Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 202. (Read 1029239 times)

legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
In my opinion, government na continuous something...if this government try small for infrastructure, the next wey go come suppose focus on another thing. If to say na so e dey be...we for dun move go far well. My brother if you see person wey dey wan even try small, make we appreciate am, e nor easy to dey fire multiple projects at a go, and you still dey complete them.

Baba BIT-BENDER shey Rruchi dun do justice to ur worries abi. One person no go fit just wake up change the country. Just look at Rivers state apart from Lagos wey get all the support, I think rivers is one of the most consistent developing state like all the government dey try no be small. If no be circular politics dey spoil the whole thing based on party mata I sure we for don go far. From Peter odili to amaechi and now wike, dis guys don give impact wey make the state stand out.

Wike own na say e carry flyover and roundabout for head and repairing of roads meanwhile amaechi been carry building of school, primary health care and market for all local government. Then na odili areangey the state. Assuming this guys na dem rule Nigeria back to back atleast we for dun see improvements.

Other governors for their states dey try too and if this guys fit do wetin dem do for their states for the county, we for don dey go far small small.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I just wish wike go enter power make e just use e gra gra put everything into place. Who dun reach pH of recent dat man don work here scatter, like if no be bad belle ehh pH now for belike hot cake for investment but Lagos no go gree dash us small compass.
My oga I go contradict you for this mata, all the politician on ground na d same thing, and wike no comot from the category, infact his involvement in unnecessary yarns to me don make matter worse.

 I no understand why my country people go dey hala my governor build roads/bridges etc as if them do una any favors, this na the most basic things them fit do for us and we day jollificate because of am.

Nor be say Wike na angel ooo, the thing na just say amongst the whole bad, e be like na im good pass. Unto the basic infrastructure wey im dey do wey you dey talk say na normal thing wey im suppose do, true, but how many governor's dun try do the basic thing make e be say dem nor chop all the money.

In my opinion, government na continuous something...if this government try small for infrastructure, the next wey go come suppose focus on another thing. If to say na so e dey be...we for dun move go far well. My brother if you see person wey dey wan even try small, make we appreciate am, e nor easy to dey fire multiple projects at a go, and you still dey complete them.

Central Bank dun hang the launch of E-naira

Be like things no longer go as planned, central bank dun delayed the launch of our awaiting Digital naira with all the mouth weh dem make say E-naira go do wonders, the thing now na the opposite.


Me i nor too put ear for the matter sef normally, i know say na person wey just wan use new project wey e know say the country never mature for take cash out. Because as government approve am, dem go allocate big money for the matter, them go just dey put big prices for things for the project. Them dey talk say na to facilitate peer to peer transaction, when e be say normal bank network nor be am, money wey i transfer give person last week, the person never still see am till date, nai dem dey talk CBDC. Dem better focus.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I just wish wike go enter power make e just use e gra gra put everything into place. Who dun reach pH of recent dat man don work here scatter, like if no be bad belle ehh pH now for belike hot cake for investment but Lagos no go gree dash us small compass.
My oga I go contradict you for this mata, all the politician on ground na d same thing, and wike no comot from the category, infact his involvement in unnecessary yarns to me don make matter worse.

 I no understand why my country people go dey hala my governor build roads/bridges etc as if them do una any favors, this na the most basic things them fit do for us and we day jollificate because of am. An onto the E-naira mata, I Know say d thing go fail even before them launch am, make the country first launch our normal naira from the ground wey e dey to a better levels before them launch any crypto-currency.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Central Bank dun hang the launch of E-naira

I been dun break dat news but I forget to update here, right from time me I know say dis their eNaira na fNaira because no pre-planning. As usual person just wake up say e way launch cryptocurrency and na so many of the project for the country dey launch dats is why e no dey last. I sure dey dun corner side some funds say na planning budget.

Just imagine a whole country dey launch their offical digital coin dem no put eye for ground reach where be say that name na another business for their country get am.  We never ready for dis country, when we ready everything go just fall in place. We need better president with version that's all.

I just wish wike go enter power make e just use e gra gra put everything into place. Who dun reach pH of recent dat man don work here scatter, like if no be bad belle ehh pH now for belike hot cake for investment but Lagos no go gree dash us small compass.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
I no get joy or even dey proud of our kontry las las but as, the kontry no make me pride in them so, them con teach me one thing. That con be say, them teach me to be strong and stand for myself! Say the life we dey no be moi-moi o and say, nobody be pikin way go dey suckle on mama naija tits. Na to shuk hand for lion mouth collect en catch make we for see food chop we dey. If you sabi this thing, you fit survive anywhere and my omo naija them no dey dull am.

This na the only upbringing way mama naija don teach me way make me dey get joy everyday say, we born for this kontry true true. So, make we dey happy dey go for our naija, life e no easy and I no fit vex for you #Burnaboy!
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Thank you very much boss man, I really appreciate your comment and stand for the matter,  make I talk true, before before, I follow for people wey dey always bad mouth Nigeria unto say our leaders no dey perform well, but of recent, God open my understanding to realize that even as bad as we think say Nigeria be, we still dey survive, many people still dey live fine, we still dey go market and we still dey afford to buy food, we still dey afford to pay our rent(for those of us still living in a rented apartments) we still dey afford to pay our children school fees even as high as it is, we still dey afford to dress well whenever we dey go out, some of us still dey buy expensive cars self, houses,you name it, we still dey afford to buy fuel put for our generator, some still dey afford to enter bar, spend so much on food, drinks, pepper soup and others.

If we look all this things, we get more than enough reason to be grateful to God, our being born in Nigeria no be mistake ooh, shebi God tell us in Deuteronomy 8 verse 18 say make we no ever forget say na him dey give us power to make wealth and riches, which mean say, even if make the country dey ok as we think, those wey God never give that power go still dey poor, so our duty is to always pray for our country and to always extend helping hands to others when we get the opportunity cus this things na privilege wey God give us say as we dey do am, we go dey receive more blessing from him.
I greet you well my brother, wetin you talk make sense and I really like am, but my brother make you reason with me, you dey talk about "we" like my brother the country is bad yes it is, and for real na efforts and education, knowledge way dey keep us going, but do you know there are some people wey dey live in abject poverty, those are the people feeling it, those wey no fit eat better food even for one time meal, those wey no get any accommodation over there head, we don see the philanthropic works of some well meaning nigerian, I go use cryptoprenurbrainboss as an example, it's wen you one give you go know say people dey suffer for the country and the leaders nothing concern them.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Alot dey to be proud of ooh, first, dey proud say as the country bad reach, you still dey alive, God no allow you be among the ones wey them adopt for either ransom or killing, dey proud say you still dey see better food chop even as food price don hike pass roof self, me as a Christian, I dey proud say God never allow Nigeria enter war even as different groups and youths dey beat drums of war every blessed day, I dey proud say, soon enough, God go intervene for every matter wey concern Nigeria....

U just give me joy na but I no get water to pour for your head but I go do am when I get am. No mata wetin dey happen we need give God all the praises broda. The country bad but we dey chop, you know how many people no chop yesterday or even due yesterday. Provided we dey alive hope always dey na just time everything go fall in place either e better for the country or e better for our individual lifes wey we fit come help others thereby helping d country too.

No mata how bad we talk about Nigeria, I still happy say I come from here e get why, reason dey for everything wey dey happen to you for life na wetin me I believe. Nothing dey just happen like dat, e get greater picture wey we no dey see. Na my believe even make me create this thread yesterday; How do a country start all over - Happy-ish Independence. we need find solution to our problem, d country go sweet more when everything fall in place.
Thank you very much boss man, I really appreciate your comment and stand for the matter,  make I talk true, before before, I follow for people wey dey always bad mouth Nigeria unto say our leaders no dey perform well, but of recent, God open my understanding to realize that even as bad as we think say Nigeria be, we still dey survive, many people still dey live fine, we still dey go market and we still dey afford to buy food, we still dey afford to pay our rent(for those of us still living in a rented apartments) we still dey afford to pay our children school fees even as high as it is, we still dey afford to dress well whenever we dey go out, some of us still dey buy expensive cars self, houses,you name it, we still dey afford to buy fuel put for our generator, some still dey afford to enter bar, spend so much on food, drinks, pepper soup and others.

If we look all this things, we get more than enough reason to be grateful to God, our being born in Nigeria no be mistake ooh, shebi God tell us in Deuteronomy 8 verse 18 say make we no ever forget say na him dey give us power to make wealth and riches, which mean say, even if make the country dey ok as we think, those wey God never give that power go still dey poor, so our duty is to always pray for our country and to always extend helping hands to others when we get the opportunity cus this things na privilege wey God give us say as we dey do am, we go dey receive more blessing from him.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Central Bank dun hang the launch of E-naira

Be like things no longer go as planned, central bank dun delayed the launch of our awaiting Digital naira with all the mouth weh dem make say E-naira go do wonders, the thing now na the opposite.
Because of the launch, some speculators been fear small yesterday say naira go appreciate against dollar na why e do slight dump yesterday.

No be our naija be the first country to adopt this CBDC of a thing but thing come be like say na we dy make headlines pass.

Source:- Businessday
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Alot dey to be proud of ooh, first, dey proud say as the country bad reach, you still dey alive, God no allow you be among the ones wey them adopt for either ransom or killing, dey proud say you still dey see better food chop even as food price don hike pass roof self, me as a Christian, I dey proud say God never allow Nigeria enter war even as different groups and youths dey beat drums of war every blessed day, I dey proud say, soon enough, God go intervene for every matter wey concern Nigeria....

U just give me joy na but I no get water to pour for your head but I go do am when I get am. No mata wetin dey happen we need give God all the praises broda. The country bad but we dey chop, you know how many people no chop yesterday or even due yesterday. Provided we dey alive hope always dey na just time everything go fall in place either e better for the country or e better for our individual lifes wey we fit come help others thereby helping d country too.

No mata how bad we talk about Nigeria, I still happy say I come from here e get why, reason dey for everything wey dey happen to you for life na wetin me I believe. Nothing dey just happen like dat, e get greater picture wey we no dey see. Na my believe even make me create this thread yesterday; How do a country start all over - Happy-ish Independence. we need find solution to our problem, d country go sweet more when everything fall in place.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
If you dey proud of your country dedicating your personal text today no go kill you besides everyone know your root already... Nice one CB
No vibe, no job employment, 2015 GDP is more than this present GDP, more loan borrowed, no freedom of speech, Twitter banned, price hike of food, poor economy, increase abduction rate for ransom. Earnestly, what to be proud about?

If we wan dy carry naija problems for head, trust me brother, the matter go just give person BP at younger age wey be say na old people self they rule us for naija. Nothing to proud, they know it but them go do anything to chase clout.
You see ba, this government know say them dun F up but you know an African man, they would dance around the bush and will never concede defeat and justify anything to their favor.
You remember FFK weh been dun dy attack Buhari for him government till this year, you know see how him make change at die minute, the thing show say this politicians no get shame and they are all bird of the same papa, I dy only pity our young brother weh dem put their matter for head.

Make we no give up sha, one day one day, naija go better again.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If you dey proud of your country dedicating your personal text today no go kill you besides everyone know your root already... Nice one CB
No vibe, no job employment, 2015 GDP is more than this present GDP, more loan borrowed, no freedom of speech, Twitter banned, price hike of food, poor economy, increase abduction rate for ransom. Earnestly, what to be proud about?
Alot dey to be proud of ooh, first, dey proud say as the country bad reach, you still dey alive, God no allow you be among the ones wey them adopt for either ransom or killing, dey proud say you still dey see better food chop even as food price don hike pass roof self, me as a Christian, I dey proud say God never allow Nigeria enter war even as different groups and youths dey beat drums of war every blessed day, I dey proud say, soon enough, God go intervene for every matter wey concern Nigeria....

My people, happy independence day ooooh, God hand dey this country, no matter how bad you think say the country be, never forget say diamond and gold dey pass through fire before they become very valuable. Nigeria🇳🇬🇳🇬🇳🇬🇳🇬🇳🇬💎
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
No vibe, no job employment, 2015 GDP is more than this present GDP, more loan borrowed, no freedom of speech, Twitter banned, price hike of food, poor economy, increase abduction rate for ransom. Earnestly, what to be proud about?
First make I salute everyone for this forum, on our independence day, we country na 61 years omo for real life matter person way day 61 na elderly man, him for don full him belle with enough experience to carry am through and even get more to share to others, but our country no be so, we just day as if we day go back for age, from wetin my dad tell me e bike say back then things was better than wetin we day see now, but regardless we no get anything to be proud of we still gat day patriotic to the flag not the rulers, I believe say there will be a country in it we go day proud of.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If you dey proud of your country dedicating your personal text today no go kill you besides everyone know your root already... Nice one CB
No vibe, no job employment, 2015 GDP is more than this present GDP, more loan borrowed, no freedom of speech, Twitter banned, price hike of food, poor economy, increase abduction rate for ransom. Earnestly, what to be proud about?
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Happy Independence Day Nigeria

We country pipo how una dey enjoy una free independence day celebration? Make una try put body to push this country forward as na the only treasure we get, make we try put head together and make it better for our future generations, the current government dey face challenges and may not be the best to some of us due to one thing or the other but we must move Naija forward it's our right to make it better.

If you dey proud of your country dedicating your personal text today no go kill you besides everyone know your root already... Nice one CB


Highlights speech by pres. Buhari


On Covid 19 vaccine
Quote
the Government of Nigeria has continued to explore all available options to ensure Nigerians have free access to safe and effective vaccines. Some five million vaccine doses have been administered to Nigerians through efforts led by the National Primary Health Care Development Agency and we will continue to explore options for purchase or acquisition of vaccines such as through COVAX and the African Vaccine Acquisition Trust.

On Food Security
Quote
I am proud to announce Nigeria has commenced its journey to pharmaceutical independence. This journey, which will take years to achieve but will ultimately result in Nigerian based companies developing the Active Pharmaceutical substances and competence needed for us to make our own drugs and vaccines.

On security
Quote
Earlier this year, I launched the Integrated National Security and Waterways Protection Infrastructure, the Deep Blue Project, which is designed to secure Nigerian waters up to the Gulf of Guinea. I am happy to inform Nigerians that we have taken delivery of key assets for this project and very soon, its impact will be felt. In the North East region alone, over eight thousand Boko Haram terrorists have surrendered.

On local refinery
Quote
Nigeria’s Roadmap on Local Refining is on track with the Commissioning of a Modular refinery in Imo State. A second is scheduled for commissioning by the end of this year in Edo State and the third one in Bayelsa State by 2022.

On Twitter ban lift
Quote
Following the extensive engagements, the issues are being addressed and I have directed that the suspension be lifted but only if the conditions are met to allow our citizens continue the use of the platform for business and positive engagements.

You fit get full tori for Here
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I for suggest something like designed avatar for those ones wey their avatar space dey available.

Belike you dey my mind although I been dey find we get the bloody flag own as e go send the main message but can't edit that so I just fall back to this old avatar wey I wear one time like dat. Na so me I wan celebrate my own independence

E go better one day and everyone go smile one's again.

Broda I give amen to that prayer, and surely one day we go jubilant as we go enjoy small freedom wey dem European dey enjoy, we go get some privileges as well like good road, water, food and better working environment. Make we just dey grind as a country we go reach there one day.

Me I dey give am Happy-ish oh because I no get joy at all but ur father na ur father nothing you go fit do.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Unto say things bad no mean say we no go celebrate am, our darling country na plus 1 today, I wish am maximum security, stabilize economy, minimum corruption, zero banditry, free country terrorism, good available social amenities, good road, standard health facilities, improved in educational standard.

I know say our fathers don dy pray teh teh say e go better but things still never dy him place but we no go give up until one day, our dear naija will be great again. Ooh, I forget to add stable power supply  Cheesy Cheesy

E go better one day and everyone go smile one's again.
legendary
Activity: 2114
Merit: 2248
Playgram - The Telegram Casino
Maybe make we organized something wey we fit use hold body celebrate the day for the forum.
The idea no bad at all, even if na to do small publicity so people wey dey the forum go know say something dey happen for Naija.
Time don go, I for suggest something like designed avatar for those ones wey their avatar space dey available.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Omehn, I forget say tomorrow na Oct 1st ohh, how d celebration go be na for the forum. I understand say our country no dey try but wetin we go do na, our country na our country.

Guy, everywhere dull normally, i remember that year when e be say before October 1st go reach, you go dun dey see green and white for everywhere, for boutique, for taxis, for stores and all that. But now, nothing like that no vibe, no joy for plenty people side. Like this sef, some people for my WhatsApp dun warn me say dem nor wan see me send them any Happy Independence day message. Lol.

My people, any independence really to celebrate? Abi na normal Happy new month nai go well pass to wish people?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Abeg i hear say d govt. don giv d admin to each group license to kill one cow sent frm daura by sai baba in a bid 2 celebrate d naija day, na so i wan ask awa own admin 4 hia 2 giv us location 4 d asunn joint.... Guys bin wan flex o or wetin be una plan against 2moro?

Omehn, I forget say tomorrow na Oct 1st ohh, how d celebration go be na for the forum. I understand say our country no dey try but wetin we go do na, our country na our country. Dem say no mata how ur mama dey, even though na witch, your mama na still ur mama and you no fit change am. Maybe make we organized something wey we fit use hold body celebrate the day for the forum.

All those people wey don chop money 4rm here, I know una names oh I no wan call name, make una come do giveaway. Sha anyone tomorrow wan be make e be  me I no dey celebrate sha, na house I go dey throughout. I just hope NEPA go dey so we fit enjoy am, maybe watch one or two Netflix because person deserve rest.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Abeg i hear say d govt. don giv d admin to each group license to kill one cow sent frm daura by sai baba in a bid 2 celebrate d naija day, na so i wan ask awa own admin 4 hia 2 giv us location 4 d asunn joint.... Guys bin wan flex o or wetin be una plan against 2moro?

Na naija we dey and we gada dey!
Abeg dis na joke o
Laffin mata wey i bin title "tiku ma ribs"
Make we laf smal 2 relif stres
Jump to: