Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 201. (Read 1029239 times)

legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.

One semester na like 3 months abi? So na like 25k for 3 months? Normally e make sense and na something wey dem fit do, e go help some kind undergraduate well well, but the matter now na say e fit just be BIG BIG TALK. Nor be the same government still talk say dem go dey give primary school children food for school? Abeg you dun say that one dey happen. Them wey wan give undergraduate that kind money, have they settled ASUU? Our government has lost credibility in the eyes of many, to believe their words is to put yourself further in the way of disappointment.

Best advice to any undergraduate here, nor too reason that talk, with the way naija economy dey go, that 75k nor go fit hold one month cun talk of one semester, just try to do your best to earn better for yourself.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.

Nigeria na government without shame. If our leaders get shame de no go de open mouth talk some kind things for outside. How the thing want carry be if no be say na another avenue for them to steal our money them de plan with that. N75,000 per student studying education and then multiply it with the population and number of schools for semester. That na better money e bi and I no sure say government go fit pay am.
Thank you very much my brother, e con be like say you collect the words from my head, this na proper avenue for them to loot our money and abeg, remove that you no sure, because me I dey sure 100 percent say dey no fit pay am.
From August to this present time, look how much buhari don borrow, why he go go dey borrow the billions and trillions wey he dey borrow, if money wey fit pay 75 thousand naira to each Nigerian student wey dey university dey this country, why he go go dey borrow money from other countries for development?

This one na better scam, they just won open another door wey go enable them steal more money from Nigeria.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Oya watch how I go write now to understand the mixed language something,  And you think that's helping our mata, only him making 70% of the post contributions that means we don't have activity and it's just a one man show and our request will hardly be listen to. Secondly english dominating the thread isn't helping mata. The mixed language is the way to go which is why everyone is voting that and not all English..

You see within I do there, I write for English come add am Pidgin small now, that how it can be done. Nothing hard there. English isn't what we bargain for. Adding one or two line can easily qualify your posts as mixed, why is that hard to understand.

Charles dun speak to you for phone, e Pidgin dey very okay which got me wondering why it's hard for him to adjust from the all English posts, abi no be him wey dey write pidgin for d thread before? E no mata if e post activity reduced but we need collective contributions no be one person doing all the posting, you think they won't put all dat into consideration?.

Charles should even be one promoting this mixed language of a thing because he's the most active here. If he continues only English odas will follow but if he add pidgin dey will still follow. I just hope e understand dat and continue posting as it'll be bad to lose his contributions.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.

Nigeria na government without shame. If our leaders get shame de no go de open mouth talk some kind things for outside. How the thing want carry be if no be say na another avenue for them to steal our money them de plan with that. N75,000 per student studying education and then multiply it with the population and number of schools for semester. That na better money e bi and I no sure say government go fit pay am.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.

The declaration was from the Minister of Education at the World teachers day celebration, lol this one na pure shawarma when I saw the headline at first I was very happy but when I com notice say nobe Pres. Buhari talk am I come lose hope know say na pure brainwash. The ministry can not provide such funds on their own that's kind of automatic employment for students because na wetin level 6 government staffs dey earn per month be that.

The way the country dey go if care is not taken China will take over the whole banking sectors and divide the land, the amount of loan dis people don collect from China dey alarming at this rate. And if dem take over the banking sector the restrictions on crypto go strong oo.

Our activities of last month was quite okay but make we try dey put body more make e no be like say na only one man dey push up the whole activities. From the stats Charles made over 70% of the whole activities of last month. and since January na him dey top for every week stats nobody come close except me too we dey try to meet up with him, and just of recent Charles don dey very quite because of the language wahala, Charles is not fluent in pidgin writing the way most of us dey and Yes!! 99% of Nigerians understands pidgin but not all can write or speak it well. Please make we pardon Charles to do whatever he pleases in terms of writing I noticed his post was deleted yesterday and I don't think it was the right decision tbh.
Top Posters

Code:
1. Charles-Tim [70]
2. igehhh [29]
3. Nathrixxx [21]
4. CryptopreneurBrainboss [19]
5. Mpamaegbu [19]
6. BIT-BENDER [13]
7. Issa56 [13]
8. Smartvirus [8]
9. Dragonfund [7]
10. Gozie51 [7]
11. Rruchi man [5]
12. Trojane [5]
13. Maestro75 [3]
14. Rath_ [3]
15. nelson4lov [3]
16. Cookdata [2]
17. Coyster [2]
18. CrossroadBTC [2]
19. CryptocurencyKing [2]
20. okorieemmanuel [2]
21. Anguwa [1]
22. Cynthia_sinach042 [1]
23. Davidvictorson [1]
24. Marykeller [1]
25. Messicryto01 [1]
26. Newlifebtc [1]
27. Wakajeje01 [1]
28. examplens [1]
29. lovesmayfamilis [1]
From the pool results( All languages is leading) and to speak as a lover of freedom and for the sake of humanity please lest go with the current result. For Nigeria we get over 500+ languages but pidgin and pure English is common language. I understand 4 local languages but I no fit write them or speak well even Spanish and Korean I dey hear some basics things so make we learn other languages too Smiley Russian dey hungry me to learn but that language is fuvkinh difficult to understand or even learn.
One love
@D-law you are welcome but please respect the forum rules and live happily ever after....we love our own but the day you do something ugly you are on your own (OYO) na de matter be dat for here so make u try e no easy.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Twitter dey na and telegram too, e go just shock you say you fit dey see status for telegram and twitter go get doings like Instagram sharp sharp haha. No dulling for this industry oh if not people go overtake sharply and Mark know that one na. What about TikTok and Snapchat. Alternative plenty na just say dis ones na the common ones but if you get business online den you need take advantage of all platforms.

Na people wey get blessings this thing affect pass. After the blackout pass i cum dey see whatapp messaging of transaction I suppose run but dey dun do am with another dealer. Na only one person call me after e notice WhatsApp dey down belike odas no notice.

NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013

Facebook Owner, Zuckerberg Loses $7billion In Hours As Facebook, WhatsApp, Instagram Remain Down[/url]

E no easy to run three big companies, why twitter no dey shutdown na say na only am dey. But the serve for mark Social media platforms dey control Facebook, WhatsApp and Instagram. I dey suspect say more dey self as dat guy sabi buy over people project. If na you be the server you no go tire lol.


Mark get power sha, and na wetin everybody just observe like this. I been feel say na airtel oooo, i dum curse dem taya that day lol, person tell me say e comot e sim from phone lick am well well thinking say na network, lol, one girl say she dun almost dey wan use phone knack ground sake of say she feel say na her network port wey she dun repair before dey worry her again. The matter na say, Mark hold plenty people panic button like this, imagine say e decide to shut down every every for like 7 days, omooooo!
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Your format of writing dey very wrong, look how odas dey write learn. No just dey cut cut your sentence. Na so spammers dey write and if you continue e go be like you be spammer and I no want make dem dey reason anyone here as one as it'll be bad both for you and the community image.

@nelson4lov na true you talk, and dem lose badly so I sure dem go arrange demself make e no occur again.
Facebook Owner, Zuckerberg Loses $7billion In Hours As Facebook, WhatsApp, Instagram Remain Down

E no easy to run three big companies, why twitter no dey shutdown na say na only am dey. But the serve for mark Social media platforms dey control Facebook, WhatsApp and Instagram. I dey suspect say more dey self as dat guy sabi buy over people project. If na you be the server you no go tire lol.

To explain those poll options above so we go understand wetin we dey vote:

All Pidgin no English means say na only Pidgin we go dey speak.   
All English no Pidgin means say na only English we go dey speak.
Mixed (Pidgin, English, indigenous dialects etc) can be combined mean say we speak speak all languages wey be say you fit add English, pidgin etc together.
NONE (Give reason why) if you no like any of the options or you get something better den talk.
member
Activity: 686
Merit: 19
@Nelson4lov,no Shaking Sha e no get as e wan play nah.
Our senior men dem, e no get wehtin dey hard them to do.
You done do well for this information you yarn lap me.
Grease dey your head.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Omen ehhhhh, federal government no want make we run our matters again ohhh.
Like dis like dis WhatsApp done gbolo!!!!
No be play ohhh, be like them done hack am finally.
People they hungry them dey use money go do something weh no make brain, omohhhhh Dem dey fuck up full time....Dem done too yones and loose guard us Wella.

Haha. Abeg make una try relax. This WhatsApp, Facebook and IG outage wahala no be just for Nigerians only and most likely no get anything to do with our government even though them dey like cause this kind of matter.  For now, nobody really know the cause of the matter sha just that Facebook and Whatsapp representative don talk say them dey aware of the matter and go fix am soon but e go take time.
member
Activity: 686
Merit: 19
Omen ehhhhh, federal government no want make we run our matters again ohhh.
Like dis like dis WhatsApp done gbolo!!!!
No be play ohhh, be like them done hack am finally.
People they hungry them dey use money go do something weh no make brain, omohhhhh Dem dey fuck up full time....Dem done too yones and loose guard us Wella.
member
Activity: 686
Merit: 19
Username:D-law
Gender:Male
Location/State: Nigeria/Rivers State
Skills:House planning.

On how e be enhhhh, I be confirmento gee so make ornah accept me Wella,make we try they be our brothers keeper, no be competition we dey do here last last,nah to grow each other to the next level.
Rugged whoever dey run him matters like this, ornah too much.
Mr brain Boss,na oluwa give you sense to run this thread, beast you Mr Brain Boss ✊
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Una gud evening 4hia o i beg i want ask say na wetin be d gbege we bin dey apun 4 watsapp n IG as d 2 ogbonge social media network no gree load since morning, i bin update d apps restart ma fon nd off nd on d data d tin tire me, a con dey tink say maybe na my fon wan get probs be dat, later a call enter ma fon we con dey gist na so i hia say no be only me dey xperience am, a belif say we dey safe as per hw dem take dey place ban on many tinz now, abeg any updates konsernin dis?
Nobi only WhatsApp and Facebook but e brodas dem like Instagram follow for the wahala, all social media dem wey Facebook /Mark Zuckerberg get follow dey experience dis wahala. You fit get more details here:

Facebook, Instagram, WhatsApp services down second time in 2021
Facebook, Whatsapp and Instagram suffer outage

Na only Twitter wey d government ban for we country and we just dey hope say dem go comot am soon.

This post been dey all english so according to wetin I been dun talk say I no go allow non english post again, I dun delete am. But the inform been vital so just gaz translate am (in the best way, wey I fit) so the user fit get the information. Nothing personal here, just encouraging more indigenous communication and not all English.

For the all English matter, if people wey no from the country come talk I go leave am for better information but e get how dem go go off topic I go delete am too.

Responding to the twitter ban; The government been dun agree to lift the ban but dem put some condition. I no sure twitter go comply sha so dat one fit be lost battle.

For the WhatsApp matta, after I see your post I just go check my WhatsApp message wey I send, dem no go oh na just now I dey realized am. Thank you for bringing dat mata up. I believe odas experience similar situation.

Ontop this mata make we use the poll above vote, so e no go be like I make decisions myself as some people dey think. Other suggestions are welcomed.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Una gud evening 4hia o i beg i want ask say na wetin be d gbege we bin dey apun 4 watsapp n IG as d 2 ogbonge social media network no gree load since morning, i bin update d apps restart ma fon nd off nd on d data d tin tire me, a con dey tink say maybe na my fon wan get probs be dat, later a call enter ma fon we con dey gist na so i hia say no be only me dey xperience am, a belif say we dey safe as per hw dem take dey place ban on many tinz now, abeg any updates konsernin dis?
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Wike own na say e carry flyover and roundabout for head and repairing of roads meanwhile amaechi been carry building of school, primary health care and market for all local government. Then na odili areangey the state. Assuming this guys na dem rule Nigeria back to back atleast we for dun see improvements.

Gov. Wike government na the worse among those three guys you mention so as far as Rivers State is concerned, the worse thing you can do to humans is to cut food out of their mouth and build dem roads and flyovers that leads to nowhere, Since Wike enter seat 2015 him never pay Pensioners till date, this is the highest wickedness I've seen since den born me, No employment, No salary increments, No staff warfare, No soft loans, No empowerment, My papa wey gain promotion since 2018 still dey chop him formal salary. Make flyover no blind us ooo that's where he is stealing his money, no reasonable person will award 10+ flyover in the same LGA when you have 21 LGA with zero flyovers. Insecurity is high,


Na for this employment and pension side wey i feel say e never do well at all, i dun hear plenty people complain for the matter well well, i nor really know why e nor wan look into pensioners matter ooo, because i know say nor be money dey cause am, but e nor good. Nai make i still use mouth take talk say nor be say na angel wike be, but e dey try for project in my opinion, nor be only flyover e dey do sef, e get many projects wey the man dey run, wey e dun even complete sef, nor be just for portharcourt and obio/akpor LGA, check am well. If you go see wetin Governor of Abia State dey construct for how many years now dey come say na flyover, your leg go shake.

 Yes e dey use flyover dey chop money fine, but at least e dey use project chop and e dey complete am, some government nor send anybody, nothing concern dem concern to use project chop money, dem go chop the money straight up.



sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
Nigeria local board is now pinned. Thanks to theymos and Cyrus for considering Nigerians to be relevant on this forum.

Thanks to CryptopreneurBrainboss for his suggestions, also thanks to Igehhh for the positive feedback, also thanks to myself  Roll Eyes. Thanks most especially to all other Nigerians that have been active on our local board, we can not achieve this without you people.

Next is to continue our local board request.
My contri people una weldone for all una efforts in projecting Naija matter in the forum I come dey search our thread for other languages and Location I no see am na  him I come see am  as Nigeria on top of Local languages, top we don commot for African matter, I salute una for dis wonderful job I dey see igehhh analysis on top of dis naija in Meta thread, our ogas patapata CryptopreneurBrainboss doing his good work, I dey hail Charles-Tim, BIT-BENDER, Fivestar4everMVP and others wey dey keep dis place with latest updates, I don come make we dey rob Naija matter together.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

I totally understand where  you dey come from my brother, and na truth you talk, but wetin I want make you understand be say, (na something wey I don talk before) even if make this country come good as me and you want, trust me, people go still dey wey no go fit afford 3 square meal per day, check USA and every other big countries, they all get poor citizens wey if you check am well, them too dey live for abject poverty, but the difference be say, their number no high as e be for Nigeria, and again, the ones wey get money for those big countries dey always see am as a duty to give out something, no matter how small, to the poor on weekly, bi-weekly or monthly basis, this na something wey only very few Nigerian big men dey do.

My brother if you fit bring USA into a context for here then you no know wetin I dey talk about, infact I no day like to talk about how poverty infested nigeria is an person go talk say poor people also dey USA. Omo there is no wey you fit compare am, do you know the US government dey give parents wey get pikin of a certain age money to take care of the pikin, money that's up to $300, average what is the salary working in nigeria, basic amenities we no get, ok make we manage the poverty, with light, water and good road but we no see, but for US them dey make road wey go last till another generation, I no go let you support this leaders by sugar coating wetin we dey see for naija.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Thank you very much boss man, I really appreciate your comment and stand for the matter,  make I talk true, before before, I follow for people wey dey always bad mouth Nigeria unto say our leaders no dey perform well, but of recent, God open my understanding to realize that even as bad as we think say Nigeria be, we still dey survive, many people still dey live fine, we still dey go market and we still dey afford to buy food, we still dey afford to pay our rent(for those of us still living in a rented apartments) we still dey afford to pay our children school fees even as high as it is, we still dey afford to dress well whenever we dey go out, some of us still dey buy expensive cars self, houses,you name it, we still dey afford to buy fuel put for our generator, some still dey afford to enter bar, spend so much on food, drinks, pepper soup and others.

If we look all this things, we get more than enough reason to be grateful to God, our being born in Nigeria no be mistake ooh, shebi God tell us in Deuteronomy 8 verse 18 say make we no ever forget say na him dey give us power to make wealth and riches, which mean say, even if make the country dey ok as we think, those wey God never give that power go still dey poor, so our duty is to always pray for our country and to always extend helping hands to others when we get the opportunity cus this things na privilege wey God give us say as we dey do am, we go dey receive more blessing from him.
I greet you well my brother, wetin you talk make sense and I really like am, but my brother make you reason with me, you dey talk about "we" like my brother the country is bad yes it is, and for real na efforts and education, knowledge way dey keep us going, but do you know there are some people wey dey live in abject poverty, those are the people feeling it, those wey no fit eat better food even for one time meal, those wey no get any accommodation over there head, we don see the philanthropic works of some well meaning nigerian, I go use cryptoprenurbrainboss as an example, it's wen you one give you go know say people dey suffer for the country and the leaders nothing concern them.
I totally understand where  you dey come from my brother, and na truth you talk, but wetin I want make you understand be say, (na something wey I don talk before) even if make this country come good as me and you want, trust me, people go still dey wey no go fit afford 3 square meal per day, check USA and every other big countries, they all get poor citizens wey if you check am well, them too dey live for abject poverty, but the difference be say, their number no high as e be for Nigeria, and again, the ones wey get money for those big countries dey always see am as a duty to give out something, no matter how small, to the poor on weekly, bi-weekly or monthly basis, this na something wey only very few Nigerian big men dey do.
God wey create rich people, na him still create poor people, and him command the rich ones to never look down on the poor and to always help them, cus the knowledge wey the rich think say them get wey contribute to their being wealthy, no be by their power they take know wetin they know, na by the grace of God, me and you wey know say person fit earn money from bitcointalk, Come dey here dey earn something every week or month, no be by our power we find out about bitcointalk, na by the grace of God my brother.

The spiritual controls the physical, things wey God dey do for me and you in the spiritual realm pass wetin me and you dey see with our eyes, that na why he command us to always give him thanks in all situations wey we find ourselves, and for those wey dey around and amongst us wey we see say them dey suffer, help them in every little way you can instead of blaming the government on their behalf, and in return, God go bless you, he don talk am for Hebrews 6 verse 10 say he no go ever forget every act of love wey we show to our neighbors in his name.... No where wey Bible talk say, if we see poor people amongst us, or even if we self poor, make we blame our government.. No. Me never see.


Wike own na say e carry flyover and roundabout for head and repairing of roads meanwhile amaechi been carry building of school, primary health care and market for all local government. Then na odili areangey the state. Assuming this guys na dem rule Nigeria back to back atleast we for dun see improvements.

Gov. Wike government na the worse among those three guys you mention so as far as Rivers State is concerned, the worse thing you can do to humans is to cut food out of their mouth and build dem roads and flyovers that leads to nowhere, Since Wike enter seat 2015 him never pay Pensioners till date, this is the highest wickedness I've seen since den born me, No employment, No salary increments, No staff warfare, No soft loans, No empowerment, My papa wey gain promotion since 2018 still dey chop him formal salary. Make flyover no blind us ooo that's where he is stealing his money, no reasonable person will award 10+ flyover in the same LGA when you have 21 LGA with zero flyovers. Insecurity is high,

He did Biometric to removed ghost workers from government payroll and about 1.8 millions staffs were dropped during the process, offices are empty, a lot of vacant spaces yet no single employment to fill in those spaces. At this rate Wike go run enter APC to save himself from Probs because EFCC dey wait for am to come down.

Having Telegram, Hangout, Bitcoin wallet apps, Binance app, large bank credit alerts na straight billing for Rivers State and sometimes you get killed for being successful. The state matter tire me abeg.
Hahahaha, to be sincere, me (been) like wike die oooh, I mean I no dey live for PH, But anytime wey I read or hear news about wetin the man the do and how he dey always tackle buhari heads on, I dey always dey happy for my mind cus I dey always feel say atleast, I don see one politician for Nigeria wey really mean well for the people, and this one even make me agree with @CryptopreneurBrainboss when he talk say if wike fit be president for Nigeria, things go better, I been agree 100 percent, BUT as I con read this your post @igehhh, I no con know wetin or who to believe again, I no even know whether I still like wike or not  Grin Grin... I still dey wait for that day wey we go get atleast one leader, (president or governor) wey no body for this country go write any bad review about. did I hear somebody say "it's not possible" ?  Grin
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Wike own na say e carry flyover and roundabout for head and repairing of roads meanwhile amaechi been carry building of school, primary health care and market for all local government. Then na odili areangey the state. Assuming this guys na dem rule Nigeria back to back atleast we for dun see improvements.

Gov. Wike government na the worse among those three guys you mention so as far as Rivers State is concerned, the worse thing you can do to humans is to cut food out of their mouth and build dem roads and flyovers that leads to nowhere, Since Wike enter seat 2015 him never pay Pensioners till date, this is the highest wickedness I've seen since den born me, No employment, No salary increments, No staff warfare, No soft loans, No empowerment, My papa wey gain promotion since 2018 still dey chop him formal salary. Make flyover no blind us ooo that's where he is stealing his money, no reasonable person will award 10+ flyover in the same LGA when you have 21 LGA with zero flyovers. Insecurity is high,

He did Biometric to removed ghost workers from government payroll and about 1.8 millions staffs were dropped during the process, offices are empty, a lot of vacant spaces yet no single employment to fill in those spaces. At this rate Wike go run enter APC to save himself from Probs because EFCC dey wait for am to come down.

Having Telegram, Hangout, Bitcoin wallet apps, Binance app, large bank credit alerts na straight billing for Rivers State and sometimes you get killed for being successful. The state matter tire me abeg.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I just wish wike go enter power make e just use e gra gra put everything into place. Who dun reach pH of recent dat man don work here scatter, like if no be bad belle ehh pH now for belike hot cake for investment but Lagos no go gree dash us small compass.
My oga I go contradict you for this mata, all the politician on ground na d same thing, and wike no comot from the category, infact his involvement in unnecessary yarns to me don make matter worse.

 I no understand why my country people go dey hala my governor build roads/bridges etc as if them do una any favors, this na the most basic things them fit do for us and we day jollificate because of am. An onto the E-naira mata, I Know say d thing go fail even before them launch am, make the country first launch our normal naira from the ground wey e dey to a better levels before them launch any crypto-currency.

This your talk BIT-BENDER e sweet me well enter belly. All this politicians de be the same thing all over. Sometimes I wonder whether them de do secret meetings together to de behave de way de behave. Wike no de any special. Tomorrow now him fit run enter APC. Shebi Godswill Akpabio do am. Who believe Akpabio fit ever enter APC after all the better work we think say him do as PDP man. Na criminals all of them be.
Jump to: