Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 181. (Read 1027819 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
We dey active here before now I dy come see say them nor even dey post here again as their rank don increase. Which kind pattern be that una dey shame for who una be abi wetin.
There was a time Hhampuz campaign no dey count local board, but I noticed this has changed, some of his campaign dey count local board now since many months ago.

What I notice is that we need to get one mind, make we know that we all get value here, be it posting in Pidgin or English. If I no lie, I noticed reduced activity for here, no new topics brought up and here seem boring.

I remembered when Nathrixxx was here, he was very active on this local thread. I told him to quote while copying from another site until he made a mistake but he included link but was permanently banned and he appealed for it but not unbanned. I wish he could still be here as he was an active local thread poster.

It all lies on us, the people I introduced to bitcoin and this forum were always active on this local thread, just that one left and one was banned. It depends on how we are introducing newbies to this local thread.

And if we noticed, moderators and staffs are concentrating on this thread but only require us to work towards it.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
When I first come here e get guys way join forum around the same time with me. We dey active here before now I dy come see say them nor even dey post here again as their rank don increase. Which kind pattern be that una dey shame for who una be abi wetin. Na cos say signature nor dey count for here nai make them ghost? E dey pain me o I nor wan call names but some of us nor dey try. This thread na our own make we make am sweet for all of us
hero member
Activity: 966
Merit: 701
As d matter be so. Make we try to the relate fine for this our forum so that we at least achieve our aim of getting our own board.
I just d think of ways way we go come together to celebrate our achievement so far for bitcointalk forum. Im go make sense, once in a year we go host guest together party for everybody to celebrate and know one another. If na gbedu of any kind you invite everyone to come jollificate with you
I like your opinion, and it sounds great, but make we no forget say this na crypto-currency not everyone go one show their face, like some go like dey anonymous even if they are legal and decent members of our group, so make we no make them feel bad, and get together can be an off forum discussion, for now I think say we dey do well, and the community dey move but I still repeat am make we no spoil am with diverse language other than the ones wey we initially agreed.
I dun notice say people nor want show their face for real life. I don invite the house come different crypto events way dey host for different states nobody don gree shake body to come. Make we reason am na we we dey here. We suppose don get one kind strong bond as like-minded people
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
As d matter be so. Make we try to the relate fine for this our forum so that we at least achieve our aim of getting our own board.
I just d think of ways way we go come together to celebrate our achievement so far for bitcointalk forum. Im go make sense, once in a year we go host guest together party for everybody to celebrate and know one another. If na gbedu of any kind you invite everyone to come jollificate with you
I like your opinion, and it sounds great, but make we no forget say this na crypto-currency not everyone go one show their face, like some go like dey anonymous even if they are legal and decent members of our group, so make we no make them feel bad, and get together can be an off forum discussion, for now I think say we dey do well, and the community dey move but I still repeat am make we no spoil am with diverse language other than the ones wey we initially agreed.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Im go make sense, once in a year we go host guest together party for everybody to celebrate and know one another. If na gbedu of any kind you invite everyone to come jollificate with you
This may not work, we are from different states, we have different ethnic groups with different states far from each other. Also some people may want to retain absolute anonymity in relation to this forum.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
As d matter be so. Make we try to the relate fine for this our forum so that we at least achieve our aim of getting our own board.
I just d think of ways way we go come together to celebrate our achievement so far for bitcointalk forum. Im go make sense, once in a year we go host guest together party for everybody to celebrate and know one another. If na gbedu of any kind you invite everyone to come jollificate with you
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na as you translate am now, I dey understand watin e been dey try talk. Na very good initiative na em e bring so o but na the means way just spoil the whole thing. I like the fact say, e bring better news way get potential or ft turn watin go go well tomorrow but, e for put am in a way way everybody go follow. Rugged am, e try shah.

One thing I go like advice be say, the forum don dey and e person behave like say, e wan impress person abi people, you con dey go do watin you big pass en hand, e fit still hit you las las. Make we dey try think after effect before we do some kind things. We dom see am for this forum say, wwtin you do today as newbie fit en you ban as a Hero member tomorrow. Translation without referencing na still plagiarism e be. Make we no con do watin we go dey fine way to defend later. I greet una for the house.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
-cut-
-cut-

This guy above just reminded me of Patrick Obahiagbon, and I'm still not sure what the point of those two Yoruba posts was because I couldn't decipher anything important until I used a google translator after staring at the image and post, the fact that we want to build the community shouldn't welcome lack of communication. Not everyone understand other languages, pidgin should have been a better option.


When I used Google Translator, I discovered something fascinating that others might be interested in:

1. It's a copy and paste straight translation. The OP used a translator to flip between two languages instantly.

I believe this is against bitcointalk rules, and the OP is a lazy poster.

I copied his original post, translated back to English and queried plagiarism checker, it was a cool copy paste post.

The first translated post from Yoruba to English.



The source[1] OP copied from



The second translated post from Yoruba to English.



The source[2] OP copied from



The two post were not quote but just additional posts to his quoted copied post. It's plagiarism in my opinion.


2. After checking his post, I went through the profile and I found that OP is a Turkish. His second and third topic were posted on Turkish local board.

merhaba bu site ve twitter hesapları uzun bi sureden beri sessiz.attıgım maillere ve twitterdan mesajlarımıda gormediler sanırım. bi ihtimal belki sahibi bu foruma uyedir diye dusundum ya da forumdan bu kişilere ulaşabilmemi saglayacak birileri vardır!?!  bu site ve kurucusu ile ilgili herhangi bir bilgiye sahip birileri var mı acaba?

*gunluk 10.000 tl ye kadar eth-etc ve ripple satabilirim.

*escrow luk için mhanbostanci dan  yardım istedim.kendisi sadece bitcoin için escrowluk yaptıgını soyledi.escrow kullanmak isteyenler foRumdaki diger trustı yuksek kişilere basvurabilir.

*kullandıgım banka enpara sadece hafta içleri akşam 5 e kadar satış yapabilirim.

*satış fiyatı coinone.co.kr deki fiyatların turklirasi karşılıgıdır. https://coinmarketcap.com/exchanges/coinone/ burdaki fiyatı  www.xe.com uzerinden cevirip birim fiyatları ögrenebilirsiniz.

*her bir koin için minimum alış 500 tl olmalı. 200 tllik xrp-100 tl etc istiyorum olmasın lutfen.

*escrow için düşündügüm yontem su sekilde: alıcı parayı escrow a yollar>ben alıcıya istedigi koini yollayıp escrowa bildiririm>escrow parayı bana yollar.escrow komisyon isterse bunu alıcı karşılar.

*TL sına karşılık sadece bu 3 koini tedarik edebilirim.lutfen diger koinlerle ilgili taleplerle gelmeyin.

The OP responded beautifully in two of the quoted topics that were made in the past(2017), and there are additional posts in which the OP has engaged perfectly. Therefore my conclusion is that it's either this is a bought account that want to be active in here or may be OP is attempting to disperse the Naija local board with his new posts.



[1] https://cointelegraph.com/press-releases/velas-powers-into-formula-1-with-multi-year-scuderia-ferrari-partnership
[2] https://www.marketwatch.com/press-release/velas-joins-the-space-race-by-partnering-with-spacechain-2022-01-03
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Please aren't we going to cause confusion with adding other languages to the board, make we no forget say Nigeria get more that 200 languages spoken, imagine if we come one flood here with indigenous languages, my own opinion be say the pidgin wey we dey speak we be the language apart from English wey everybody can ready understand, this extra language go cause division, we no need am. This na new year and we are happy about the development we get last year, make we no spoil am with unnecessary things like adding extra local languages here go dey divide.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Baba you dey very correct native language like Yoruba and other Nigeria language go give us strong ground to fit get our own board, I dey always wish say I understand language like Turkish but I must value my own native language.
This thing where dey guys dey try to talk for Yoruba dey very correct despite the fact say me no too understand Yoruba but I pick some words.
E for sweet me say, this thing way you write now, na for Yoruba you write am. The whole matter just be like say, e wan stir up something abi, the info na for only the Yorubas way dey forum. Person fit say, na this one be for all naija because, na watin we all understand than the other one, I no even fit read, talk more of to u destiny the something.

Nobody dey argue say, language no go give us edge or strong base but, e still gets be language way everybody way call enself Nigerian go understand. Them Chinese, French, Portuguese, Germans etc, I sure say, them get one language way unify them and that no mean say, them no still get some kind mother tongue from there rural locality. Even like this cef, me never really code my pighin but, if na to code am, e fit still turn up unique.

E just be like say we dey drag the matter wey no worth dragging for, I hope you people fit understand the reason I post this. No need for a king to dey fight saying he wan be king na  Grin.
No reason am tight man, we still dey together for the struggle. All follow to make the place active and I just dey try talk the one way I feel say e go sure for all of us. Before we go turn naija local board now to tribal board!
hero member
Activity: 1008
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Awọn agbara Velas sinu agbekalẹ 1 pẹlu Ọdun Ọdun Scuderia Ferrari Ajọṣepọ



Gege bi ofin forumu yi lati ni ede Naijiria kan Lati soro ti Yoruba je okan larawon. Velas network se ikede ajosepo re pelu space chain ni ojo meta seyin,ile ise mejeji yi yangan nipa ifowosowopo won,nitori wipe wonje okan lara awon blockchain akoko tinsise ni agbaye.
Ifowosowopo awon ile ise mejeji yi(velas ati space chain)  je ipinnun fun aseyori gidi nitoriwipe space chain yoo ni anfani ninu okan ninu awon imo ero block chain tio yara julo, Alelo velas EVM token ninu Ethereum  netiwoki Lati yi VLX pada si Ethereum, space chain je ajo ti oda space ati block chain po Lati ko sisikale  blockchain to da Lori satellite.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Than for for to dey speak watin the next man no go understand, that one cast.
E just be like say we dey drag the matter wey no worth dragging for, I hope you people fit understand the reason I post this. No need for a king to dey fight saying he wan be king na  Grin.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Translation no sure abeg are person no scatter this place for us. One naija!

If we get that person reach 5 for this place we for dun get strong case instead of the English wey they flow here. If you dey use chrome to understand wetin e dey write e no hard na Yoruba. I prefer other languages than English because na strong case for us be dat. To dey read things for English just tire me here. Make I say dem plenty wey dey use their mother tongue not minding the language then we reply with pidgin we for dun get wetin we go use argue no be to tell dem we want board wen wetin dey here na English no make sense at all.
I still maintain say, e no sure. Imagine say, I begin dey drop my mother tongue for here now, how many person wan understand. The worst be say, many of our Nigerian languages then no get reference or source for the Google cef, way be say, person for wan translate. When you speak language way your people cef no follow, I wonder if the person cef fit stand talk say, e don communicate because, na the whole essence of the forum and pasting whatever. Na for communication and when person pass information without anybody or make I say, majority understanding nothing, the person don successfully spam the board. E go sure say, we write our pighin well, core pighin than this one way person go carry mother tongue drop for here.

I fit remember say, one major criteria way dey necessitate local board na when, threads way relate one particular nation don too many for a particular board. Upgrade00, Charles and Mpamaegbu don reason this matter before way I capture.  Like for other languages now, we don get our naija corner, con still get our naija proverb thread too and others fit still come up. If we get Yoruba, Hausa and Igbo or even Fulani thread with something way point out to forum say  na naija something, e no for bad. The bad thing be say, even the indigenous tribe way dey forum as e be now, them no go even reason to make am active. So, how them wan carry reason us...? Even if na to translate some matter way sup for the main board come for that side, e for sure because, e go active at least. Than for for to dey speak watin the next man no go understand, that one cast.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Translation no sure abeg are person no scatter this place for us. One naija!

If we get that person reach 5 for this place we for dun get strong case instead of the English wey they flow here. If you dey use chrome to understand wetin e dey write e no hard na Yoruba. I prefer other languages than English because na strong case for us be dat. To dey read things for English just tire me here. Make I say dem plenty wey dey use their mother tongue not minding the language then we reply with pidgin we for dun get wetin we go use argue no be to tell dem we want board wen wetin dey here na English no make sense at all.

All languages dey acceptable na wetin we vote for, so anyone you sabi write make we no use u no understand pursue person oh. We no plenty so the house dey open to everybody and Nigeria language. We go arrange ourselves later. Na just say na advert be dat if not I for like relate with dat discussion.
Baba you dey very correct native language like Yoruba and other Nigeria language go give us strong ground to fit get our own board, I dey always wish say I understand language like Turkish but I must value my own native language.
This thing where dey guys dey try to talk for Yoruba dey very correct despite the fact say me no too understand Yoruba but I pick some words.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555

Anyways, na another year be dis abeg as una dey teach/educate people here make una dey bring update too. Anything wey go put money for person pocket wey legit make una update. Nobi only to dey learn learn, man need chop too. After God preach finish e give people bread and fish to chop so if we fit dey do the same e go go well. Make we make this year sweet for this board abeg.
I support wetin CryptopreneurBrainboss talk. We be crypto community make we do like one. E dey vex me say newbies way nor even sabi wetin we sabi dey make better dough for the industry. Crypto universe big n we dey learn everyday make we nor be those hypocrites way dey claim say dem enter Bitcoin for the tech.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Certainly, there's none among us here who doesn't know how to write those two basic language of communication in Naija
This no need much approach, the language we speak most will be the one that will evolve.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
However, d ish wey I raise na d use of translator. I sure sey I don read am here wey some DT members frowned at it. I nor fit trace that thread now. But persin nor supposed dabble into wetin im nor sabi handle in order to deceive others na.

I understand you well brother, Make we make point clear oh nobody dey encourage use of translation to use communicate, wetin you no sabi comot hand. The translation na only to use understand then you fit reply for pidgin. E no go make sense to dey carry translation talk.

Anyways, na another year be dis abeg as una dey teach/educate people here make una dey bring update too. Anything wey go put money for person pocket wey legit make una update. Nobi only to dey learn learn, man need chop too. After God preach finish e give people bread and fish to chop so if we fit dey do the same e go go well. Make we make this year sweet for this board abeg.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
If we get that person reach 5 for this place we for dun get strong case instead of the English wey they flow here. If you dey use chrome to understand wetin e dey write e no hard na Yoruba. I prefer other languages than English because na strong case for us be dat. To dey read things for English just tire me here.
Na true wey you yarn here. I nor wan go back again to the back and forth wey happen here unto the kain language wey we supposed use here. I'm all for any language here, except English. I nor get any ish with vernacular at all. I don even post one time for dat Yoruba thread with d little Yoruba wey I sabi 👇

Waawu! O ya mi l'enu l'opo l'opo lati ri wipe ede Yoruba ni aaye oto l'ori website yi. Inu mi si dun sii gidi gidi ni. Nje a ri eni ti o le fun mi ni merit? Inu mi yio dun gidi gaan ni. Ese pupo pupo...
Kilo je "Waawu" nibiye? Shey nyi je ijile ede Yoruba ni? Mo ro kpe ede English niye.


However, d ish wey I raise na d use of translator. I sure sey I don read am here wey some DT members frowned at it. I nor fit trace that thread now. But persin nor supposed dabble into wetin im nor sabi handle in order to deceive others na.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Translation no sure abeg are person no scatter this place for us. One naija!

If we get that person reach 5 for this place we for dun get strong case instead of the English wey they flow here. If you dey use chrome to understand wetin e dey write e no hard na Yoruba. I prefer other languages than English because na strong case for us be dat. To dey read things for English just tire me here. Make I say dem plenty wey dey use their mother tongue not minding the language then we reply with pidgin we for dun get wetin we go use argue no be to tell dem we want board wen wetin dey here na English no make sense at all.

All languages dey acceptable na wetin we vote for, so anyone you sabi write make we no use u no understand pursue person oh. We no plenty so the house dey open to everybody and Nigeria language. We go arrange ourselves later. Na just say na advert be dat if not I for like relate with dat discussion.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
if they do not understand how to speak and write in English or Pidgin, then it would be good to communicate here in other language that they understand. But, I do not think there would be anyone here that do not know how to speak and write in English and Pigdin.
Certainly, there's none among us here who doesn't know how to write those two basic language of communication in Naija
Shuu I taya o we go come dey do like say we be illiterate abi we nor sabi ourselves again. Which person way get iq to fit register account for forum make posts way bread am merits na him nor go come sabi English or him native language Pidgin. Abeg make we call a spade a spade. 
Oh, boy! This matta choke oh. Na im be sey e use translator be dat. Na heavy deceit be dat na. We nor even want intruders for dis we angle sef. Na so na wen im commit now dem go check im post history and come sey na one of us. Abeg, I go like make we all put mouth for dis matta. Even to use translator sef na tag offence sef.
If na Nigerian he supposed know say we get protocol here. You introduce yourself to the community make we sabi you. Which one you come dey write for yoruba abi french to confuse us.
Jump to: