Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 206. (Read 1347748 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
~
I nor think sey all dis explanation really matta except we dey try make outside persin dem reason am. But if na for we we, I sure everybodi understand dem. And if e get anybodi wey nor understand dem or any oda slang wey anybodi use here, you fit quote d person to explain am give you. E dey dat simple. Make we just dey gbadu owa local flavour go. We nor suppose dey look Uche face for dis kain matta.

Trojane, my broda I welcome you home oh. Wey bread wey you carry come. Na true, your name resemble Chinese true true. Abeg, make you read and follow rules oh. Many ojokokoro dey shine untop we matta here.
member
Activity: 294
Merit: 28
NEW TOPIC
 
Am new to the forum my follow brothers and sizters  Grin
Shebi my name resembu Chinese😂
I been get some kind complexity wen i start but as time come dey gooooooo
I come dey understand things better
Abeg i be part of una ..
Make una follow recognise me 🙏
Person no dey die for the midst of him country pple
Advise me ...
Guide me cuz e still get plenty things wey i still gads learn oo


Finally,i dey celebrate my self for upgrading to a new rank
Brothers and sisters
E no easy!!!
I don pas through alot of discouragement...
At a point i almost gave up..
But na me be dis tday
Sooooooo happy 😊
The post go dey for begginers and help
Ma fellow country pple
I greet una ooooo
👐👋🏾🙌🏿🙌🏿🤝
member
Activity: 294
Merit: 28
Username:Trojane
Gender: male
Country: Nigeria/akwa ibom state
Skills: STAGE COMEDIAN,musical artist, Artist,crypto dealer,programmer(still on processes)
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I no see reasons to delete the old ones CB just leave am.. Happy weeken guys. Grin

I no say I go delete old ones, I say from Sunday no all English again. An no article copy and paste. For Nathxxx mata dat one na old something sha and dem dey reason you using here for activities so to avoid others doing the same and Maybe giving us bad name stop the article posting:

You fit run am like this; Tuchel's anger with Werner, new midfield hierarchy: Four things spotted in Chelsea vs Man City den add your view, we discussed simple.

People dey observe dis thread and e no make sense dem go just dey see everything we rit. I no understand why somebody go dey angry for making Pidgin as official language. Shey wen English was brought up people dey against am I say make we try am out no difference self, now we dey go back to old ways of writing e come dey be like I kill person.

The end mata be say mixed your post starting Sunday, no just write straight up english, dis no be English board, it was never the intention from day one.
hero member
Activity: 1666
Merit: 709
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
           Some sentences in pidgin and English meaning.

This board is a nigerian board, so we would like to speak in pidgin, but from the looks of things there is no pidgin translation any where, so that said I would like to drop the popularly used pidgin and there english meaning, I would be updating it, but also if you can have an idea of the meaning of this pidgin sentences you can use them on others.


+ Pidgin sentence: I dey come
+ English meaning: I Coming

+Pidgin sentence: mata day rise
+English meaning: mata arising

+Pidgin sentence: make we gather join
+English meaning: let's come together

+Pidgin sentence: I been day talking about
+English meaning: I was talking about

+pidgin sentence: I no sabi
+ english meaning: I don't know

+pidgin sentence: oyinbo comment
+english meaning: english/white comment

+pidgin sentence: I hear say we get yarns
+english meaning: I heard that we were going to talk about something

+ pidgin sentence: shey I tell una
+ english meaning: like/as I told you all

+pidgin sentence: make una comot okpata yarns from the mata.
+english meaning: let's all remove bad sentiments from the discussion of this matter.

+pidgin sentence: una reasoning dey tortori me
+english meaning: all of you thought on this issue give me joy.

+pidgin sentence: free the case e no make sense.
+english meaning: leave that issue it's not sensible.

+pidgin sentence: abeg who go helep me on this mata.
+english meaning: please who would help me on this is matter/issue.

+Pidgin sentence: I no go come dey tell you tori way no pure.
+english: I wouldn't tell you things that are bad/illegal

+pidgin sentence: how i for take know
+english meaning: how would I have known

+pidgin sentence: crypto-currency go make sense in future
+English meaning: crypto-currency would be awesome in the future.

+pidgin sentence: the forum go like make we use our local language for Local board.
+english meaning: the forum would like us to make use of our local language on the local board.

+pidgin sentence: if you do mumu dem go thief your coins from your wallet.
+english meaning: if you aren't smart, your coins would be stolen from your wallet.

this aren't all the pidgin sentences but with this and understanding it you can use your imagination to go around other not mention. in between I would be updating this thread maybe with words and meaning added


staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

@igehhh, I couldn't expect you to start to turn back on what all of us agreed on with just a post we should not considered (I mean that foreigner post which is just a question and nothing more), you are still an active member I can't turn back on if having solid evidence.

Hahahah omoh see chats...I  never turned back on my decision right from day one I was against all English and if you checkmate ma doings/posts you go see say I dey mix d two 2gether I nodey go all English. For the telegram group you raise one point like dat say some of our pipo nodey follow talk 4 here via say dey no too dey comfortable writing in English we come agreed say na all language since we no want some pipo to feel left out.

But the fact dat we changed am to the all languages no still solve the problem cos those two Nigerians no dey even still post for the English here. Everybody here is okay with de pidgin except you, but I understand that you are not fluent with Pidgin and you are the most active members for here, What CB is saying is that a post must contain pidgin at least and not all English which is quite understandable, from your previous posts you are adding pidgin is quite okay, and for the article copy and paste I totally dey against am too cus edey make thread difficult to talk on so make Nathxxx try dey cut am but I no see reasons to delete the old ones CB just leave am.. Happy weeken guys. Grin

Abeg I get $100 steam card for exchange.....( Btc or user)
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
All languages was our conclusion on this thread, and not a single decision we shouldn't be self-centered like it is common among our political leaders.

You speak of self centered decisions like you take decisions with consultation from the group yet it worked out for all. Who give vote for you to create local board appeal thread, isn't that self centered. Did we also take vote before appealing for a pinned board? Yet we did it and it all worked out. You have to understand that decision don't have to be accepted by all as most time the majority don't see the bigger picture.

Mata been come on board, I accept all languages, now mata don change and I dey reject english language completely I no mean say u no fit write am but anything wey get English all through no go dey accepted and soon all the article upon article will soon start getting deleted go other local board and check if you see things like dat ongoing.

Genuine conversation, na wetin we dey find here. Dat India board you speak about go ask if English was there right from the start. The English for Naija board go come later now we have to find a way to let them know we communicating in other languages. Same way we lost our focused in Nigeria when we abandon our locy language come accept whites own na wetin I dey notice here and I can't stand and accept that.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I been dey neutral but d english is overtaking the Pidgin and no be wetin we sign up for.
The OP was even in English.

Wetin dey there to gain with countless sharing off news article. Where have you seen such habits welcomed on the forum?. If you wan share just write your own opinion drop link or small quotes no be to use the article dey spoil the whole thread.
I think we should value what we are posting even if we use English, all tribes understand English too and also Pidgin. Bringing news to the forum is not againsting the forum rules, but completely copy/paste of the whole news article can make the post quality reduced. In fact, I can give examples of many merited posts of such on English boards if need be. I did always messaged natrixxx about this and I believe he will change as time goes on.

If we no get language, our request will be rejected. English isn't doing us any good instead talking away our identity. Leaders stand up to take decisions even though it's not understood now but letter it'll be appreciated. Some choices are hide but have to be made.
Indian board was never rejected, and they use all the English and native languages in their country and all accepted.

Is this suggesting I am not part of the established member here. I do not totally agree, or more light would have been revealed off the forum.

Before now article no dey spoil dis thread as the discussion was pidgin Based, I gave English a stand and now pidgin and other dialect has theirs at the end we'll see which best fits.
All languages was our conclusion on this thread, and not a single decision we shouldn't be self-centered like it is common among our political leaders.


@igehhh, I couldn't expect you to start to turn back on what all of us agreed on with just a post we should not considered (I mean that foreigner post which is just a question and nothing more), you are still an active member I can't turn back on if having solid evidence.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I bin don talk dis pidgin matta before but una come begin see am as sey may be I nor too sabi speak English na im make I dey go dat way. Even dat time sef Brainboss come sey make d thing dey neutral but una don see sey e nor dey help us at all now? One time sef e come be like sey me and Charles wan take am begin get gbenge, I shift leave d matta. See, d truth be sey since na local board we dey, na local flavour we suppose dey use here. Dis thing supposed be we we and nor be for us to dey write to please anybodi. Na as d matta touch us e for reach. Nobodi for Naija wey go claim sey dem nor sabi speak or write pidgin. Whether na Babcock, Covenant, Madonna, just name anyone wey you go, you sabi pidgin. Even Oyedepo and Adeboye nor go claim sey dem nor sabi pidgin. One love my people.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

I been dey neutral but d english is overtaking the Pidgin and no be wetin we sign up for. Beside the decision has always been neutral but it's not going in the right wey. Wetin dey there to gain with countless sharing off news article. Where have you seen such habits welcomed on the forum?. If you wan share just write your own opinion drop link or small quotes no be to use the article dey spoil the whole thread.

Activity you say dun increase by how many members and genuine users for dat mata, no be just small people dey repeat article upon article for here, you think say the forum no dey see all dis things. Genuine engagement dey miss from the thread.

This thread was built on pidgin before English come take over, wat we're fighting for na Naija pidgin board no be Nigeria English local board because e no make self. Go meta go drop mata you go here am as dem go ask what the need of having a board which language is english when you can just chat in other English board.

If we no get language, our request will be rejected. English isn't doing us any good instead talking away our identity. Leaders stand up to take decisions even though it's not understood now but letter it'll be appreciated. Some choices are hide but have to be made.

Before now article no dey spoil dis thread as the discussion was pidgin Based, I gave English a chance and now pidgin and other dialect has theirs at the end we'll see which best fits.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Any post wey get Oyinbo completely, I go delete am from next week (Sunday).
I see this like how our president is acting and yet..., although this is self-moderated thread but is for all Nigerians, and you supposed to be the best person to be neutral here regardless of what is going on, but all languages in Nigeria are welcomed. Be it English, Pidgin or local language, this is not what we agreed to in the past with evidences I can bring up. Or is there no one that understand English too here?

If you wan rit for oyinbo go main board dem, dey plenty here no be una go come use english dey spoil the whole thread. I no care if we no get the local board but no spoil here.
If activities increase, we will get it.

Again: Official language na pidgin and native dialects (I dun update am for main post). E no mata how ur pidgin be. If you wan add am slangs no problem but know say straight up oyinbo yanings no go dey welcomed here again.
This is not what we agreed to, all news in Nigeria are in English, English is our official language. Why this now? All languages Nigerians are speaking are said to be accepted.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Any post wey get Oyinbo completely, I go delete am from next week (Sunday). And no be debating something again and if you dey write the oyinbo try add am Nigerian writings like instead of 'this' you fit rit 'dis' no be mandatory sometin but just suggestions. Here no be englsh board and all those copy post of news article shey una know the forum no dey too welcome am. Here no be were to get post activities as people for d forum dey reason am say na wetin we just dey do.

If you wan rit for oyinbo go main board dem, dey plenty here no be una go come use english dey spoil the whole thread. I no care if we no get the local board but no spoil here. The idea here na for we to hangout gossip. How we go dey talk odas go dey understand which kind tin be dat. You see how our pidgin dey confused dem wen e go main board, e no sweet you?.

Proof: https://bitcointalksearch.org/topic/ban-evasion-5360695

Again: Official language na pidgin and native dialects (I dun update am for main post). E no mata how ur pidgin be. If you wan add am slangs no problem but know say straight up oyinbo yanings no go dey welcomed here again.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
For example, the word CAP is not everyone that uses it, infact you say that word around my area you would need to identify who you are, I think the issue of pidgin and English is important
Exactly both are important, I just do not want to raise more valid points, but I would if need be, I got points before bringing a matter up, we should not act more like English is not widely spoken in Nigeria or that bitcoin and other crypto users do not understand English, yet it is our official language that we should not deny. I hate the fact that I am dedicating my time here with much activities to learn and gain from other Nigerians and yet people correcting me on what is not, when I believe if 20 other members post just like me, it will be easy to achieve local board. I have once said, achieving local board should be a gradual process.

Yet we post in both and our local thread was pinned recently, I do not expect this to be coming when we have made a conclusion about it just few months ago and more progress came after.
hero member
Activity: 1666
Merit: 709
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
For example, the word CAP is not everyone that uses it, infact you say that word around my area you would need to identify who you are, I think the issue of pidgin and English is important, but language is not all about speaking it's also about understanding, if I can see a pidgin language which has no translator version and still understand it then to me it's a Local board communication, and we can't compare ourselves with other Local board they can easily find their translation on translator for those who do not understand their language, I don't have any problem speaking pidgin, i use it also in the outside world, amongst my friends, neighbor and colleague, because I know they understand, so I think we can do better, and also I would try to add some pidgin to my post here and in such a way I think anyone who reads it can understand.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Baba if u no sabi cap for pidgin fluently you fit dey add am small small for your talk make e no be pure English
You still not get me, make we leave everyone be, check the last four most quality topics, 3 na in English, yet most people post for pidgin. If 75% of post na Pidgin, no need to bring this up imo.

if you be yoruba you fit still dey talk with am I go still follow you talk for Yoruba.
If you no sabi Hausa, Igbo, or Yoruba, translators can mislead people, just leave people speaking it among us to post in it, post the one you understand which is Pidgin or your language if it can be active as people from your side plenty pass for here.

We don addressed this before, and there was positive result.

Activities matters but de language too still gum body for criteria for making a local board
Posting qualities and activities matters most, no be language. I dey surprised we dey get back to what we don addressed before after many positive changes for the good conclusion among us.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Baba if u no sabi cap for pidgin fluently you fit dey add am small small for your talk make e no be pure English, if you be yoruba you fit still dey talk with am I go still follow you talk for Yoruba  Grin Activities matters but de language too still gum body for criteria for making a local board

Tbh. I still dey feel say na language make dem never give us this local board cus I myself no see reason why dem suppose give us since na English we still dey yarn for here, wetin dat user example...n talk na legit matter and as e be so make we dey try dey put pidgin for our discussion
Pretty obvious na activities, no be language. Then why is the thread pinned after both are active here. Three of the threads I included for the pinned local thread request dey completely for Oyibo.

Request for pinned Nigerian local thread

Posting for whatever we want spoken in the country no bad, and yet Pidgin plenty pass for here.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Tbh. I still dey feel say na language make dem never give us this local board cus I myself no see reason why dem suppose give us since na English we still dey yarn for here, wetin dat user example...n talk na legit matter and as e be so make we dey try dey put pidgin for our discussion
Pretty obvious na activities, no be language. Then why is the thread pinned after both are active here. Three of the threads I included for the pinned local thread request dey completely for Oyibo and yet strictly pertaining to Naija.

Request for pinned Nigerian local thread

Posting for whatever we want spoken in the country no bad, and yet Pidgin plenty pass for here.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Why you don't write in the Nigerian language here (I mean it's the local part of this forum)?

Thank you for that observation.

Shey I tell una to only write for pidgin una no hear, this oyinbo no make self at all and if I be admin ehh I no go fit give una local board when na oyinbo una dey speak throughout. I go ask wetin una need the local board for if na just oyinbo una go just dey speak. Make una dey speak pidgin abeg, so argument no go dey wen we wan appeal again.

Tbh. I still dey feel say na language make dem never give us this local board cus I myself no see reason why dem suppose give us since na English we still dey yarn for here, wetin dat user example...n talk na legit matter and as e be so make we dey try dey put pidgin for our discussion, if our check my posts here I dey cap for pidgin for most of my discussion here. Abeg we fit dey talk for Yoruba and hausa here from now on till we open our appeal again in December? Us wey nodey hear go use backyard dey translate am den cap.

Na this make dat una telegram group been make sense for dis kind cappins abeg we need to cap vital for telegram abeg.

China to Establish Banks in Nigeria – In the Digital Currency Era, It May Be The Game Changer

[........]
All these na part of the terms and conditions wey follow for all the loan we dey borrow from China e don dey hook for our throats small small, we are independence country and having Non-Nigerian bank for we country no make sense at all but these will unbank our local banks with non-interest loan and the rest

o yẹ ki a gbiyanju ati lo ori wa ni aaye yii, jẹ ki a lo yoruba ni igbagbogbo
legendary
Activity: 1498
Merit: 1116
Top-tier crypto casino and sportsbook
China to Establish Banks in Nigeria – In the Digital Currency Era, It May Be The Game Changer



Nor be say i dey carry the matter play lol, but make person see laugh to laugh small for naija. The matter na say anyhow this matter wan go, na so e go be. Whether the thing go dey beneficial or not to us, i feel say with the kind money Nigeria dun already borrow from china and with the one dem still dey plan to borrow, anything wey China government want, na so e go be for this country. Our government dey sell their right with the plenty borrow borrow.
full member
Activity: 140
Merit: 128
China to Establish Banks in Nigeria – In the Digital Currency Era, It May Be The Game Changer

Could dis be a gud news to 9ja or a gridlock to economy setback?
I bin dey remember somtimes back wen d govment encourages patronizing awa own home made local items in the likes of cars, rice, maize and fabrics to mention few and I can recall that such action and decision wey bin dey place ban on importation of dis dis dem awa items cause inflation to d market price, nd yet we engaged in buying low quality Nigerian products with no choice.

Bringing China banking sector into operation in Nigeria 2me is like going back to an era of colonization in disguise or claiming dependency on China 4 economi survival. If una fit remember dem USA, dey will dash u N5 and take am collect N50 back from u.

Abeg wetin una tink frm una own aspect on top dis opata mata?

the world’s second-largest economy is moving to establish its presence in the Nigerian banking industry.

This, the envoy said, would boost Nigeria’s economy and expand trade relations between the two nations.

When you list the world’s 10 big banks, six are in China. The banking sector is very important because, without money, we cannot build our industries,”


However, China’s move to add banking to its menu of businesses in Nigeria has come at a time when the Central Bank of Nigeria (CBN) is moving to establish the Nigerian International Financial Centre (NIFC), in a bid to put Nigerian banks in a global spot.

Una dey hear talk.... dis bin one of dem reasons, d wisemen talk bin say " use wetin u get achif wetin u want" e no dey work for dis kind mata o
Jump to: