Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 179. (Read 1027501 times)

legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Hello guys I just dey reason Nigeria is one if the biggest crypto enthusiast, every where on telegram you go see Crypto lord's, vendors and big boys I just dey wonder dem no dey remember this forum, why we never get a Nigerian project, the thing has got me thinking, and this thing go give us better rep for the forum, we get Nigerian crypto companies or them no know about this forum wetin be the problem?

This place na very small place normally, as bounty manager I dun see reason projects dey hardly reason here. The toxic nature of the forum is very bad. They no dey welcome altcoins like dat and 90% of people here dey look for their belle and no go even fit raise better funds for your project assuming you dey find investors.

Again this forum dey lose e value daily, watch out no better information again for the forum na just repeated discuss over and over again. Project dey find community and if you check, here no fit reason dem am. If you get better engagement for ur ANN careless people go just concluded na bumping service you dey use but on a general note, the forum no dey give altcoin room to prove otherwise and we understand the reason since e plenty wey dun run people street for the industry.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Hello guys I just dey reason Nigeria is one if the biggest crypto enthusiast, every where on telegram you go see Crypto lord's, vendors and big boys I just dey wonder dem no dey remember this forum, why we never get a Nigerian project, the thing has got me thinking, and this thing go give us better rep for the forum, we get Nigerian crypto companies or them no know about this forum wetin be the problem?
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

The one weh sweet my belle be say immediately weh dem lift the twitter ban, #endsars begin trend on Twitter. Na shame go kill all of dem. They wan use am help Tinubu and the rest of the APC politicians weh want to run for elections. We know their plan and it will not work.

Funny country honestly. The country wey don make many pepo foreigners 4 anoda man land wey the country get boku stuff to better men. Everything wey government do na political reason. Which way naija, we don tire. If no be crypto wahala for dey.

Make I even go find my login details for twitter.

This country dun finish but sha we no go lose hope maybe one day God go answer our prayers  for now na just to find our belle first because if you dey hope on this government or the next to come, you dey OYO state.

Yes oo the belle dey important pass anything bro. If persin dey complain no so new government dey enter and no progress. This APC own na worse, all of us know how much be cost of goods before buhari enter. We sabi how much be dollar, euro , pounds. We sabi how much be fuel, kerosene, diesel. Them say them don remove fuel subsidy but we still dey hear them say them want remove am lol Grin funny country.

Abeg belle dey important joor.

hero member
Activity: 1498
Merit: 702

The one weh sweet my belle be say immediately weh dem lift the twitter ban, #endsars begin trend on Twitter. Na shame go kill all of dem. They wan use am help Tinubu and the rest of the APC politicians weh want to run for elections. We know their plan and it will not work.
The thing dey funny, one of the reasons wey them dey ban twitter don still rise again, one thing our government dey forget be say them think say we be mumu and we no know wetin dem dey do, well I thank God for crypto wey dey make many of us independent and they help many escape the problem of our country financial issues, but I urge all of us to make our voice heard in the coming election, don't sell out.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Who tell you say their plan no go work? See waiting APC do for the last election when INEC dey declear some election wey PDP won to be inconclusive and APC come win the election.

You think say e no go work? People don wise up now. You see that interview for AriseTV with that director general of Tinubu Support Group, Abdulmumin Jibrin. Only two questions weh the journalist ask, everywhere burst there. The Tinubu man begin stammer. They never see anything.

How far  u no be Nigerian? The government always wins. You think say dem never plan everything finished?

Why not. I bi better Naija pikin well well and I dey represent my country well. Those thieves weh call themselves politicians no fit make me denounce my country. I like to always dey optimistic in anything weh I deh do. Na the same mentality I still take believe say wetin happen for Anambra election go repeat itself for Abuja in 2023. Tinubu fit even die before that time sef as many Nigerians deh believe. The man is old and sick.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

The one weh sweet my belle be say immediately weh dem lift the twitter ban, #endsars begin trend on Twitter. Na shame go kill all of dem. They wan use am help Tinubu and the rest of the APC politicians weh want to run for elections. We know their plan and it will not work.

How far  u no be Nigerian? The government always wins. You think say dem never plan everything finished? Bad as e bad dem go make we feel like say we win meanwhile them get bigger plans dem dey arrange. This country dun finish but sha we no go lose hope maybe one day God go answer our prayers  for now na just to find our belle first because if you dey hope on this government or the next to come, you dey OYO state.

Based on the twitter unban  I get joy sha because this VPN dun put me for trouble well well. I dey always on my own and sometimes I dey forget to off am before I leave house. Two times SARs offical dun stop me see say I dey put location as USA but dem dun search tire dem no see anything den allow me go. My own twitter sha dey worry me as sometimes e dey say this site can't be reached but other time e dey alright.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

The one weh sweet my belle be say immediately weh dem lift the twitter ban, #endsars begin trend on Twitter. Na shame go kill all of dem. They wan use am help Tinubu and the rest of the APC politicians weh want to run for elections. We know their plan and it will not work.
Who tell you say their plan no go work? See waiting APC do for the last election when INEC dey declear some election wey PDP won to be inconclusive and APC come win the election. APC even dominate most state for gubernatorial seat. You also know Naija, ₦5000, they go vote. APC come get money.

Chances dey for PDP to win too, no get me wrong.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

The one weh sweet my belle be say immediately weh dem lift the twitter ban, #endsars begin trend on Twitter. Na shame go kill all of dem. They wan use am help Tinubu and the rest of the APC politicians weh want to run for elections. We know their plan and it will not work.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I dey see this lifting of the ban placed on twitter as another government strategy una know say election don dey reach them one reach as much people likes as they can and this na one wey to do am, make we wise up, besides they deprived us of simple utilities like twitter and I know how many of us wey dey Crypto wey dey used paid VPN all this while. Well am happy that it lifted but am not blinded to the plans as to why it was lifted
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Support for crypto rally by politicians go soon start.
Oga Poka, you believe sey 2023 election wey dey come fit make our politicians lift the crypto ban? If na so, e for go well.
Mayb opposition fit userm as selling point, tell us sey if we vote them, them go unban crypto for 9ja.
You know wella sey people wey too dey into crypto for Nigeria na youths and the population high.

Uche Chi, ndewoo! I salute you for de 1 star wey you dash me too.
Ndewoo, nke imere ka...
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
~snipe~
So now way be say that lift the ban so, that na to say people no go carry am promote any story or organise protest again? I believe say, the ban before na just to use am calm youths down for the revolution way been dey come up. One truth way remain be say, the ban bin be for people way no know howfar and some kind people way be say, na from there them dey carry chop becuase, men way sabi been still dey run there matter with the tweeter wella. The only matter way bin be wahala be say, you gats on another app before you run your tweeter matter. As e be now, them no do any big thing to remove the ban, them just open there foolishness to the world as them no dey get shame normally. Say them put hold on freedom of expression and information. Mtchewwwwww for Nigerian government!
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You can now access Twitter with out VPN, Twitter has been unban my people ooh.
I don see ham for BBC Pidgin
https://www.google.com/amp/s/www.bbc.com/pidgin/59969898.amp

BBC News - Nigeria lifts Twitter ban after seven months
https://www.bbc.co.uk/news/world-africa-59958417

E go help the masses but e no help me. I dey post tweet even for this forum wella when the so called Buhari government banned Twitter. Just like they ban bitcoin and other crypto, I dey buy and sell crypto.

In relation to Twitter ban, I dey to give thanks to Tor, VPN and DPN developers.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
I nor dey excited about this news. 2023 elections dey corner so I dey expect a lot of funny antics from politicians this year. Them go find every means to gain favor from the people. Support for crypto rally by politicians go soon start, the one way go enter market go buy tomatoes post online go do...some go post picture way dem dy buy roadside corn. We don see all this in the past nothing has changed. E get one oyibo saying: “the players may change but the game remains the same “ but for Nigeria even the players sef nor dey change na the same cartel dey rule us.
member
Activity: 742
Merit: 30
NEW TOPIC: Nigeria finally lift Twitter ban.

Update!!!

You can now access Twitter with out VPN, Twitter has been unban my people ooh.

Finally, congratulations to my Nija people I know how we they feel as we they use that VPN they run the Bird App (Twitter), but we are now free like a bird to use our Twitter accounts without VPN. The way this our Nija government just they give restrictions on many things ehn, I hope it will not happen again😔😔😔
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
NEW TOPIC: Nigeria finally lift Twitter ban
So it's official and has been confirm by our oga patapa at the top say Twitter will be finally unban and we go fit use am the normal way. Dem go unban Twitter on 13 of January as promised by Mr. Abdullahi.

Quote
The Federal Government of Nigeria (FGN) directs me to inform the public that President Muhammadu Buhari, GCFR, has approved the lifting of the suspension of Twitter operation in Nigeria effective from 12am tonight, 13th January 2022,” Mr Abdullahi said. “The approval was given following a memo written to the President by the Honourable Minister of Communications and Digital Economy, Prof Isa Ali Ibrahim.

Source: https://todaypoliticsng.com/breaking-nigeria-lifts-twitter-ban/

After men don use vpn for about 222 days, they have finally have a change of mind, election dun deh corner and since na platform dem use win before, they will come back to youth that made them. I spit on this government and na why I hate political discussion. I just want any of my things to associated with them because na the same car get all of them.

Them also advice your to dy make use of the platform socially and for business purposes and not to agitate anything but me I trust my naija people say as them unlit the ban, them go use am trend for 2 days straight except say Twitter bots fit deh delete things sha as dem don promise to abide by federal government terms.
member
Activity: 163
Merit: 65
You see this matter so. We use am baff, sew asoebi sef join last year. Everybody do their best to make sure say our plea just moderators ear. Wetin we nor try..the thread still dey meta although e dey locked now. My brother nor think say we nor want better oh we want but e never stew we dey wait patiently.

Nawa oo! The thing get as e bi o. If na to carry card make we carry placards go demonstrate give them. Or make we write formal petition give dem?  Grin

Anyway, since una don talk am wella, I believe they don dey consider am for their table. Make we just keep the pressure on, until we get wetin we want.

Welukum Oga Drip. Abeg no be by mistake, naso God want am. Na yesterday I locate here. Thank you as you bless me with 2 stars from here. E ginger my moral. No worry we dey together for here.

Uche Chi, ndewoo! I salute you for de 1 star wey you dash me too.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
My dear people, how una dey?

Na by mistake I take see this beta naija thread. As I no know say Naija get mouth for here o. I dey new for Bitcointalk but I no too dey new for Crypto matter.
Welukum Oga Drip. Abeg no be by mistake, naso God want am. Na yesterday I locate here. Thank you as you bless me with 2 stars from here. E ginger my moral. No worry we dey together for here.

Oga Charles, I bin see you for technical board wey you answer my question. You dey do well.

Quote
E just be like say person do Suzuki machine and e wan come convert am go Power bike Grin Grin

Quote
You see this matter so. We use am baff, sew asoebi sef join last year

Lolx abeg, I don die for laugh. I don love here. The forum too serious. Atleast we go dey catch small cruise for here.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555

Welcome to our korna. Drop your blog make we patronize you we be one family. I really see say you never tay here one tin I go add be say nor dey keep smerit to yourself. Quality topics berekete if person dey hoard E dey make people feel say if them sama you better score he no go circulate. I know wetin I dey yan as I don ask this question before

Thank you all brodas and sistas,

I no wan dey hodl sMerit o. My problem be say all the fine fine post wey deserve merit na from people wey don get like thousands of merits. E go come dey hard me to give them more because I go feel say them no need am again. New new people no dey gree make posts wey I fit say this one na bam for merit. Na em be my problem. But I go try give all of them out for here sha today.
Posts way get quality full here. One thing you need to get for mind be say quality dey relative you fit merit post cause you find am funny, educative or any reason na at your own discretion. Nobody go worry you because you nor break rules which is don’t trade or sell merits or share to your alt.

The thin be say e get as e be to dey talk all our matta for inside one thread. E no dey convenient at all. So I dey beg una wey don get mouth for this forum, make una talk to dey ogbonge admins make them create Pikin Board for us. We deserve am and we merit am because Naija na power house for Crypto matta.

Even small small country them wey no too get mouth for Crypto matta but them come get their own Pikin Board. So why we no go get our own? I believe say e go make sense die if we get our own child board. Abi how una see am?
You see this matter so. We use am baff, sew asoebi sef join last year. Everybody do their best to make sure say our plea just moderators ear. Wetin we nor try..the thread still dey meta although e dey locked now. My brother nor think say we nor want better oh we want but e never stew we dey wait patiently.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
The thin be say e get as e be to dey talk all our matta for inside one thread. E no dey convenient at all. So I dey beg una wey don get mouth for this forum, make una talk to dey ogbonge admins make them create Pikin Board for us. We deserve am and we merit am because Naija na power house for Crypto matta.
Dis wan truly show sey you neva actually go thru dis thread wella. Dis matta wey we carry baff last year tire for here. Na wetin even make us dey where we dey today wey you com meet us. Try read like 10 pages back from dis page.
member
Activity: 163
Merit: 65

Welcome to our korna. Drop your blog make we patronize you we be one family. I really see say you never tay here one tin I go add be say nor dey keep smerit to yourself. Quality topics berekete if person dey hoard E dey make people feel say if them sama you better score he no go circulate. I know wetin I dey yan as I don ask this question before

Thank you all brodas and sistas,

I no wan dey hodl sMerit o. My problem be say all the fine fine post wey deserve merit na from people wey don get like thousands of merits. E go come dey hard me to give them more because I go feel say them no need am again. New new people no dey gree make posts wey I fit say this one na bam for merit. Na em be my problem. But I go try give all of them out for here sha today.

( If I mention my blog here, many of you go know am)
Shuuu! Mention the blog na. Abi you be one of those people wey dey like wear clothes baff for baffroom. Shey you nor need vicibility ni 🙄

I don sell the blog give Israeli people but it's still my legacy. So, make we leave de blog matta.

One thin wey I wan make we put mouth be this. I no say una fit don talk about am, I no sure, as the thread don long wela.

Jump to: