Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 128. (Read 1024127 times)

hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
~snipped~
So, you even be my cowtri man sef. Nice wan comin to associate with us here. Finally, owa guys are coming back home. E get wan other user wey be "naira" wey I don sight. From d username may be na owa persin too sef. Anyhow wey e bi, ogoro must jump. I greet everibodi here.

Hehe 🤠 no reason am oo..
Evil plenty for this industry o if man too do them go humble pesin like this so I say make I go village go relate with my village pipo maybe after everi thin I fit show back. Anyhow me dey see you too but na eng. Ighh and brainboss pay my tp come back to village na so me carry bag come back home say make i relax.
A big shout-out to them @Igehh @Brainboss na so e supposed be say if monkey go market e no return the owners go find am go market carry am come back house 🏡 na so them carry me come back home as well.
Somehow I dey give charles-Tim green light but him dey see me as threat so I no too gum body were him dey but I believe say from here him go know me wella.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC: Why Nigeria may not adopt Bitcoin as legal tender.

As usual, I dey normally search for Bitcoin related news every now and then just to stay updated Incase any new development dun dey for the country. Today research make we see this news article and after reading am, I just gaz share am make we discuss. This thing wey we all want fit no come to pass oh, as day they go by I dey understand say e go hard for Nigeria to accept Bitcoin as as legal tender. I understand say constitution gaz change and na one thing wey dey hard is to do be dat. Abeg make una go through and give feedback, wetin you think and you go dey satisfied if Nigeria accept Bitcoin as a means of exchange but not a legal tender?.

However, experts believe that nations have to be cautious regarding the adoption of BTC and other forms of crypto as legal tender. They stated that BTC wasn’t designed to become a legal tender.

According to them, Nigeria might someday consider BTC as a form of payment, but it would never replace the Naira. They added that using it as Naira would contravene the constitutional purview of the CBN.

They further stated that the nations that had accepted or thinking of accepting crypto as a form of payment were those on the brink of economic collapse and Nigeria wasn’t necessarily one.

My broda I don read am like this and my head full, plenty thing wey hold we country back and I believe say those old men wey seat down for that place no go even give us space to accept bitcoin as legal tender, though whether CBN or FG only I thin I see there be say we don dey already use am as a means of payment and me really dey comfortable with that so if CBN like make them no lift their ban. P2p still working perfectly, thank God say your service still dey available and strong, reliable and trusted with 100 percent. Them know say from there country will develop but them wan short down every angle to carry lift our country from economic crisis and them wan remain at the top to control the country but I believe say e no go work for them as boys don shine eyes 👀 pass them, If not as them limit people from bank transaction with cryptocurrency by now we for don finished.

So in Summary it can only be used as a means of payment but not legal tender.
member
Activity: 499
Merit: 16
NEW TOPIC: Why Nigeria may not adopt Bitcoin as legal tender.

As usual, I dey normally search for Bitcoin related news every now and then just to stay updated Incase any new development dun dey for the country. Today research make we see this news article and after reading am, I just gaz share am make we discuss. This thing wey we all want fit no come to pass oh, as day they go by I dey understand say e go hard for Nigeria to accept Bitcoin as as legal tender. I understand say constitution gaz change and na one thing wey dey hard is to do be dat. Abeg make una go through and give feedback, wetin you think and you go dey satisfied if Nigeria accept Bitcoin as a means of exchange but not a legal tender?.

Given the government body language regarding the use of cryptocurrency generally, I don't think we are ever going to adopt Bitcoin as a legal tender. However, i do reason with the government on full adoption of cryptocurrency. Cryptocurrencies are decentralised based on blockchain technology, and central banks do not issue them. They are unregulated, speculative and volatile, as prices can nosedive within the shortest possible time crippling the whole economic activities of the nation

Moreover, they can be used to launder funds, and carry out illegal transactions, which is why it has also been banned in so many other countries like China
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
~snipped~
So, you even be my cowtri man sef. Nice wan comin to associate with us here. Finally, owa guys are coming back home. E get wan other user wey be "naira" wey I don sight. From d username may be na owa persin too sef. Anyhow wey e bi, ogoro must jump. I greet everibodi here.
Oga Mpa, you make sense. I don see that username 'naira', I look am finish say na Naija be that, e no fit be coincidence. I know say if our local board lap main main, men go fall out to meet us here.

Thank you very much my brother. You guys are putting in impressive efforts to keep this thread active and ongoing, and a very good example of the work ethics is this impressive appraisal post. I believe we will get there very soon and eventually get recognized and approved by Theymos and co.
Thank you my brother for falling back to base with your people. E better make we dey together here dey manage till our own board go finally show.

#My suggestion is, can we cut down on political and other non crypto matters and focus more on cryptocurrency talks, while adding bits of Naija politics once in a while?

Na nice observation be this brother. But e get wetin happen. E get wetin dem dey call contemporary topic (National topic wey dey everybody for mouth). For Nigeria now, na primary elections and campaigns dey reign and we no fit discuss without talking about wetin dey affect our country. Even larger forum understand this and that is why dem get politics board. E beta as we dey talk am here. If we stop politics here, e go shock you how person go enter forum politics board go raise topic like "Atiku is a corrupt presidential aspirant", then our imge go dent the more.

I believe say after election, politics matter go slow down for here.

#My suggestion is, can the Mod somehow, find a way to streamline topics? Something like choosing topics of the day? Once that is chosen, every member should refrain from starting many more fresh topic and instead, join in the ongoing discuss and follow it to the logical conclusions?
Na nice observation be that, we dey see how important topics no dey hard bury for here. No be any body fault shaa. If board come e no go dey like that.
As BIT-BENDER don already chuck mouth, make I throw more light. This forum believe in freedom. Even for main forum too much moderation no dey. So, if we bring that kind moderation idea, some people go mute and here go dey scanty.  E no go make sense say if I no like topic, I no go talk till another one I like come on board. Even the moderator sef no go get that kind time

I have been more active at the Gambling section but from now on, I hope to be here 24/7 to enjoy and discuss with my brothers and sisters.

Thanks
I dey see you for gambling true true, welcome back home my brother.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
If una ask me I believe everything Dey fine and the topics wey dey come in Dey of good proportion and it Dey give people the opportunity to up this of interest, personally I no go consider say to many topics are being brought up here, I like the leave it is, and we need here to be more active so dropping topics per week what if we have a serious topic of interest that is not inline with the pinned topic for the week it doesn’t mean we wouldn’t contribute. Also I must personally thank everyone for the show of maturity, intelligence dedication and commitment towards the growth of this thread and as for me so far so good, we are on the right track.
member
Activity: 1540
Merit: 68


 
#My suggestion is, can the Mod somehow, find a way to streamline topics? Something like choosing topics of the day? Once that is chosen, every member should refrain from starting many more fresh topic and instead, join in the ongoing discuss and follow it to the logical conclusions?
 
Thanks



I think this is a good suggestion. In addition to this, i feel it would be great if we can have a topic per week, gives every locals enough chances to contribute their own quota to the topics.  Couple of topics to pick from as a naija guy, from economics, to politics, to sports, the internal struggles etc.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
~snipped~
So, you even be my cowtri man sef. Nice wan comin to associate with us here. Finally, owa guys are coming back home. E get wan other user wey be "naira" wey I don sight. From d username may be na owa persin too sef. Anyhow wey e bi, ogoro must jump. I greet everibodi here.
member
Activity: 336
Merit: 41
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

My people, I start this topic for this our thread to help motivate us to dey contribute wela here. E clear for our eyes say we dey hustle make theymos recognize us and give us our own board. Then, no body sabi the criteria we need meet before we get our board. But for sure sure, increase participation na one of the criteria.

First, I wan thank us, we don increase activity for this our thread. When I come here new, e dey be one or two persons dey serious for here. But today, plenty people don join body and plenty new people don show too. I say congratulations.

This topic I go dey drop am here immediately Rikafip drop him monthly update for Meta. This my own na to show us how we perform individually for every month here.
I get 1 merit reward for anybody wey top the list every month.
Make 1 merit no small for our eyes because me no be merit source but I go find wey to reserve that 1 merit every month. Anyhow wey e be, na appreciation and honour. Other senior men here wey like the idea go fit still sponsor the idea based on the merit thing.

I drop March and April own make we see how we take try:

FOR MARCH


Observations
  • Charles-Tim dey try wella as na him top for the month of March. Him na man wey sabi post for here even when him campaign no dey count post for local board. I comot cap for you.
  • Maestro75 na regular name for our local thread. Him and the like of Wiwo dey always give their best when e come to dey contribute for our local thread here

FOR APRIL


Observations
  • Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up
  • CryptopreneurBrainboss don dey consistent for this thread since wey him come back with full force. I hail you sir. Keep trying
  • uchegod-21 na person wey don dey consistent for this thread, him no dey top as number 1 but him dey always dey among the top contributors for this thread. Keep up!
  • Another observation be say Charles-Tim drop hands well well from last month, I no know wetin sup. But I know say him go pick up again.
  • Wiwo also drop hands, I no know weda na him new born pikin cause am    
  • Igehhh kuku comot for the list totally. E fit be say na when him dey work on his Services launch. Now wey him don launch, him go come back full.
    N/B: Make we try go comment related things for him thread, atleast praise him small there. Naso these things dey work, e go help keep him for first page, serve as cool review and also increase him view. I dey go do my own now.
  • New names like Marykeller and Oluwa-btc face dey show small small, make una put more efforts. Person like Davidvictorson don appear for the list. Keep up!
  • Other senior men like BIT-BENDER and Coyster dey try consistently. SatoPrincess dey try but you suppose try pass wetin you dey try now.


Fellow Nigerians make we continue in love and unity, the future dey bright.

Thanks to Rikafip for your wonderful thread.

uchegod-21


Thank you my broda, as e be like this we all know say every bodi get one or two wey dey weigh them down but e no means say them removed hands for this place. I happi say you don rate pipo based on their activeness enough put am Little challenge onto say if pesin serious him go get merit award.
Me happi wella bicus I know say e no dey easy for every bodi. Thank you broda man. We go try our best to bring 9ja get local boad so from now my eye 👀 no go lack from this place I go put efforts as well.
I thank all the rest brodas and our sister way dey try to put effort mostly our Princess I say thank you, as e be so na she be only woman here I know say her eyes dey red for the industry so I Honor you ma.

Lastly I say congratulations to our broda Oluwa-btc for him new achievement of entering another phase of forum rank.
We Welcomed you into Full member cartel awaiting swearing in for Sr.member, and I believe as Oluwa carry you from Newbie to Full member na so him go pilot you enta Sr. Member and above.
Once again Congratulations my broda @Oluwa-btc

I come in Peace ✌️
I really gbadu dis leg u bring come out like dis... Na to motivate men Dem mk our face show for all corner for the forum. As for the merit sure sure inno look much but for peson wey get love for wetin we dey pursue here him go understand say d race na famili race no be one man race.

@brainboss and other snr snr men Dem, aswr I dey enjoy d coordination una d maintain for dis we local thread. It goes well.
member
Activity: 163
Merit: 65

My people, I start this topic for this our thread to help motivate us to dey contribute wela here. E clear for our eyes say we dey hustle make theymos recognize us and give us our own board.

I come in Peace ✌️

Thank you very much my brother. You guys are putting in impressive efforts to keep this thread active and ongoing, and a very good example of the work ethics is this impressive appraisal post. I believe we will get there very soon and eventually get recognized and approved by Theymos and co.

But I have some little observations of my own. The last time I came here (shortly after I signed up to this forum) I was very eager to participate but one of my major draw back was excessive amount of political discourse going on here. Some of us would appreciate if we could leave the toxic politics for the people of the world and focus more on Crypto related issues as it relates to us the Naija people. I know you guys are trying already and by God's willing, we'll keep getting better and better until we attain the promise land. I just think we need to do more in this regard.

#My suggestion is, can we cut down on political and other non crypto matters and focus more on cryptocurrency talks, while adding bits of Naija politics once in a while?

Another one is lack of streamlining of topics. It seems though as if everyone is more interested in starting a topic rather than participating in the ongoing discussions.

#My suggestion is, can the Mod somehow, find a way to streamline topics? Something like choosing topics of the day? Once that is chosen, every member should refrain from starting many more fresh topic and instead, join in the ongoing discuss and follow it to the logical conclusions?

These are just my little observations and it's by no means conclusive. Perhaps something like these has been discussed in the past as the thread is just too long to be covered in one sitting. If that is the case, please do pardon my ignorance.

I have been more active at the Gambling section but from now on, I hope to be here 24/7 to enjoy and discuss with my brothers and sisters.

Thanks

hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Dis 1 na very serious embarrassment to my kontri pple. So like dis, dem dey try tell me say, na hungry pple fu 4 dis kontri way con mak dem dey try use food 2 bring persn out 2 com register voters card. Voters card way dem go still buy via say, dem go use am rig election.

Normally, our votes no dey count. Na why persn no get d ginger 2 even come out 2 run voter's card via election matter. Watin dey even mak persn reason get d card cef na via bank wahala if not, e no get use as per election matter.

Dis pple get mind shah, to com run dis kind update nd our pple no tak offence. Anyway, pple way like feed 4 a day still dey shah, dem no go understnd.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
NEW TOPIC: Why Nigeria may not adopt Bitcoin as legal tender.
I just read that news few minutes ago on punch newspaper, but one thing were i want make we understand be say the mainstream media are so lazy this day to conduct investigative journalism, all their know how to do is to make headline that will capture not minding the message the headline will send to their readers, i no see any thing serious in the news at all that can pause as a threat to Bitcoin development in Nigeria, indeed no country will ever replace it currency with an external currency most especially a decentralized currency like Bitcoin that their can not have control of so there for no body is expecting Nigeria government to adopt Bitcoin as a replacement to the naira rather what we must focus on is the regulations that will allow the accommodation of cryptocurrency as an alternative currency, and if you ask me i will say we are ok the way we are using p2p to carry out transactions i know the wider public will get to know about Bitcoin in the near future. But in the main time let us focus less mainstream media articles Bitcoin related businesses are thriving and there seem to be no problem from the government on that only the Central bank who has always been an anti Bitcoin agent right from time.

I been don read about the reason wey make dem no even wam use ear hear any tin about Bitcoin talkless of em adoption for Naija here,
Dem even dey talk for news say for dem to have an alternative unregulated currency to become a legal tender say dem go need to legitimized am by altering the Constitution. So oga dem wey dey on top feel say Bitcoin adoption for get head if to say we no dey use naira or our economy don collapse finish. De way I dey see dis adoption of Bitcoin for naija eeh e go only dey possible if a new government wey go dey in support of bitcoin enter power come do some amendment of our constitution and dem even comot that Constitutional Purview of CBN for law, e go make the ban kuku useless before dem talk of to make Bitcoin leger tender for Naija here.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Many people don talk am say naija nah scam. Things wey dey work for another side no dey work for naija. As you talk them regulate how much people go put for account and yet 100m dem use buy form.

Na we the youth them take that one deh target. These thieves weh call themselves politicians no want make youths liberate at all. Their mind be say if we no get job and money web go deh do anything weh them ask us to do. That na why them deh try ban anything weh go make youth deh independent. Them know say crypto follow and na why them ban am. But we go shock them.

Na on 7th June wey Tinubu suppose defect, unless something else play out.

Thank you my brother.
This one go loud pass Buga o. I really like wetin deh happen for the political space now. Make we see how things go scatter. I dey tell people since Tinubu declared to run say Buhari no go like hand over to Tinubu them deh argue with me. No be only Buhari sef. All the former heads of state no trust Tinubu and they go don discuss am.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

Observations
  • Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up

Ope o! So I finally carry golden boot sha. Make I go find where I go buy chilled bottle water to celebrate am.
My brother your hand clap, your shoe shine and your face show. You be one man wey dey always dey here dey contribute. You dey try no be small and you deh dey objective for most of your posts dem. Remember me if you dey chill with your beer. That bottle water you put there na camouflage.

My 9ja people, I hope una deh see wetin deh happen for APC at national level. Tinubu frustration don begin make the grandpa begin run mouth anyhow. E don clear for him eye now say Buhari no want to give am opportunity. Make we deh watch whether him go jump comot for APC or remain there. I like wetin deh happen to Tinubu. 
My brother, if say you dey follow my political post here, you for no surprise for wetin dey happen to Tinubu now. Tinubu himself know say na so e go happen. Na wetin make him DG decamp tey tey to go soften ground for him for SDP.
Na on 7th June wey Tinubu suppose defect, unless something else play out.

For Buhari anointed candidate and consensus. As of this evening, na two strong candidates them dey debate.

OSIBANJO and APC governors  Vs Amaechi, Buhari and parts of APC governors.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
From my own point of view be say, the rich for Nigeria no want make the poor climb the ladder, una no hear the news wey them tell banks say if person money pass a certain amount of millions in niara(mind you the figure wasn’t big) make the bank report, but 100m was used to buy president tickets that the type of country we are, and they have seen they can’t keep track of crypto-currency and this sector is helping Nigerians especially the youth and the government not wanting any of this are trying hard to close that avenue up.

Many people don talk am say naija nah scam. Things wey dey work for another side no dey work for naija. As you talk them regulate how much people go put for account and yet 100m dem use buy form. Efcc self no dey try but sorry dem be the same thing. Nigeria need to get someone wey no too get corrupt record to try do something for the country, otherwise see us see fall na ground be that.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
From my own point of view be say, the rich for Nigeria no want make the poor climb the ladder, una no hear the news wey them tell banks say if person money pass a certain amount of millions in niara(mind you the figure wasn’t big) make the bank report, but 100m was used to buy president tickets that the type of country we are, and they have seen they can’t keep track of crypto-currency and this sector is helping Nigerians especially the youth and the government not wanting any of this are trying hard to close that avenue up.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
NEW TOPIC: Why Nigeria may not adopt Bitcoin as legal tender.
I just read that news few minutes ago on punch newspaper, but one thing were i want make we understand be say the mainstream media are so lazy this day to conduct investigative journalism, all their know how to do is to make headline that will capture not minding the message the headline will send to their readers, i no see any thing serious in the news at all that can pause as a threat to Bitcoin development in Nigeria, indeed no country will ever replace it currency with an external currency most especially a decentralized currency like Bitcoin that their can not have control of so there for no body is expecting Nigeria government to adopt Bitcoin as a replacement to the naira rather what we must focus on is the regulations that will allow the accommodation of cryptocurrency as an alternative currency, and if you ask me i will say we are ok the way we are using p2p to carry out transactions i know the wider public will get to know about Bitcoin in the near future. But in the main time let us focus less mainstream media articles Bitcoin related businesses are thriving and there seem to be no problem from the government on that only the Central bank who has always been an anti Bitcoin agent right from time.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NEW TOPIC: Why Nigeria may not adopt Bitcoin as legal tender.

As usual, I dey normally search for Bitcoin related news every now and then just to stay updated Incase any new development dun dey for the country. Today research make we see this news article and after reading am, I just gaz share am make we discuss. This thing wey we all want fit no come to pass oh, as day they go by I dey understand say e go hard for Nigeria to accept Bitcoin as as legal tender. I understand say constitution gaz change and na one thing wey dey hard is to do be dat. Abeg make una go through and give feedback, wetin you think and you go dey satisfied if Nigeria accept Bitcoin as a means of exchange but not a legal tender?.

However, experts believe that nations have to be cautious regarding the adoption of BTC and other forms of crypto as legal tender. They stated that BTC wasn’t designed to become a legal tender.

According to them, Nigeria might someday consider BTC as a form of payment, but it would never replace the Naira. They added that using it as Naira would contravene the constitutional purview of the CBN.

They further stated that the nations that had accepted or thinking of accepting crypto as a form of payment were those on the brink of economic collapse and Nigeria wasn’t necessarily one.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
NEW TOPIC:  Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal

Observations
  • Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up

Ope o! So I finally carry golden boot sha. Make I go find where I go buy chilled bottle water to celebrate am.

My 9ja people, I hope una deh see wetin deh happen for APC at national level. Tinubu frustration don begin make the grandpa begin run mouth anyhow. E don clear for him eye now say Buhari no want to give am opportunity. Make we deh watch whether him go jump comot for APC or remain there. I like wetin deh happen to Tinubu. 
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
My brudda, Adbitco, thank you for the good wishes, last last I dey wish you whatever you done wish me.
And you go reach anything and get anything weh you want, na planned life, you go get am.🖤
My bruda we dey move forward compare to other countries but we need to dey help each other make tins dey go well for us in dis family because I don see gud tins ur oga wa dey up Don do for many people for dis house wa dey give me joy to dey come here dey no wetin dey board. Adbitco ur talk make sense Sha, I believe say we go change for dat one to move dis community well like d way others countries dey move their own well.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Frankly speaking enhhh, if d government no ready to give Asuu what dey owe make the fvckn strike continue!
I post am for twitter, some people support me, some bash me, but how long we need to dey watch all them stupidity to dey kwantunew?
Make them pay what dey owe else make Asuu no call off, if not I no go fit watch my younger bruder enter acada come face same thing I face,make this set pay the price so others go follow enjoy next on. Add 8 years to your current years, look how e be ? Na so the next president go dey. So make we vote Wisely!

My brudda, Adbitco, thank you for the good wishes, last last I dey wish you whatever you done wish me.
And you go reach anything and get anything weh you want, na planned life, you go get am.🖤
Jump to: