Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 131. (Read 1024127 times)

legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Make we dey wait on APC primaries but i no go surprise if na Bola Tinubu emerge, i mean e go be disrespectful to him political career say party wey him start go give another person ticket wey no be am. Peter Obi na third force and e go hard am to emerge as winner, anyhow sha i just dey wish anyone wey go enter go better pass buhari and dey industrious. dis na just personal opinion.
I dy expect baba Tinubu to win am (na primaries i they talk about oh), i no want make e win am oh, but e get as Naija be, and the man strong for APC wella, Osinbajo na strong opponent too sha, and na him be incumbent vice president, so e suppose sabi as things dy go for the party. If Tinubu no win, i dy feel so e fit join another party contest, e go just dump APC, carry vex join body for another party run for president, i no know if Osinbajo go do like that if e lose, cause e no dy do like person wey power dy hungry too much. But Tinubu eyes dy red, e wan be president for this his lifetime before e go rest, i hope say that one no go happen.

As for Peter Obi, i believe say Naija eye go don open small and this election no go dy like the ones wey dy happen for past, Naija people don suppose understand say if we continue to they vote for party then nothing good go fit come, we suppose focus on the individual wey we feel say get the swag to take rule us well well, if you ask me Peter Obi na that man oh, and e suppose get strong chance come 2023, na just this one wey e no dy contest under one of the two major parties, and Naija people na party them they like vote for, but make we buy popcorn sit down see as things go pan out, and also grap your PVC oh, e dy very important.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Wike try sha, e no easy. if no be 30 wey dey play am e for dun give atiku more fight. Make we tell ourselves the truth.

Baba, e go as them show 30. Wike just deh run him mouth like new born baby for politics. Instead of him to align with Peter Obi and see wetin them fit achieve he was there casting Obi. Now him don see how the northerners take show am wetin deh. Make him continue to cry o. I see where him deh talk say na deception. Peter Obi saw all those things and japa but Wike no get eyes to see ahead.

If you watch how the power been dey move from PDP to APC during the last election wey bring APC into power you go undetected say Labour Party never get the momentum yet. This election na between PDP and APC.

For Nigeria, nothing like PDP and APC. Which politician never jump from one party to the other, maybe Wike for now. Even Atiku weh people deh talk about sef run enter APC one time, do frog jump comot there again enter PDP. And if to say them deny am ticket for this one e for run enter another party again. Atiku desperation deh warn us of wetin we see with Buhari. I no see any change at all if Atiku or Tinubu becomes president.

Make we dey wait on APC primaries but i no go surprise if na Bola Tinubu emerge, i mean e go be disrespectful to him political career say party wey him start go give another person ticket wey no be am.

That great grandfather should just go and rest. Let him relax and enjoy the rest of his old age with his grand children. We no need another president on medical excursion.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Guys it was just announced that atiku abubakar would be the flag bearer of the former, in termed of publicity and money the PDP has a lot to achieve over the ruling party, I believe we Nigerians has a say in global crypto-currency, the promise team also lost the primaries only a few had the upper hands. Believe people what to learn more about how things works

Wike try sha, e no easy. if no be 30 wey dey play am e for dun give atiku more fight. Make we tell ourselves the truth. If you watch how the power been dey move from PDP to APC during the last election wey bring APC into power you go undetected say Labour Party never get the momentum yet. This election na between PDP and APC. if e comes to free and fair elections, then PDP go win since Nigeria dun tayh for their governance but if na cheating something, believe me APC no go give up this power especially when they get all the institution at their disposal.

Make we dey wait on APC primaries but i no go surprise if na Bola Tinubu emerge, i mean e go be disrespectful to him political career say party wey him start go give another person ticket wey no be am. Peter Obi na third force and e go hard am to emerge as winner, anyhow sha i just dey wish anyone wey go enter go better pass buhari and dey industrious. dis na just personal opinion.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Guys it was just announced that atiku abubakar would be the flag bearer of the former, in termed of publicity and money the PDP has a lot to achieve over the ruling party, I believe we Nigerians has a say in global crypto-currency, the promise team also lost the primaries only a few had the upper hands. Believe people what to learn more about how things works
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
This country is not for us, na for them, my prayer be say make God pity us put person wey go give us back this country. Amen!
This statement should go the other way, this country is for us and not for them, prayer is good, but prayer alone will change nothing brother, we sef for Nigeria dun too pray! If we can have one voice and back one candidate that the youths see is capable of helping, we gats do our part and look pass only PDP and APC candidate wey dem bring, vote for individual and not party... we actually have a chance of fixing this country and forcing this greedy politicians to an early retirement. God is not a magician, the country nor go automatically dey better because say you dey pray, on your own part...you have to work for it.

sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Everything show, na we wan dey optimistic in vain. Go check poster, all these big men dem, their children don win tickets for Assembly, Senators, Governors etc. Dem don use their children position to succeed them. Politics na their private sector, entitlement and their inheritance, you no fit change am.

No forget say Governor Ben Ayade of Cross River State failed to get Senate ticket of him APC party. The matter cast o, e no deh that easy for them as we deh think am here. Na serious battle and na our money them deh take fight the battle. Yesterday, I counted 32 hummer buses weh Wike buy just for that primaries. If them tell you how much of our money weh don go down you go scream. Atiku the same thing. And now many people deh criticise Peter Obi say him deh stingy. Obi na man weh make sense. Every other ones na business them want to take Nigeria do.

This country is not for us, na for them, my prayer be say make God pity us put person wey go give us back this country. Amen!

Nothing concern God for politics o. Na we Nigerians go get up and take our country from the cabals by force. But we need to be united like wetin happen fir that #endsars matter in 2020.
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
Well I think Labour Party was Peter Obi’s next best option. Although for good number of years, Nigeria has been a two political party nation and the dominant two has always been PDP and APC(formerly known as AC party), it may interest you to know that Peter Obi has never won a political election under PDP, his gubernatorial victory was under the political party of APGA, so I think he put all this in consideration before leaving. Well we are a big nation that has been through lot of political and economical issues, I urge all the eligible citizens of Nigeria to make sure they are ready to vote.
I think, citizens will not miss it this time around because men are very ready to follow Peter Obi to save Nigeria from corruption. Peter Obi past record will definitely make people from South south , West and East to vote for him because when the man was a governor he changed so many things in that environment and also reduced unemployment in the state. I believe Nigeria will get it right in 2023 by God grace.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
You Dey correct say our country Dey corrupt and the corruption don eat deep, even now I fear for the future of the country, but I no go for once down play education. Education is power, education is essential for every human, even if the system of education for Nigeria no be am, the moment you give up on education we Dey give upper hand to illiteracy, I know many people are very successful even without education, but success should not only be tired to money, a vastly learned person will always consider himself successful. Let’s just pray for our country a lot is going wrong.

I agree with you. Education in whatever form is the most powerful tool. If even our corrupt leaders know this truth. From President Muhammadu Buhari, Rotimi Amaechi, VP Osinbajo Rochas Okorocha, Yakubu Dogora, Bukola Saraki and all their children dey abroad dey acquire or don already education.  Shey una see as their pikin dey win primaries, aside form their parents, education still play a role.

Some Nigerian leaders and their kids who schooled abroad.

The thing be say make person just acquire education in whatever form. If the person no get money for Uni, make him go Poly. If him no get money for Poly make him go college of Education. If him no get money for that one make him go do one professional certification course. All na part of education.

You know, anytime I see's how they trained their children send them abroad and make NGN educational system very bad and unbearable tears always role out of my eyes. ASUU have been on strikes but pay less attention to them only thinking about political satisfaction and powers leaving the youths and leaders of tomorrow to be uneducated there's no good facilities around all the Universities within the country and yet they sent their children Abroad for best education.
It's really a cool time everyone should know whom to Elect as a president/Governor before living in another bondage for years.
Who dey shake this table? Why government go reason Asuu when their children dey abroad. I see former governor of rivers state Rotimi Amaechi for there, vice presido Osinbajo, Presidential aspirant Atiku, Efcc scapegoat Rochas, and others. For this picture we get rivers, Yoruba, Hausa, Ibo persons way dey do the same thing. Wetin I dey talk be say the problem of the country no be one tribe na all of us.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Make I SHOCK you full time!
Even if Peter Obi succeed become Nigerian President, he will change NOTHING. Absolutely, he cannot do anything.

My brother, abeg make we no deh get this type of mindset. Optimism deh good for progress, and as people weh go school small e deh necessary for us. Wetin make you think say Obi no go fit defeat the cabals if he is prepared for it. You no see how Adams Oshomole take tackle them for Edo State for him first tenure before he messed up for second tenure? Na strong will e need to do am.
My brother, difference dey between optimism and deceit. E just be like say I tell you say after theymos be the admin of this bitcointalk na you be the next person, you say make we dey optimistic and you begin work towards it. Things no dey work like that. I don monitor Nigerian politics from 1999, wey I don sabi something till today, nothing come out.
If say Obi mistakenly go yesterday primaries of PDP na 25 votes him for get. Him sef sabi, na why him japa.
Make I still shock you again, if Atiku fail for 2023 and returns back 2027 to contest for PDP ticket, na him go still win.

Everything show, na we wan dey optimistic in vain. Go check poster, all these big men dem, their children don win tickets for Assembly, Senators, Governors etc. Dem don use their children position to succeed them. Politics na their private sector, entitlement and their inheritance, you no fit change am.
This country is not for us, na for them, my prayer be say make God pity us put person wey go give us back this country. Amen!
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You Dey correct say our country Dey corrupt and the corruption don eat deep, even now I fear for the future of the country, but I no go for once down play education. Education is power, education is essential for every human, even if the system of education for Nigeria no be am, the moment you give up on education we Dey give upper hand to illiteracy, I know many people are very successful even without education, but success should not only be tired to money, a vastly learned person will always consider himself successful. Let’s just pray for our country a lot is going wrong.

I agree with you. Education in whatever form is the most powerful tool. If even our corrupt leaders know this truth. From President Muhammadu Buhari, Rotimi Amaechi, VP Osinbajo Rochas Okorocha, Yakubu Dogora, Bukola Saraki and all their children dey abroad dey acquire or don already education.  Shey una see as their pikin dey win primaries, aside form their parents, education still play a role.

Some Nigerian leaders and their kids who schooled abroad.

The thing be say make person just acquire education in whatever form. If the person no get money for Uni, make him go Poly. If him no get money for Poly make him go college of Education. If him no get money for that one make him go do one professional certification course. All na part of education.

You know, anytime I see's how they trained their children send them abroad and make NGN educational system very bad and unbearable tears always role out of my eyes. ASUU have been on strikes but pay less attention to them only thinking about political satisfaction and powers leaving the youths and leaders of tomorrow to be uneducated there's no good facilities around all the Universities within the country and yet they sent their children Abroad for best education.
It's really a cool time everyone should know whom to Elect as a president/Governor before living in another bondage for years.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Make I SHOCK you full time!
Even if Peter Obi succeed become Nigerian President, he will change NOTHING. Absolutely, he cannot do anything.

My brother, abeg make we no deh get this type of mindset. Optimism deh good for progress, and as people weh go school small e deh necessary for us. Wetin make you think say Obi no go fit defeat the cabals if he is prepared for it. You no see how Adams Oshomole take tackle them for Edo State for him first tenure before he messed up for second tenure? Na strong will e need to do am.

Well, the cut the story short, the only thing wet go correct this abnormalities, na #Ends EndSars Pro or Restructuring. Unless Obi go enter today and quickly restructure the government. But if you continue with the faulty foundation, men go loot you reach your dinning table.

We the youths need to rise up too and take this country by force from this politicians like wetin happen during #endsars. Fear catch all of them, even know he security agents for all the states begin wear mufti go work for fear say civilians fit attack them on the road.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
You Dey correct say our country Dey corrupt and the corruption don eat deep, even now I fear for the future of the country, but I no go for once down play education. Education is power, education is essential for every human, even if the system of education for Nigeria no be am, the moment you give up on education we Dey give upper hand to illiteracy, I know many people are very successful even without education, but success should not only be tired to money, a vastly learned person will always consider himself successful. Let’s just pray for our country a lot is going wrong.

I agree with you. Education in whatever form is the most powerful tool. If even our corrupt leaders know this truth. From President Muhammadu Buhari, Rotimi Amaechi, VP Osinbajo Rochas Okorocha, Yakubu Dogora, Bukola Saraki and all their children dey abroad dey acquire or don already education.  Shey una see as their pikin dey win primaries, aside form their parents, education still play a role.

Some Nigerian leaders and their kids who schooled abroad.

The thing be say make person just acquire education in whatever form. If the person no get money for Uni, make him go Poly. If him no get money for Poly make him go college of Education. If him no get money for that one make him go do one professional certification course. All na part of education.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
90 minutes of silence for football lovers. Everybody dey football center or house with friends dey watch the champions league final. I been dey for cab, the driver dey drive spend to make sure say e close early to meet the match. The way I see am na only me no dey watch this finals. I no go like see Liverpool lose this one o.
I believe say you don reach house by now, abeg no vex say wetin you no want make e happen dom happen just go take cold water drink because Vinicous Junior don make all the Liverpool fans cry. Next champions league dey come I believe say before that time Liverpool go dom learn how to beat Real Madrid, Hala Madrid.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
90 minutes of silence for football lovers. Everybody dey football center or house with friends dey watch the champions league final. I been dey for cab, the driver dey drive spend to make sure say e close early to meet the match. The way I see am na only me no dey watch this finals. I no go like see Liverpool lose this one o.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
(.     )
You Dey correct say our country Dey corrupt and the corruption don eat deep, even now I fear for the future of the country, but I no go for once down play education. Education is power, education is essential for every human, even if the system of education for Nigeria no be am, the moment you give up on education we Dey give upper hand to illiteracy, I know many people are very successful even without education, but success should not only be tired to money, a vastly learned person will always consider himself successful. Let’s just pray for our country a lot is going wrong.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
I spoke to different people to hear there own opinion and 40% of individual talked about self thought/education is different from schooling were they talked about our generation being different from that of our parents were several ways they to make money e.g freelance , crypto,forex e.t.c so depending on schooling alone no be better thing . While some other people talked about determination and other factors that are the key things to archiving your goal.

But omo if e no be all these new stuffs wey come out for this generation wey men take dey hold body men go dey tin like lizard oo. Youth for sufa die no be joke.
Men dey try help their life with stuffs wey you mention to put food for the table as naija govement no gree do am yet they dem pursue person here and there .
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Do people still believe in education
They have made education to have lost its value in Nigeria were the unemployment have increased and the number of graduates increasing drastically naija get about 33.6 million youths and students and among this people we get about 64% wea no get job we get 3 stages of skul wea we they do for Nigeria which are primary, secondary, tertiary with different duration primary na 6 year and also 6 years and tertiary either 5-6 years and plus asuu strike. Then at of 2012 about 11 million youth were unemployed and in 2021 them put am for record say naija na him be the second in position for unemployment. E no be like them oyinbo wea before or after skul it will just take months to acquire your dream job .the truth of the mata be say education get role wea he they play for everybody life were you learn how to read , write and communicate. I spoke to different people to hear there own opinion and 40% of individual talked about self thought/education is different from schooling were they talked about our generation being different from that of our parents were several ways they to make money e.g freelance , crypto,forex e.t.c so depending on schooling alone no be better thing . While some other people talked about determination and other factors that are the key things to archiving your goal. Since our government  is not concern about our well being we go encourage our selfs at least to have one thing or the other to they do .When I first came to this forum I was not easy , watched other peoples work it always encourages me to be like them ,especially for our local board here senior men they always carry us along with plenty encouragement which to me is success, when you they always carry people along thanks guys you all appreciated especially big man for forum brainboss I hail sir more blessings for everybody.
jr. member
Activity: 269
Merit: 4
E hard gor man to get hope gor this kontry. But make I gor ask you, how #EndSars wan con help matters if e no fit put person for seat inside the government na... e no go sure say another youth die for nothing o. We see as them carry play this one commot as na them still seat don fir the chair!
My brother, e go hard make cabals commot hand for the leadership of Nigeria. See, men money too long and dem wan elongate am the more. See, tomorrow bah, more millionaires would be made because of PDP primaries. Atiku go spend nothing less than $50M plus the ones him don dey spend already o. No hope. Person wey spend $100M to enter seat, no be NNPC him go sell to recover?
#EndSars Pro, go come...dem don too push youths to the wall, that one wey happen na testing. See time go reach wey dem go kill politicians for dey light burn dem, others go run leave this country. Mark dis thing wey I tell you this night.

Abeg, no cite violence for here . Abi u be Papa pessimistic?

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Well I think Labour Party was Peter Obi’s next best option. Although for good number of years, Nigeria has been a two political party nation and the dominant two has always been PDP and APC(formerly known as AC party), it may interest you to know that Peter Obi has never won a political election under PDP, his gubernatorial victory was under the political party of APGA, so I think he put all this in consideration before leaving. Well we are a big nation that has been through lot of political and economical issues, I urge all the eligible citizens of Nigeria to make sure they are ready to vote.

It was a nice move at least he would be on the ballot box for the first time, he knew he's chances with PDP was very slim with Atiku and Gov. Wike spending so much money buying delegates every part of the state, Labour party may pull the string if the flag bearer of the PDP and that of the APC are not convincing enough, but sadly our citizens only vote for party and not who's contesting.  Cheesy
Jump to: