Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 229. (Read 1031340 times)

hero member
Activity: 1288
Merit: 504
In the Northern states money still get value, even N5 wey no get value for South South still be major money for North, with N50 you go buy rice plus onions join, for North N5 onions, pepper and maggi still dey. N100 tuber of yam still dey too, house rent for self contain na 30k, 50k you go see legit one.
Omo eh, those guys no dey easy going o but life for there via money matter, na soft soft. You fit enjoy all the value way the least kobo carry. I get men them way don attest to most of the fact about this matter. Where wahala dey na always the insecurity, religious difference and the weather plus, you no fit dey groove anyhow. That one na wahala for the southerns and Westerners. The Eastern own be say, na the hustle first, the jeloffing na for the DC @December.

To talk am finish eh, na for hear being the South na em, Aboki come con wise up o. We just spoil those people finish na why, them just gum body with us finish.l except festive periods for there side.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Georgejohn go there go dey quarrel problem dey this country oo  Grin

Ah I dey backward like dis wetin sup, I no see e quarrel abi na miss I miss am, make person play me tape. Hope say the thing no serious oh. Regarding dat Kano matta, I just google, dat state tight. I been dey think say na only for election their hand strong but no know say dem tight for other area too. Kudos to dem, dey just surprise me.

Is the file too large in size, or there is a particular pixel size for image

Follow wetin Charleso talk and if the image too big after you don get that bbcode, just add width= den any size wey you wan reduced am to same thing for height. Something like dis width=50 and make sure the width dey inside bracket of the bbcode. e.g
Boss, your example no show ooh, permit me to finish am from where you stop.
This na the example wey boss mean :

Code:
 [img width=50]http://Image url[/img]
You fit also follow the above procedure to increase or reduce image height too, and again, you still fit do width and height inside the same image if e need be.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Georgejohn go there go dey quarrel problem dey this country oo  Grin

Ah I dey backward like dis wetin sup, I no see e quarrel abi na miss I miss am, make person play me tape. Hope say the thing no serious oh. Regarding dat Kano matta, I just google, dat state tight. I been dey think say na only for election their hand strong but no know say dem tight for other area too. Kudos to dem, dey just surprise me.

Is the file too large in size, or there is a particular pixel size for image

Follow wetin Charleso talk and if the image too big after you don get that bbcode, just add width= den any size wey you wan reduced am to same thing for height. Something like dis width=50 and make sure the width dey inside bracket of the bbcode.
Code:
e.g [img width=50]. ... Image link [/img]
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
How do I upload an image without getting the 'invalid image' error !!

Is the file too large in size, or there is a particular pixel size for image
There are images you no fit upload for sites like imgur, but you can upload png and jpeg. Most images are png and jpeg, you can upload ham on third-party sites like imgur and copy the bbcode link and paste ham here on your post.

This link go help you know more about it:
https://bitcointalksearch.org/topic/how-to-upload-images-on-bitcointalk-5034682


If you are above the rank of Jr.member or Copper Member, You can follow this to upload images :

1. Go to https://imgur.com/    

2. Click on New Post



3. Upload your images



Then copy/paste your image link between two img tags

You can get sth like a bitcointalk code :

∨ -> get share links -> BBcode



I hope this is helpful to beginners

jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody
How do I upload an image without getting the 'invalid image' error !!

Is the file too large in size, or there is a particular pixel size for image
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Kano is very industrious, the first in the north. But northerner dey collect any money, the ones that are dirty and not good also.

<...>
You wan buy the dip, this go make sense for short term, do not be surprise if the price go below $30000, I may not be right, but that is according to what I analyzed and I am not sentimental about it, speculating the price fit remain around $30000 or may later dip below. Before next halving, no dey surprised if you see the price around $20000 at certain point in time.

In the Northern states money still get value, even N5 wey no get value for South South still be major money for North, with N50 you go buy rice plus onions join, for North N5 onions, pepper and maggi still dey. N100 tuber of yam still dey too, house rent for self contain na 30k, 50k you go see legit one.

Georgejohn go there go dey quarrel problem dey this country oo  Grin
Things dey cheap for North but the obvious recent bad economy also dey affect them.

If na that telegram thing, I think GeorgeJohn dey right o.

Kano na the most industrial state in the country and one of the top 10 in Africa, that place nain most of these packaged foods we dey eat come out from, the state legit wella.
Lagos na the first o, Rivers State come follow, maybe Kano is the third but not certain as state like Ogun, Anambra, Abia and Oyo still go compete.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

Omor one contest I just get notifications for, so I say make I reason una incase any qualified members dey here for the community, the rules simple. You go just predict wetin you think bitcoin go be for dat day and why you think so. If u no get hundred activity or you never recieved reach 250kposa comot body as your prediction go just be waste but for people wey don get those requirements, go try try luck dat money no be small amount oh.
Nobe juju be that innondey see my name for that LoyceV list of users with at least 250 earned merits I be na my eye, abi sentiments don dey? Abeg make una help me check I no sure say that list comprises a of all the users with at least 250 earned merits  I sure say I don end more than that pass some people wey even dey the list.. Make dem get out I no even do again  Grin

wetin dey Kano self?
Kano na the most industrial state in the country and one of the top 10 in Africa, that place nain most of these packaged foods we dey eat come out from, the state legit wella.

People dey go school dat area? I hear say dis northerner region say any money nomata wetin happen to am dey acceptable, like dem no dey select money for there, how true be dis mata?.
In the Northern states money still get value, even N5 wey no get value for South South still be major money for North, with N50 you go buy rice plus onions join, for North N5 onions, pepper and maggi still dey. N100 tuber of yam still dey too, house rent for self contain na 30k, 50k you go see legit one.

Georgejohn go there go dey quarrel problem dey this country oo  Grin
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Bitcoin market be like say pump dey while altcoin is following in the price increase, recently the Bitcoin price falled below $29000 but the price come dey above $34500. I dey think even if the price go increase, the resistance still dey $40000, I dey think e may not even increase up to that level before the next fall. Bitcoin price to get to $50000 go take long time, not this time and I still believe another low is coming. Waiting you people think?

At this point, I no really get anything to talk about Bitcoin other than the fact say I still dey bullish long term for am. Whenever I check the chart this week, I just see how messy e dey. But one thing dey sure, the way bitcoin use bounce back from $28K price na just clear indication say enough buying power dey around that zone. Even microstrategy average bitcoin buy price dey mid $20K price so I know say them go fight very hard to keep the price above that level. Na why I no dey expect price to go any lower. No way to be sure other than watch market next move. My prediction na up sha.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Summer dip, December 7th Game

what will the price be on December 7th  ......  00.00 CET  December 7th "2021"

The one guessing closest to the end price of that given date..... Wins 0.077BTC from me  (⬅ winner takes that price )

-You can give your price prediction until: 10-07(July)-2021  13.00 CET

-to participate you must HAVE 250 EARNED MERIT and at least 100 ACTIVITY

Omor one contest I just get notifications for, so I say make I reason una incase any qualified members dey here for the community, the rules simple. You go just predict wetin you think bitcoin go be for dat day and why you think so. If u no get hundred activity or you never recieved reach 250kposa comot body as your prediction go just be waste but for people wey don get those requirements, go try try luck dat money no be small amount oh.

That Kano school don try, as others dey celebrate their own make I join celebrate my own too but out of context question, wetin dey Kano self? People dey go school dat area? I hear say dis northerner region say any money nomata wetin happen to am dey acceptable, like dem no dey select money for there, how true be dis mata?.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Kano school accepts cryptocurrency, asks FG to embrace digital payment
I was happy to read this news of a school in Nigeria adopting Bitcoin as a method of students paying school fee.
Oh yea that's recommendable I hope say Federal Government nogo ban or restrict the school sha, this country anything is likely to happen.


No follow the crowd, if you believe in anything just do am, we all get different path to success no allow person block your own. Dis day, I dey reason Shiba,
I get eye for that token too my mind dey there, I be don buy small I go still throw money there too, abeg all the bounties wey Hhampuz dey do make una take them serious the guy sabi better project him no dey promote anyhow projects oo... The Heven token be like dem want build their own blockchain.. I dey do the bounties with the hope of buying too.... E good to follow mind ooo nobe crown, all my bounties I sell most of them wey been get value for nothing less than $20, some I sell the stakes... I dey vex here.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Me I just dey watch I no go fit hodl bitcoin if I no get 1btc Instead I go use am invest in shitcoins and wait for 5-6 years to cash out.
Don't mean to challenge you, Engr but to save shit coins for this long time no really dey too dangerous?
Dangerous? No na for how much investment $50 abi na $100 life na risk if person must make it in life person must take risk, losing $50 or $100 Is not a big deal, most of the shitcoins wey blow today people been no reason them... When Ethereum and dogecoin was introduced to this forum many people no gre buy, the ANN was very scanty. Today people who invested are millionaires. Just invest and believe.

No be lie sha, this forum no be better place to to follow people here for investment advice, when I join crypto for 2015  been get some shitcoin like xrp, xvr etc but after my full involvement for 2017 as I come join this forum I sell all my altcoins including Ethereum, I get enough when e be around $3 but sell all and no even reason dogecoin as investment.

I just dey imagine if I still hold those coins today or even BNB wey I been dey get dem for free for Twitter giveaway wey dem dey do then like 10 10 BNB for $3 dat year if your retweet or tagged somebody for their post. I no go lie you, sometimes just do the opposite of wetin every other person dey do and you go make am.

No follow the crowd, if you believe in anything just do am, we all get different path to success no allow person block your own. Dis day, I dey reason Shiba, If any shitcoin was to become successful I strongly believe it'll be Shiba so I dey find way buy dem small small just to hold and no dey reason as an investment but throwing away small dollars, make we see how e go be.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Kano school accepts cryptocurrency, asks FG to embrace digital payment

A Kano-based school, New Oxford Science Academy, Chiranchi, has adopted cryptocurrency as means of payment of school fees. The school’s principal, Sabi’u Musa Haruna, who confirmed the development to our correspondent said the decision was taken after extensive consultations with parents. He added that it would ease the payment of school fees. “We have decided to accept cryptocurrency, as school fees, because the world is tilting towards the system. “We believe that very soon digital money will be a lot more acceptable than paper money.

According to Haruna, countries, like El-Salvador and Tanzania are already accepting cryptocurrency from parents as means of payment in their schools.

I was happy to read this news of a school in Nigeria adopting Bitcoin as a method of students paying school fee.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Me I just dey watch I no go fit hodl bitcoin if I no get 1btc Instead I go use am invest in shitcoins and wait for 5-6 years to cash out.
Don't mean to challenge you, Engr but to save shit coins for this long time no really dey too dangerous?
Dangerous? No na for how much investment $50 abi na $100 life na risk if person must make it in life person must take risk, losing $50 or $100 Is not a big deal, most of the shitcoins wey blow today people been no reason them... When Ethereum and dogecoin was introduced to this forum many people no gre buy, the ANN was very scanty. Today people who invested are millionaires. Just invest and believe.

Me dey think the price fit fall go $20000 before the next halving.
Lie lie e no no no fall below $29k again the support at $30k is too strong to fall below
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Don't mean to challenge you, Engr but to save shit coins for this long time no really dey too dangerous?
It depends on the shitcoin, some dey wey no go get value, some dey wey no go exist again, while few dey wey fit turn someone into millionaire. So, it depends on the shitcoin, the worst time for shitcoins are bear run when the market dey fall, and many still dey wey no go even rise during bull run. As for me, I like to hold Bitcoin and strong altcoins, but no be now, na when the price go fall. Me dey think the price fit fall go $20000 before the next halving.

Na true sha. The whole market done make person no really know wetin we dey do again, some shitcions done follow the bull die. No matter how much Bitcoin run for the next bull some shit coins no-go still move. Na to try find the best altcoins for market hold for body and stay put.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Don't mean to challenge you, Engr but to save shit coins for this long time no really dey too dangerous?
It depends on the shitcoin, some dey wey no go get value, some dey wey no go exist again, while few dey wey fit turn someone into millionaire. So, it depends on the shitcoin, the worst time for shitcoins are bear run when the market dey fall, and many still dey wey no go even rise during bull run. As for me, I like to hold Bitcoin and strong altcoins, but no be now, na when the price don fall. Me dey think the price fit fall go $20000 before the next halving.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Me I just dey watch I no go fit hodl bitcoin if I no get 1btc Instead I go use am invest in shitcoins and wait for 5-6 years to cash out.
Don't mean to challenge you, Engr but to save shit coins for this long time no really dey too dangerous?
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

According to the Chinese people," War brings opportunity" the same thing goes to crypto space, Bear market create billionaires " bear market is not for the weak-hearted, it takes a lot of courage to buy the dip, the bear market go crate a lot of billionaires when the bull run starts and from the past bitcoin price history we have seen bitcoin fall 50-80% in price. The rise go start between November and December when El Salvador finally finalised the adoption.

Me I just dey watch I no go fit hodl bitcoin if I no get 1btc Instead I go use am invest in shitcoins and wait for 5-6 years to cash out. I dey vex self people just dey cash out Airdrop of 3-4 years ago, meanwhile none of my own even get any value, most of them are dumped, I just pack shitcoins like Okrika market.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
The bitcoin matter for now eh, e tire everybody but, na from now we dey take know or determine who go be bigman tomorrow. Bitcoin price now na watin go teach person how to dey patient, person way no dey patient on go fit survive make anything out of crypto with this thing way bitcoin dey do now.
I remember when all these bullrun start, e hit me say, the value of small sat way I sell for the least $10 rise from $10 to about $90. The thing weak me like this eh but, I believe say I no bin get choice for the matter via say, na when you need money you go sell. Now like this eh, the bullrun don open person eye say, this business na to hodl. For market to go back $50000 no go be today but when e go enter there, na speed e go carry pass am and na people way hodl go enjoy am. Na the patience we need now.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Bitcoin market be like say pump dey while altcoin is following in the price increase, recently the Bitcoin price falled below $29000 but the price come dey above $34500. I dey think even if the price go increase, the resistance still dey $40000, I dey think e may not even increase up to that level before the next fall. Bitcoin price to get to $50000 go take long time, not this time and I still believe another low is coming. Waiting you people think?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
That idiot John McAfee killed ESH kpatakpata. I follow people wey lose betta cash. ESH na betta project wey for do well only sey d developer wey be Josh trusted  McAfee and allowed d guy run promo for am to airdrop GHOST coin. After the airdrop na so ESH dive begin find crude oil for ground. Na long story, anyway. But I read for Twitter sey something dey fishy about the death. In fact, after dem announce sey im die his IG account make post wey be just "Q". And some dude talk sey McAfee follow am for Twitter. I see the tweet too.
So sorry about the loss, na so crypto be, new projects are also still very risky to go for, though I do not know much about the coin you are talking about. About the death of McAfee, I think some people are thinking he killed himself, some people even think maybe it is fake by making deals with the prison officials, these will all be the rumours going on for now.
Jump to: