Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 110. (Read 1022611 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Broda no even reason this man matta because like this i no see anything to write home about him, wetin him come do na to just go borrow money full our head as him wan commot for seat like this i wonder wetin our PO go carry pay those debt wey Bubu don borrow borrow full everywhere, like i dey pitty who wan enter there because for their first year and second year go be to pay debt and if they no fit work anything na still we go also cry say nothing government don do for us. So as we dey vote make we vote wisely and carefully because another heat go burn people for next 4 to 8 years before them open door for us.

Make we remove religion, tradition, Ethnicity, political parties. But voting in someone who will change our country for Good. My PVC is resting under my locker waiting for that very day to function effectively.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
E be like you nor know say this talk PMB dey yarn na political talk,

Lol abeg I no dey see buhaha as a politician. He is just someone with interest to become president at all cost like Tinubu, Atiku. Look at people wey want do things for the country for a long time like pat utomi but the system no dey want make real mind, industrious and achievable portfolios wey eyes don see enter there. All these Nigerian past president, how many really go inside formal school, I mean university as a young man with the dexterity of knowing what they want out of life and chasing it, no be one part time school for one place or the other dem dey go and after much there certificate and proof go still dey debatable, some na NDA. But labour party get presidential candidate with defined purpose to where them dey go and living ready for it. Buhaha no be politician at all, he was just zealous and now wey him don spoil tins finish 4 us him mind don com down and him want to go.

How can kontri lik dis 4 Africa go shut down schl 4 6months bcus govmnt nd ASUU no fit agree nd evn d ASUU cef, dem get wahala. Na evry time dem dey do dis tin.

My broda mak ASUU hold dem dere. If ASUU no dey stubborn like that, e no go good. Na the small tin wey remain for the youth be that and families wey no too hold like them for up. Dem dey carry deir pikin enter private universities and som dey go abroad go sch and dem want spoil tertiary institutions kpata kpata just like public secondary and primary school no be anything now.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

Muhammadu Buhari AKA, 'Oga am not aware'. See as the man open mouth like fish weh need water. E clear say for many years now no be this man deh run this country. Nigeria became unsecured and  poorer under his regime. Na wetin we go deh remember am for be that.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Dis wan wey wi dey nyan like dis, make wi dey take our pvcs oooo!!! Weti nijiria government do us 4 #endsars go end 2023. 20023 #endbadgovernment, #enduneployment. 2023 4 Obi
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
Well, the matter no suppose cause too much wahala for our mind, na only few month remain make the man go rest, even though he will be handing over a Nigeria that has completely degenerated, wetin matter now na make better person succeed am, the person go inherit a terrible country with plenty plenty debts, but with hardwork and determination the person go fit bring Nigeria on track for better things, and the only person wey fit do this in my opinion na Peter Obi.

Nigerian politicians dey resign?
I no know where we get am wrong. But make God try forgive us shaa. For Nigeria our leaders don come humanity for mind use ethnicity, religion and thievery full the mind. No body fit stand up for good.

Buhari on him own fit resign, but based on say make power remain for North and remain with Muslims he will not. If he does he would be called a betrayer.

Even Tinubu eey dey waka upandan to become president, even if he wins, him go still tire. You no go fit cheat nature .
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
No mind am bro, it is always very difficult for Nigerians to resign from a position, even when them know say them no they perform well, them go prefer to stay there till them tenure end, them no sabi say the most reasonable thing to do when person no they perform well for him position as public officer na to resign, comot there make another person enter, e fit come be say na that person go come do the job wella.

Well, the matter no suppose cause too much wahala for our mind, na only few month remain make the man go rest, even though he will be handing over a Nigeria that has completely degenerated, wetin matter now na make better person succeed am, the person go inherit a terrible country with plenty plenty debts, but with hardwork and determination the person go fit bring Nigeria on track for better things, and the only person wey fit do this in my opinion na Peter Obi.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Omo bubu no send anybody o like this him want wait till his tenure is over na wetin make i like away pipo them for resign with the remaining 10 months of his seat but we country no dey like that oo, them go wait till everything empty whether them go still get small chance to loot more before running away. This one vex me badly
Him cef do see am say, d seat no easy to seat down on top nd d kontri too hard to manage, na why we no need anoda sick old man to seat down for dat seat and dey run kontri way dey on d verge of collapse frm sick bed. I beliv in Obi evn if I no see qualification nd If na suffer dem say e wan bring, I don suffer watin I no xpect frm pple I bin hope to bring change so, e no go mak any difference. Obi na d only tin way gud 4 dis we kontri now nd d truth be say, e go eida bring better on a broad scale or e go mak am bad on a broad scale way b say, evn dose way dey seat go feel am. Dat na to say, e go touch evrybodi.

How can kontri lik dis 4 Africa go shut down schl 4 6months bcus govmnt nd ASUU no fit agree nd evn d ASUU cef, dem get wahala. Na evry time dem dey do dis tin.
Bubu way dey cry touch time so, e no resign o bcus e wan collect en last moni to use settle en children life becus en own down finish nd to use blind EFCC eye.

Mak we get our PVC nd carri ourcef com polling unit.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.

Resign for where? These people go prefer to die there than to resign. God help us. Where him dey eager to go to? Which kind talk be that? Oh I see now why him dey travel anyhow na because say him don tire. When him carri incompetent people full office why him nor go dey eager to go? Wait sef where Isa Pantami dey? People wey dem kidnap for Kaduna train pay 100 million each to commot, I sure dem use phone take communicate, why dem DSS nor fit trace all these people. Nor be Isa Pantami talk say make we link our line. We never hear anything from am since.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
E be like you nor know say this talk PMB dey yarn na political talk, if e be say third term dey for naija, e for still wan continue...To hold political position for nigeria na big thing ooo...you go chop money, plus do as you like based on say the system dey bad. Resignation is never an option for most nigerian politicians, e better make dem die holding their political position than let another person, which is just too bad. One good thing i dey happy about na say as nor be Buhari candidate be APC presidential flag bearer, e be like e nor go wan too put body for inside.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Quote
The President, Major General Muhammadu Buhari (retd.) on Monday, described his seven years in office as “tough” saying “I am eager to go.”

Him say him wan go , afta him don mak contry worst. Just imagine that.  

I hope say we don hear the info wey buhaha give from his kastina house corridor during the Muslim festival wey him go village go do amidst visitors including Tinubu and many governors wey go see the old man. Them still dey discuss how to win election inside bathroom, chai this people dey carry us play ludo.

Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.

Omo bubu no send anybody o like this him want wait till his tenure is over na wetin make i like away pipo them for resign with the remaining 10 months of his seat but we country no dey like that oo, them go wait till everything empty whether them go still get small chance to loot more before running away. This one vex me badly
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
Na only God fit rescue this country, but make we sha try wake up and use our PVC well to vote who we want, not who they want.

The help wey God go do for us na to make the PVC results to count. Make all the juju and wuru wuru wey Apc and PDP go do fail. Na the miracle wey this country need be that so that the wishes of youth and reasonable Nigerians go manifest. We don tire for old men taking us backward. Tinubu and Atiku no get anything to offer except say them want make their names enter as Nigerian past president.
hero member
Activity: 952
Merit: 742

Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
This our country mata self they tire me all times, imagine weting a hole president they talk say him de eager to live; After him don help d chop plenty debt him wan run live us, and al those old men Tinubu dem, and others wey they look for political seat they follow am because na similar mindset them gather get. Na only God fit rescue this country, but make we sha try wake up and use our PVC well to vote who we want, not who they want.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Quote
The President, Major General Muhammadu Buhari (retd.) on Monday, described his seven years in office as “tough” saying “I am eager to go.”

Him say him wan go , afta him don mak contry worst. Just imagine that.  

I hope say we don hear the info wey buhaha give from his kastina house corridor during the Muslim festival wey him go village go do amidst visitors including Tinubu and many governors wey go see the old man. Them still dey discuss how to win election inside bathroom, chai this people dey carry us play ludo.

Instead wey him go even try mak d history of the first Nigerian president wey resign frm office him dey still wait till him tenure go finish. I sure say nigerians go take his resignation as good news but him still want stay till next 10 months.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Uchegod-21 as God use you to ensure say we no dey for water rain enter our eye, eh go better for you, your wife and children. I been visit Bangladesh thread I come see the way them dey make mouth how them top for post review, shame come catch me well well. How I go dey for house, rain come dey beat cloth wey my wife spray for outside.

Na true you talk. But any time weh person do well to attract our praise, make we deh do wetin deh necessary. Na the reason why we get merit. Make we deh use am bless others for their constructive efforts. Nothing else we want take am do outside this forum. We no fit use am buy crayfish or maggi for market. No just appreciate people for mouth.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
INEC must still provide voters some kind of security I think that's the only way to get maximum result.
Security of voters is very essential to the peaceful conduct of an election, especially with the extremely high rate of insecurity in Nigeria at the moment, i am pretty sure many Nigerians will be afraid to come out and exercise their franchise come 2023 general elections because of fear of loss of lives and property, i do hope that INEC and the government make it a prority to protect voters on that day, that is what is expected of a responsible government.
This Obidient movement is becoming something oo, I like the unity but I dislike the threats and treatment opposition are getting for voicing their right.. 
No reason all this talk bro, all of it na just propaganda wey opposition parties they try talk to make Peter Obi look bad, you sabi as online arguments they be, people they always talk anyhow and say things wey no too make sense, but make we they honest, it doesn't really affect matters in the grand scheme of things. Look wetin Reno Omokri they do/talk for some days now, all of that na just ploy to discredit Peter Obi, and any serious Nigerian wey really want change no suppose take am seriously.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
The Voters card sanitization and awareness campaign this period make sense wella, I like the fact that the youths are now fully involve in politics now. But my issue me say no be to register for PVC come keep am for house oo, I know say most of the youths nogo gree come out to vote that day due to fear of oppression from political thugs. INEC must still provide voters some kind of security I think that's the only way to get maximum result.
D awakening way com dis period eh, e no dey lik anytin way 9ja don xperience b4. Dis na 2 shw complet trust 4 INEC nd d voting system. Our hope dis time be say, mak INEC no con betray us bcus na dere hand e dey 2 decide who win despite our vote.
But, on a serious note, I lik d way tins dey go nd dis day born out of d sufferin way we don endure for yrs. I no doubt say, we go see youths plenty 4 polling unit dis time, after all, dem thugs na stil youth kwa nd d diaspora wth some pple way want change dey ready 2 join bodi wth INEC to ensur security of polling unit nd credible election.

Men dey remember wetin don sup. The spirit of Endsars and Lekki Killings dey alive. We are not giving up. Men are into this seriously.
I no dey talk say Peter Obi na messiah, but wetin I dey talk be say the other two options no go well for us.
For sure say everybody get choice but this time around, I feel like everybody wey mean well for Nigeria, no be only youths, go vote Peter Obi. Wetin these men wan tell us again wey we never hear?

Dem go work road for us abi? For this 21st century our leaders still dey campaign with road and electricity. Mehn! We have been raped.

Today, Wike son graduate from UK University with 2.1 for law why some bright stars here dey wait for ASUU.

Ekweremadu dey fly UK to save daughter while millions of our daughters dey die for poorly equipped hospitals here without making headlines.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Things are getting heated up, there was an attempt on the life of Osun state Labour party governorship candidate, Lasun Yusuf by some unknown gunmen after the governorship debate on channels news, good thing he lived to recount the ordeal. I just hope that as there is huge awareness now for Peter Obi, that an attempt is not made on his life because it is not impossible for our Nigerian politicians to orchestrate, we saw how they mobilized thugs during the peaceful ENDSARS protest.

I like the unity but I dislike the threats and treatment opposition are getting for voicing their right.  
If you hold a different view from the majority, you have to be careful where you voice your opinions, a lot of persons have been aggrieved by the present government and treat anyone who decides to still support the very obvious corrupt politicians as enemy and may even become hostile, Abeg make everybody try dey careful, if you nor dey support OBI or you dey support am, still dey careful.

This Obidient movement is becoming something oo, I like the unity but I dislike the threats and treatment opposition are getting for voicing their right..  
No sane person would ever like the threats and hullabaloo coming from both camps. But I can not even start to wrap my head around the justification any youth presently living in Nigeria has for either wanting to vote for PDP or APC in the forthcoming Presidential election. It is absolutely beyond me. Lemme quote a tweet from Dr Chife. He tweeted, "I’m here for the younger generation; to defend their future against usurpers. If you’re young and come to Twitter to defend your oppressors for crumbs just remember: we were already “successful” at your age (20s and 30s). Top of our game - Execs, businessmen, academia. Carry on"
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
The Voters card sanitization and awareness campaign this period make sense wella, I like the fact that the youths are now fully involve in politics now. But my issue me say no be to register for PVC come keep am for house oo, I know say most of the youths nogo gree come out to vote that day due to fear of oppression from political thugs. INEC must still provide voters some kind of security I think that's the only way to get maximum result.
D awakening way com dis period eh, e no dey lik anytin way 9ja don xperience b4. Dis na 2 shw complet trust 4 INEC nd d voting system. Our hope dis time be say, mak INEC no con betray us bcus na dere hand e dey 2 decide who win despite our vote.
But, on a serious note, I lik d way tins dey go nd dis day born out of d sufferin way we don endure for yrs. I no doubt say, we go see youths plenty 4 polling unit dis time, after all, dem thugs na stil youth kwa nd d diaspora wth some pple way want change dey ready 2 join bodi wth INEC to ensur security of polling unit nd credible election.

This Obidient movement is becoming something oo, I like the unity but I dislike the threats and treatment opposition are getting for voicing their right.. 
Evn INEC nid dey Obedient nd d youths wa go dey in charge of these process kwa, mak dem try to dey Obedient for der ened. We gats get am ryt dis tym.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
but I come reason say at least the journey go begin some where, my first advice to anyone na to go get their pvc i just two days earlier got mine. And make we check the best option on our table now, like i no understand how we go continuously let this politicians fool us and then suffer for the next 8 years, i believe say by now amongst the major competitors we get now we all know which is closer to taking Nigeria even if it’s an inch out of our current situation. Vote wisely.

If to say we get our fellow brothers from north to dey reason and talk as we dey talk like this, that one for mean say we already know where we dey go but we never really dey sure of how the voting pattern go be for that side especially that North West ,all those Sokoto, Kano, kastina, Kaduna, zamfara, jigawa and kebbi area. If the youths for these area fit wake up and vote for the progress of the country then na done deal because Nigeria go come dey obedient. If you know you be correct guy  Grin

Jump to: