Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 180. (Read 1027831 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
( If I mention my blog here, many of you go know am)
Shuuu! Mention the blog na. Abi you be one of those people wey dey like wear clothes baff for baffroom. Shey you nor need vicibility ni 🙄

BTW, how una see the declaration to run for presidency by Bola Ahmed Tinubu come 2023.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
My dear people, how una dey?

Na by mistake I take see this beta naija thread. As I no know say Naija get mouth for here o. I dey new for Bitcointalk but I no too dey new for Crypto matter. So my people, this na who i be 👇

Username: Dripstoil
Gender: Na Man I Be
State of resident: Dubai, UAE.
Skills: Content writer, UX design director, Domain trader, and Ogbonge blogger ( If I mention my blog here, many of you go know am)

E neva reach 3 months wey I dey here so make una show me small love my brothers and sisters. I go dey try my best to dey contribute beta things to this thread and to this forum in general.

Thanks
Welcome to our korna. Drop your blog make we patronize you we be one family. I really see say you never tay here one tin I go add be say nor dey keep smerit to yourself. Quality topics berekete if person dey hoard E dey make people feel say if them sama you better score he no go circulate. I know wetin I dey yan as I don ask this question before
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
guyman don sharpely make new year resolution for 2022. Dat one good sha... Keep am up. We dey ya back like pickpockets.
We dey together to achieve the same goal.

State of resident: Dubai, UAE.
Naija in diaspora. Welcome.

E neva reach 3 months wey I dey here so make una show me small love my brothers and sisters.
Try bring quality topics and posts for here. You go see say we no dey stingy with showing love if you don check this thread posting history. But more notice go dey if you dey bring new topics, but no make ham hard on yourself o.
member
Activity: 163
Merit: 65
My dear people, how una dey?

Na by mistake I take see this beta naija thread. As I no know say Naija get mouth for here o. I dey new for Bitcointalk but I no too dey new for Crypto matter. So my people, this na who i be 👇

Username: Dripstoil
Gender: Na Man I Be
State of resident: Dubai, UAE.
Skills: Content writer, UX design director, Domain trader, and Ogbonge blogger ( If I mention my blog here, many of you go know am)

E neva reach 3 months wey I dey here so make una show me small love my brothers and sisters. I go dey try my best to dey contribute beta things to this thread and to this forum in general.

Thanks
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
No English on my side here again for 2022.
😅😅 guyman don sharpely make new year resolution for 2022. Dat one good sha... Keep am up. We dey ya back like pickpockets.


Who tell you IDO na small money e dey chop? Only God know much I spend last December dey try enter new projects from IDO. If na launchpad you go first stake thousands of tokens just to enter lottery and no guarantee say you go win then get allocation. Then if you come win, wetin you use thousands of dollars buy you go come dey get $30, $50 (small small allocation). Of you need sure plug to get higher allocation, you go buy over hundreds of thousands worth of their token come enter top tier to get sure plug. You know wetin dey vex me pass, you go come dey get your token small small and no be say you fit sell all one time move to already established project like Bitcoin etc
The part distribution na to discourage dumping na. D good thing about some of those launchpads be sey as you stake dem to qualify for IDOs, dem dey yield more of that tokens for you. Anoda one be sey even d $30 allocation wey dem give you go cover your entire $30 on first distribution wey fit be just 10% of your entire allocation. I don even take $4 allocation get over $120 on first distribution and I sold immediately oh. Otherwise I for even make over $200 if to sey I leave am for a week longer.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin

    Who tell you IDO na small money e dey chop? Only God know much I spend last December dey try enter new projects from IDO. If na launchpad you go first stake thousands of tokens just to enter lottery and no guarantee say you go win then get allocation. Then if you come win, wetin you use thousands of dollars buy you go come dey get $30, $50 (small small allocation). Of you need sure plug to get higher allocation, you go buy over hundreds of thousands worth of their token come enter top tier to get sure plug. You know wetin dey vex me pass, you go come dey get your token small small and no be say you fit sell all one time move to already established project like Bitcoin etc


    This IDO been just sweet when e fest start, if I remember well ehnn, na yearn finance begin that craziness and then other small small projects begin follow but now e dy boom again as market no too good and doing IDO is as good as dead. Even some projects when them be like say them no get value utilize am for their place and them use am raise their prices and if you luckily hold before those events, na lambos money be that then

    Quote
    Sista play me more tape, like how much be the return. No talk how much you put (for security/privacy) but like how much percentage come out and e worth am?. I Know say binance sabi dash people new coins as me too dey receive steady but dat staking thing I never try am. belike we go need am for this bear market oh.

    I need time when I see how bnb don perform over the years, I go deh so like say make I knock my self why I been no buy that thing when e cheap, if person get that thing like 50 now, na very hot cake for the exchange as per say na requirements for IEO that year.

    Quote
    Coins plenty wey no move or move well my broda. Even research self fit no give you most profitable coins. E get when them debate about EOS and DOT. Na EOS win but today their price no be the same  DOT wey lose dun perform pass eos as e no do well for this bull market. The market just tire me. See small sandbox wey dem launch for Binance launchpad 2017 just come dominate everywhere while OG's still dey sleep. [/list]

    Bros that EOS and DOT argument, na base on the transaction speed abi na just base on the people behind am? Project this days they only succeed when they have good foundation like for example Solana but fit lack good resources because I read say dem collapse like twice, see ethereum. Despite say transaction weh people they pay for that chain, them no wan lower the price, as soon as they see new caps they near their price, them go push but techily na mumu chain, their proof of stake no even sure. E just be like say person do Suzuki machine and e wan come convert am go Power bike  Grin Grin
    legendary
    Activity: 2380
    Merit: 4265
    eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
      2.The ones wey go chop small money or no chop money atall.
      • ICOs/IDOs
      • Airdrop

      Who tell you IDO na small money e dey chop? Only God know much I spend last December dey try enter new projects from IDO. If na launchpad you go first stake thousands of tokens just to enter lottery and no guarantee say you go win then get allocation. Then if you come win, wetin you use thousands of dollars buy you go come dey get $30, $50 (small small allocation). Of you need sure plug to get higher allocation, you go buy over hundreds of thousands worth of their token come enter top tier to get sure plug. You know wetin dey vex me pass, you go come dey get your token small small and no be say you fit sell all one time move to already established project like Bitcoin etc

      My only experience for this matter be say I dey stake bnb for binance for like five months now, binance dey give me some %profit daily for my staking. And I notice say them dy dash me new coins way just come out or about to come out.

      Sista play me more tape, like how much be the return. No talk how much you put (for security/privacy) but like how much percentage come out and e worth am?. I Know say binance sabi dash people new coins as me too dey receive steady but dat staking thing I never try am. belike we go need am for this bear market oh.

      But the main thing be say make someone make more research, some people buy some altcoins wey no increase at all, and some coin become dead, some no increase like bitcoin but dey fall more than bitcoin. Over 16600 altcoins now, some dey very unprofitable wey fit ensue losses.

      Coins plenty wey no move or move well my broda. Even research self fit no give you most profitable coins. E get when them debate about EOS and DOT. Na EOS win but today their price no be the same  DOT wey lose dun perform pass eos as e no do well for this bull market. The market just tire me. See small sandbox wey dem launch for Binance launchpad 2017 just come dominate everywhere while OG's still dey sleep. [/list]
      legendary
      Activity: 1512
      Merit: 4795
      Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
      NEW TOPIC: How Nigerians are making money from the Crypto.
      Source: https://nairametrics.com/2021/11/25/how-nigerians-are-making-money-from-the-cryptocurrency-industry
      Future and option can be a way to dey make profit but trading dey risky, na the means many people lose be future and options. Even if someone wan start to trade future derivatives, make him no forget to use only litttle amount wey he can lose and never affect him. Trading generally dey highly risky.

      Bitcoin hodling still dey make sense, the profit can be low but still making sense, if someone buy when the price dey low, the profit can be more. I remembered when bitcoin dey $3800 for 2020 and reach all-time-high of $69000 for 2021, no be small amount be that too. But some altcoins reached 100x to 300x. Like doge, solona,  tera luna and shiba Inu.

      But the main thing be say make someone make more research, some people buy some altcoins wey no increase at all, and some coin become dead, some no increase like bitcoin but dey fall more than bitcoin. Over 16600 altcoins now, some dey very unprofitable wey fit ensue losses.
      hero member
      Activity: 1036
      Merit: 625
      BTC, a coin of today and tomorrow.
      NEW TOPIC: How Nigerians are making money from the Crypto.
      Source: https://nairametrics.com/2021/11/25/how-nigerians-are-making-money-from-the-cryptocurrency-industry
      This topic make sense wella. E get wetin I discover as I readam finish. All the ways wey dem mention say 9ja youth dey carry make money for crypto. I dividam into 3.
      1. The ones wey go chop money
      For dis category you go need get rubbers before you go make more rubbers. You no fit carry empty hand near here. Infact even if you get beta idea you still need rubbers to start. These ones na:
      • Buy and Hodl
      • Staking
      • Yield farming
      • Future and Options
      My advice na make we get some idea for these ones before we go put body. Dem just dey like high tension. But na the number one wey I dey do, me sef don loose wela, base on say I no de do my own research. I just dey base on news. Shiba wey I go buy for high don finish for my hand.
      2.The ones wey go chop small money or no chop money atol
      For this category you no need plenty rubbers to involve. Wetin you need na beta update wey no be scam and you go cash out big with small money. You no even need too much experience for this wan. Me I believe say the one dem dey drop from air suppose dey for this category. These ones na:
      • ICOs/IDOs
      • Airdrop
      3.The ones wey go chop only experience
      For this wan, you no need money. Na only idea them want. You go make out time study well well. Me I don chop small money under here base on say I write article for one company. But e been dey stress me because me go need research before I go write beta tin and too my english no too polish.While others no dey too research because dem know the thing already. Na wetin make me enter this forum to come learn bitcoin well. This one na:
      • Crypto-Related jobs

      Mazi Brainboss thank you for this topic as I dey wait make other people wey get experience chuk mouth for this mata.

      hero member
      Activity: 966
      Merit: 701
      NEW TOPIC: How Nigerians are making money from the Crypto.
      Source: https://nairametrics.com/2021/11/25/how-nigerians-are-making-money-from-the-cryptocurrency-industry

      I dey get joy when I see article wey dey talk sense instead to the body shame the youth of fraud and other things. I just read this article today and e go make sense if we discuss how wey dey make our profit for this industry. Out of all those ways wey dem list, how many you dun try wey favor or no favor you. Also e go other means you dey involved in wey dey give you small small rubbers wey dem no list. Maybe if you talk, one or two persons fit learn and follow you dey run am.

      I dun dey understand (after reading some investment books) say passive income na him sure pass and for this crypto na staking fit give that come pass. My issue now na say alts na dem give highest APY but them dey lose value welle. Anybody dey into the staking game, e get advice you fit give me in how to get better return. No go copy paste oh I need personal experience nobi wetin google talk.
      Thank you for the talk you bring up. I don talk am before say make we dey try bring aza talk for here nor be only technology we go dey talk everytime.
      My only experience for this matter be say I dey stake bnb for binance for like five months now, binance dey give me some %profit daily for my staking. And I notice say them dy dash me new coins way just come out or about to come out.
      legendary
      Activity: 2380
      Merit: 4265
      eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
      NEW TOPIC: How Nigerians are making money from the Crypto.
      Source: https://nairametrics.com/2021/11/25/how-nigerians-are-making-money-from-the-cryptocurrency-industry

      I dey get joy when I see article wey dey talk sense instead to the body shame the youth of fraud and other things. I just read this article today and e go make sense if we discuss how wey dey make our profit for this industry. Out of all those ways wey dem list, how many you dun try wey favor or no favor you. Also e go other means you dey involved in wey dey give you small small rubbers wey dem no list. Maybe if you talk, one or two persons fit learn and follow you dey run am.

      I dun dey understand (after reading some investment books) say passive income na him sure pass and for this crypto na staking fit give that come pass. My issue now na say alts na dem give highest APY but them dey lose value welle. Anybody dey into the staking game, e get advice you fit give me in how to get better return. No go copy paste oh I need personal experience nobi wetin google talk.
      hero member
      Activity: 1036
      Merit: 625
      BTC, a coin of today and tomorrow.
      Make Oluwa pick your call. But u dey yarn oyibo grammar here. I don even see pipu wey dey mix our pidgin with oyibo grammar. E no too make brain. If e get how you go mixam with your native language e go make sense. Naim go be the beauty wey dey here. If you go fit put salt and pepper like Ekegait language for people wey dey carried e go make sense wella. Udo my pipu.
      Calm down. I wan believe say you just come forum u don dey correct people you jam here. U no read wetin people before you agree before you start to yan who make brain/wetin no make brain.
      Adaeze. I no fit read everything finish. I talkam say if e get laws wey dey make you reason me. Checkam too. I no nid dey here for 100 years before I go know wetin no make brain.
      -snipped-

      My bad. No fight broda, I been don open reply keep and forgot say na our local board. Cheers man.

      Ah catch baba. Dat topic wey you write wey be 2021 library. You try well well.
      hero member
      Activity: 1078
      Merit: 903
      Not Your Keys, Not Your Bitcoin
      -snipped-

      My bad. No fight broda, I been don open reply keep and forgot say na our local board. Cheers man.
      hero member
      Activity: 966
      Merit: 701
      Make Oluwa pick your call. But u dey yarn oyibo grammar here. I don even see pipu wey dey mix our pidgin with oyibo grammar. E no too make brain. If e get how you go mixam with your native language e go make sense. Naim go be the beauty wey dey here. If you go fit put salt and pepper like Ekegait language for people wey dey carried e go make sense wella. Udo my pipu.
      Calm down. I wan believe say you just come forum u don dey correct people you jam here. U no read wetin people before you agree before you start to yan who make brain/wetin no make brain.
      hero member
      Activity: 1036
      Merit: 625
      BTC, a coin of today and tomorrow.
      sniped

      Welcome to Naija unofficial board, You didn't miss much, we have Naija 2021 Library You can easily look at some important topics that were discussed and you can also share other Naija interesting topics here. cheers.
      Make Oluwa pick your call. But u dey yarn oyibo grammar here. I don even see pipu wey dey mix our pidgin with oyibo grammar. E no too make brain. If e get how you go mixam with your native language e go make sense. Naim go be the beauty wey dey here. If you go fit put salt and pepper like Ekegait language for people wey dey carried e go make sense wella. Udo my pipu.
      hero member
      Activity: 1078
      Merit: 903
      Not Your Keys, Not Your Bitcoin
      sniped

      Welcome to Naija unofficial board, You didn't miss much, we have Naija 2021 Library You can easily look at some important topics that were discussed and you can also share other Naija interesting topics here. cheers.
      hero member
      Activity: 1036
      Merit: 625
      BTC, a coin of today and tomorrow.
      Username: Uchegod-21
      Gender: Male
      Country and state of resident: Nigeria/Lagos
      Skills: HTML and CSS

      My Experience
      I neva get beta experience here. But I just dey try to sabi bitcoin for here. Dis oyibo people sabi bitcoin well well. Na one person here show me road to dis side wey be cookdata.
      I don try read haw tins dey roll here, but I no fit read evertin. Make una wey old here try reason me how e dey be. Make una too welukum me.
      legendary
      Activity: 1512
      Merit: 4795
      Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
      ---snipped---
      Make we bring ham on, I dey ready to have few posts here for Pidgin. No English on my side here again for 2022. I don talk ham say the language will evolve as it will dominate but making sense how we accept all languages. We don make it all clear now in case of later when local board don dey.

      I dey think we no need to debate on this any longer, I believe Pidgin go dominate 99.99% for here now if no be 100%. 100% Pidgin from me willingly. I no go change my words this time because say na willingly.
      hero member
      Activity: 1078
      Merit: 903
      Not Your Keys, Not Your Bitcoin
      It all lies on us, the people I introduced to bitcoin and this forum were always active on this local thread, just that one left and one was banned. It depends on how we are introducing newbies to this local thread.

      And if we noticed, moderators and staffs are concentrating on this thread but only require us to work towards it.

      Bros you see ehhnnn, this matter weh you talk na true but sometimes, the consensus for this thread no get lead na why to post deh do me anyhow. E deh get times wey i go see important topic of discuss but to address am in a proper language weh go sweet everybody go dy like say make I free am because engagement no go too dy. They dun vote but the community no dy follow wetin dem vote. As Boss brainboss no like the English weh people go dy yarn, I go dy make my discussion deh on normal pidgin level and use english support am till dem get officially lead language.
      As e be so ehhnn, I go also plead with others make them dy engage on discusion, one day your name go be history say you contribute to how them take give here official local board as naija.
      sr. member
      Activity: 1960
      Merit: 329
      www.Artemis.co
      I dun notice say people nor want show their face for real life. I don invite the house come different crypto events way dey host for different states nobody don gree shake body to come. Make we reason am na we we dey here. We suppose don get one kind strong bond as like-minded people

      You sure say no be the protect your privacy thing deh cause all the dodging dodging weh members for here de do? Maybe nobody want to expose themselves yet to avoid long stories or e fit also be say people no just deh free the time weh the shows dem deh happen. Inside 2 things, na one fit cause am.

      Na cos say signature nor dey count for here nai make them ghost?

      This one fit also follow wetin cause am. I no make excuse for anybody o but I feel say if we think say members no dey constant here, we suppose inbox them to find out why. People get challenges weh dem deh battle secretly. No be everybody deh like table him matter for public. Let us be our brother's keepers.
      Jump to: