1. We get fake credit alert
Na this one dey follow make all these vendors nor dey gree recently if person wan use run transfer for them for transaction, e dey very discouraging for people like me wey nor dey carry plenty cash waka plus we wey sabi loss ATM card.
Money doublers them go tell you say put 2k to get 10k,
This one go still dey till tomorrow, the people wey dey run am dey constantly repackaged am make e dey make sense for ear, and people go still dey fall victim till tomorrow.
4. FG covid 19 fund you go receive message say make you send your account details so that you self go partake for the money federal government they give people for my area
Government wey dey hide palliative when COVID dey reign, na now dem wan give you money...sense suppose to tell you say na scam.
E get the one wey you nor add, "Immigration Scam", this one dey attract people wey dey plan comot naija, dem go build fake immigration website, you go dey pay money to process documents wey you nor go ever see. Bottom line na make everybody wise up, cun understand say no easy way to make money effortlessly.