Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 203. (Read 1029239 times)

jr. member
Activity: 269
Merit: 4
Dem don already launch Enaira website. Enaira payment solutions limited no do their homework well. enaira.com dey na
Mehn! You dey dis forum since 2017 and I nor think sey I don even run into you till now? Na wa oh. Dis forum dey dat big be dat. Anyway, welcome broda. I hope sey you show with Agege 🍞 sha.

Abeg!? No b today. Una well done o. I no dey show my face always. But our country just dey one kind now. so make I contribute my own.

Name: Emmanuel
Location: Lagos Nigeria
Occupation: Mechanical Engineer

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Dem don already launch Enaira website. Enaira payment solutions limited no do their homework well. enaira.com dey na
Mehn! You dey dis forum since 2017 and I nor think sey I don even run into you till now? Na wa oh. Dis forum dey dat big be dat. Anyway, welcome broda. I hope sey you show with Agege 🍞 sha.
jr. member
Activity: 269
Merit: 4
^^

Quote
We are Solicitors to ENAIRA PAYMENT SOLUTIONS LIMITED (RC 508500) which was incorporated on the 7th of April, 2004. Our client is and remains a valid and existing legal entity having complied with the statutory requirements as regards the filing of its annual returns and the payment of company income tax,

Source:-  The Cable

Seems like things are not longer going as planned by our CBN, they just got sued for trademark and contravention. They also further warned CBN from issuing of Enaira and anything related to their product.
No be juju be this?




Dem don already launch Enaira website. Enaira payment solutions limited no do their homework well. enaira.com dey na
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Source:-  The Cable

Seems like things are not longer going as planned by our CBN, they just got sued for trademark and contravention. They also further warned CBN from issuing of Enaira and anything related to their product.
No be juju be this?
This owa people dem sef nor dey eva dey tired to dey shame us. Which kain embarrassment be dis wan na again. So, FGN with all dem advicers nor fit find out sey na copyright infringement dem dey take play before now?

Make dem no go fuck up say dey no go take compensation oh if not the country fit fuck dem up and dem go lose everything self.
Make dem insist on dem compensation abeg, and nor fear anything at all. Which kain fcuk you dey talk about again. If you steal persin property, you gat to pay for am na. Na simple matta be dat.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Awa guyz bin dey japaa! na so den dey ring am full everywhere 4 dem twitter
Bro dat stori been full twitter yesterday wen I login to see if any update dey for one of my coins I been buy becus while all market dey down na only am been they pump.
E get one picture all man wey don move been dey use, dat picture from King of boys movie wey d woman dey raise glass. E sweet me oh I no go lie, if me I see way to comot dis country I no go waste am but I hear say to settle dat side no easy oh. Wetin dose pipo wey dey comot, wetin dem go go do for dat side self?.

Seems like things are not longer going as planned by our CBN, they just got sued for trademark and contravention. They also further warned CBN from issuing of Enaira and anything related to their product.
No be juju be this?

Try dey use pidgin communicate na the official language for here be dat.  The mata wey you point out go dey interesting Aswear but I feel say they fit settle dem sharp sharp and dem go allow the country use the name. Make dem no go fuck up say dey no go take compensation oh if not the country fit fuck dem up and dem go lose everything self.

@Trojane hear igehhh advice, make your sentence they complete if not them go reason say you just they give space to increase post quantity.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
^^

Quote
We are Solicitors to ENAIRA PAYMENT SOLUTIONS LIMITED (RC 508500) which was incorporated on the 7th of April, 2004. Our client is and remains a valid and existing legal entity having complied with the statutory requirements as regards the filing of its annual returns and the payment of company income tax,

Source:-  The Cable

Seems like things are not longer going as planned by our CBN, they just got sued for trademark and contravention. They also further warned CBN from issuing of Enaira and anything related to their product.
No be juju be this?

full member
Activity: 140
Merit: 128
awa guyz bin dey japaa! na so den dey ring am full everywhere 4 dem twitter

Shey una don hear say na so our tori been dem full twitter for naija on top say awa youths bin dey joni outside d kontry and con dey flood d twitter wt different terms dey yarn se dey don "japa" some say dey don "delete vpn" while odas bin dey yarn talk say nna " welcom 2a new dispensation" as d mata dey totori dem 4 bodi na so den dey take interesting and captivating word nak am say de don free 4 naija hand o, Mixed reactions trail ‘Goodbye Nigeria’ trend on Twitter even d twitter sef una sabi as we take dey enta am now, na so te awa bois dey comot d kontry dey japaaa. Na so guyz dey huzle dey go nd e go mak sens if me sef fit jam such opotunity dey go oh.... A swear! Bcos me i bin dey rizin sey naija guyz no lazy nd na enitin wey fit comot moni dey hand dem fit huzle get o, or wetin una own yarn be konsanin de tori bin hia.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
This is how your post formats suppose dey why you dey cut dem short short wit unnecessary punctuations, your writing style dey draw attention to yourself.

I no say i don fuck up my people. But i want make una understand say na wen i been still be newbie wey i go plagarize I don go against the rules i know,Abeg make una pardon me Forum po po don talk say the moderators them don pardon me I promise say this kind thing no go happen again 🙏I don take through out yesterday review all my post From beginning to end Make i for avoid any problem wey go spoil our native reputation...Abeg,make una no too reason my mata as i don accept my fault say i plagiarise This time,i go dey very careful. Thank u country pepu once again
God bless una 🙏🙏

Just try and de careful I've told you before try dey the board you know say you can talk and give helpful contributions without reading from the net to post, and find something meaning to add to the forum, mod ignore that plagiarism case but the wahala thing about the forum be say history will always locate person by the time u want become something or u apply for sumtin wey big

NEW TOPIC: Nigeria's eNaira Platform Records One Million Hits Ahead Of October Launch

Ahh my pipo it's happening oh, u know say me no believe dis eNaira something go work out but e b like dem serious oh well make we dey watch how e go play out.
It's happening no going back although u never can tell with the way the government dey handle things at times but I can't wait to see how the whole drama goes.
member
Activity: 294
Merit: 28
I no say i don fuck up my people....
But i want make una understand say na wen i been still be newbie wey i go plagarize ...
I don go against the rules i know,Abeg make una pardon me
Forum po po don talk say the moderators them don pardon me
I promise say this kind thing no go happen again 🙏
I don take through out yesterday review all my post
From beginning to end ...
Make i for avoid any problem wey go spoil our native reputation...
Abeg,make una no too reason my mata as i don accept my fault say i plagiarise
This time,i go dey very careful
Thank u country pepu once again
God bless una 🙏🙏
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Ahh my pipo it's happening oh, u know say me no believe dis eNaira something go work out but e b like dem serious oh well make we dey watch how e go play out.
My broda, to tell you d truth I nor think sey dis eNaira thing go dey different 4rm d regular online banking wey we dey do already oh. D only thing wey go make me even begin look dem side na if dem go compose am enta blockchain to avoid stories wey dey touch like naked wires.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The more they catch dose plagiarizing or farming accounts the more bad name they give the community. Make we teach people we bring come the forum on how to use the forum properly. E no just make sense, we dun suffer for this recognition, it's not just fair wat u guys are doing to the legacy we created so far. And for those wey dey think dem go just spoil wetin we don surfer build, if you enter wahala you're on ur own.

Please if you dey introduced anybody to d forum, let am know wetin d sup, make sure e read forum rules well and understand am. E no hard to just follow rules and please avoid scam campaigns. The forum no dey against alts and I no say make una no get oh but no just merit or trust urself, or promote scams.

NEW TOPIC: Nigeria's eNaira Platform Records One Million Hits Ahead Of October Launch

Ahh my pipo it's happening oh, u know say me no believe dis eNaira something go work out but e b like dem serious oh well make we dey watch how e go play out.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
There are many Nigerians I dey chat with often, I seek for opinions when I created that local board request, some chose both English and Pidgin which has been what I have been following. There have being one or two that even corrected me say I don dey use Pidgin again which seems like I did not keep to my word after the whole drama that happened before this one, and that could be disappointing for some that what I am supporting is what I am also againsting.

If na only me left to this here except the time you showed up now, it could be like it is for my interest while I have asked few people in the past that support both English and Pidgin. That was why I had to reply Mpamaegbu say I no feel bad at all because I was only acting with what people I chatted with told me. If some of these people wey even dey encourage me about both the English and Pidgin matter no support again but now strictly embrace Pidgin recently while others no post for here about their opinion, it go be like say only me support English and if we no achieve local board, the blame go be on me, this makes me feel like heavy load was lifted off my head.

So, with what dey happen now, I have made up my mind to just be neutral about this and not follow what most people already told me in the past, what dey appear here is what I go follow now for transparency. If dey say na Pidgin, then na Pidgin so nobody will think that I am the one distrupting anything.

Thanks for your distinct opinion Smartvirus as you come out straight about this, but let us just leave it like that, but I sincerely appreciate you for coming out distinctly about this. For people that recently against English but supported it before, I understand the whole thing and no grudge against anyone from me. Let us enjoy the Pidgin.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The thing I go talk be say, I no really get the criteria for local board matter though, I believe say, language na something way suppose sure via say, e go make am unique. Say e sure say, we dey speak our local tongue and people dey grab, that na very sweet thing but, we gat look ourselves. If we look, we go see say, Charlie no good for this pighin matter, e dey understand but to speak dey worry am wella. I no really know why e be like that for the G but, na en know how e be. No be everybody upbringing or every body way dey okay with the pighin and that no mean say, e no be Nigerain or we go pursue am commot. No be say e fit happen like that shah but, one thing I dey try talk be say, make we free Charlie to run en thing and then, we go carry hand dey carry am too as person way dey try. Na beg I dey beg, make we reason ourselves well for those way dey try.

Omoh baba u caprisome wella I no get cold water to take use am baff your nyash for the matter you address so. Tbh we don address this matter and me too don cap with Charles, it's obvious say him nobe that kind pidgin person and we no want something wey go kill our activities for here because nobody dey post reach wetin Charlse dey deliver weekly for here and we all cone to conclusion say make him dey speak the English but at least make him try put pidgin for one sentence or at least for the sensitive part of the post


Quote
Another thing I go like talk kwa, na the interpretation of pighin part. E no too sure o. If you look well, you go see am say, for  meta abi na reputation cef I see that thing, way this squirrel guy con dey try argue Brainboss. Say the interpretation way e dey get for the pighin way Brainboss speak no be watin e actually mean or imply. The thing tire me when I see am! E con be like say we get brother Judas among us, abi squirrel cef na omo naija undercover. That no funny me at all. So, if you dey sell your people like crayfish for here, you no do well, no dey interpret pighin to anyhow person (that na if you go do am at all cef) and lastly, try to dey know watin you dey do, make e no turn wahala for you later. Una weldon.

I been don talk this matter to person say fat kind na nails guy from the way he just dey decide and dey argue with a pidgin speaking person and if not then one of our brothers assist am for the matter in an attempt to fish merits which in my opinion is very bad. E no go make sense say we get mole among us as we small so.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I no wan quote any body for here but I go talk on a general note. Make e no be like say, the small archivement way we don attain go con turn watin go divide us or the reason way, some persons (this part na about Charlie) no go fit dey participate wella or free themselves to do watin for dey help our struggle for here.

We no need to dey attack ourselves, dey throw  stones say, one person dey act like dictator or the other person day self centered on any step e dey take for the forum. I fit remember when the decision say, make this our corner carry the normal English join body, I fit still remember after the Becky Burial Donation matter way I use English run my analysis and e con even wan bring small kasala.

Anyway, we bin don try dey stand, I go like make we for continue like that, in unity towards our aim. No doubt, e get some people way there contribution for this our course dey pass some people own, men like Charlie, Brainboss and Igehhh. The things una dey do dey make me happy for una and I thank una well well. As una dey always try to think ways, sometimes una go suggest am, other times una go just run via say, una don think am through and i believe say, e follow for watin don make us reach where we dey now. Nobody really dey self centered so long as, e turn watin go benefit our course. Some persons for here dey put themselves in line, in ways way most other persons no go gree because of fear. Yet, una go do am and we dey see results. Abeg, make we no discourage ourselves, person way know how to better forward our matter, make e go ahead. Nothing spoil for consultation o, but if you sure say e no go worry you and the community, that one still sure.

The thing I go talk be say, I no really get the criteria for local board matter though, I believe say, language na something way suppose sure via say, e go make am unique. Say e sure say, we dey speak our local tongue and people dey grab, that na very sweet thing but, we gat look ourselves. If we look, we go see say, Charlie no good for this pighin matter, e dey understand but to speak dey worry am wella. I no really know why e be like that for the G but, na en know how e be. No be everybody upbringing or every body way dey okay with the pighin and that no mean say, e no be Nigerain or we go pursue am commot. No be say e fit happen like that shah but, one thing I dey try talk be say, make we free Charlie to run en thing and then, we go carry hand dey carry am too as person way dey try. Na beg I dey beg, make we reason ourselves well for those way dey try.

Another thing I go like talk kwa, na the interpretation of pighin part. E no too sure o. If you look well, you go see am say, for  meta abi na reputation cef I see that thing, way this squirrel guy con dey try argue Brainboss. Say the interpretation way e dey get for the pighin way Brainboss speak no be watin e actually mean or imply. The thing tire me when I see am! E con be like say we get brother Judas among us, abi squirrel cef na omo naija undercover. That no funny me at all. So, if you dey sell your people like crayfish for here, you no do well, no dey interpret pighin to anyhow person (that na if you go do am at all cef) and lastly, try to dey know watin you dey do, make e no turn wahala for you later. Una weldon.
legendary
Activity: 2072
Merit: 4265
✿♥‿♥✿
But i no see anything wrong with my post them,everything wey i post there Na either experience wey i don get,or difficulties wey i pass through or the way i feel say certain things supposed don de improvised !!
I no dey go copy from net come paste ctrlc+Ctrl v
If i do am,na plagiarism be that an i knw say the forum dey against am....


Democracy is the best form of government, as it is the "rule of people". In this form of the government, the citizens have the right to take part in the decision making of the nation.
From these characteristics below,it show that the mind of the masses is considered and sometimes participate in some programmes..
1).Elected representative.
2).Civil liberties.
3).Independent judiciary.
4).Organised opposition party.
5).Rule of law.
Citizens in a democracy have not only rights but also the responsibility to participate in the political system.
https://loyce.club/archive/posts/5768/57681428.html


https://www.virginialeenlaw.com/help/faq-how-can-a-person-participate-in-a-democratic-society.html
https://boardgamestips.com/wow/what-is-it-called-when-there-is-no-government-power/
 Cheesy

you're not entirely honest!
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
No we no dey hide anything here I just cap him as e suppose be cause a no go make sense say him build account finish den him no fit join pay sig via say him him writing format look like spam despair say him dey talk sense, but people dey judge things from far. And your privacy matters too I see say your email also dey visible try follow format wey Cookdata provide to disable it. I go send you the telegram link for Pm. Cookdata welcome other jungle.

Your profile lead me here as I dun reply one of your post for Bitcoin development board and I noticed say you didn't hide your email, I no be tech person but e dy risky na why I think say everybody dy hide their own, e go good if you do the same.
Abeg u fit help add me for the telegram group ?
Send the link for my watsap gimme,i go join
09072.....*06
-Trojane

I thought Bitcointalk na platform, bitcoin particularly and what'sApp too na platform and each with it own way and purpose. I think the aim for this board will be defeated if another place exists apart from this place.
Anything wey dy happen and mistakes, e no better make una address am here? Many go learn from the mistakes and e go better so make others no go loose guard in some places, the thing go carry everybody along and encourage me too.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Your profile lead me here as I dun reply one of your post for Bitcoin development board and I noticed say you didn't hide your email, I no be tech person but e dy risky na why I think say everybody dy hide their own, e go good if you do the same.

Go to Profile >> Account Related Settings >>  Hide email address from public?  tick the check and save changes, that's all.

Abeg u fit help add me for the telegram group ?
Send the link for my watsap gimme,i go join
09072733406
-Trojane

I thought Bitcointalk na platform, bitcoin particularly and what'sApp too na platform and each with it own way and purpose. I think the aim for this board will be defeated if another place exists apart from this place.
Anything wey dy happen and mistakes, e no better make una address am here? Many go learn from the mistakes and e go better so make others no go loose guard in some places, the thing go carry everybody along and encourage me too.
For example as him don give you hint now as per say the written style no blend, I grab something from there but imagine am say na for WhatsApp the discussion happens, I no go fit see am, so abeg allow everything to be done here just the way others dun learn and improved for here too.
member
Activity: 294
Merit: 28
Quote
I just checkmate your profile now and to be honest you dey follow de wrong format in terms of writing style If I be manager I no get accept you for any campaign( I see say you want join 777) I see say you deg mostly post for Mining and Bitcoin dev & tech board I don read those posts and be like something wey you just read for internet

Abeg my broda, person no dey sabi all
But at de same time,wetin be the format wey u say i no dey follow in terms of writing style?
Make i understand that part Abeg
Yes...
I wan apply for campaign for 777
But i no see anything wrong with my post them,everything wey i post there Na either experience wey i don get,or difficulties wey i pass through or the way i feel say certain things supposed don de improvised !!
I no dey go copy from net come paste ctrlc+Ctrl v
If i do am,na plagiarism be that an i knw say the forum dey against am....
I spend 5_8 hours everyday to read
@zilon dey aware of wetin i dey talk
So Abeg ,u no be manager and na how u view my post ,e no mean say Na wetin e be..
I dey post frequently on tech dis* board cus na there i don come dey used to.and prolly everything wey i dey read about the sup for there so i no fit come the waste time for pol.n soc. Or bitcoin diss* or economics
That one no mean say i no dey go there
U fit even check my former post them...
Na just recently i started to post there sef**
I understand say as human being,we dey get thoughts sometimes,but e good as u ask me sef...so that i fit follow amend my ways for the side wey i no perfect...
NO forget say i still get a long way to go...
Make we relate normal bout the encryption broda,that thing don gimme headche tire oooo
I use kleopatra run am...i no still get am
Thanks boss 🙏
I cut 🧢 for u

Abeg u fit help add me for the telegram group ?
Send the link for my watsap gimme,i go join
09072733406
-Trojane
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Username:Trojane
.....]

I just checkmate your profile now and to be honest you dey follow de wrong format in terms of writing style If I be manager I no get accept you for any campaign( I see say you want join 777) I see say you deg mostly post for Mining and Bitcoin dev & tech board I don read those posts and be like something wey you just read for internet just to flow maybe you tink say cool water full there broda cold water full everywhere as far say you dey post quality, just be yourself make you no go plagiarize. The encryption message you do for OG thread is wrong too I see why he skipped you... If you dey telegram holla me for the group make I show you highway to run am. No reason am oo na just the way I see am

Abeg una in d name of God mak we let go of all forms of grudges, n kontinue d gud wok we dey do so dat e go enkorage newcomers.
We are all brothers, no grudge, especially Brainboss and I. You wouldn't believe Igehhh and I still chat very often, yet our opinion here could be different, but I respect what he chatted me is what he posted here, I respected that forever because yet the different opinion, nothing ever changed about both of us even on this forum.
You na correct Gee wey sabi things.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@Charles-Tim, (na you make me edit dis) nor feel bad about the whole thing. Na so dat we go fit showcase owa pidgin to the rest of the world make us wan go pidgin way.
Bad ke! No.

Welcome. Hope to dey see you here.
Jump to: