Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 230. (Read 1031340 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
That idiot John McAfee killed ESH kpatakpata. I follow people wey lose betta cash. ESH na betta project wey for do well only sey d developer wey be Josh trusted  McAfee and allowed d guy run promo for am to airdrop GHOST coin. After the airdrop na so ESH dive begin find crude oil for ground. Na long story, anyway. But I read for Twitter sey something dey fishy about the death. In fact, after dem announce sey im die his IG account make post wey be just "Q". And some dude talk sey McAfee follow am for Twitter. I see the tweet too.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
OUR ONCE CRYPTO SHILLER, MR JOHN MCAFEE IS DEAD....

Nice one sapa, I been dey come update group self as I just dey see the news, make I no lie sha, I pity for the guy. No nata wetin e do the crypto market with all e shilling something wey Elon dey do now but dat one na only doge and Bitcoin been e problem unlike Mr John wey tumble the whole coins. Just say e mention your coin name, e go dey do 100% plus. That year ehh people make money die but the bear come collect all back anyway my his soul RIP.

To our broads dem wey win award, I join the family celebrate una, more wins to come. Make una just keep una head straight and avoid any reason dem go begin dey attack una. Everybody dey win so the family go dey alright. We dey make name small small, very soon na wey go run d show for here.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
OUR ONCE CRYPTO SHILLER, MR JOHN MCAFEE IS DEAD....



https://bitcointalksearch.org/topic/m.57303565
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I think una see as Buhari dey take style enter 18-yard box. But e nor go work for am and his cabinet. 🧐
Don not t believe any news from Sahara reporters most of their news na fake, na the most corrupt news platform for we country, there was never a time Buhari proposed anything like this, my brother the government is shit Yes we know but make we try dey avoid that Sahara reporters platform dem na anti-Buhari. No time wey the government talk say dem go ban Facebook, Instagram or any other social media platforms. Even the Twitter ban they are working towards to get Nigeria back on board again.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I think una see as Buhari dey take style enter 18-yard box. But e nor go work for am and his cabinet. 🧐

legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Remarkable Achievement For The Nigerian Community



My pipo I cum with another wondaful tori wey go cooly our heart I know say e no too big but Aso rock was not built in a day na small small. Congratulations to @Bit-BINDER for winning the remarkable award and for achieving the Hero Rank, you are indeed a good man and we wish to see more of you on the local board. And also I want to congratulate my humble self on winning the Award and a prize of 100 merits.
Won take this time out to say a big congratulations to you guys for this remarkable and incredible achievement, e no easy ooh, and for una to take this kind of honor mean say una really work hard, congratulations again, this go serve as encouragement for we wey still dey struggle to get to the level where we fit take the next step on the ladder, thanks to you all for making our dear Nigerian community here proud, God go continue to move us from glory to glory.. Amen
God almighty bless us all.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
50 is max you can send to an individual in a month so he owes me and the rest people another 50 merits to make it 100... Either way I'm thankful baba
Omo, anybody way still believe say we naija no dey try or dey do something fir this forum eh, e be like something dey do them. But my G, how e be way you still believe say the guy dey owe you more 50 na, e weak me just now o. Una try shah, e shock me when I confirm am, no be chaise. Just like that, paddiman don boost measure boosting. Na so e suppose be some kind times and e sweet my belle now say 2 persons from here collect watin no good plenty... hehe hehe
I sure say, next time, na so many of us go run go show face to collect una own. Make una try remind me make I hold una fir hand o. We dey together for the struggle.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
My guys wey win award @ igehh, @ BIT-BENDER I throway salute and congratulations to you guys. This na gud tin to see and e go make lower ranks to put effort even as igehh talk. I wish una more good tidings as I sabi say una go last last no how e dey go. No be juju, even blind man sabi say una don try.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
50 is max you can send to an individual in a month so he owes me and the rest people another 50 merits to make it 100... Either way I'm thankful baba
Anyhow e go be, but congrats.

Lol you no talk lie bro na small small we go hit the Hero milestone then I go retire leave the forum for una as I be don talk Sam before..make we rest small make the up comings enjoy too.
If you dey post good dey go, your merit go dey increase because say people go always merit good posts. I dey see some members wey no dey spend much time for here but their merit dey increase, all needed na to dey make quality posts.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
And also I want to congratulate my humble self on winning the Award and a prize of 100 merits.
You were awarded 50 merits, not 100. Congratulations! Surely one day you will be a hero member, certainly. Probably, this year.  I hope the thread will still be opened for others to participate, as indicated by the OP in the next 30 days?
50 is max you can send to an individual in a month so he owes me and the rest people another 50 merits to make it 100... Either way I'm thankful baba


Lol you no talk lie bro na small small we go hit the Hero milestone then I go retire leave the forum for una as I be don talk Sam before..make we rest small make the up comings enjoy too.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@BIT-BENDER & @igehhh, I jollificate with both of una. I wish sey dat Igeeh own sef land am for Hero too. Una try. If na for Naija sch now una go don spend up to 4years (dat is if ASUU not go on strike at all) to get dat certificate with betta sorting oh and intimidations from lecturers too. But here, na free knowledge we dey gather unto pay oh. Na attention dey pay us here unlike for school wey na we dey pay attention 🤔. BIT-BENDER, I dey come join you soon for dat Hero class. Make una enjoy.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Remarkable Achievement For The Nigerian Community



My pipo I cum with another wondaful tori wey go cooly our heart I know say e no too big but Aso rock was not built in a day na small small. Congratulations to @Bit-BINDER for winning the remarkable award and for achieving the Hero Rank, you are indeed a good man and we wish to see more of you on the local board. And also I want to congratulate my humble self on winning the Award and a prize of 100 merits.
Thank you guys so much, I really appreciate to be part of a Nigerian community in a wonderful forum like this makes it even sweeter.
And I thank everyone here for being purposeful and am see everyone here is try there best for a better forum and this is giving Nigeria a better name, as our government are not making things easy, we don't have to cry but try to use all our resources in the places to propel the name Nigeria onwards, I encourage any struggling, low rank, or anyone thinking of giving up to keep on striving your best is still on the way.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
And also I want to congratulate my humble self on winning the Award and a prize of 100 merits.
You were awarded 50 merits, not 100. Congratulations! Surely one day you will be a hero member, certainly. Probably, this year.  I hope the thread will still be opened for others to participate, as indicated by the OP in the next 30 days?
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Remarkable Achievement For The Nigerian Community



My pipo I cum with another wondaful tori wey go cooly our heart I know say e no too big but Aso rock was not built in a day na small small. Congratulations to @Bit-BINDER for winning the remarkable award and for achieving the Hero Rank, you are indeed a good man and we wish to see more of you on the local board. And also I want to congratulate my humble self on winning the Award and a prize of 100 merits.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
This one na real matter shah. Me no been even believe say, the correction go reach the low way e drop reach but the next matter way come board na say, e no only drop reach that way but, e con dey maintain that range till kow, ah ah! And na so almost all the alt them join body.

As man way dey live money for coin via say, na the business and life we dey live, person mo ey just dey half anyhow, e tire me. No be play o but, all this one na to test person endurance and me I ready for this one. Anyhow e be, I go wait a out make I no con dey regret like say, I no been know before say na so the market be normally. This one now na to test patience and I go buy patience full basket.

I no go lie you bro. E tire me to always go back to my wallet and the the value of my tokens don diminish to a bare minimum. Coins like BNB and eth don even go classic 50% dump. That's more than half of person holding. Regardless of market correction, I believe say reversal dey very close. E no go dey too long now, I mean, If you look how much institutional investors dey in the business already and that correction been somehow dey expected. Also point no dey to sell now for person wey no sell earlier when price still dey at the top.

~Snipped
I think so too, that is just bitcoin, bull and bear market. What I am just thinking is that the highest price may not be more than $60000 (I mean less than $60000) again until next halving but the dip may still be less than $30000.

I for like argue this your bias but I no be top trader to be able to make valid analysis but I no think say bitcoin go dump like people dey expect without a full fledged bear market.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
E get whitie way yarn say, Nigerians no fit get local board via say, na the English wedey yarn. So, I no just know how e wan be via say, the criteria cef, we no sure.
First of, no be Theymos talk ham, no be admin wey talk ham, not be any Bitcointalk.org staff wey talk ham, na just a member wey talk ham. I never tay for this forum, but I know some occurrences. The first issue wey we get na because say na Africa board we wanted, but later we make a conclusion underneath say make we change ham to Nigeria as per say na we Nigerians dey here. Later I remembered the day I made a suggestion with Brainboss say make we even change the language to Pidgin, but I thought that no go mean say at least some of our posts no go be for English until I dey see ham recently when people wan dey attack English posters.

We proposed for local board, I know the legendary guy wey talk ham say na English we dey speak, that Pidgin go help, but na just a member (although highly ranked, my respect) wey talk ham, no be admin, no be staff. I still dey maintain my stance on this 'that na activities' we need, we fit dey communicate in any language we want. If we dey communicate for Pidgin and no English, it can result to some setback for us later. I gave all my valid reasons which I believe would help us in the long run. If no reasons dey, that go be different case.

Make we no even get the mind set say we want local board, let us just dey post and be helping one another for here, if we go get local board, not should be what we go dey haste about. Let us just be real and contribute good posts here, and most especially, helping one another here with quality posts. I have seen many valid reasonable questions that fit here but on Telegram group, we need to change our orientation, that is why this thread is existing, to ask quality/genuine questions and to contribute quality posts. If I no go lie you, Bitcointalk is even my social media, I like it here than any other place.

Make we give BTC more time and everything go stew before the end of the year.
I think so too, that is just bitcoin, bull and bear market. What I am just thinking is that the highest price may not be more than $60000 (I mean less than $60000) again until next halving but the dip may still be less than $30000.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
~Snipped
~Snipped
Onto another mata, how una dey see the market, wetin una dey predict. Bitcoin don try many times to break out but e no dey sure for am. Una tink say we dey enta bear or make we just give btc small time more.

For my own opinion, I still maintain my earlier argument say bitcoin never reach the top yet regardless of the current market conditions wey make all crypto coins and tokens to dey on red mode. But I go like acknowledge the fact say the correction don dey last longer than I been expect. I been dey expect say bitcoin suppose don recover go $50000+ zones but every time e try to break those resistance, e go just break down back to $31K to $40k range. So wetin be my conclusion now?

Make we give BTC more time and everything go stew before the end of the year.
This one na real matter shah. Me no been even believe say, the correction go reach the low way e drop reach but the next matter way come board na say, e no only drop reach that way but, e con dey maintain that range till kow, ah ah! And na so almost all the alt them join body.

As man way dey live money for coin via say, na the business and life we dey live, person mo ey just dey half anyhow, e tire me. No be play o but, all this one na to test person endurance and me I ready for this one. Anyhow e be, I go wait a out make I no con dey regret like say, I no been know before say na so the market be normally. This one now na to test patience and I go buy patience full basket.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
~Snipped
~Snipped
Onto another mata, how una dey see the market, wetin una dey predict. Bitcoin don try many times to break out but e no dey sure for am. Una tink say we dey enta bear or make we just give btc small time more.

For my own opinion, I still maintain my earlier argument say bitcoin never reach the top yet regardless of the current market conditions wey make all crypto coins and tokens to dey on red mode. But I go like acknowledge the fact say the correction don dey last longer than I been expect. I been dey expect say bitcoin suppose don recover go $50000+ zones but every time e try to break those resistance, e go just break down back to $31K to $40k range. So wetin be my conclusion now?

Make we give BTC more time and everything go stew before the end of the year.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
On the local board matter way Charlie dey talk eh, we don try and I clap for una way day active for the small corner we hold for hand first. If e bee say, na the pighin we dey try promote dey turn hindrance on our progress for the matter, na to try another means be that. Though, we never still know the criteria for local board something. For the application way we been drop for meta, e be like na Charlie been create that thread. E get whitie way yarn say, Nigerians no fit get local board via say, na the English wedey yarn. So, I no just know how e wan be via say, the criteria cef, we no sure.

Charlie talk about turn up for pages so, make we try am. If na the English go help, make we join mouth dey drop talk though, the whole essence of local board na say, make person for fit cap on code. Though, the main idea now na to get am first so, make we do watin them want.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December not feasible for CBN digital currency launch – Experts

The CBN made an announcement recently about the launch of digital Naira before the end of this year, but economist and the Chairman, Chartered Institute of Bankers of Nigeria, Abuja Branch, Prof. Uche Uwaleke, told our correspondent  that the level of the country’s economic development among other financial concerns makes the launch of a CBN digital currency before the end of the year unfeasible.

Waiting you people think about this? If you read the news in details, there are good points how CBN can not be able to launch digital naira in haste. Even digital Yuan has been a long term project now while also USA has declared their move to launch digital Dollar long time ago last year IIRC. Me too dey think why the rush, I think CBN do not have to be in rush to launch digital Naira. Waiting you people think about this?


You can read the interesting news using this link:
https://punchng.com/december-not-feasible-for-cbn-digital-currency-launch-experts/
Jump to: