Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 107. (Read 1022340 times)

sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
This one too about begging on behalf of sick people wey need surgery with pictures for road, some people too dey say some people don take am as business that the surgeries are not done.

Those people weh deh do this one na pure business o. One of my friends don even interview one of those sick people weh them deh use and she reveal how the matter deh be. I know deh look them side again since then. Sometimes I deh feel like cursing those people parading them to make money. Nothing weh idiots no go do to cash out. Now wetin some of those sick people deh do na to go solo and beg by themselves. Nigeria no be country at all.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

About surgery matta dem dey always beg.. like wetin I no know and that one tire pesin e com be like say na you give them does illness and after you contribute them go share the money carry feed them selves leaving the sickness for another dey of hustling again.
Nothing we no go see for Naija

For that aspect self I tink say our govt no dey try. Lol govt wey no even see road before.
On a good day the government suppose dey responsible for those kind of people wey need obvious medical help but which one we go even clap for dem self. The government just be like roof wey everywhere dey leak water. Shocked
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
Some of these scams now don dey open for the public but some people still dey fall for them. Like this one wey someone go call you for BVN, ATM say make persin send number or something, na greed dey cause dat kind of tin. Me never fall for naija scam bcos e don tay wey I don sabi say nothing dey come free to you, you go work to earn something from your labour.

But e get scam wey people don dey suspect now and dat one na just by appeal either for food, transport and other small small help appeal for road. E get some people wey you go continuously meet for eating joint wey na to dey beg for money to eat and when you ask dem to eat there dem go say make you give dem d money  Grin. Some people too, you go meet dem for road asking you for transport or food money on a daily and same spot.

This one too about begging on behalf of sick people wey need surgery with pictures for road, some people too dey say some people don take am as business that the surgeries are not done.

Na true my broda
See eh for de road begging matta be say I dey give when my spirit say give or help but if I see you there on my way back that means I don mark the pesin be that and I no go ever give next time wey him beg me because I know say na business him don turn am be that.
About surgery matta dem dey always beg.. like wetin I no know and that one tire pesin e com be like say na you give them does illness and after you contribute them go share the money carry feed them selves leaving the sickness for another dey of hustling again.
Nothing we no go see for Naija
This thing don turn to normal lifestyle for all this people Dem, wey be say if you no go e then it be like say u be bad person. I cone the ask , if everybody start to the beg for this country cos say tins hard then nah who go com give who nah?

Na so last week, I just the com back from hustle towards the evening, as I reach my junction com com down from the bus I enter nah I com remember say the money my Bossman pay me for the job I do I no even count am check weda it complete or not sake of say I no wan do am for him front base on boss make it no look somehow to am.

Na so I put hand for pocket bring out money the count for the street, gbaam na so one young boy just burst into tears by my side so serious oh. Say money them send am message don loss from him pocket and if him go house them go beat am die, omoor my spirit tell me say na lie, na so I just shout for am, na him run ooh.

Going forward na person tell me say thank heavens I no give am the money say that boy na so him the act for the street.
Can you imagine the nonsense nah
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Some of these scams now don dey open for the public but some people still dey fall for them. Like this one wey someone go call you for BVN, ATM say make persin send number or something, na greed dey cause dat kind of tin. Me never fall for naija scam bcos e don tay wey I don sabi say nothing dey come free to you, you go work to earn something from your labour.

But e get scam wey people don dey suspect now and dat one na just by appeal either for food, transport and other small small help appeal for road. E get some people wey you go continuously meet for eating joint wey na to dey beg for money to eat and when you ask dem to eat there dem go say make you give dem d money  Grin. Some people too, you go meet dem for road asking you for transport or food money on a daily and same spot.

This one too about begging on behalf of sick people wey need surgery with pictures for road, some people too dey say some people don take am as business that the surgeries are not done.

Na true my broda
See eh for de road begging matta be say I dey give when my spirit say give or help but if I see you there on my way back that means I don mark the pesin be that and I no go ever give next time wey him beg me because I know say na business him don turn am be that.
About surgery matta dem dey always beg.. like wetin I no know and that one tire pesin e com be like say na you give them does illness and after you contribute them go share the money carry feed them selves leaving the sickness for another dey of hustling again.
Nothing we no go see for Naija
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Some of these scams now don dey open for the public but some people still dey fall for them. Like this one wey someone go call you for BVN, ATM say make persin send number or something, na greed dey cause dat kind of tin. Me never fall for naija scam bcos e don tay wey I don sabi say nothing dey come free to you, you go work to earn something from your labour.

But e get scam wey people don dey suspect now and dat one na just by appeal either for food, transport and other small small help appeal for road. E get some people wey you go continuously meet for eating joint wey na to dey beg for money to eat and when you ask dem to eat there dem go say make you give dem d money  Grin. Some people too, you go meet dem for road asking you for transport or food money on a daily and same spot.

This one too about begging on behalf of sick people wey need surgery with pictures for road, some people too dey say some people don take am as business that the surgeries are not done.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Smiles..
Simple answer to all @Rockbell is that " In life one don't have to be too greedy about getting rich quickly". Na this one pipo dey fall victim 🤣 dem dey always see am as opportunity to blow or make good money but without Knowing say na just small trap dem set for pipo wey no get sense to go fall into am quickly.
For me anytime I see anything wey no dey really to my believe I block them straight or delete such messages.
In fact any body wey know about here supposed get Sense pass normal pipo wey no belong to this industry because na here politics plenty pass.
Na here make me shine eye 👀 like say tomorrow no dey, during ICO time pesin go just carry free ETH go waste for project wey no get head before you know dem closed telegram group tuama 🤸 na that time you go know say here no be for pipo wey no shine eye.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Topic: Frequent scams you should be alert in Naija

1. We get fake credit alert
2. Money doublers
3. Fake customer service
4. FG  covid 19 fund
5. Investment scams/winning a price from most of this network people scams like this na text message
6. Fake charity them go disguise they collect money from people
7. Work-at-home job scams,
8. Impersonation
 9. Fake celebrity news
10. Instagram likes scam

We no fit list all of them, this post na just to enlighten our self things wea done happen and still they go own so lets play safe thanks.
Well done @RockBell as you take your time list some of the scams wey they happen 4 our Nija. Make I tell u, this once fit be the least ones compare to wetting people don carry there eye see as scams. Some people they even use jaz to initiate the scam so that u wey they wan scam no go now until they don go.
But these scams wey u mention na they amoung the common once wey them they use wella this days, and still yet our people still they fall for the scam. Thank you 4 the update I just hope say our people go get sense to think am say nobody get money to double your own, person wey go talk say make you send 5k and get 10k self no get to give himself talk less of u, make we they wise.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
1. We get fake credit alert
Na this one dey follow make all these vendors nor dey gree recently if person wan use run transfer for them for transaction, e dey very discouraging for people like me wey nor dey carry plenty cash waka plus we wey sabi loss ATM card.

Money doublers them go tell you say put 2k to get 10k,
This one go still dey till tomorrow, the people wey dey run am dey constantly repackaged am make e dey make sense for ear, and people go still dey fall victim till tomorrow.

4. FG  covid 19 fund you go receive message say make you send your account details so that you self go partake for the money federal government they give people for my area
Government wey dey hide palliative when COVID dey reign, na now dem wan give you money...sense suppose to tell you say na scam.

E get the one wey you nor add, "Immigration Scam", this one dey attract people wey dey plan comot naija, dem go build fake immigration website, you go dey pay money to process documents wey you nor go ever see. Bottom line na make everybody wise up, cun understand say no easy way to make money effortlessly.


sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Topic: Frequent scams you should be alert in Naija

SCAM done chop our people eye for this country to extent wea them done sabi us for the some part of the world when the matter come to scam but today matter wea I wan talk about na about scams wea they occur for niaja and we get different types of scams for this our country with the way things be for this country (things done hard) and people no wan work but they wan enjoy and the country no take this matter serious as he come be now, the thing just they increase and eating dip like disease, he come be say has naija people take feel say them smart reach or say them they alerted them still they fall victims of this people. I go list and explain most of these popular scams wea they sup.

1. We get fake credit alert were people them go buy or send money, the person go receive alert but them no go credit am, I don get experience of one when I they school, we go execution for one water board like that na so this guy take excuse say him wan withdraw money for POS na so this guy go send fake alert the guy come check balance the money no show and him receive alert naso them arrest my guy oh.

2. Money doublers them go tell you say put 2k to get 10k, is either we hear or we self do am, plenty of us do MM the thing been crash still put plenty people for problem till now all does kind thing he still they.

3. Fake customer service them go just call say your BVN OR DATE OF BIRTH  get issue and they say make you send your bank acct details, you send your money go.

4. FG  covid 19 fund you go receive message say make you send your account details so that you self go partake for the money federal government they give people for my area no rest because of this matter, people wan collect covid grant.

5. Investment scams/winning a price from most of this network people scams like this na text message them they send give people, them go come refer i.e they go drop number make you call there agent, them go come make am real and they fit tell say investment they you go invest your money and every week you go they cash out.

6. Fake charity them go disguise they collect money from people say them they run charity organization, real charity organization they but be like say fake plenty pass , so abeg make we shine our eyes.

7. Work-at-home job scams, this scam guys them get sence wea them they always use bring new ideas come they go just enter social media come they tell people about say work they for online, that you can earn from 50-500k every month actually works like that they when the matter come to freelancing and also for this our forum but there own them go tell say make you pay for materials and video clips to watch which them get sweet mouth wea fit drawn person.

8. Impersonation they go use another person identity they collect money from people I done see one ,this one get police uniform ID card them they go oppress people they extort money with people they stand for road they collect roger and some men go disguise as women for facebook they come recharge and when the guy start request to see them they go start request for T.P and since the guy they curious to see to see the banny him self go send and this guys them go operate like say them been banny if you call self them go use magic voice so to some extent them they always try convince there client.
 
9. Fake celebrity news them they always like use all this social media especially facebook they go paste fake news say one celebrity die or something that have to do with naked woman or girl guys go definitely get interest to click once you click that link your account details do they expose be that na why you go see say frequent hacking of facebook account they every na the reason be that.

10. Instagram likes scam plenty- people for this social medias like facebook and Instagram, things people they concern about na likes so scammers they use that one they collect money from people for them to get likes them been drop one app like that around 2013 called InstLike they go ask of your Instagram account details so that them go give you likes plenty people done lose most of there accounts because all this kind thing once them get access to your account they fit they use am they task your follows.

We no fit list all of them, this post na just to enlighten our self things wea done happen and still they go own so lets play safe thanks.
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
I open internet today I come dey see say na Fake bishops dey trend. Dem say Tinubu and his men go hire ordinary people give them clergymen close to come pose like men of God. I no fit laugh shaa, these politicians don too much take us for granted and they think say lying to us is a normal thing to do.

But at the same time e get one man wey 3 different people identify differently. One say na agbero for oshodi, another say na carpenter for osun etc. Man no sabi wetin to believe again.
This one dey show say make everybody dey open eyes well because we don see unknown gun men but what we saw yesterday in Abuja here na unknown bishop who no won talk to journalist the reason why dey came for APC rally. I believe say more confession go dey come from many states were all those unknown bishop came from because dey identify some that came from Nasarawa for the neighboring state as a bike rider. Even APC leader no say many people no happy for this Muslim - Muslim they declared yesterday because Christian suppose be vice presidoo so that Naija go believe that dey plan well for 2023.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Abeg tell me why people no go attack person wey they support Tinubu online, because how you go they support person wey fit worse pass Buhari.

That APC be like say na cult. All these people wey still dey support APC na card carrying members of APC na the reason be that if no be say I no understand wetin go make person wey dey carry mouth eat go still dey support APC or PDP as them don create more homeless people dan dey create homes. Most of the people wey Tinubu go higher as bishop na their members. Na so one come dey talk say dem still dey own out of 100k wey dem promise, na only 40pin him don collect, the thing funny.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
I open internet today I come dey see say na Fake bishops dey trend. Dem say Tinubu and his men go hire ordinary people give them clergymen close to come pose like men of God. I no fit laugh shaa, these politicians don too much take us for granted and they think say lying to us is a normal thing to do.
I no even blame Tinubu nor APC, i blame any Nigerian wey they see all this acts of desperation from Tinubu, still they support/campaign for am, right from the APC primary elections, the matter they evident say Tinubu they obsessed with being president, the baba no get any vision or goals to achieve if him enter there, baba just wan enter Aso Rock, and that is that, yet person go still they campaign for the man, yesterday the desperation reach apex level, baba had to hire fake bishops to prove say Christians they in support of his Party's choice of a muslim-muslim ticket, i don't really know what to say, i just hope Naija people eye they open to see all this things wey they happen.

Abeg tell me why people no go attack person wey they support Tinubu online, because how you go they support person wey fit worse pass Buhari. Lord Acton said: "power corrupts, but absolute power corrupts absolutely", now imagine say this kind power fall into the hands of a man wey they desperate; i fear for wetin fit happen to this country.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
I open internet today I come dey see say na Fake bishops dey trend. Dem say Tinubu and his men go hire ordinary people give them clergymen close to come pose like men of God. I no fit laugh shaa, these politicians don too much take us for granted and they think say lying to us is a normal thing to do.

But at the same time e get one man wey 3 different people identify differently. One say na agbero for oshodi, another say na carpenter for osun etc. Man no sabi wetin to believe again.

Our Naija be like Netflix movie. We all the movie genre dey. Sometimes na comedy e be. Another time na action movie. Somedays na horror movie. Some other days na war film. Even crime and thriller. E sweet to watch sometime other times e dey man cry. After d nonsense them do yesterday, Tinubu Campaign Organisation still get mind to come do damage control dey talk say "They(The clergymen) are not big names in Christendom yet, they are gradually building up their missions."  Kai, if we fail this next election eh even our children wey we never born nor go forgive us unless say we Japa born them for yankee Grin.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
na very embarassing stuffs dem do today, and na religious trouble dem tinubu wan cause. the apc do that thing to spark reaction from can and the catholic diocese. for like 1 month now, the catholic church been de under attack, from bomb blast to kidnap and killing of bishops, yet tinubu and apc decide seh na to test the docility of citizens remain to do for clout

i don taya for these political season aswear. tinubu and apc are pushing for religious/tribal sentiments again and again
CAN no even get their time, me na people wey them hire as Bishops na them be my concern. That mean say some people never learn lesson from weting APC don do us, them still they collect small change/money, go they act. We'll I sha hope say this things no go affect them politically in future, because as it stands now, them Tinubu don they cast for this coming election.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

This politicians just they use our head, them still they thin say we never get sense,

No time wey naija people no get sense. Naija people get sense and dem dey see as government dey take human being to play ball. The wahala about the whole thing wey make the gbege come be like this be say nigerians we too dey fear. We dey like suffering and smiling as Baba fela talk am far back. Selfishness and self aggrandisement, when one man get him own, him go enter keep quiet against the empty stomach of him broda
member
Activity: 1540
Merit: 68
I open internet today I come dey see say na Fake bishops dey trend. Dem say Tinubu and his men go hire ordinary people give them clergymen close to come pose like men of God. I no fit laugh shaa, these politicians don too much take us for granted and they think say lying to us is a normal thing to do.

But at the same time e get one man wey 3 different people identify differently. One say na agbero for oshodi, another say na carpenter for osun etc. Man no sabi wetin to believe again.

na very embarassing stuffs dem do today, and na religious trouble dem tinubu wan cause. the apc do that thing to spark reaction from can and the catholic diocese. for like 1 month now, the catholic church been de under attack, from bomb blast to kidnap and killing of bishops, yet tinubu and apc decide seh na to test the docility of citizens remain to do for clout

i don taya for these political season aswear. tinubu and apc are pushing for religious/tribal sentiments again and again
hero member
Activity: 952
Merit: 742
I open internet today I come dey see say na Fake bishops dey trend. Dem say Tinubu and his men go hire ordinary people give them clergymen close to come pose like men of God. I no fit laugh shaa, these politicians don too much take us for granted and they think say lying to us is a normal thing to do.
This politicians just they use our head, them still they thin say we never get sense, like say we never know weting they happen for this country. No any politician go lie give me now, nothing remain wey Musa never see for gate, na your quality and weting u fit do to move Nigeria go forward fit make me vote you this time.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
I open internet today I come dey see say na Fake bishops dey trend. Dem say Tinubu and his men go hire ordinary people give them clergymen close to come pose like men of God. I no fit laugh shaa, these politicians don too much take us for granted and they think say lying to us is a normal thing to do.

But at the same time e get one man wey 3 different people identify differently. One say na agbero for oshodi, another say na carpenter for osun etc. Man no sabi wetin to believe again.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Me I just want say our govt just dey make the portable guy dey more popular as them go dey invite am about the allegation of forming a cult group, one million gang but the guy don change am for dem say na one million fans lol. But forget our Nigerian police, na him case dem want look when we get people wey dem still accuse to be leaders and sponsors of boko haram, dem still dey carry ticket for election give dem. Dis na our naija for now.

We no need another person to tell us again say our country naija na cruise nation, imagine IGP dey invite zazu mad man  wey call himself Portable for questioning unto dat em careless yarning. Dem leave important matter dem wey dey give us headache na person wey em brain knock na him matter dem dey discuss now chia who we offend like dis?

Inviting portable over his statement that he is the founder of 1 million boys cult group is a wise movement by the government. I don't see the reason anyone should kick against it. Portable is not a mad man, portable is a millionaire, portable is not a mad man, portable is a celebrity, portable is not a mad man, portable is a brand ambassador, portable is not a mad man, portable is one of the most popular musicians in Africa.
There are millions of people whose role model is portable. He shouldn't be ignored for making such an unguided statements.
Na true you yarn my naija broda. Omo, persn way get d ability to influence ordas, na persn way suppose dey watch watin e dey dish out. Eida na highness abi na deal way e use street bag mak am mak such pronouncement, mak dem use dat one choke am 4 throat bcus, I beliv say, small truth dey inside dis talk way e yarn. Last last, e don get fame and money, watin e go result to na to sponsor dem. Dis guy don course plenty havoc dis few days way e don dey as celeb. How e go openly go associate encef wth criminal gang like dat... investigation na d right way to go since, e too like invite for station. E go soon enter rehab nd na dat time e go know say, some kind means to use get fame nd build fan base no worth am.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

My brother dose men wey dia name show out say na dem dey sponsor dose bad men boko babies dem be stunch men ooo you no go ever hear our presido or em information minister wey be lie lie Mohammed talk about dem, dem dey fear to talk because dia hands no clean to na to dey talk Irrelevant tins wey no get head dem asbi.

Na our problem be that for the country. Selective justice. Wey government dey look face dey do wetin dem dey do, so boko haram sponsors pass the government? Na because dem selves follow dey sponsor some agenda dat na why dem no fit just stop d thing and more groups come dey show up. If we keep having shenanigans in government, the country will still be going down.
Jump to: