Oyibo talk say team work makes the dream work.
The thing wey i just like mostly na say this our local thread get activity well well, Na just time e go take but finally i believe say we go get our own board. @uchegod you du try well. This you and Igehh doings go dey ginger person to wan dey show face more often for this way.
(Golden Penny Spaghetti wey I buy 390 last week don turn 450 today)
E dun dey go 500 like this and na so the quantity and even quality dey follow reduce.
Now wey Obi don Pick Yusuf some of we naija people dey yarn say Yusuf nor get political weight.
Obi and Yusuf candidacy dey very alright to me and na our best hope for nigeria to dey better. I see the two of them picture today, see as them young, fresh, looking healthier, and more capable than the candidates from APC especially and PDP. This ones their certificate dey nor be say "my waec certificate is missing, or eaten by rats kind of story", better track record of accountability and most importantly dem nor dey fear to go talk for any station wey invite them for questioning.
I really hope we can get it right this time.