Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 130. (Read 1024127 times)

hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.


I like your number 3, 4 and 5 as you take arrange mouth talk am, especially number 5. I go like make e happen self so we go know wetin Tinubu go do. People don too believe in Tinubu even when them deh see signs say the man no deh fit. He is sick and old yet they still deh push am go. But that your number 1 no too enter well for my eye because I know Buhari to always deh nepotistic and will favour his people in the north. E go shock you say he will want a northern candidate to win, irrespective of the party weh him take contest. After all PDP and APC na the same people.

To the extent I understand Nigeria politics reach, Buhari no go fit dey for APC dey work for PDP candidate. Remove that Kind matter for mind. Buhari no be person wey enter power with ease, him suffer well well for different parties before the mega merger wey bring him happen. Dem show the man shegea when him dey CPC no matter say na North o. Buhari understand say average Nigerian dey vex for him and him self no believe sey he will under perform. So to appease Nigerians, he cannot give us another old man again If Buhari wanted a Northern candidate according to you, him for tell Zulum or El Rufai to contest under APC. He cannot hand over power willingly to PDP in the name of Northern Agenda.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
There are internal problems in the APC, very soon some of the APC members will start defecting to PDP and this will give PDP the advantage. It’s a shame Peter Obi left PDP, he had a better chance winning in PDP than Labour Party. We know that PDP has been the ruling party for the longest, APC only got powerful when certain persons in PDP left to APC.
This is just speculation, and I can confidently state that our party, the APC, is more united than ever before, and that we will decide our next flag bearer in a few days. The president and leader of the party had already directed the aspirant to seat, discuss, and come up with a candidate before he traveled, saying he wanted someone accessible and accepted by Nigerians, and looking at the current aspirants, only Ameachi and Osibanjo meet such demands. We will select our aspirant by consensus, and the others will be refunded.

Peter Obi's chances of winning the PDP ticket were slim because he knew he was never going to win because the northerners would always see him as an Igbo man, defecting to the Labour Party was his best shot.


. Make we dey watch how everything go turn out sha.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
APC 2023 Presidential Race no go be small matter. APC get about 23 aspirant wey d come out under the part.

The whole North get about 4 aspirants (With 1,257 delegates)
The whole South come get about 19 aspirants (With 1,068 delegates)
NW- 2 aspirants
NC- 1 aspirant
NE- 1 aspirants
SE- 8 aspirants
SW- 7 aspirants
SS- 4 aspirants

APC cabals wan style remove Tinubu and Rochas Okorocha from the presidential race of the party. The screening committee d accuse Tinubu age and certificate forgery and having a drug case with the UK.
Efcc d accuse Rochas of  5 billion fraud. He bailout is 1.5billion naira.
All this their katakata na to remove the strong two founders of the party cos they stand a better chance of winning the APC presidential primary race.
Make we see how dia own matter go be. PDP don display their dollars bills for buying delegates
All this magumagu wey them don they display so, na how them go take remove better people way them know say fit win because them wan put person wey them fit they control as party. But if them no serious bring better person for the party, PDP fit collect the power from them.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Thank you my brother for understanding this mystery.  E simple to understand but some people no wan understand the game. Make I just update us wetin they happen currently for the country because I dey get first hand information.
1. Buhari want Amaechi to succeed him.
2. Tinubu no wan give up for Amaechi. Tinubu no want Amaechi at all and Tinubu no want him son (Osibanjo) because him feel say PYO betrayed him. If Tinubu change mind now endorse PYO,  na wetin go fit make Amaechi get problem.
3. PDP and Atiku know say na Amaechi be Buhari candidate, so dem dey wait make APC give him ticket, then them go use Wike as running mate to Atiku so that him no go fit support him brother Amaechi.
4. But if APC no give Amaechi ticket, Atiku go use Okowa or Udom as running mate.
5. Jagaban don make him plan B finish to shift go SDP incase APC fvck am up.
6. Northern cabals being the king makers want Atiku or Amaechi as the next president.

I like your number 3, 4 and 5 as you take arrange mouth talk am, especially number 5. I go like make e happen self so we go know wetin Tinubu go do. People don too believe in Tinubu even when them deh see signs say the man no deh fit. He is sick and old yet they still deh push am go. But that your number 1 no too enter well for my eye because I know Buhari to always deh nepotistic and will favour his people in the north. E go shock you say he will want a northern candidate to win, irrespective of the party weh him take contest. After all PDP and APC na the same people.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

E dey burst my head say na the northerners way we dey call illiterates, the ones way no go school, the so called shoe makers and aboki na he out king maker. We for south-south wey suppose dey educated na  we dey look down on the electoral process. This election we go shock them we go come out with our PVC and vote our candidate.
My brother, the odds favour dem for everything. Education no be only for book or western education. We get money education, sex education, politics education etc. For politics education, leave am for North. Dem sabi de game pass us by far.
My I shock you now...
During Salah and their Muslim celebrations, all the Northerners no dey travel. Dem go observe am were dem dey. But during elections, na trailer go pack dem go back. If na war dem ready because dem dey their Father land.

But we no dey come home for election, but during Christmas na must say we go come home celebrate. If we wan do pvc we go register for Lagos, when election tension don high we go run back village where we no register and automatically disfranchise ourselves.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
D lack of unity weh dey less for APC and division nah go fit make PDP triumph.
As per PO, the move good, but that Labour party no too get weight. I'm only paranoid seeing same thieves will rule 9ja once more.
If I be Atiku, I no go wan use Wike as my vice seff. Governor weh no fit pay people for Rivers State, make the country expect worst.
Cause the predators go still dey feed on the prey's weh no Waka well. Last Las, 9ja na casset!!! Fvckl
hero member
Activity: 966
Merit: 701
There are internal problems in the APC, very soon some of the APC members will start defecting to PDP and this will give PDP the advantage. It’s a shame Peter Obi left PDP, he had a better chance winning in PDP than Labour Party. We know that PDP has been the ruling party for the longest, APC only got powerful when certain persons in PDP left to APC.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Buhari don meet with APC governors today for Abuja and em talk many things but all the things wey him talk, I go point out some here:
1. Baba talk say make APC governors support him to choose who go succeed am. This one show well well say Baba get interest to produce who go replace him.
2. Baba describe the kind person wey him want to succeed him.
3. Him say he go like person wey dey acceptable to the people.
4. Person wey sabi dey core value of APC
5. Person wey go fit unite people.
6. And before now him talk say he go like hand over power to a younger person.

All the above qualities no match Tinubu atol and him kuku understand shaa
Anybody way get eye go see say Tinubu no be Buhari candidate, na Rotimi Amaechi be the chosen one.
Before I been dey talk say I no go involve myself for politics because of the things wey don hapun in the past. But I come reason am again, if our votes nor dey count as many of us believe, why the northerners dey always go back home during elections to vote?
Thank you my brother for understanding this mystery.  E simple to understand but some people no wan understand the game. Make I just update us wetin they happen currently for the country because I dey get first hand information.
1. Buhari want Amaechi to succeed him.
2. Tinubu no wan give up for Amaechi. Tinubu no want Amaechi at all and Tinubu no want him son (Osibanjo) because him feel say PYO betrayed him. If Tinubu change mind now endorse PYO,  na wetin go fit make Amaechi get problem.
3. PDP and Atiku know say na Amaechi be Buhari candidate, so dem dey wait make APC give him ticket, then them go use Wike as running mate to Atiku so that him no go fit support him brother Amaechi.
4. But if APC no give Amaechi ticket, Atiku go use Okowa or Udom as running mate.
5. Jagaban don make him plan B finish to shift go SDP incase APC fvck am up.
6. Northern cabals being the king makers want Atiku or Amaechi as the next president.
E dey burst my head say na the northerners way we dey call illiterates, the ones way no go school, the so called shoe makers and aboki na he out king maker. We for south-south wey suppose dey educated na  we dey look down on the electoral process. This election we go shock them we go come out with our PVC and vote our candidate.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Buhari don meet with APC governors today for Abuja and em talk many things but all the things wey him talk, I go point out some here:
1. Baba talk say make APC governors support him to choose who go succeed am. This one show well well say Baba get interest to produce who go replace him.
2. Baba describe the kind person wey him want to succeed him.
3. Him say he go like person wey dey acceptable to the people.
4. Person wey sabi dey core value of APC
5. Person wey go fit unite people.
6. And before now him talk say he go like hand over power to a younger person.

All the above qualities no match Tinubu atol and him kuku understand shaa
Anybody way get eye go see say Tinubu no be Buhari candidate, na Rotimi Amaechi be the chosen one.
Before I been dey talk say I no go involve myself for politics because of the things wey don hapun in the past. But I come reason am again, if our votes nor dey count as many of us believe, why the northerners dey always go back home during elections to vote?
Thank you my brother for understanding this mystery.  E simple to understand but some people no wan understand the game. Make I just update us wetin they happen currently for the country because I dey get first hand information.
1. Buhari want Amaechi to succeed him.
2. Tinubu no wan give up for Amaechi. Tinubu no want Amaechi at all and Tinubu no want him son (Osibanjo) because him feel say PYO betrayed him. If Tinubu change mind now endorse PYO,  na wetin go fit make Amaechi get problem.
3. PDP and Atiku know say na Amaechi be Buhari candidate, so dem dey wait make APC give him ticket, then them go use Wike as running mate to Atiku so that him no go fit support him brother Amaechi.
4. But if APC no give Amaechi ticket, Atiku go use Okowa or Udom as running mate.
5. Jagaban don make him plan B finish to shift go SDP incase APC fvck am up.
6. Northern cabals being the king makers want Atiku or Amaechi as the next president.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Buhari don meet with APC governors today for Abuja and em talk many things but all the things wey him talk, I go point out some here:
1. Baba talk say make APC governors support him to choose who go succeed am. This one show well well say Baba get interest to produce who go replace him.
2. Baba describe the kind person wey him want to succeed him.
3. Him say he go like person wey dey acceptable to the people.
4. Person wey sabi dey core value of APC
5. Person wey go fit unite people.
6. And before now him talk say he go like hand over power to a younger person.

All the above qualities no match Tinubu atol and him kuku understand shaa
Anybody way get eye go see say Tinubu no be Buhari candidate, na Rotimi Amaechi be the chosen one.
Before I been dey talk say I no go involve myself for politics because of the things wey don hapun in the past. But I come reason am again, if our votes nor dey count as many of us believe, why the northerners dey always go back home during elections to vote?
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Buhari don meet with APC governors today for Abuja and em talk many things but all the things wey him talk, I go point out some here:
1. Baba talk say make APC governors support him to choose who go succeed am. This one show well well say Baba get interest to produce who go replace him.
2. Baba describe the kind person wey him want to succeed him.
3. Him say he go like person wey dey acceptable to the people.
4. Person wey sabi dey core value of APC
5. Person wey go fit unite people.
6. And before now him talk say he go like hand over power to a younger person.

All the above qualities no match Tinubu atol and him kuku understand shaa
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Personally sha, I believe say one day kontri go better.
I believe so too. But for it to be better we the citizens must take action, we must exercise our rights to vote, and if we actually want things to be better we must vote for that candidate that is most credible, i know there cannot be any general consensus as to which candidate is prolly the best, but personally if you indeed know that candidate that will work better than others then vote for him, do not vote for candidates on the basis of party, bias, religion, ethnicity, or cause you were told to face 'reality', or cause you were bribed, etc, it is hightime Nigerians did what it right, if we miss this chance then another four years of suffering awaits us.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
APC 2023 Presidential Race no go be small matter. APC get about 23 aspirant wey d come out under the part.

The whole North get about 4 aspirants (With 1,257 delegates)
The whole South come get about 19 aspirants (With 1,068 delegates)
NW- 2 aspirants
NC- 1 aspirant
NE- 1 aspirants
SE- 8 aspirants
SW- 7 aspirants
SS- 4 aspirants

APC cabals wan style remove Tinubu and Rochas Okorocha from the presidential race of the party. The screening committee d accuse Tinubu age and certificate forgery and having a drug case with the UK.
Efcc d accuse Rochas of  5 billion fraud. He bailout is 1.5billion naira.
All this their katakata na to remove the strong two founders of the party cos they stand a better chance of winning the APC presidential primary race.
Make we see how dia own matter go be. PDP don display their dollars bills for buying delegates
member
Activity: 364
Merit: 13
Username: Bhig daddy
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria/ Niger state

Oboy, naija sha no de carry last, we de everywhere sha. I no even know say we get forum for this place oo, I happy sha because sometimes e de easy for pasin to talk about em problem with pigin pass English. I greet una oo. Any problem wey I get now an this forum I de run come.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Guys it was just announced that atiku abubakar would be the flag bearer of the former, in termed of publicity and money the PDP has a lot to achieve over the ruling party, I believe we Nigerians has a say in global crypto-currency, the promise team also lost the primaries only a few had the upper hands. Believe people what to learn more about how things works

Wike try sha, e no easy. if no be 30 wey dey play am e for dun give atiku more fight. Make we tell ourselves the truth. If you watch how the power been dey move from PDP to APC during the last election wey bring APC into power you go undetected say Labour Party never get the momentum yet. This election na between PDP and APC. if e comes to free and fair elections, then PDP go win since Nigeria dun tayh for their governance but if na cheating something, believe me APC no go give up this power especially when they get all the institution at their disposal.

Make we dey wait on APC primaries but i no go surprise if na Bola Tinubu emerge, i mean e go be disrespectful to him political career say party wey him start go give another person ticket wey no be am. Peter Obi na third force and e go hard am to emerge as winner, anyhow sha i just dey wish anyone wey go enter go better pass buhari and dey industrious. dis na just personal opinion.

My broda make I tell you truth, PDP oo or APC oo all na d same bicus as them spend all those money to take enter that position na so them go take carry the money as well to take pay all the money them borrow carry enter seat. My only anger be say these two parties no wan remove hands for young youths to enter there people way go reason way forward and to bring all necessary developments for the country unlike other presido outside we country naija. Secondly I go personally talk am say our youths too dey cause some problems wey we dey face for the country, during campaign if those old men give them small NGN their heads go begin shake still carry themselves go vote for wetin go still trouble us for next 4 to 5 years again, e com be like say youths no get hope again. Statistically the numbers of youths inside Naija na 10x and if 9x stand wella for ground say them no go vote any old man say na Young youth go represent us go enta seat my brother we for do am fine and win them out from the system.

Well make i no reason the matta too much before me get BP.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
...say make we forget credibility as Nigeria dey far from that...
Na this kind talk wey Nigerians they talk wey go make am impossible for this country to better in a very long time, look well well everybody wan japa, wetin cause am, talk like this during crucial time to make decision wey go make country na im cause am, the one wey they burst my head pass na when you they follow Nigerians talk politics, them go tell you say "we sabi say this candidate na the best oh, but make we face reality", abeg i wan ask ehn, which reality worst pass wetin we they experience for Nigeria now, which reality worst pass the hunger, insecurity, unemployment, suffering, etc wey Nigerians they go through now, abeg make una tell me.

Wetin we need now for this country na just hope. One stark reality be say, All man no fit japa. To japa no dey easy sef. That one na another project on it's own.  About the PDP primaries wey just end now, we know say the so-called delegates no vote sake of say dem like the aspirants. Na the person wey bring plenty money them vote for. Now na the time wey I think say EFCC suppose swing into action to do post primary investigation on vote buying and the other mago-mago but we no go see them. Now na the time wey dem suppose punish the offenders. Because if them no make scapegoat of anybody them imagine how the general election go come be. Personally sha, I believe say one day kontri go better.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
...say make we forget credibility as Nigeria dey far from that...
Na this kind talk wey Nigerians they talk wey go make am impossible for this country to better in a very long time, look well well everybody wan japa, wetin cause am, talk like this during crucial time to make decision wey go make country na im cause am, the one wey they burst my head pass na when you they follow Nigerians talk politics, them go tell you say "we sabi say this candidate na the best oh, but make we face reality", abeg i wan ask ehn, which reality worst pass wetin we they experience for Nigeria now, which reality worst pass the hunger, insecurity, unemployment, suffering, etc wey Nigerians they go through now, abeg make una tell me.

If Nigerians never wise up and take decision into their hands through voting the most credible candidate, then na another 8 years wey go worst pass Buhari own they come so, na make all man dy find way to japa be that, until Nigerians stop to they face this their yeye 'reality', na so so suffer go continue for the country oh.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I they reason am say Atiku go carry Wike as him running mate, and if him do that them go fit win the Election because them go really get plenty vote as APC still they confuse of who to give the flag bearer.

You want to burn this country be that o. Na one week 7 troubles e go be. E for be better arrangement to make Wike running mate for Atiku but if this one ever happen, Aso rock go deh deh on fire steady. Wike get hot blood and him mouth no deh rest. One day, Wike fit wake up from sleep begin think say na him be president. Na this same over sabi make Obasanjo no gree pick Rotimi Amaechi for YarAdua. Instead e go pick GEJ give am.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
***

I dey somewhere dem dey discuss this politics thing, from the guy explanation, e say the best candidate na him win for PDP like this, say make we forget credibility as Nigeria dey far from that. Say make we look person wey fit take power from APC say na only Atiku based on previous experience. say if you look at the other aspirant na their first time. As for the Tinubu matta him say Tinubu get structure pss the other delegate say make we no forget say na delegate dey vote and no be social opinion.

This person na very political person, like e dey involved for grassroot, e say the only chance of Peter Obi winning was getting a ticket as flag bearer for PDP say that labour no fit give am vote to win. That for someone to emerge he need major support of the northern state, Lagos and then Rivers state. Him come use the outcome of the just concluded PDP primary, that's northern go hardly leave their own vote outsider unless they stand to be benefit. Obi go fight well but na third candidate e be.
member
Activity: 742
Merit: 30
Guys it was just announced that atiku abubakar would be the flag bearer of the former, in termed of publicity and money the PDP has a lot to achieve over the ruling party, I believe we Nigerians has a say in global crypto-currency, the promise team also lost the primaries only a few had the upper hands. Believe people what to learn more about how things works
This PDP primary elections been they competitive, at some points I no believe say Wike no go win am, because him get mouth of the voiceless people of South East and South West. I they reason am say Atiku go carry Wike as him running mate, and if him do that them go fit win the Election because them go really get plenty vote as APC still they confuse of who to give the flag bearer.
Jump to: