Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 204. (Read 1029550 times)

member
Activity: 294
Merit: 28

Quote
Trojane, my broda I welcome you home oh. Wey bread wey you carry come. Na true, your name resemble Chinese true true. Abeg, make you read and follow rules oh. Many ojokokoro dey shine untop we matta here.

Abeg make una forgive me tday oooo
As i no carry bread join body 😂
But make i see as thing go be
If Na give away wey i go do,
So that everybody go follow benefit
Nothing is too small
Thanks alot as una follow recognise me
E no easy
👏👏
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Nobodi dey hide anything or encourage anything like dat. My point be sey make we nor water d local flavour down with transliteration wey nobodi don ask us for. If anybodi nor understand as someone use word, dem fit ask. E nor pass like dat.

@Brainboss, nothing dey my chest unto dat matta oh. If him get d strength to dey do the transliteration make im continue but make im too sabi sey some slang dey different for different zones.

Happy Sunday, all. I hope una enta church sha.
After I drop this I no go talk about this mata again, I day translate with my own strength and I no get any problem about that, and if there is anything I fit do to make outsiders understand pidgin I go do am, I want make we take our nigerian potential and promote the country as people way dey pure and knowledgeable about crypto-currency mata, and na basic pidgin I dey translate wether you day sokoto or lagos, kaduna or enugu you go grab am, abeg make we dey together, one love.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Honestly I no understand all this anymore, why we day reason like this please, abeg am I missing something here, are we trying to hide something from the forum?
Nobodi dey hide anything or encourage anything like dat. My point be sey make we nor water d local flavour down with transliteration wey nobodi don ask us for. If anybodi nor understand as someone use word, dem fit ask. E nor pass like dat.

@Brainboss, nothing dey my chest unto dat matta oh. If him get d strength to dey do the transliteration make im continue but make im too sabi sey some slang dey different for different zones.

Happy Sunday, all. I hope una enta church sha.

Edited:
@Charles-Tim, (na you make me edit dis) nor feel bad about the whole thing. Na so dat we go fit showcase owa pidgin to the rest of the world make us wan go pidgin way. Owa pidgin dey sweet die na, abi you nor dey feel am?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg una in d name of God mak we let go of all forms of grudges, n kontinue d gud wok we dey do so dat e go enkorage newcomers.
We are all brothers, no grudge, especially Brainboss and I. You wouldn't believe Igehhh and I still chat very often, yet our opinion here could be different, but I respect what he chatted me is what he posted here, I respected that forever because yet the different opinion, nothing ever changed about both of us even on this forum.


That said, I preferred English to be included among the languages but most of you people have now gone against it, it could look political but majority will carry the vote which is just the fact.

Happy Pidgin thread.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Yes wetin bender talk and I believe the Pidgin too no go be problem with you  any language you speak dey welcome. Nigeria dey diversify for language and we're losing that because of English. We get to encourage the speaking of our local dialect more and pidgin too since dat one be like the universal language for we country. No problem to speak English but no make all just English throughout.

One thing you need understand na say, no do something wey anybody go use hold against you for here becus the moment you do, others go begin find fault for your account and since we be humans and dey all make mistakes, dey fit find something wey go worry you.

You dey try make nobody discourage you. Na help we dey do so, yes we need activities but we need am rightly. And to others abeg make una no carry Alts dey discuss here because if dey find out e go come belike we dey use here farm account like gaining activities. We need paint the best picture possible because people here no dey help mata at all, all the good name we dey create dun dey go down the drain with countless accusations on Nigerian related accounts of recent and e no make sense.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702


I greet you my brother @nathrixxx I feel say you don do well to come out open about the whole thing even though the mata no be new mata, you don do well for your self so I think you dey try in your own way, and as you know say learn no get end na so life just be, but if I go yarn something about the mata, I go talk say, there is no where were posting of article no day the thing be say na to put source to every article so you no go fall in the hands of plagiarism. Also I think wetin you do na excessive posting of article and to me e be like spamming, na why I dey always suggest to read article and post about wetin you learn from the article you fit add some quotes from the article and adding source to am.
full member
Activity: 140
Merit: 128
I dey greet una all 4d ouse nd apy sundae,
Na yesterdae nite I bin get time 2dey check online 2 discova plenty gbege wey don apun, but e no go make sens if I no yarn konsernin it as my mata dey top d table gist among dem others, to dey start with pls I wan beg all of us 2 mentain dis unity we don start, nd communication mata make sense make we dey clear am, 4 Yoruba dem dey yarn say "if 2 brodas laf comot 4 ouse na him be say den no yarn true mata for each Oda" so I reazin wetin apun yestadae as normal tru talk wey everi one yarn him own mind.

I appreciate una leadership, advise, mentorship 4 hia, nd I Neva regret am 4 one day say a belong hia.
2 stat wit ma post, if u chek ma profile u go knw say I be jjc but dey learn everyday na just 3 monts I jst dey knack so, d wey I dey post no b say I too Sabi but una frm dis board dey put me tru nd I kip improving ma posting skills. Una instituted dis tread nd we gats go by wot una instruct, if no rule den no trespas.

I no knw se posting an atikle no too dey welcom 4 hia, me I don't knw say una bin get yarn tehteh regarding it. I go dey work on ma sef on top dat, even sef if u chek my post histry u go c improvment frm hw e take stat.

Abeg una in d name of God mak we let go of all forms of grudges, n kontinue d gud wok we dey do so dat e go enkorage newcomers.

naija we mouve!

legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013

People dey observe dis thread and e no make sense dem go just dey see everything we rit. I no understand why somebody go dey angry for making Pidgin as official language.


Who dey vex for the pidgin matter na?, omoooo the pidgin dey sweet me die! Black power. Like this sef ehn, i dun dey count am say na three languages i know so - Small of my Local dialect (Igbo), Pidgin & English language. Smiley

Abeg make we try dey sell ourselves, English normally na borrowed language. If to say Naija nor get plenty ethnic group, na language we for dey speak for here. The only original Language wey e be like say almost every people sabi this way na pidgin, so make we dey knack am dey go.

How pidgin language take start sef?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Guide me cuz e still get plenty things wey i still gads learn oo

Congratulations for ur new rank and welcome for dis community. The advice here no much as e dey very clear. No plagiarism (dats to copy person work from internet come dey use am as ur own), no spam (dats to dey write rubbish just so ur hirer go dey pay you), or scam person (I no need explained dis one na). Broda just go Meta boards and read the Rules and regulations of the forum or you check OP for this thread I update am there.  Just do dis things and if you get more questions you come back come ask. Welcome again.

Mpamaegbu dat tin wey BIT-BENDER do no bad and it's welcomed. We no dey hide anything from the forum. Wetin we need na just privacy to communicate freely. If the forum want to understand something we gaz explain am to them. I no say make we use the local thread as some hideout to organize any scheme/scam we want. Make we no dey get the wrong idea no forget other local get translators.

The main goal here is not to communicate totally in English so we can have a stand. The last three times we try apply, that has always been the main disapproval. So if we fit give them reason say english no be wetin we dey talk e fit give us advantage which is what we want. Anything wey you think is a step to achieving this goal that started two years back is welcomed.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I nor think sey all dis explanation really matta except we dey try make outside persin dem reason am. But if na for we we, I sure everybodi understand dem. And if e get anybodi wey nor understand dem or any oda slang wey anybodi use here, you fit quote d person to explain am give you. E dey dat simple. Make we just dey gbadu owa local flavour go. We nor suppose dey look Uche face for dis kain matta.
Honestly I no understand all this anymore, why we day reason like this please, abeg am I missing something here, are we trying to hide something from the forum? The purpose of Local board no be to make forum no understand wetin we day do, make we correct this mis-conception, other boards they speak for local language, but anybody fit translate and understand wetin them day talk. I have always wanted this local board for we nigerian but I no want am because make outside to get wetin we day talk, infact na big opportunities door this thing fit open for nigerian crypto-currency community to the world, I feel say atleast make others who day interested in nigeria mata grab the little they can, we no get issue with the outside forum. In between my small post na to assist outsiders an not for nigerians because majority of us already sabi pidgin english language.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
~
I nor think sey all dis explanation really matta except we dey try make outside persin dem reason am. But if na for we we, I sure everybodi understand dem. And if e get anybodi wey nor understand dem or any oda slang wey anybodi use here, you fit quote d person to explain am give you. E dey dat simple. Make we just dey gbadu owa local flavour go. We nor suppose dey look Uche face for dis kain matta.

Trojane, my broda I welcome you home oh. Wey bread wey you carry come. Na true, your name resemble Chinese true true. Abeg, make you read and follow rules oh. Many ojokokoro dey shine untop we matta here.
member
Activity: 294
Merit: 28
NEW TOPIC
 
Am new to the forum my follow brothers and sizters  Grin
Shebi my name resembu Chinese😂
I been get some kind complexity wen i start but as time come dey gooooooo
I come dey understand things better
Abeg i be part of una ..
Make una follow recognise me 🙏
Person no dey die for the midst of him country pple
Advise me ...
Guide me cuz e still get plenty things wey i still gads learn oo


Finally,i dey celebrate my self for upgrading to a new rank
Brothers and sisters
E no easy!!!
I don pas through alot of discouragement...
At a point i almost gave up..
But na me be dis tday
Sooooooo happy 😊
The post go dey for begginers and help
Ma fellow country pple
I greet una ooooo
👐👋🏾🙌🏿🙌🏿🤝
member
Activity: 294
Merit: 28
Username:Trojane
Gender: male
Country: Nigeria/akwa ibom state
Skills: STAGE COMEDIAN,musical artist, Artist,crypto dealer,programmer(still on processes)
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I no see reasons to delete the old ones CB just leave am.. Happy weeken guys. Grin

I no say I go delete old ones, I say from Sunday no all English again. An no article copy and paste. For Nathxxx mata dat one na old something sha and dem dey reason you using here for activities so to avoid others doing the same and Maybe giving us bad name stop the article posting:

You fit run am like this; Tuchel's anger with Werner, new midfield hierarchy: Four things spotted in Chelsea vs Man City den add your view, we discussed simple.

People dey observe dis thread and e no make sense dem go just dey see everything we rit. I no understand why somebody go dey angry for making Pidgin as official language. Shey wen English was brought up people dey against am I say make we try am out no difference self, now we dey go back to old ways of writing e come dey be like I kill person.

The end mata be say mixed your post starting Sunday, no just write straight up english, dis no be English board, it was never the intention from day one.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
           Some sentences in pidgin and English meaning.

This board is a nigerian board, so we would like to speak in pidgin, but from the looks of things there is no pidgin translation any where, so that said I would like to drop the popularly used pidgin and there english meaning, I would be updating it, but also if you can have an idea of the meaning of this pidgin sentences you can use them on others.


+ Pidgin sentence: I dey come
+ English meaning: I Coming

+Pidgin sentence: mata day rise
+English meaning: mata arising

+Pidgin sentence: make we gather join
+English meaning: let's come together

+Pidgin sentence: I been day talking about
+English meaning: I was talking about

+pidgin sentence: I no sabi
+ english meaning: I don't know

+pidgin sentence: oyinbo comment
+english meaning: english/white comment

+pidgin sentence: I hear say we get yarns
+english meaning: I heard that we were going to talk about something

+ pidgin sentence: shey I tell una
+ english meaning: like/as I told you all

+pidgin sentence: make una comot okpata yarns from the mata.
+english meaning: let's all remove bad sentiments from the discussion of this matter.

+pidgin sentence: una reasoning dey tortori me
+english meaning: all of you thought on this issue give me joy.

+pidgin sentence: free the case e no make sense.
+english meaning: leave that issue it's not sensible.

+pidgin sentence: abeg who go helep me on this mata.
+english meaning: please who would help me on this is matter/issue.

+Pidgin sentence: I no go come dey tell you tori way no pure.
+english: I wouldn't tell you things that are bad/illegal

+pidgin sentence: how i for take know
+english meaning: how would I have known

+pidgin sentence: crypto-currency go make sense in future
+English meaning: crypto-currency would be awesome in the future.

+pidgin sentence: the forum go like make we use our local language for Local board.
+english meaning: the forum would like us to make use of our local language on the local board.

+pidgin sentence: if you do mumu dem go thief your coins from your wallet.
+english meaning: if you aren't smart, your coins would be stolen from your wallet.

this aren't all the pidgin sentences but with this and understanding it you can use your imagination to go around other not mention. in between I would be updating this thread maybe with words and meaning added


staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

@igehhh, I couldn't expect you to start to turn back on what all of us agreed on with just a post we should not considered (I mean that foreigner post which is just a question and nothing more), you are still an active member I can't turn back on if having solid evidence.

Hahahah omoh see chats...I  never turned back on my decision right from day one I was against all English and if you checkmate ma doings/posts you go see say I dey mix d two 2gether I nodey go all English. For the telegram group you raise one point like dat say some of our pipo nodey follow talk 4 here via say dey no too dey comfortable writing in English we come agreed say na all language since we no want some pipo to feel left out.

But the fact dat we changed am to the all languages no still solve the problem cos those two Nigerians no dey even still post for the English here. Everybody here is okay with de pidgin except you, but I understand that you are not fluent with Pidgin and you are the most active members for here, What CB is saying is that a post must contain pidgin at least and not all English which is quite understandable, from your previous posts you are adding pidgin is quite okay, and for the article copy and paste I totally dey against am too cus edey make thread difficult to talk on so make Nathxxx try dey cut am but I no see reasons to delete the old ones CB just leave am.. Happy weeken guys. Grin

Abeg I get $100 steam card for exchange.....( Btc or user)
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
All languages was our conclusion on this thread, and not a single decision we shouldn't be self-centered like it is common among our political leaders.

You speak of self centered decisions like you take decisions with consultation from the group yet it worked out for all. Who give vote for you to create local board appeal thread, isn't that self centered. Did we also take vote before appealing for a pinned board? Yet we did it and it all worked out. You have to understand that decision don't have to be accepted by all as most time the majority don't see the bigger picture.

Mata been come on board, I accept all languages, now mata don change and I dey reject english language completely I no mean say u no fit write am but anything wey get English all through no go dey accepted and soon all the article upon article will soon start getting deleted go other local board and check if you see things like dat ongoing.

Genuine conversation, na wetin we dey find here. Dat India board you speak about go ask if English was there right from the start. The English for Naija board go come later now we have to find a way to let them know we communicating in other languages. Same way we lost our focused in Nigeria when we abandon our locy language come accept whites own na wetin I dey notice here and I can't stand and accept that.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I been dey neutral but d english is overtaking the Pidgin and no be wetin we sign up for.
The OP was even in English.

Wetin dey there to gain with countless sharing off news article. Where have you seen such habits welcomed on the forum?. If you wan share just write your own opinion drop link or small quotes no be to use the article dey spoil the whole thread.
I think we should value what we are posting even if we use English, all tribes understand English too and also Pidgin. Bringing news to the forum is not againsting the forum rules, but completely copy/paste of the whole news article can make the post quality reduced. In fact, I can give examples of many merited posts of such on English boards if need be. I did always messaged natrixxx about this and I believe he will change as time goes on.

If we no get language, our request will be rejected. English isn't doing us any good instead talking away our identity. Leaders stand up to take decisions even though it's not understood now but letter it'll be appreciated. Some choices are hide but have to be made.
Indian board was never rejected, and they use all the English and native languages in their country and all accepted.

Is this suggesting I am not part of the established member here. I do not totally agree, or more light would have been revealed off the forum.

Before now article no dey spoil dis thread as the discussion was pidgin Based, I gave English a stand and now pidgin and other dialect has theirs at the end we'll see which best fits.
All languages was our conclusion on this thread, and not a single decision we shouldn't be self-centered like it is common among our political leaders.


@igehhh, I couldn't expect you to start to turn back on what all of us agreed on with just a post we should not considered (I mean that foreigner post which is just a question and nothing more), you are still an active member I can't turn back on if having solid evidence.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I bin don talk dis pidgin matta before but una come begin see am as sey may be I nor too sabi speak English na im make I dey go dat way. Even dat time sef Brainboss come sey make d thing dey neutral but una don see sey e nor dey help us at all now? One time sef e come be like sey me and Charles wan take am begin get gbenge, I shift leave d matta. See, d truth be sey since na local board we dey, na local flavour we suppose dey use here. Dis thing supposed be we we and nor be for us to dey write to please anybodi. Na as d matta touch us e for reach. Nobodi for Naija wey go claim sey dem nor sabi speak or write pidgin. Whether na Babcock, Covenant, Madonna, just name anyone wey you go, you sabi pidgin. Even Oyedepo and Adeboye nor go claim sey dem nor sabi pidgin. One love my people.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

I been dey neutral but d english is overtaking the Pidgin and no be wetin we sign up for. Beside the decision has always been neutral but it's not going in the right wey. Wetin dey there to gain with countless sharing off news article. Where have you seen such habits welcomed on the forum?. If you wan share just write your own opinion drop link or small quotes no be to use the article dey spoil the whole thread.

Activity you say dun increase by how many members and genuine users for dat mata, no be just small people dey repeat article upon article for here, you think say the forum no dey see all dis things. Genuine engagement dey miss from the thread.

This thread was built on pidgin before English come take over, wat we're fighting for na Naija pidgin board no be Nigeria English local board because e no make self. Go meta go drop mata you go here am as dem go ask what the need of having a board which language is english when you can just chat in other English board.

If we no get language, our request will be rejected. English isn't doing us any good instead talking away our identity. Leaders stand up to take decisions even though it's not understood now but letter it'll be appreciated. Some choices are hide but have to be made.

Before now article no dey spoil dis thread as the discussion was pidgin Based, I gave English a chance and now pidgin and other dialect has theirs at the end we'll see which best fits.
Jump to: