Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 233. (Read 1031636 times)

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I no wan reason am now at all o because this one eh, na to carry another full grown adult way dey like you, e don tire eye, e belle big pas your own and the worst be say.
Omoh how many girls u dey chuuck? you know say that one na semi marriage already cause you dey settle some kind bills

Signature money no go fit pay fees, e never even buy beer for some kind men talk more of fees.
I no get shishi savings from sig na wetin I dey use settle middle of the month bills na so so chop chop, una wey get savings make God bless una with that kind heart o

I go dey watch ina from corner shah, make una dey try. You fit still name one pikin after me shah, lol.
My friend go marry no wait for brainboss
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
All this marriage talk una dey bring now don dey make me fear o. I no wan reason am now at all o because this one eh, na to carry another full grown adult way dey like you, e don tire eye, e belle big pas your own and the worst be say, na the bae go first wan hurry to double up with pikin. The bills fear me bros. E go wayh no be chaise. All of una way don marry for here, ina weldon o, una dey try. Signature money no go fit pay fees, e never even buy beer for some kind men talk more of fees... I go dey watch ina from corner shah, make una dey try. You fit still name one pikin after me shah, lol.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Abeg comot marriage talk for my side oh, I never make money finish. Me self I never for fit feed myself you dey come advise I carry person pikin put for House and probability dey say she go come give me my own in the soonest time possible as my (you know na) dey fertile die

Omoh baba comot body for marriage myself I don tell myself if I never dey successful marriage thoughts nogo ever fit enter my head except say one of these my oyibo women friends come marry me make I carry their money run go naija divorce her..sha if I continue with this momentum wey I dey on now I go hit my target in the next 3-5 years time.

nelson4lov uav far you na, I hear and j don see say you be altcoin lord. The millions I dey hear say you dey count ehh me self go like follow.
Nelson hit $20k for ICp token ooo baba don leave us run God knows where.... Abeg anybody wey get money make e buy all those tokens wey Hhampuz dey run or do the bounty na major projects dem oo.

But if e don dey too late, na to enter ham o.
This is wrong marriage node compulsory na pocket be marriage oo if e no reach don't go into it.

Governments destroy people economy, they just stole, crypto will cover all the world in some years
Just the way it has been for a long time now.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Omo. This one all of all of una wan marry, wetin dey play now? I go dey singles markets for more years. Na people like @CryptopreneurBrainboss and @ Charles-Tim go marry very soon.

Abeg comot marriage talk for my side oh, I never make money finish. Me self I never for fit feed myself you dey come advise I carry person pikin put for House and probability dey say she go come give me my own in the soonest time possible as my (you know na) dey fertile die.

Abeg I never reach to dey struggle dat kind thing, una wey dey run family matta make God help una as I know e no easy. @nelson4lov uav far you na, I hear and j don see say you be altcoin lord. The millions I dey hear say you dey count ehh me self go like follow.

I don comot cap for head dey ask you make you show me(us) wey. Just drop update on the bounty you dey run and make we see if we go fit follow body make we too chop small abi how u see am
Marriage na one life thing, me never get time at all, without no enough money, no good family go be established as a learned people. As a husband and a father, the faith and confidence should dey more for husband side, money dey needed in family which go make love stronger. But if e don dey too late, na to enter ham o.

Lol... I see say una don yarn about marriage and Una dey talk of making all the money first haha. But e no suppose to be like say na, money follow but no be say na to make all the money finish before reasoning that side. See dangote still dey look for money add and that one follow because if you no get how to add join, 30 billion go turn three billion soon when you just dey draw comot inside am. Wetin dey important na to get ability to make money, that's financial intelligence.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Omo. This one all of all of una wan marry, wetin dey play now? I go dey singles markets for more years. Na people like @CryptopreneurBrainboss and @ Charles-Tim go marry very soon.

Abeg comot marriage talk for my side oh, I never make money finish. Me self I never for fit feed myself you dey come advise I carry person pikin put for House and probability dey say she go come give me my own in the soonest time possible as my (you know na) dey fertile die.

Abeg I never reach to dey struggle dat kind thing, una wey dey run family matta make God help una as I know e no easy. @nelson4lov uav far you na, I hear and j don see say you be altcoin lord. The millions I dey hear say you dey count ehh me self go like follow.

I don comot cap for head dey ask you make you show me(us) wey. Just drop update on the bounty you dey run and make we see if we go fit follow body make we too chop small abi how u see am
Marriage na one life thing, me never get time at all, without no enough money, no good family go be established as a learned people. As a husband and a father, the faith and confidence should dey more for husband side, money dey needed in family which go make love stronger. But if e don dey too late, na to enter ham o.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Omo. This one all of all of una wan marry, wetin dey play now? I go dey singles markets for more years. Na people like @CryptopreneurBrainboss and @ Charles-Tim go marry very soon.

Abeg comot marriage talk for my side oh, I never make money finish. Me self I never for fit feed myself you dey come advise I carry person pikin put for House and probability dey say she go come give me my own in the soonest time possible as my (you know na) dey fertile die.

Abeg I never reach to dey struggle dat kind thing, una wey dey run family matta make God help una as I know e no easy. @nelson4lov uav far you na, I hear and j don see say you be altcoin lord. The millions I dey hear say you dey count ehh me self go like follow.

I don comot cap for head dey ask you make you show me(us) wey. Just drop update on the bounty you dey run and make we see if we go fit follow body make we too chop small abi how u see am 🙏
member
Activity: 131
Merit: 10
Governments destroy people economy, they just stole, crypto will cover all the world in some years
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
About TB Joshua, no be say I no know say na mere mortal, and mere mortal must die, but as a Christian, I dey get this mentality say a true man of God suppose live long so as to carry out the work wey God almighty give the person
To dey sincere eh, e don tay way I last here of this man guy. E bin be to me say, en tike don pass until now way en death tori con hut ground gidigba so. Maybe e been still dey rain for una side well but for my end, the guy no sound hands like that again.

About the long life matter for pastors way be pastors true true, that na your own idea as you take talk am. One thing we gat know be say, God get as or how e dey do en thing and e pass our understanding wella. So, the guy passing on, dey beyond our comprehension and na so e just be. Criteria no dey for true man of God. Even fake man of God cef, e fit still lead people go heaven, for those way believing say heaven dey while, him way be pastor cef, e go enter place of torment. The life cef, nobody really know.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Even the Twitter ban sef nor be like sey dem even block am well sef. My own still dey show oh small small and I neva begin use VPN sef. Nothing wey these people sabi do well sef.
Them ban something yet den no get better firewall to prevent penetrating the site even with VPN, I hear say dem want go china go hire expert wey go build strong firewall against twitter operation, this country yeye too much so dem look the country finish den no see any capable people wey go run that matter. President or not President if you violate twitter community den get the right to delete or ban anybody as far as e dey against the rules.

This move dey against our freedom of speech.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Fivestar4everMVP, wetin make you shock about TB Joshua? You follow for those wey think sey death dey respect person? Joshua na just another mere mortal like you and me. Na because we too worship people like dem and politicians dey make dem misbehave. Man na man, God na God. Bible yarn sey man na dust and na dust im go return to. No exceptions. Congrats though. I nor sabi sey you dey married too. I bin think sey na only me & Posi dey dat cruise here. Oya, all the married peeps here Tiree Gbosas for una oh!

About TB Joshua, no be say I no know say na mere mortal, and mere mortal must die, but as a Christian, I dey get this mentality say a true man of God suppose live long so as to carry out the work wey God almighty give the person, and I believe say no be only me get this kind idealogy, the world wey we dey today is full of uncertainties and many mysterious things Sha, and  I believe we all know the many controversies wey surround TB Joshua and him way of ministration, some people for my area the talk say the man don know say him time to die don reach due to some comments wey he make some few weeks back... But anyways, make we allow sleeping dog lie, I pray make the spirit find rest in God's bossom.

And concerning marriage, me don marry since 2015, that was before I enter crypto self,  na she be my first girlfriend, after I see her character, I decided to make her my bus stop to anything relating to women and dating, soon, I go invite una for my second child dedication.

Quote

About dat orbit thing wey you mention here. Abeg you fit put out the link because orbit yakpa for playstore. Make persin nor go download Linus Mohammed dem own.

Sorry, I make small mistake, na Orbot be the name of the application no be orbit, na my auto correct na im change the Orbot to orbit and I no notice.
Na the Android link be this : ORBOT

Quote

Yes, Becky666 was a nice guy to relate with. You see how owa guys dem rally round the family as we hear the news na.
Yes ooh, I see am, and I dey very sorry to the community say I no dey around when this event happen, I for follow contribute, but I pray God go bless all of una wey participate for this kind gesture, I also pray say the next event wey we go contribute like this to go be for good event wey all of us go dey very happy to talk about.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Fivestar4everMVP, wetin make you shock about TB Joshua? You follow for those wey think sey death dey respect person? Joshua na just another mere mortal like you and me. Na because we too worship people like dem and politicians dey make dem misbehave. Man na man, God na God. Bible yarn sey man na dust and na dust im go return to. No exceptions. Congrats though. I nor sabi sey you dey married too. I bin think sey na only me & Posi dey dat cruise here. Oya, all the married peeps here Tiree Gbosas for una oh!

About dat orbit thing wey you mention here. Abeg you fit put out the link because orbit yakpa for playstore. Make persin nor go download Linus Mohammed dem own.

Yes, Becky666 was a nice guy to relate with. You see how owa guys dem rally round the family as we hear the news na.

Omo. This one all of all of una wan marry, wetin dey play now? I go dey singles markets for more years. Na people like @CryptopreneurBrainboss and @ Charles-Tim go marry very soon. Nothing do una. even as life hard and this nonsense Nigeria abi UAR make am even harder for us, make we no forget to try and enjoy life. I remember those days during the days of 2go. them dey talk say make we no dey take life seriously as nobody go make am out alive.

My people, how una dey survive for the shitty market na? Hope una dey this bandwagon?
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Fivestar4everMVP, wetin make you shock about TB Joshua? You follow for those wey think sey death dey respect person? Joshua na just another mere mortal like you and me. Na because we too worship people like dem and politicians dey make dem misbehave. Man na man, God na God. Bible yarn sey man na dust and na dust im go return to. No exceptions. Congrats though. I nor sabi sey you dey married too. I bin think sey na only me & Posi dey dat cruise here. Oya, all the married peeps here Tiree Gbosas for una oh!

About dat orbit thing wey you mention here. Abeg you fit put out the link because orbit yakpa for playstore. Make persin nor go download Linus Mohammed dem own.

Yes, Becky666 was a nice guy to relate with. You see how owa guys dem rally round the family as we hear the news na.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
RIP to one of our own Becky666: https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732

Death na bastard, our brother wey been dey handle this account wey I write above don just go like dat. When I hear am I no believe, I try to reach am but e number no dey connect again, I check e WhatsApp and account for forum and dem no dey active again.

Quote from:   date=08/05/2021
Good morning sir, I lost my elder brother day before yesterday 😭 I don't know how to get your contact now so that we can talk well sir, this is my phone number 🙏

As the message come, I no believe then now I recieved another message na e I know say the mata don serious and no be joke again. I sabi Becky666 (as account) well well. I know when e start to dey hustle for the growth of the account. E dey pain me say e just go like dat. E family (children and wife) go don here about me and everybody here because e sabi talk good about the forum and how e don help am.

Abeg if anybody fit reach e family for here make dem send mine and our condolences, our prayers and love dey for dem. I go still try reach e family and if we fit organized any small thing for the family e go make sense.

Quote from: date=10/05/2021
Good day Bros, sad to bring to your notice the demise of my friend and former colleague  whom I introduced here in this forum and he is your good friend here too.

The owner of Becky666 https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732 died last week Tuesday at Wuse General Hospital Abuja.

I just go through our chat come remember this message,
 
RIP brother.

During the time this was posted, I no dey active here, I just found this out through @Mpamaegbu personal text when I dey read one of his posts on one thread like that.
Am so saddened right now, though I never get any personal conversation with bekky666 before, but this news of his death really touch me like say na person wey I know personally, tears dey fall from my eyes as I dey type this, I feel very bad right now 😢😢, my prayer be say through the mercy of our God almighty, make him find peace in his bossom, and for the family, make God give them the fortitude to bear the loss.
This guy was a good soul, I can tell from the way I dey feel right now, I no dey feel like this for most people when I hear say they die, I no even feel this bad for most of my family members wey don pass, but see as I dey here won even cry for person wey me and him never even chat before talk more of knowing each other. I urge us all as brothers, friends, family and as a community to use Isaiah 57 v 1-2 to console ourselves for our brother is resting in the lord.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
As of yesterday our minister of information wey be Lai Muhammad come talk say Twitter NG go stop operation for wey country for disgracing our incompetent presido, and e no end here ooo the shamless people still come twitter to tweet about the ban for the same app  Grin. Our country na yeye.
You dey mind Linus Mohammed? The surprising thing be sey most of these yeye people wey dey yarn dust be highly educated people oh. But their belle because of wetin dem wan eat nor dey allow dem brains work well. Shebi Linus na lawyer sef. Dem forget sey even Jack delete Donald Trump tweet and nothing happen. Jack wey dey US still get mind delete Trump message and nothing happen to am, no FBI worry am. If na naija the guy dey those fish brains for don worry am tey tey.

Even the Twitter ban sef nor be like sey dem even block am well sef. My own still dey show oh small small and I neva begin use VPN sef. Nothing wey these people sabi do well sef.

Since wey that nonsense man wey call himself Mohammed announce the ban of Twitter for we country naija, my Twitter dey work well even until yesterday night, na this morning I come discover  say the app no update again, I try to make use of the website but e still no dey load, so this kind of mean say the ban don take effect.
But as a sharp guy, ban no be for people like me, I don hurriedly go download orbit from Google playstore, and now everything is cool as ice, both the Twitter app and website dey work well now ones I connect VPN from orbit, I advice any body wey get any issue accessing Twitter to download orbit from Google playstore or iPhone app store, the app na totally free of charge, and no kind of in-app subscription or purchase either, no ads too, very clean and easy to use app.

Quote

Ehen, about TB Joshua sef. Una see sey death nor get respect for anybody na. Death nor send anybody oh. Once the time reach, e dey show sharp sharp.
The news shock me oooh, I no believe am when my wife tell me on Sunday morning when we dey prepare to go church, she say she see the news for Facebook, wetin I quickly think be say na fake news, na when I come enter Twitter na Im I come see say the matter na true oooh.
But my question na be say, why him people no won disclose the cause of him death or how he take die? Abi e get wetin they no want make the general public know?
Because e surprise me say a powerful man of God like TB Joshua go just die like this.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
As of yesterday our minister of information wey be Lai Muhammad come talk say Twitter NG go stop operation for wey country for disgracing our incompetent presido, and e no end here ooo the shamless people still come twitter to tweet about the ban for the same app  Grin. Our country na yeye.
You dey mind Linus Mohammed? The surprising thing be sey most of these yeye people wey dey yarn dust be highly educated people oh. But their belle because of wetin dem wan eat nor dey allow dem brains work well. Shebi Linus na lawyer sef. Dem forget sey even Jack delete Donald Trump tweet and nothing happen. Jack wey dey US still get mind delete Trump message and nothing happen to am, no FBI worry am. If na naija the guy dey those fish brains for don worry am tey tey.

Even the Twitter ban sef nor be like sey dem even block am well sef. My own still dey show oh small small and I neva begin use VPN sef. Nothing wey these people sabi do well sef.

Ehen, about TB Joshua sef. Una see sey death nor get respect for anybody na. Death nor send anybody oh. Once the time reach, e dey show sharp sharp.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
So my simple and straightforward conclusion be say, altcoins dey more risky to invest in than bitcoin, but the profit dey always dey higher than bitcoin's profit if one invest in the right one.

Ah you don finish work be dis, another thing person need considered na the taking of profit thing. Many people don get millions but e just dey online, I be one of those people. E get one altcoin I buy, e rise but I no dey satisfied as my target never reach. For my very before that coin show me waka, e drop like say na buhari age.

Ah, I comot cap as I dey twale for you sir, I won appreciate your response to the matter.
Wetin I get to talk for this one be say altcoins gets grades just like okirika get grades for market, grade A to grade E if i should put it that way, wetin me dey do be say, when I see altcoin wey look promising to me and buy am, or maybe I get am as reward from bounty, I go try to determine the grade wey the altcoin dey from A to E, this go help me also determine a realistic price wey I go set as my target price to sell that particular altcoin, and once it hit that price or very close to that price, I go sell am and comot eye for anything wey concern that altcoin again, but this particular strategy na for low grade altcoins.
For altcoins in grade A to C, when my sell target hit for this altcoin, I go sell am, wait for the price to come down, then I buy again and set another sell price target, just like that until I tire.
How I dey personally rank this altcoins na based on their roadmap and accomplishments so far, based on how good the team is, based on the quality of their working product and current and potential use case for the token, and lastly but not the least, number of people that's makes up the community of that altcoin.
Quote

No be like make una look market una self, see Ethereum, BNB, dot, link, uni etc dis na all coins I know when dem dey $1 but see my life na I no buy I dey dey form Bitcoin maximalist. I don tayah abeg make una show me way for the altcoins hustle even bounty self I fit drop enter any better one.

For here self dis $100 dey do me like slavery, I hate salary related things, I like when my hustle pay me like risk plenty nobi comfort zone something as I don already they feel relax and the thing dey vex me.
Bitcoin paying bounties dey very OK oooh if you ask me, cus for this kind of bounty, risk of person not getting paid is drastically reduced, and also risk of working for weeks only to end up receiving tokens worth close to shit(this na if they worth any thing at all) is drastically reduced, altcoins bounties carry all this risks but if person get luck jam better altcoin bounty, better money dey always come out, like for example, in 2017, I participate for one altcoin bounty for 3 weeks and total tokens wey I receive as payment for the 3 weeks after I convert to naira na 2.3 million naira, in 2020 also, I participate for another altcoin bounty for 4 weeks and total tokens wey I receive for that bounty after I convert to naira na 3.8 million naira.
So risk dey, but money also dey if person jam luck.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
So my simple and straightforward conclusion be say, altcoins dey more risky to invest in than bitcoin, but the profit dey always dey higher than bitcoin's profit if one invest in the right one.

Ah you don finish work be dis, another thing person need considered na the taking of profit thing. Many people don get millions but e just dey online, I be one of those people. E get one altcoin I buy, e rise but I no dey satisfied as my target never reach. For my very before that coin show me waka, e drop like say na buhari age.

No be like make una look market una self, see Ethereum, BNB, dot, link, uni etc dis na all coins I know when dem dey $1 but see my life na I no buy I dey dey form Bitcoin maximalist. I don tayah abeg make una show me way for the altcoins hustle even bounty self I fit drop enter any better one.

For here self dis $100 dey do me like slavery, I hate salary related things, I like when my hustle pay me like risk plenty nobi comfort zone something as I don already they feel relax and the thing dey vex me.
Lol, If boys dey complain boss you sef go complain? The thing na when to invest and the best time to take profit, e really matter for this altcoins trading sha. See as Sh1tcoins been print many thousands of dollars to some people during their season. Some of us just overlooked them because of capital and impatience. But lasals make BTC head correct we go know where to chuck head.

How Una dey see this suspension of twitter for Nigeria? No be threat to Our Fundamental human rights? No be democracy we dey practice again? The reading been follow the assembly before them ban am in less than 24 hours? Why the same effect never happen to kidnappers and bandits using registered SIM cards in Nigeria to solicit for ransoms?
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Men dey run am we too go run am one day.
Big Amen to this one my brother, after all, people wey dey run am no get two head, why our own go come dey different? na the thing wey most people no dey understand na im you just explain so, but then, this life na osondi owendi as late chief osadebe sing am, every body get wetin dey sweet them and wetin no dey sweet them.. But e good make we dey use our head, e dey surprise me when I see some people go use their life savings manage buy maybe upto 0.05 btc, they go hold am dey expect x1000, or dey expect to become multi millionaire from 0.05 btc in bitcoin's one up ward movement, they forget say those people wey they dey follow for Twitter wey dey tweet "buy bitcoin" almost everyday get nothing less than 10 to 20 or even more bitcoins, whereby when bitcoin go up like 5 to 10 percent in a day, they dey always see better profit.
For me and my house, na altcoin all the way oooh, atleast until I become multi millionaire, then I go see whether I fit switch to bitcoin  Grin
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
FG To Ban Twitter Operation In Nigeria; Another Set Back To Bitcoin/Crypto Information?

After President Buhari controversial tweet was deleted by Jack in what seems to be a genocide, war waving, tribal and hate speech tweet. The tweet cause plenty wahala for twitter as Twitter Ng nodey carry last come dey agitate say make Jack suspend the account of we presido as dem do to Trump account. First our president deactivate comments for all him tweets as Nigerians nodey carry last dem beginning use the "quote tweet" button dey tumble our presido with different curses wey carry weight.

As of yesterday our minister of information wey be Lai Muhammad come talk say Twitter NG go stop operation for wey country for disgracing our incompetent presido, and e no end here ooo the shamless people still come twitter to tweet about the ban for the same app  Grin. Our country na yeye.

As of yesterday #VPNs don trend for twitter as we people dey recommend both free and paid VPN for people wey no get idea should in case the ban take place by moment we go dey use VPN dey bypass....this country na cruise.

The problem now is that twitter is the fastest growing space for crypto information and now wey the ban go take place how una fit say e go take reduce crypto exposure with the current crypto restrictions in Nigeria?

Jump to: