My pipo how una see this suggestions, make una put mouth make we see how the matta go be.
Abeg make una dead the idea. I nor agree at all. anything wey we gats talk, make we yarn am for here. Shikena. As Charles-Tim don talk you fit update your guys if any update show.
Hello guys I just got a news say Amazon is planning to come to Nigeria next year, this news really got me Excited but on the other thought the competition this would bring to online marketing like Jumia, konga and so on, and for those that are wishing to have more foreign Gadget or stuff would be glad that Amazon would be coming. In terms of Amazon I believe this would be very profitable for them because Nigeria has a large population that are very active on line and I believe we would patronize them more.
E make sense make if Amazon come. We need the competition. Competition nor be bad tin atleast e go force Jumia, Konga, Jiji and the other upcoming to sit up. Na either to innovate or go extinct like Kingsway Departmental Stores In Lagos, 1975 (I know them nor dey the same category sha but atleast you get the idea). However, till e happen sha. I hope say dem nor go later change their mind carry the shop go Accra.
As bad news de dominate the countri every now and then, make we use this our sister milestone shake bodi for this new week. After Nigeria happened to her at the african event weh dem no switch on timer, she don do am again at the world scene weh system de work well.
Tobi Amusan break World record for Nigeria
Congratulobia to Tobi. Na this kind news dey give joy. She just remind me of Olusoji Fasuba(We been stay d same estate). You wetin dey burst my head for this tin na say, she don train for years just to run 12.06 seconds. Hardwork don pay. I dey happy for am. Anytin wey we dey do make we know say na Naija we dey represent.