Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 129. (Read 1024127 times)

hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

My people, I start this topic for this our thread to help motivate us to dey contribute wela here. E clear for our eyes say we dey hustle make theymos recognize us and give us our own board. Then, no body sabi the criteria we need meet before we get our board. But for sure sure, increase participation na one of the criteria.

First, I wan thank us, we don increase activity for this our thread. When I come here new, e dey be one or two persons dey serious for here. But today, plenty people don join body and plenty new people don show too. I say congratulations.

This topic I go dey drop am here immediately Rikafip drop him monthly update for Meta. This my own na to show us how we perform individually for every month here.
I get 1 merit reward for anybody wey top the list every month.
Make 1 merit no small for our eyes because me no be merit source but I go find wey to reserve that 1 merit every month. Anyhow wey e be, na appreciation and honour. Other senior men here wey like the idea go fit still sponsor the idea based on the merit thing.

I drop March and April own make we see how we take try:

FOR MARCH

Observations
  • Charles-Tim dey try wella as na him top for the month of March. Him na man wey sabi post for here even when him campaign no dey count post for local board. I comot cap for you.
  • Maestro75 na regular name for our local thread. Him and the like of Wiwo dey always give their best when e come to dey contribute for our local thread here

FOR APRIL

Observations
  • Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up
  • CryptopreneurBrainboss don dey consistent for this thread since wey him come back with full force. I hail you sir. Keep trying
  • uchegod-21 na person wey don dey consistent for this thread, him no dey top as number 1 but him dey always dey among the top contributors for this thread. Keep up!
  • Another observation be say Charles-Tim drop hands well well from last month, I no know wetin sup. But I know say him go pick up again.
  • Wiwo also drop hands, I no know weda na him new born pikin cause am    
  • Igehhh kuku comot for the list totally. E fit be say na when him dey work on his Services launch. Now wey him don launch, him go come back full.
    N/B: Make we try go comment related things for him thread, atleast praise him small there. Naso these things dey work, e go help keep him for first page, serve as cool review and also increase him view. I dey go do my own now.
  • New names like Marykeller and Oluwa-btc face dey show small small, make una put more efforts. Person like Davidvictorson don appear for the list. Keep up!
  • Other senior men like BIT-BENDER and Coyster dey try consistently. SatoPrincess dey try but you suppose try pass wetin you dey try now.

Fellow Nigerians make we continue in love and unity, the future dey bright.

Thanks to Rikafip for your wonderful thread.

uchegod-21

Thank you my broda, as e be like this we all know say every bodi get one or two wey dey weigh them down but e no means say them removed hands for this place. I happi say you don rate pipo based on their activeness enough put am Little challenge onto say if pesin serious him go get merit award.
Me happi wella bicus I know say e no dey easy for every bodi. Thank you broda man. We go try our best to bring 9ja get local boad so from now my eye 👀 no go lack from this place I go put efforts as well.
I thank all the rest brodas and our sister way dey try to put effort mostly our Princess I say thank you, as e be so na she be only woman here I know say her eyes dey red for the industry so I Honor you ma.

Lastly I say congratulations to our broda Oluwa-btc for him new achievement of entering another phase of forum rank.
We Welcomed you into Full member cartel awaiting swearing in for Sr.member, and I believe as Oluwa carry you from Newbie to Full member na so him go pilot you enta Sr. Member and above.
Once again Congratulations my broda @Oluwa-btc

I come in Peace ✌️
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
No matter how we paint am to be beautiful,  the truth be say Nigerian Education System dey faulty and outdated.
You have described the true condition of schooling in Nigeria infact some parents go as far as sorting for the children just to carry that A4 paper called degree results, in other news since we are discussing the 9ja educational matters here let me bring this here, human right Radio and television station also known as berekete family located in Abuja, a nongovernmental organizations have raised concerns about the continues ASUU strike that have kept millions of Nigeria university students at home for months now. So the organization have called for charity donations to settle ASUU and send the students back to class room as soon as possible.

This is a commendable one from the Ordinary PRESIDENT CEO of human right Radio and television.
Address: plot 1184 Kaura District Abuja
Source: https://twitter.com/breketeConnect/status/1532305692576579587?s=20&t=NYzDpfqlEeqg17IPMXD9VA
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Na who get house nai dey hold remote control. Outsider nor go fit come dey follow who get house drag remote. Na the way I dey see the politics Buhari and  Tinibu dey play. Them carry Goodluck Jonathan to divide southerners vote so that Peter Obi no go see chance. All the Northerners and part of the west already know who them go vote
If only the Eastern and southern people come fit come together with one voice to say na only Peter Obi dey go vote. Em go see sae APC presenting Goodluck Jonathan no make sense to them again.
There are consensus that APC go fit bring a Northerner as their presidential flag bearer of the party. Anyway make we just sit tight the watch them as they display unpalatable logic.

I just wish sae Kwakwasho and Peter Obi go just work together to fight PDP and APC
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
No matter how we paint am to be beautiful,  the truth be say Nigerian Education System dey faulty and outdated.
For society I no too dey in the position to fault the system, because if I begin talk, people go say but you go school.
Me I be the kind student wey no go miss one lecture for the whole semester.  I be the kind student wey dey read from 8pm to 8am. I gave my all to school and I graduate with 1st class (distinction) wey nobody don do for about 10yrs from my own option of discipline.  But all those things doesn't worth it in Nigeria.

Make I  shock us now small.
Na for Naija wey dem go arrange special centre for student1 to write WEAC pass. When the student pass, dem go pay to get Jamp answers 1hr before jamb or manipulate the CBT2. When JAMB come out, the student go pay like 200k and above to gain admission3. When admission come out, the student go dey sort till him graduate4. Even the parents go borrow to ensure their child answer graduate. After the student graduate, him go waste another 1yr in the name of NYSC5. After NYSC no sure job for the person. The person go begin carry file to look for 35k job6.
Person wey talk say this kind system dey work dey heartless abeg.
This one na small corruption o, but I get hundreds of reasons not to rely on Nigerian system of education, but I hold am back for now till when time go permit.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
The tin be say how many of our university curriculum/courses get real life meaning, infact Nigeria academic curriculum don expire, most of them without real world meaning.
Not all university courses are a waste of time, there are still some gainful university courses you can study that can give you an edge in society and have practical applications. Wetin just dey sup most times for naija na say we dey choose to study things wey nor revolve around our passion, sometimes it is not our fault really but traditional crude thinking of everyone wanting to become a doctor, an engineer, a lawyer etc (environmental factor) and also the fact that our government has neglected the educational sector and constantly frustrated it's program through incessant strikes and poor funding.

Say for instance you like to draw & sketch normally, why not delve into Architecture, Fine and applied arts, wetin you dey follow your friends and opinions of people dey go apply for Medicine?  If you really love acting for instance, wetin you dey find for Pharmacy?  Or you really like business, why you apply for engineering?

Also, everyone must not go to the university, there are schools that offer professional courses and certification in some courses not traditionally in the university curriculum... If you like journalism for instance, after secondary school education, go straight to obtain a degree in a specialised Journalism school, likewise photography, computer programming etc you don't need to waste time going through the university when you know that what you are studying has no relationship with your passion.

What i mean in short be say, nor talk say our all our university courses nor get meaning, na mostly sake of say we choose to follow the one wey society talk dey okay based on money than our real passion.

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.
Omohhhhh e no sexy 4 9ja, 9ja no be for the weak, politics nah your mate ? Wahala for who no bow for Nigeria ohhh.

Belike you dey forget easily say school na scum, no dey believe anything wey dem tell you for school if not, you go just useless. Go school oh but go am with sense, understand say real life no be school life. U dun forget say school tell us say immediately we study get good grades and pass well say we go get better work, how far. Since how many years now graduate dey jobless upadan. Dem tell us say we be leaders of tomorrow when the system dey corrupts wey be say before you even get chances to be the leader, you dun become grandfather too.

Naija na just cruise, go school to learn and get a skill to earn. Now if you understand the way forward you go know say na digital skills be the 411 and now blockchain just add spices to am. Get skills wey relate to blockchain as soon the whole world go need skillful professional from the sector to put them on and better pay go dey involved.
The tin be say how many of our university curriculum/courses get real life meaning, infact Nigeria academic curriculum don expire, most of them without real world meaning. Person go go school finish still yet can not profer solution to him real life problem base on what is thought in the lecture room, this na why many people dey refer to school as scam for 9ja be that. E get one mathematics formula were still dey suprise me them go say Xy√2=zxy fine X. Waiten this formula get to do with calculation of money and how to use balance sheet in the banking sector. Our school curriculum need to be updated to meet real time needs this expired curriculum na the major reason why most Nigeria graduates end up as expired product in the international Labour market, and make up for the refurbished work force we have in Nigeria which automatically translated into poor economy. As Brainboss talk skills acquisition is the best form of knowledge we need for self reliance. if we must move forward, just like i have said previously we need to equipped our self with relevant knowledge/skills that have the power to transform us into a better persons and blockchain technology is one of those contemporary skills that will transform us individually and as a nation.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Las las,no be like say sckul nah scam! Na just say 9ja dey kill dreams.
I swear bah, some people done change wetin Dem wan be for future like three to four times.
And no be joke, men weh we dey meet for acada, na them follow shape our lives.
The system gats pass through you and yourself gats pass through the system.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.
Omohhhhh e no sexy 4 9ja, 9ja no be for the weak, politics nah your mate ? Wahala for who no bow for Nigeria ohhh.

Belike you dey forget easily say school na scum, no dey believe anything wey dem tell you for school if not, you go just useless. Go school oh but go am with sense, understand say real life no be school life. U dun forget say school tell us say immediately we study get good grades and pass well say we go get better work, how far. Since how many years now graduate dey jobless upadan. Dem tell us say we be leaders of tomorrow when the system dey corrupts wey be say before you even get chances to be the leader, you dun become grandfather too.

Naija na just cruise, go school to learn and get a skill to earn. Now if you understand the way forward you go know say na digital skills be the 411 and now blockchain just add spices to am. Get skills wey relate to blockchain as soon the whole world go need skillful professional from the sector to put them on and better pay go dey involved.
Nor be lie uni na scam them no dey teach anything new na continuation of where them stop for secondary school. I dey grateful for the personalities I jam for university na them follow shape me to be how I be today. Everything not be class e end nai be one thing we need to know. University dey broad, people from all over they come one place to learn, the connections we make within the four - five years you go spend for university fit change the course of your life.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I hope say all of them igbo's go partake for these matters ohh.
I been dey go watch Rivers United match yesterday, oga weh dey drive cab say nah Biafra Igbo people want.
Saying Peter OBI dey waist him time... Make we try to vote and change the system.
E no go bad nah!
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

My people, I start this topic for this our thread to help motivate us to dey contribute wela here. E clear for our eyes say we dey hustle make theymos recognize us and give us our own board. Then, no body sabi the criteria we need meet before we get our board. But for sure sure, increase participation na one of the criteria.

Great job Uche. You do well. I admire your consistency. I agree say our activity level don increase pass the way wey e take be before. I don cross my fingers knowing say one way, I go wake see say oga Theymos do give us our own board as e don request. We be Naija we nor dey carry last.

4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.

With wetin our eyes don see since the past 8years, I nor believe say e get anybody wey still dey talk say we be leaders of tomorrow. The youths don tire na him make them do the EndSars protest(one of the reasons). Now them don dey organize young people wey dey eligible to go register for their PVC or temporary voters card. Heavy sensitization dey go on.We must take back our kontri.

legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.
Omohhhhh e no sexy 4 9ja, 9ja no be for the weak, politics nah your mate ? Wahala for who no bow for Nigeria ohhh.

Belike you dey forget easily say school na scum, no dey believe anything wey dem tell you for school if not, you go just useless. Go school oh but go am with sense, understand say real life no be school life. U dun forget say school tell us say immediately we study get good grades and pass well say we go get better work, how far. Since how many years now graduate dey jobless upadan. Dem tell us say we be leaders of tomorrow when the system dey corrupts wey be say before you even get chances to be the leader, you dun become grandfather too.

Naija na just cruise, go school to learn and get a skill to earn. Now if you understand the way forward you go know say na digital skills be the 411 and now blockchain just add spices to am. Get skills wey relate to blockchain as soon the whole world go need skillful professional from the sector to put them on and better pay go dey involved.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

Wiwo also drop hands, I no know weda na him new born pikin cause am   

BABA I SALUT YOU WELL
Baba you try wella for this idea, i no know how others go take see the idea but for me i see e make brains, this one go be like reminder for us here to see how we dey contribute to discussion on the local board. And also the monthly price reward na good thing and i know say other people go the contribute to make the board more interesting and devoid of spam posts just to increase post counts to get the rewards.
Make we dey bring up topics worth discussion most especially as e relate to cryptocurrency development in Nigeria because we country dey come first for cryptocurrency volume so we need positive vibes that will drive the industry. As i dey pray for myself na so I dey pray for all of us here make we increase our quest for development and most especially in the area of cryptocurrency many things dey we fit learn new.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

My people, I start this topic for this our thread to help motivate us to dey contribute wela here. E clear for our eyes say we dey hustle make theymos recognize us and give us our own board. Then, no body sabi the criteria we need meet before we get our board. But for sure sure, increase participation na one of the criteria.

First, I wan thank us, we don increase activity for this our thread. When I come here new, e dey be one or two persons dey serious for here. But today, plenty people don join body and plenty new people don show too. I say congratulations.

This topic I go dey drop am here immediately Rikafip drop him monthly update for Meta. This my own na to show us how we perform individually for every month here.
I get 1 merit reward for anybody wey top the list every month.
Make 1 merit no small for our eyes because me no be merit source but I go find wey to reserve that 1 merit every month. Anyhow wey e be, na appreciation and honour. Other senior men here wey like the idea go fit still sponsor the idea based on the merit thing.

I drop March and April own make we see how we take try:

FOR MARCH

Observations
  • Charles-Tim dey try wella as na him top for the month of March. Him na man wey sabi post for here even when him campaign no dey count post for local board. I comot cap for you.
  • Maestro75 na regular name for our local thread. Him and the like of Wiwo dey always give their best when e come to dey contribute for our local thread here

FOR APRIL

Observations
  • Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up
  • CryptopreneurBrainboss don dey consistent for this thread since wey him come back with full force. I hail you sir. Keep trying
  • uchegod-21 na person wey don dey consistent for this thread, him no dey top as number 1 but him dey always dey among the top contributors for this thread. Keep up!
  • Another observation be say Charles-Tim drop hands well well from last month, I no know wetin sup. But I know say him go pick up again.
  • Wiwo also drop hands, I no know weda na him new born pikin cause am   
  • Igehhh kuku comot for the list totally. E fit be say na when him dey work on his Services launch. Now wey him don launch, him go come back full.
    N/B: Make we try go comment related things for him thread, atleast praise him small there. Naso these things dey work, e go help keep him for first page, serve as cool review and also increase him view. I dey go do my own now.
  • New names like Marykeller and Oluwa-btc face dey show small small, make una put more efforts. Person like Davidvictorson don appear for the list. Keep up!
  • Other senior men like BIT-BENDER and Coyster dey try consistently. SatoPrincess dey try but you suppose try pass wetin you dey try now.

Fellow Nigerians make we continue in love and unity, the future dey bright.

Thanks to Rikafip for your wonderful thread.

uchegod-21
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
He dey very painful say the southerns never learn anything about Nigeria politics all dis time, I no fit understand why dem no fit pick one person make Dem stand behind that person. All them know na to wan grab power make dem for thief more money, if dem continue like this I no believe say the presidential sit go fit come South for a long time.

I no go blame them, you think say wike for reason dem if them step down for am. When person feel say dem big pass you dem no go appreciate wetin you do for them. All those governors, dem no betray wike as all of dem been dey fight for themselves. No even think say wike was fighting for South South oh, na him own ego him be dey fight for, make e dey record say na him do am and that's our problem over here. We no dey united, for a start we dey hardly call ourselves one instead we preferable to be addressed based on tge region we foem but North na North no matta where dem from.

Another thing na language barrier, e go hard to call person wey you no understand their language your brother and una self get different characters. Make we sha go vote person wey we feel get better chance to carry the country forward. God no go shsme us las las.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.
Omohhhhh e no sexy 4 9ja, 9ja no be for the weak, politics nah your mate ? Wahala for who no bow for Nigeria ohhh.

No just reason that one oo, leader's of tomorrow forward those people don abort them since early 2000, them already planned how the 9ja go be how them go circulate the powa. Anything you dey see now na just to say make them talk if not things already don underway. As my broda from community I go tell you say make you just focus wetin go give you money remove eye 👀 from FG, SG because them no fit help matta like this.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Omo politics no be person mate oo.
How I wish say any one of us here don dey count on $B we for form our party begin make move to sponsor the next presidential movement make we remove those old people for seat put youth wey brain 🧠 dey hot for Technology to structure we country back set compass for the new generation to come.
My brother this our country politics na God fatherism they happen oo, because all those old people wey don lead us before na them they select who go be the leader for all the parties. If way go they make all this old politician them just stop to they put mouth for this politics matter, make the youths hold and continue e go better small.
for primary school them they tell us say "we are the leaders of tomorrow"  but people wey they since day before yesterday never live when we go come start our own.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.
Omohhhhh e no sexy 4 9ja, 9ja no be for the weak, politics nah your mate ? Wahala for who no bow for Nigeria ohhh.
member
Activity: 74
Merit: 18
He dey very painful say the southerns never learn anything about Nigeria politics all dis time, I no fit understand why dem no fit pick one person make Dem stand behind that person. All them know na to wan grab power make dem for thief more money, if dem continue like this I no believe say the presidential sit go fit come South for a long time.

And besides that Nigeria need person wen sabi waything him dey do, no be another old man when go make things worst pass how he be so. Make them just find way tell jagaban to metete first, that ma don to old for the country.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
My brodas make I tell una d truth ehh, see Northerner's sabi politics pass us wella wella and like this them use all strategies to set confusion amongst East, West and South (PDP) then them balance for ground pass every body like no tomorrow, see remember one thing say East and West e dey hard before power enter our hands, for instance ex. Presido GEJ. Him enter powa as a successor of his chairman ( late presido) based on say him na vice then that was the only chance him get to collect powa from them but as e be so them ginger GEJ (Goodluck E Jonathan) with all threatening here and there, even to the extent them say him na woman say im no get heart na so we do so tayyyy carry powa comot for our hand go back North again. Now them see again say much talk go dey ground again if them take powa this time around, them still play with GEJ intelligency say him go come out as presido to calm people down so that much talk no go dey but them know say e no easy for them to pull am out without convincing him to join APC and na him be pillar for PDP like this and now everywhere don open for attack and to be easily manipulated but believe me Northern sabi all the games them get for mind but their major target na to remove the 001 for PDP and their plans has been achieved.
Bet me GEJ no go ever become president again. Northern wey like powa like say tomorrow no dey.
 After all this calculations na so P. Obi decamped from his party to new party to start afresh so that him go become 001 there to get more backup for the next presidential move.

Jump to: