Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 106. (Read 1022333 times)

member
Activity: 1540
Merit: 68
As bad news de dominate the countri every now and then, make we use this our sister milestone shake bodi for this new week. After Nigeria happened to her at the african event weh dem no switch on timer, she don do am again at the world scene weh system de work well


Tobi Amusan break World record for Nigeria

[/url]
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
NNPC Saga
The Fear of Atiku by APC is the beginning of losing. Atiku promised say, he go sell nnpc and people at the south south come like the idea bcos d oil wey dey south south e dey 4 Fulani hand. No Niger Delta pikin e get oil block. Talk of work. APC come fear say Atiku go use dat wan win d election. So APC come sell the Oil giant company give wan Fulani man last week. But APC dey deny am. But na d true talk be that. Nai make fuel come cost now 4 we contri.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Please, let us keep this local thread as official as always. Transparency can always be on this forum, not any other group.

If you having some friends, tell them to notify you of any campaign available and you too can do the same for them. Enable notification like https://t.me/BTTSuperNotifier_bot, and forum notification to track existing threads of your choice.

Hello guys I just got a news say Amazon is planning to come to Nigeria next year, this news really got me Excited but on the other thought the competition this would bring to online marketing like Jumia, konga and so on, and for those that are wishing to have more foreign Gadget or stuff would be glad that Amazon would be coming. In terms of Amazon I believe this would be very profitable for them because Nigeria has a large population that are very active on line and I believe we would patronize them more.
There has been some items i wish to buy from Nigeria in the past that I can not see on Jumia and Konga, if I can be able to see it in Nigeria store like Amazon Branch in our country directly, it would be of good pleasure for me.

For items I can see on Konga, I will prefer to order it directly from those Nigerian shops through Konga. Although, it also depends on which service is faster and better.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Hello guys I just got a news say Amazon is planning to come to Nigeria next year, this news really got me Excited but on the other thought the competition this would bring to online marketing like Jumia, konga and so on, and for those that are wishing to have more foreign Gadget or stuff would be glad that Amazon would be coming. In terms of Amazon I believe this would be very profitable for them because Nigeria has a large population that are very active on line and I believe we would patronize them more.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
My pipo how una see this suggestions, make una put mouth make we see how the matta go be.
i support wetin you talk, But i think say we get one of such groups for telegram, though no be oga brainboss dey in charge of that one, i think na igehh na im be the admin there, though the group no really dey active like that.

I support say make oga Brainboss reopen the group, but make he move am to telegram where e go dey very easy for him to moderate, whatsapp na shit to me because there is absolutely no way for group admins to moderate their own group, no feature to delete spam posts self for group wey be say na you be the admin, but for telegram, if anybody post nonsense, the admin fit immediately delete such post and fit ban the person wey post am too.
So this na my take on the matter, if Brainboss fit do am, make he re-open the group but this time, make e be for telegram where he go get more control to manage and moderate the group well.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
My pipo how una see this suggestions, make una put mouth make we see how the matta go be.
I nor fit speak for everybody, but that group idea make una lock up am... nothing come out, it is unnecessary...we have tried it and it didn't work so let us move on. The circumstances that lead to the dissolution of the group get as e be and although say the intention of the group dey good, it was abused. I nor know how una see am...but any group is a no no for me. This our corner for here dey okay for discussion at least for the now.
member
Activity: 756
Merit: 30
You see dis talk, quite am! We no need am or d group!! Persn way dey find update, try dey active on d forum, u go get update!!!
Before I talk further, which W-App group una dey talk about first sef? 🤔 Oga chairman you no get joy 😂 you just reject the suggestion on arrival using "we" ahh but sha where dem boss dey talk who I be to put mouth? Make una pardon me sha I be loyal boy.
Ehhey talking about our dem parents spoiling this country ehh e don finish ooo cus I hear say Tinubu say nothing concern him with dollar rise against naira cus na naira him go dey use pay salary 😂 no be juju talk be that one? 💔 Before dem kill our happiness abeg make somebody dey give us update on BBN joh
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Permit me to differ I don’t think His excellency Governor Nyesome Wike giving players of Rivers United $20,000 each for winning the league a prove of his capability to rule a country, we are always thrilled when government do little things, well I don’t think it’s our fault, the have had series of government mismanagement that we don’t know it’s their duties as government to fix things like roads, power e.t.c. Now to Rivers United. And Nigeria league in general you would see that we are far away from leagues like the South African leagues, players are been owed, management is poor, officiating is poor and so on. A governor giving his side $20,000 to his players for winning the league isn’t so much of deal to make him capable to rule a nation.
Oga BIT-BENDER, please you have your choice to differ abeg, you wey be say you no be Rivers man understand these things, me wey be Full flag Rivers man no happy with Wike at all. We have been robbed and we are doomed. These guys keep sharing our money in dollars to their delegates, associates and friends and we keep praising them as if it's their money. We have suffered so much that we think that our servant we elected worked road, it's a favour to us.
With huge treasury if Rivers State, no youth empowerment program, no employment and no promotion of the employed for goof 7years. They carry dollar along in their country, pay with dollar and bank in dollar, yet we what miracle to happen in exchange.  Make I sleep abeg.
Una 2 dey see road no b play. I no knw bt I consider Wike as one of d worst leaders way we don get to evr rule Rivers pple nd I no go evn ft imagine am to rule dis kontry any day. Yes, if e rule, Rivers pple abi mak I say Ikwerre as a whole go benefit o bt d orda side dem go suffer major neglect. D same tin e dey do as governor na em e go do if e be president way no go soft at all.
D main has a hardened heart nd dey too obsessed wth power, dwells in d belief dat, its his tenor nd as e be lik dat, na as e tak hungry am, wagin dey en bodi, na watin e go do nd nobodi go fit cough.

Na big shame say, 4 we kontri as e be so, our apparents dem con b d pple way con dey downsize naira, dey spend dollar 4 a very important activity way go project party candidate 4 d 001 position 4 Nigeria.

Yes, e try say e approve to giv does athletes dat kind money o nd d sponsorship e deh do if e rch dem at all bt I sure say, e still collect sometin inside dere too as, dem no dey do watin no go profit dem. D fact still remain say, Wike no b gud candidate to rule dis kontri.

NEW TOPIC: Appeal/Suggestion

You see dis talk, quite am! We no need am or d group!! Persn way dey find update, try dey active on d forum, u go get update!!!
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC: Appeal/Suggestion

From the recent developments wey happened for we BTT - W-app discussion group wey our number 1 closed am for about 3 weeks to 1 month or if not more than. I know say e no easy to control pipo most especially pipo wey we no dey see one on one rather than chats from we various states. Due to inability to adhere to instructions whereby talking out of points make our No. 1 closed the group,  though I have no objection by closing the group but I want to suggest and appeal to our Oga brainboss to; instead of closing down we group he should set it as only read, maybe since that place na instant message and it appears on notifications pop-up than any other platform. And I believe say that our BTT-W-App group dey more secure than TG group so I want our No. 1 to open and keep am for us as only read only meaning say e go dey easy for us to get any update or information that concerns urgency than this web platform wey be say we must login to web and go down our thread before we go get updates. Another thing wey make me come here come beg be say, e go dey us easily if our no. 1 get new project or any other person wey launch any campaign e go help us apply quickly than say we no get updates earlier.

For example: few sig campaign wey I join na from that our btt w-app group I carry join and the thing really help me so I believe say na so e go take help another pesin. So I loyally beg our no. 1 brainboss to help us activate the group again but make him set am as announcement place maybe for any upcoming events or launching of new campaign or something similar, maybe our Oga fit select like 2 to 3 pesin wey fit dey give us updates on the regular basis and e go help us settle any issues internally before maybe the thing get k-leg wey be say other pipo go come hear am so e better make we settle our fuckup insidely than openly.
Abeg make una no vex if I dey speak everybody mind but make our boss brainboss consider am too make we join hand together make things better and remaining united. A believe say we all na one body onto say we no fit play ourselves or harm anybody belong to the body.

My pipo how una see this suggestions, make una put mouth make we see how the matta go be.

Thank you.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Permit me to differ I don’t think His excellency Governor Nyesome Wike giving players of Rivers United $20,000 each for winning the league a prove of his capability to rule a country, we are always thrilled when government do little things, well I don’t think it’s our fault, the have had series of government mismanagement that we don’t know it’s their duties as government to fix things like roads, power e.t.c. Now to Rivers United. And Nigeria league in general you would see that we are far away from leagues like the South African leagues, players are been owed, management is poor, officiating is poor and so on. A governor giving his side $20,000 to his players for winning the league isn’t so much of deal to make him capable to rule a nation.
Oga BIT-BENDER, please you have your choice to differ abeg, you wey be say you no be Rivers man understand these things, me wey be Full flag Rivers man no happy with Wike at all. We have been robbed and we are doomed. These guys keep sharing our money in dollars to their delegates, associates and friends and we keep praising them as if it's their money. We have suffered so much that we think that our servant we elected worked road, it's a favour to us.
With huge treasury if Rivers State, no youth empowerment program, no employment and no promotion of the employed for goof 7years. They carry dollar along in their country, pay with dollar and bank in dollar, yet we what miracle to happen in exchange.  Make I sleep abeg.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Permit me to differ I don’t think His excellency Governor Nyesome Wike giving players of Rivers United $20,000 each for winning the league a prove of his capability to rule a country, we are always thrilled when government do little things, well I don’t think it’s our fault, the have had series of government mismanagement that we don’t know it’s their duties as government to fix things like roads, power e.t.c. Now to Rivers United. And Nigeria league in general you would see that we are far away from leagues like the South African leagues, players are been owed, management is poor, officiating is poor and so on. A governor giving his side $20,000 to his players for winning the league isn’t so much of deal to make him capable to rule a nation.
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
I don't know how this may sound to some of us here, but politics aside. Let's talk about team motivation which to a great extent, Wike's $12,000 gift and free trips to Madrid to River United players for coming top in the just concluded league will go a long way to keep the players motivated high-spirited for future competition.

Dis one show say governor wike go fit govern Naija very well,if dey give am chance to rule the country because this gift can make all those players succeed in future. Dis is how to motivate youths in a society so that dey will have a good plan for the state of country wen dey get to that positions cristiano Ronaldo and Messi dey today. Many governors will like to follow dis governor wike step because the man believe that youth are the leaders of tomorrow.
member
Activity: 1540
Merit: 68
I don't know how this may sound to some of us here, but politics aside. Let's talk about team motivation which to a great extent, Wike's $12,000 gift and free trips to Madrid to River United players for coming top in the just concluded league will go a long way to keep the players motivated high-spirited for future competition.


Not only that, the Rivers Utd are one of the few teams that pay high wages in the NPPL, with wages as high as 2/3m in the Nigeria professional League. Wike has invested squarely in the sports sector of the state. A trip to Spain = successful migration for atleast half of the team hehe. I hope Rivers get good scouts to watch the team as they tour spain. and i also hope Rivers united are scouting Nigeria leagues for replacements already
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Dis coming election don make Nigerian pastors enter into research wella. Dem don really come out full full to speak for good governance and the need to safe Nigeria and to support Peter Obi and criticising APC and PDP candidate say enough is enough. I watch one pastor use this bible quote from Isaiah 1:19. The thing self enter as I go check out and see am, me too come dey think say hmmm these pastors don dey carry bible quotation follow the thing.

Dis kind tin sweet me and e make sense for ear. All the pastors suppose take dis election matta seriously because if tins continue as e be for naija so eeh, dem self no go fit cash out weller via tithe and offering. Make all the pastors use dia preaching time  advise dia members to go do dia PVC so dat dem fit join hands change dis kind bad government wey the country dey experience so. Bible even talk say when good person dey rule people dey rejoice but when bad person like APC, PDP and Buhari dey rule everybody go suffer and na the suffering we dey like dis so make all our pastors speak out so dat tins go begin go well as dem support Peter Obi to be our next presido.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Dis coming election don make Nigerian pastors enter into research wella. Dem don really come out full full to speak for good governance and the need to safe Nigeria and to support Peter Obi and criticising APC and PDP candidate say enough is enough. I watch one pastor use this bible quote from Isaiah 1:19. The thing self enter as I go check out and see am, me too come dey think say hmmm these pastors don dey carry bible quotation follow the thing.
Nor be lie. Dis one na the first time wey man pikin dey see men of God dey actually use their platform dey shook mouth wella inside this politics matter. I swear d tin sweet nor be lie. Las las dem sabi say if their pipo make mistake for the election go vote the wrong party na everybody to suffer am. E get one time wey I hear say dem shun one Iman for mosque as him dey try convince him pipo to consider Atiku since na their side person. Right now my fear be say as INEC go soon close their PVC registration, still enough pipo never still register. Na there small wahala dey and the tin dey give me concern.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624


Dis coming election don make Nigerian pastors enter into research wella. Dem don really come out full full to speak for good governance and the need to safe Nigeria and to support Peter Obi and criticising APC and PDP candidate say enough is enough. I watch one pastor use this bible quote from Isaiah 1:19. The thing self enter as I go check out and see am, me too come dey think say hmmm these pastors don dey carry bible quotation follow the thing.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Some of these scams now don dey open for the public but some people still dey fall for them. Like this one wey someone go call you for BVN, ATM say make persin send number or something, na greed dey cause dat kind of tin. Me never fall for naija scam bcos e don tay wey I don sabi say nothing dey come free to you, you go work to earn something from your labour.

But e get scam wey people don dey suspect now and dat one na just by appeal either for food, transport and other small small help appeal for road. E get some people wey you go continuously meet for eating joint wey na to dey beg for money to eat and when you ask dem to eat there dem go say make you give dem d money  Grin. Some people too, you go meet dem for road asking you for transport or food money on a daily and same spot.

This one too about begging on behalf of sick people wey need surgery with pictures for road, some people too dey say some people don take am as business that the surgeries are not done.
Na true I no mention them finish they get some self na for ATM them go come wait for you has you they withdraw finish you go see them some go tell you say person no well for there house or they never chop street scammer lolx   And also this issue of carrying pictures they go about they show people say them involve in accident and they need money for surgery na when I been they secondary school that one been they sup wella base on we go definitely get pity and we go remit  doh legit ones dy oh that actually need help but scammers done take am as business to venture into God go  help us for this country.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Wetin I dey do be say anyone my conscience gree me drop money I go drop, if my spirit no carry I go pass you. Problem no dey finish, if I no help you today, I go help another person tomorrow. Plenty people just busy dey cash out illegally for this country.
Na here u tak talk am finish my broda man my sista woman. Na jst conscience persn dey use reason some of dem mata nd wen u com across does once eh, e go dey lik say dem do juju 4 u bcus, ur conscience no go gree u rest. U go dey waka front bt ur mind dey 4 bck nd until u mak dat "U" turn con show dem luv, ur mind go jst dey worri u.

I don't know how this may sound to some of us here, but politics aside. Let's talk about team motivation which to a great extent, Wike's $12,000 gift and free trips to Madrid to River United players for coming top in the just concluded league will go a long way to keep the players motivated high-spirited for future competition.
No b small live Wike show dem o nd true true eh, na big motivation b dat. We no go lik trip abroad or collect dat kind gbojom 4 en account. D matter b say, tins fit change wen Wike commot 4 d seat shah bt dat mean say, dem no go beta dem cefs.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
I don't know how this may sound to some of us here, but politics aside. Let's talk about team motivation which to a great extent, Wike's $12,000 gift and free trips to Madrid to River United players for coming top in the just concluded league will go a long way to keep the players motivated high-spirited for future competition.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
This one too about begging on behalf of sick people wey need surgery with pictures for road, some people too dey say some people don take am as business that the surgeries are not done.

Those people weh deh do this one na pure business o. One of my friends don even interview one of those sick people weh them deh use and she reveal how the matter deh be. I know deh look them side again since then. Sometimes I deh feel like cursing those people parading them to make money. Nothing weh idiots no go do to cash out. Now wetin some of those sick people deh do na to go solo and beg by themselves. Nigeria no be country at all.
No be small thing, if you understand how all these things dem dey work, you no go give arms again for naija. One thing be say genuine people wey need help dey too, but the scammers don spoil their fortune finish. Wetin I dey do be say anyone my conscience gree me drop money I go drop, if my spirit no carry I go pass you. Problem no dey finish, if I no help you today, I go help another person tomorrow. Plenty people just busy dey cash out illegally for this country.
Jump to: