some go even want look inside your phone screen to know wetin you dey do with am, the whole thing tire person. I believe this power bank suggestion make sense and that one go reduce the burning of generator during the day and maybe weekend go better.

Congrats @Agbe, you don really try because e no easy and brainboss na really encouragement. Make God show him brainboss more love
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
and con mistakenly dey on generator for afternoon.. they don tag you Yahoo boy straight oh.
I just dey compelled to chook mouth put for dis particular comment. I read oda nice suggestions by oda members too but dis wan need make I emphasize am. Na true you talk here. At all cost, make una avoid anything wey go make una put gen on for afternoon on work days or leave am on into midnight. E dey follow make people think sey someone na yahoo guy. Get a strong power bank wey go serve your phone wella. You nor even too need laptop to stay for dis forum sef, except you be bounty manager. Me na phone I dey use since I enta dis forum.

@Agbe, congratulobia my guy! You deserve your new rank. Continue to dey keep your head low.
hero member
Activity: 798
Merit: 1045
Goodnight, ohh Leo!!! 🦅
Hello my pipu, omo e don Tay wey I cross this side chaiii
....no be small stress plus come add say body no well ontop, e worry well well .. Embarrassed
But ah still dey see how our thread dey blossom, I pray blessings on the pepu wey don dey hold am stand , likes of @wiwo, @smartvirus, @igeeh @CB @uche-god..una too much....e no easy but this time ah just need to recover then ah go try my best to dey show face

Happy Sunday, ah hail everybody well for the Arma👐
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Una Dooo!!! Happy Sunday. First of all. Make una thank you. I bin dey hustled 2 hv 100 merits 2 enta full member. Di mata tired me at dat time, I nearly leave am 4 d hustle. But our boss nd odas encouraged me. So I come dey do am. 2di I don get hero member merit while in full member. I dey speechless. All glory to God nd CryptopreneurBrainboss and dose who helped me 2 achieve dis great achievement. I am still ur boy.
Thanks 2 all. Dose wey dey talk 4 dis thread nd come  1st 2 3 go collect reward. Every week I go give if I get reward 2 encourage ourselves here.
bros you they inspiring and the the truth be say e no easy but as the thing be now i don tie my belt i want to do more  one thing wey they sweet me be say people wey they here they always guide and encourage us for here and as una continue, una well no go run dry especially my boss CryptopreneurBrainboss  you don show say we rise by rising others God bless us all.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Your rugged! Most of all, I like as you don cucuma find your own way to use your achievement to motivate people for this corner. You try wella I no go lie you. That gbojom way you collect, me dey fine am and e no come board but, on a low, doing your shit, you dey on major joy. E sure for you na. Mea while, no mess up o, rank no pass rules o but the Hero don sure for you be that.
At least, now you go get Tim to dey learn some kind things for the forum so, make you dey put eye for watin we go help you. Deep into the bitcoin matter. Congrats Agbe.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Una Dooo!!! Happy Sunday. First of all. Make una thank you. I bin dey hustled 2 hv 100 merits 2 enta full member. Di mata tired me at dat time, I nearly leave am 4 d hustle.
Congratulations brotherly and always remain focused because the journey just started, and have this at the back of your mind.  A SMOOTH SEA DOES NOT MAKE A GOOD SAILOR
You break a good record in this our community and we go recognize your hustle and I know say you go do better in the future, keep moving bro and see.you all at the top.
hero member
Activity: 1022
Merit: 723
Waiten make us different from Them
One of the ways to know yahoo boiz na true there lifestyle, if you notice yahoo boiz always move in group and most times stay together with they extravagant live style sake of say na stolen money,  but bitcointalker is a lone walker and can survive all alone but yahoo boi can not survive alone because him go need clique to cash out, again bitcointalker dey decentralized and highly privacy oriented.

This one na the wey you define us oh, but you don think about the way your neighbour, those around your house and the bad bele people wey just dey observe you for street define you? Because one thing I have noticed is that as long as you be young guy, you dey always press phone, you no dey go work and you are living okay, and con mistakenly dey on generator for afternoon.. they don tag you Yahoo boy straight oh. So the best thing na to just be on the safer side oh. To avoid any unnecessary spending oh
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Una Dooo!!! Happy Sunday. First of all. Make una thank you. I bin dey hustled 2 hv 100 merits 2 enta full member. Di mata tired me at dat time, I nearly leave am 4 d hustle. But our boss nd odas encouraged me. So I come dey do am. 2di I don get hero member merit while in full member. I dey speechless. All glory to God nd CryptopreneurBrainboss and dose who helped me 2 achieve dis great achievement. I am still ur boy.
Thanks 2 all. Dose wey dey talk 4 dis thread nd come  1st 2 3 go collect reward. Every week I go give if I get reward 2 encourage ourselves here.
Congratulations brother for real the matter no easy, you have really put in your all and so yea you deserve your followers, I hope say this story and you rise go inspire many Nigerians and others for this forum, and to always believe and never give up, my brother I believe say this is just the beginning for you and you go still continue to Dey rise just keep the fire burning.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
his current Government don spoil so many things even as work no they for us, small hustle wey boys they use bring food to their own table them wan still am, to me oo, them want make all of us no succeed na only them them go succeed, but God no go shame us.

I no too understand you for here. For this matter no blame government abeg, blame young boys wey dey do yahoo. You no know the kind bad things dem don do us. I know so many occasions wey I go meet up genuinely online, but I no go introduce myself as a Nigerian. If I mistakenly do, hook up or business don end. When you talk say you be Nigerian, wetin you talk be say "you be scammer".
Sometimes you go wan do better thing online, but you go dey change location like yahoo person. Even for this forum, you no know how dis oyibo people dey see us shaa.
The main coco be say boys don overdo my brother.

@Agbe congratulations, I been see your potential for long and I been talk say if you sabi your way finish say you go be spike and e don happen. By next activity Wednesday you go become senior member, congratulations again in advance. But you go need to wait for queue for Roobet before you go enter senior member for spreadsheet.  My advice towards that be say, if you enter Snr Member and you see better campaign wey dey pay well for senior member no fear to switch, because your merit count too good. But if na yeye campaign, sit down for Roobet because enjoyment too dey Roobet.  15posts no dey stress atol.
hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death
Una Dooo!!! Happy Sunday. First of all. Make una thank you. I bin dey hustled 2 hv 100 merits 2 enta full member. Di mata tired me at dat time, I nearly leave am 4 d hustle. But our boss nd odas encouraged me. So I come dey do am. 2di I don get hero member merit while in full member. I dey speechless. All glory to God nd CryptopreneurBrainboss and dose who helped me 2 achieve dis great achievement. I am still ur boy.
Thanks 2 all. Dose wey dey talk 4 dis thread nd come  1st 2 3 go collect reward. Every week I go give if I get reward 2 encourage ourselves here.
Agbe!!! More grace, plenty mercy, blessings follow you more and I dey tap for your testimony. Oluwa wey do am for you to do am for us. More grace to our oga them especially the Brain himself, much respect sir. As you dey give us water to baff soup no go ever enter your eye.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I believe probably dressing smart may not totally secure you from the harassment but puts you at a better position.
If you stay in an environment where people go to work from say 8am - 4pm, and you don't, unto say na 24/7 you dey dey forum dey package, my best advice for you na to blend in and stay low-key.

Stay low-key unto say make you nor go come dey run some kind immature doings and lifestyle for your neighborhood make eye nor dey your body because people sabi talk well well and all those plenty talk nai fit carry your matter enter ear of people wey be informants for EFCC abi na SARS.

Blend in unto say dey act the way people for the area dey do, on weekdays during working hours when people dun go work, try dey stay inside house, nor dey waka anyhow...make people nor notice say you nor deh follow do 8am-4pm.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Una Dooo!!! Happy Sunday. First of all. Make una thank you. I bin dey hustled 2 hv 100 merits 2 enta full member. Di mata tired me at dat time, I nearly leave am 4 d hustle. But our boss nd odas encouraged me. So I come dey do am. 2di I don get hero member merit while in full member. I dey speechless. All glory to God nd CryptopreneurBrainboss and dose who helped me 2 achieve dis great achievement. I am still ur boy.
Thanks 2 all. Dose wey dey talk 4 dis thread nd come  1st 2 3 go collect reward. Every week I go give if I get reward 2 encourage ourselves here.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
New Sub Topic: what differentiate us from Yahoo boiz, in 9ja and ways to stay save from bad belle men.

The way tinz dey go now for 9ja, everybody need to dey careful and with the high rate of insecurity and political oppression going on in the land some elements are now used to either tarnished 9ja youths image and that is yahoo one of the tinz were make End Sars
protest no go far na because speculations have it that the protest was sponsored and funded by yahoo boiz, which to a great extent there is an element of truth in that.
Now the major issue now na EFCC harrasment of youths but the truth be say e get way because my people make proverb say, there is no smoke without fire, truth be say the way some of our youths dey carry yahoo matters for head like say them no know say differences no dey between scam and terrorism because there both impact the victim negatively so I like the way them dey boost them.
Waiten make us different from Them
One of the ways to know yahoo boiz na true there lifestyle, if you notice yahoo boiz always move in group and most times stay together with they extravagant live style sake of say na stolen money, but bitcointalker is a lone walker and can survive all alone but yahoo boi can not survive alone because him go need clique to cash out, again bitcointalker dey decentralized and highly privacy oriented.

Ultimate advise:
Stay in trenches, and live below you income but be comfortable.

Make anybody no fear nothing go happen, God know his own and know how to protect us all but be ON GUIDE

na true talk my brother living a low key life is the is best na waithing yahoo boiz no fit do be that them they always wan show there self and spend to oppress , they like to be notice even in night clubs , the problem wey come  they them  go disguise if they ask the waiting them they do for a living they go say na bitcoin he come reach matter wey if you tell people say you they do bitcoin them go they reason you yahoo boy , all this police men if some of them see all this bitcoin apps they go wan start matter with you God go just help us for this country.
hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death
My brothers and sisters this matter tire me. The way EFCC dey raze boys like no man's business, even sometimes fear dey catch me. Immediately Dem check your phone see any cryto wallet, you bi Gboy. EFCC na just glorified SARS we just dey collect boys. The people wey don marry and get children own try better small because dem go show small respect to family man. The only way forward na to believe say this 2023 we go get good government, if not no hope oh.
member
Activity: 756
Merit: 30
Discussion: EFCC massive arrest ongoing in Port Harcourt, what's your take on this and any solution to stop this abuse?

So if u never hear, for the past 4-5 weeks PH dey on fire oh massive arrest of young guys between 16 to 30 yrs dey ongoing and no how you go tell me say all of them dey guilty, personally self I fit count how many nights I dun sleep for my house since July. No be say I dey guilty but if them get information come your house see you and you be young guy with expensive lifestyle na money matta before you come out even though you no dey guilty and I dey avoid careless expenses this days. I understand say na Intel dem dey carry move and we know how this business be, e require you to spend enough time for house as na your hustle be this and people wey no understand go think say you dey press since you no dey comot house go work and you dey very alright I come be young guy too (double wahala) 😂😂😂

Besides yahoo boys dun spoil the whole coverage of been a crypto trader/investors as na wetin dem dey talk before dem catch them so now dem believe you're guilty even though you talk say na crypto you dey into. My concern now he say, how this country go move forward from this phrase, we need another endsar kind of protest, wetin we fit do to stop this abusive massive arrest. EFCC no fit do their findings before they come pick somebody instead of to disgrace person finish, spoil image for area and e come be say him innocent. What's the way forward, no be so e dey for outside, why our own dey always different. Worst part dem go spoil your property on the purpose..
The truth of the matter be say we dey do too much for this our country. Come to think of it we know say EFCC sef dey fuck based on so many grounds which among of it be say they are mostly after yahoo Boys and forget about our politicians who be real thieves. I never see or hear of any yahoo boy wey win case for court sha. If yahoo boy Don hamar you before ehh you won't see EFCC fault for arresting them. Imagine one yahoo boy called me and speaking hausa while from the background sound I was hearing one guy speaking English on phone asking some one to send him code just like the one on call with me dey tell me in hausa. Fear those sets of people boss
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Discussion: EFCC massive arrest ongoing in Port Harcourt, what's your take on this and any solution to stop this abuse?

So if u never hear, for the past 4-5 weeks PH dey on fire oh massive arrest of young guys between 16 to 30 yrs dey ongoing and no how you go tell me say all of them dey guilty, personally self I fit count how many nights I dun sleep for my house since July. No be say I dey guilty but if them get information come your house see you and you be young guy with expensive lifestyle na money matta before you come out even though you no dey guilty and I dey avoid careless expenses this days. I understand say na Intel dem dey carry move and we know how this business be, e require you to spend enough time for house as na your hustle be this and people wey no understand go think say you dey press since you no dey comot house go work and you dey very alright I come be young guy too (double wahala) 😂😂😂

Besides yahoo boys dun spoil the whole coverage of been a crypto trader/investors as na wetin dem dey talk before dem catch them so now dem believe you're guilty even though you talk say na crypto you dey into. My concern now he say, how this country go move forward from this phrase, we need another endsar kind of protest, wetin we fit do to stop this abusive massive arrest. EFCC no fit do their findings before they come pick somebody instead of to disgrace person finish, spoil image for area and e come be say him innocent. What's the way forward, no be so e dey for outside, why our own dey always different. Worst part dem go spoil your property on the purpose..

This issues tire me abeg, na this kind thing make me I no dey carry lapi walker for road or say I wan carry am travel this same issues make me I no dey wear shortnika walka because them believe say na new way of gee boys be that. This same issues make me I no gree buy Iphone because them believe say any young boy or man wey dey use am na gee boy so lot of thing dey hinder me like this so me self wan just look for small physical business I fit run wey be say if them get intel about me or something like that I go show them my business make e be say that one na backup and na my advice to my brothers here.
Secondly, people don over do am because wetin the gee boys dey do no be am atall dem supposed melow down know say the gee work na illegal and yet them carry am for head say na empowerment for youth be that.

Why EFCC no go face government and those people wey dey power, na those people be the real geeboys wey dey loot us, borrow money from China for project yet project we no see, money we no see and them leave those criminal come dey face innocent people wey no do anything for life.

Brother we need another protest wey go be #endefcc make the efcc go face government and question them about all our money wey them borrow and make them explain how those billions carry finished without any tangible results.
Yet inflation rate dey very high people dying every day by day, killing and pipeline vandalization (Kporfire) everywhere dem get mind to come worry Young innocent people wey dey hustle to survive.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
New Sub Topic: what differentiate us from Yahoo boiz, in 9ja and ways to stay save from bad belle men.

Ultimate advise:
Stay in trenches, and live below you income but be comfortable.
Make anybody no fear nothing go happen, God know his own and know how to protect us all but be ON GUIDE

Oga Wiwo, first off I throw way congratulations for you on top your new pikin. E nor easy. Now back to the topic. Your advise make excess sense I like am. Omo but e nor easy for all these small boiz wey never see block before and when e come land for them to say low keep. Na the other day wey I been read for one of this our naija online gossip site wey one small buy dey celebrate 1 year wey him don lodge for hotel. The money get him own spirit wey dey follow am. And another thing wey I don notice for we naija be say we get this culture of showing off. We get the culture to show say we don better pass our neighbour. Na him make anytime wey person get problem with his fellow the next thing you go hear be say, "Do you know who I am?" Also, another reason wey I think be say these bois want respect and admiration from the public. Them wan be big-name. All this reason go make am hard for them to say for "trenches". They other one wey we nor dey talk about be say some of the EFCC agents dey use them cash out big time. How of the boys they actually go prison? Who get money to settle. Next day e don relocate go another area to continue.
full member
Activity: 882
Merit: 207
New Sub Topic: what differentiate us from Yahoo boiz, in 9ja and ways to stay save from bad belle men.

Well for this matter no one is completely safe, I think I have entered a conversation with learned people about this same topic, but if I am to be very honest and you may call be Old school all you want but one of the ways them Dey use hold people is appearance we may be saying that everyone is allowed to express themselves in any fashion sense they want and I must say that’s so true. But the topic here is safety measures right, so I believe until a government that truely believes in upholding citizens right come then we should try to dress smart, even in developed countries you hear people learned people telling those who tattoos their faces hardly get jobs, so now in our under developed world ones you do crazy dreads, rings and tattoos in a fancy cars and this government knows there isn’t much job they tag the person a cyber criminal.

No my suggestion is that it you can appear in that fashion sense and still bold enough to defend it at all cost then I respect that so much, but if you are the type that doesn’t want to fall into the hands of the present unfair regime then I believe probably dressing smart may not totally secure you from the harassment but puts you at a better position.

As person dey dress smart, no forget to live a humble or rather low key life with some form of legit job wey get identity card. Avoid too much waka o.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Discussion: EFCC massive arrest ongoing in Port Harcourt, what's your take on this and any solution to stop this abuse?

Besides yahoo boys dun spoil the whole coverage of been a crypto trader/investors as na wetin dem dey talk before dem catch them so now dem believe you're guilty even though you talk say na crypto you dey into. My concern now he say, how this country go move forward from this phrase, we need another endsar kind of protest, wetin we fit do to stop this abusive massive arrest. EFCC no fit do their findings before they come pick somebody instead of to disgrace person finish, spoil image for area and e come be say him innocent. What's the way forward, no be so e dey for outside, why our own dey always different. Worst part dem go spoil your property on the purpose..
I believe say this EFCC no they do their work well, them they after weting boys go use settle them na why them they run after all those small young Yahoo boys because them sure say money go fall out.
Any small Yahoo boy now go they use Bitcoin investment disguise na im make everybody wey be young guy no fully they safe now, once them see say you get big phone them don already conclude am say na yahoo boy you be. this current Government don spoil so many things even as work no they for us, small hustle wey boys they use bring food to their own table them wan still am, to me oo, them want make all of us no succeed na only them them go succeed, but God no go shame us.

Jump to: