Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 176. (Read 1027501 times)

hero member
Activity: 1498
Merit: 702

This one serious and very sad but e go good make we deh shame dem join too as deh no want to hear word. Abeg e go good make you put out the olé handle or name here so that we go know the thief. Na the surest way to avoid these shit eating yahoo boys in cryptos. Name and shame them is the way.
I really no post am too spoil anybody's name since no be me be victim, but rather I post am so make we dey very careful because all this crypto-currency vendor wey you no dey sure of fit be scam i go recommend you deal with people way don already run business with you before, and the deal go on very smoothly na those one's you fit trust.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Na the surest way to avoid these shit eating yahoo boys in cryptos. Name and shame them is the way.
"shit eating yahoo boys"  Grin God abeg oo

You deh laugh? Na serious matter so o. I deh see them for online and the thing deh irritating. Youths just deh destroy their destinies for money. E good as that pastor David curse them all.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
This one serious and very sad but e go good make we deh shame dem join too as deh no want to hear word. Abeg e go good make you put out the olé handle or name here so that we go know the thief. Na the surest way to avoid these shit eating yahoo boys in cryptos. Name and shame them is the way.
"shit eating yahoo boys"  Grin God abeg oo
You don notice say these days na scammers full binance p2p their rate dey high but their number of traders na mostly 0-5. One particular day na only them full the page I gats sell my btc to usdt so I fit sell to others for binance. The only thing I fit advise na if you dey trade for binance make you read the seller/buyer reviews well well especially the negative ones. E go help you
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

2. Vendor?
E make sense if you know the vendor like them CryptopreneurBrainboss and Igehhh. I no expect say this kind news go dey among us. We dey Sokoto, we come dey look for waiting we need for Kano when the thing dey Sokoto. Make we dey recommend their service to friends and families as well.
Thank you so much, Charles! Please remember that decentralized peer-to-peer is based on trust and should be taken seriously; do not trust a random advertisement you see on internet or social media, and do not trust any random people here either; instead, go to reputable members to conduct your transactions. Please know that I am at your disposal, as I also run an escrow service.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I get very important information, although it's a sad one, my person just reach out to me that a popular crypto-currency vendor don carry him Bitcoin japa, guys it's now getting serious, make we dey careful would we deal our crypto-currency with, do am with person wey you sabi leave unrealistic high exchange rate e fit be scam

This one serious and very sad but e go good make we deh shame dem join too as deh no want to hear word. Abeg e go good make you put out the olé handle or name here so that we go know the thief. Na the surest way to avoid these shit eating yahoo boys in cryptos. Name and shame them is the way.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I get very important information, although it's a sad one, my person just reach out to me that a popular crypto-currency vendor don carry him Bitcoin japa, guys it's now getting serious, make we dey careful would we deal our crypto-currency with, do am with person wey you sabi leave unrealistic high exchange rate e fit be scam, also no follow social media influencer mouth, they are only making their hustle to work, we have been trying to reach the vendor support group but they aren't responding, guys be wise here in crypto-currency

This na really sad news, something wey person discipline e self to hold for God knows how long reach now, nai person japa with, na wa. i only sell coins to persons i know personally, everyone should do too. When you get ridiculously high rates for your coins, sense suppose tell you make you check well make dem nor do you take. If you dey this community, nor go outside to go find who go buy your coins, some community members for this our side dey buy at good rates, ask question.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I get very important information, although it's a sad one, my person just reach out to me that a popular crypto-currency vendor don carry him Bitcoin japa, guys it's now getting serious, make we dey careful would we deal our crypto-currency with, do am with person wey you sabi leave unrealistic high exchange rate e fit be scam, also no follow social media influencer mouth, they are only making their hustle to work, we have been trying to reach the vendor support group but they aren't responding, guys be wise here in crypto-currency
This one na big time yawa give everyone wey d trade crypto for this our country. Must everyone find means to defraud his or her fellow human being for this our country. It's very terrible and pathetic for someone to defraud his fellow being for this hard time wey everywhere red. Nobody is to be trusted when it comes to dealing with money. Na why I d trade with caution to avoid heartbreaking stories like this. Everyone don become suspect for this our country Naija
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
1. Make you use decentralized exchange, no think say Naija no dey there wey wan buy and sell too, they dey there, but the trading volume no dey much like centralized exchanges, but e make sense for privacy.

2. Vendor?
E make sense if you know the vendor like them CryptopreneurBrainboss and Igehhh. I no expect say this kind news go dey among us. We dey Sokoto, we come dey look for waiting we need for Kano when the thing dey Sokoto. Make we dey recommend their service to friends and families as well.

If you no know the vendor, better say make you use escrow, or if the person sabi multisig wallet, 2-of-2 multisig setup no bad. If the vendor no release money, you too no go sign the transaction, the vendor no go get anything. But know say if na 2-of-2, you too no longer get access to the coin again. But vendor fit wicked up to that extent? I no think so because e no go get the coin as well.

As for me, I go like either decentralized exchange or direct p2p (vendor) wey dey trusted, we get two for forum. Any vendor wey I no know, wey I no know him family, I no fit trust ham pass people wey dey do ham on this forum.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I get very important information, although it's a sad one, my person just reach out to me that a popular crypto-currency vendor don carry him Bitcoin japa, guys it's now getting serious, make we dey careful would we deal our crypto-currency with, do am with person wey you sabi leave unrealistic high exchange rate e fit be scam, also no follow social media influencer mouth, they are only making their hustle to work, we have been trying to reach the vendor support group but they aren't responding, guys be wise here in crypto-currency
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nor be sey dem ban any account per se because of that. Wetin happen be sey pepper body begin make people chook eye enta owa matta and some accounts wey get yamayama begin suffer because of am. BTW, you supposed dey aware of the awards last year because you enta forum b4 then

sadly super eagles no dey game again but na still our own so fir una wey need gambling post make una utilized am welle.

Like seriously say super eagles no dey game 😳😳😳, this one shock I swear down, after all the gra gra wey dey first do as the game start,? This na real disappointment, and abeg, make una no blame me say I no even know say Nigeria don commot for the ongoing Afcon football match, when e comes to football, I dey Nigeria like say I no dey Nigeria ooh, cus me no dey watch Ball, na where people dey discuss ball me dey always put ear and for some time now, I never hear or see where people the discuss the matter...

Quote

How far dis market now, how una dey see am. You feel we go still go down or you believe we dun dey rebounce. The market just dey confused me. I dey try say make I see how things dey go asin find one or two coin to just hold but market dey fear me. Which project una dey look into like dis make person follow una research see whether 2022 fit stew for my side via investment.
Abeg oga boss, help us pump bitcoin 😂, make we wey be children fit benefit from our altcoin investment, my hand no reach to buy bitcoin, and when I come buy the one wey my hand reach to buy, bitcoin no go allow the thing pump make children for house see food chop, the thing dey make me won cry like baby 😭😭😭.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I nor dey the time them don the last award so I nor know wetin sup if them ban users and the condition why them ban them. As brainboss don cap say kasala burst via the matter make everybody shine their eye wella make you nor use your leg go kick stone. E go sweet my belle if we win even if na one category. E go be boost for us as a community.
I believe say we go get one or a couple of awards we deserve am, Brainboss na big name, and he has lead by example for people for we country and outside, but we still get some good Nigerians way I think Dem no dey recognize, imagine we get Brainboss and few others under am we Dem recognize I believe we fit even get the local board, so how we go make the mata happen?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Nor be sey dem ban any account per se because of that. Wetin happen be sey pepper body begin make people chook eye enta owa matta and some accounts wey get yamayama begin suffer because of am. BTW, you supposed dey aware of the awards last year because you enta forum b4 then na.

Yes oh so this time around, no matta wetin una dey dey avoid anything wey go put you for trouble. Posi na one of the people wey been surfer this thing then assuming I dey remember wey. I just hope e dey alright and dey do fine. Also make una no forget say we get African discussion thread for gambling for this our AFCON wey dey go on and other future tournament wey go show face, sadly super eagles no dey game again but na still our own so fir una wey need gambling post make una utilized am welle.

How far dis market now, how una dey see am. You feel we go still go down or you believe we dun dey rebounce. The market just dey confused me. I dey try say make I see how things dey go asin find one or two coin to just hold but market dey fear me. Which project una dey look into like dis make person follow una research see whether 2022 fit stew for my side via investment.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I nor dey the time them don the last award so I nor know wetin sup if them ban users and the condition why them ban them. As brainboss don cap say kasala burst via the matter make everybody shine their eye wella make you nor use your leg go kick stone. E go sweet my belle if we win even if na one category. E go be boost for us as a community.
Nor be sey dem ban any account per se because of that. Wetin happen be sey pepper body begin make people chook eye enta owa matta and some accounts wey get yamayama begin suffer because of am. BTW, you supposed dey aware of the awards last year because you enta forum b4 then na.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
I nor dey the time them don the last award so I nor know wetin sup if them ban users and the condition why them ban them. As brainboss don cap say kasala burst via the matter make everybody shine their eye wella make you nor use your leg go kick stone. E go sweet my belle if we win even if na one category. E go be boost for us as a community.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

Brother, no body be pikin for here ooh, we fit get bosses like CryptopreneurBrainboss them, like mpamaegbu them and the rest, but that one no mean say other maybe newbies members na small pikin, so all I dey try talk be say, make you no go the look down on yourself say you never reach, general knowledge no be by rank on bitcointalk ooh....😜😜
Oga Five-star, you know say na adage be that "Wetin elder sit-down see, pikin go climb coconut tree, e no go see" Pikin for the adage no mean age or number, e mean experience. Like I check your profile and you Don dey here since 2016. But check me, I never reach 6 months. So, for this forum, I be pikin to you.
To show more, you see Oga Brainboss talk say dem don do collabo for award before and the thing lead to ban some of us. I never know this kind thing, but as elder him don chuk mouth.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
***

The mata based on update wey I get na say na P2P scammers Binance dey target but you sabi how e dey been na, People go just dey claim claim when nothing happen to them. If you read some of the tweets you go understand say na fakes. Onto other notes I believe say Binance no go just target Nigerian carelessly when them know say na there their choppings dey in regards to amount of people wey dey use their exchange our country.

Recently ehh na Binance all work boys dey use cash out and this thing dey worry their reputation so if them begin seized funds wey dem feel say dey linked to scam make we no just blame them although the. supposed give better reasons and valid ones instead of all those rubbish reply I dey see online. Na the relys dey vex me no be even say them lock people out of their funds.

For the voting, abeg just go do your mind, last time due to our collaboration dem begin attack us and ban some accounts. I no wan make anything like dat happen again. Just vote wetin dey your mind. Anyways belike I dun dey active again make we see if I fit pick up from where I stop.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I throway salute to everyone I just one know how una dey feel about this whole bianance something because this matter don dey trend and I am still not too sure about thebmata, is bianance really at fault or they are just tackling discrepancies and illegal activities, regardless what it is this mata is really causing alot for Nigeria crypto-currency world, I suggest we talk about this bjata it would really help many people under stand the mata so them fit know wetin to do.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
BTW, I sey make I remind us sey our guy Brainboss follow people wey carry award last year. Him win for "Golden Feather" category. For those wey never enter forum dat time, make una see the award here https://bitcointalksearch.org/topic/discussion-bitcointalk-community-awards-5277804. All of us rallied round am and na im make am win. This year e go nice make we still support am and SatoPrincess. Abeg, make una leave my nomination out. I nor even know wetin my name dey do there sef as e nor supposed show face at all. These two people don prove dem worth here. E go good make we really round dem. Dem sey na for house wey Sister Charity dey always like stay.
I dey surprised to hear say our own cryptopreneurBrainboss win the 2020 awards...a Nigerian win in the midst of other notable names. Nor be small feat, na big thing. I dey see the way this year own dey go and our people nor dey show much interest. All of sudden this thread don dry. Nobody dey talk again. Naija I hail una
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If true true I dey eligible, I go vote sharply.
Your suggestion to use it as FAIL OF THE YEAR instead of discovery of the year make sense.
I go like make our ogas we dey here for years before we come put mouth for this talk. Because, African Proverb in pidgin talk say "Something wey elder sit-down for chair see, pikin go climb coconut tree e no go see am"

Brother, no body be pikin for here ooh, we fit get bosses like CryptopreneurBrainboss them, like mpamaegbu them and the rest, but that one no mean say other maybe newbies members na small pikin, so all I dey try talk be say, make you no go the look down on yourself say you never reach, general knowledge no be by rank on bitcointalk ooh....😜😜

Anyways, hi brethrens, been a while here, sorry for being a run away solider, e get as things been be ooh, una know say be every thing person dey make public, but all the same, I greet everyone here both new and old.. Una weldone sirs and mas.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
If na oyibo people, dem go say "Please find attached the relevant part of the information herein theretofore." Kai, I sabi grammar 🤪 👇 nor be lie!

      How it works?
  • Up to 3 users you can vote in each category ➥ Note.
  • You can edit your application until the thread is locked ➥ Note.
  • You must have 50 merit or be a full member or higher to vote ➥ Note.

Jump to: