Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 237. (Read 1031926 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no dey too use Konga I think I don't really like their products e time wey I been compare their prices Konga market cost pass Jumia own even their shipping fees too so ever since na jumia I dey like shop anytime I want do online shopping sha.
I know say konga shipping fee take 250 naira pass Jumia shipping fee before, I dey talk of the time when the the fee na 1250 naira for Konga and 1000 naira for Jumia, but e don long I order, so I no know the price again. I no dey sure about Jumia, but there was a time before when if I wan order five products for Konga, only 1 shipping fee they will take, but now na the whole five item shipping fee they go take now, one of the reason I no dey use online mall unlike before, I don't know if Jumia dey work like that.

I dey check the two sites, e just be like say Jumia get product pass Konga but that no mean Konga no get almost all people wan buy, but I like the kind service Konga dey give me pass Jumia. Another thing about Jumia why I no use them again be say you can order for blue, they go bring green, Konga never do ham for me before.

About products price, it depends. I no wan use smart watch compare the price, but you fit take look of the hardware wallet I posted recently. At times, konga product go dey cheap while at times Jumia product go dey cheap. But I noticed Jumia product always dey cheap often pass Konga sa, but I dey believe the authenticity of Konga product, and the fee difference not that much.

     


     
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
~Snipped

Kudos to you bro for translating for the community. You only translate am but na still serious work go into am. Well done.
Thank u for the time carry read I appreciate baba na u do pass..one love

Thank u baba u toomuch


so I prefer to make use of Konga, I can even easily be able to get the phone number of sellers directly on Konga which I can call to make the delivery as fast as possible, Konga store has been the best for me.
I no dey too use Konga I think I don't really like their products e time wey I been compare their prices Konga market cost pass Jumia own even their shipping fees too so ever since na jumia I dey like shop anytime I want do online shopping sha.


Please, try to check the last link you posted, I think it needs correction. Or, is the fault from my end?
Fixed
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
E show how we imitate rice wey dey on top fia as na by coperation dem dey take full pot. Kudos, all man!
You eh, you sabi get talk for mouth, lol. Na community we be and na so e suppose dey kwa. This one na em show say, our bond strong and say, we really value ourselves for here. No matter say, person pour abi e no pour you water, give you update or not, we still know say, na hustling we come do and the people say we come to know for this foreign 0lace and hustle, na our people. E go well.

This thing una do so, na only Oluwa fit equate am and even within ourselves cef, we no go dey fear issue again. E goes well, make we hustle dey gi front because, life really goes on.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Nice translation. I have bought a smart watch like that before when I helped a friend to ordered it using my Konga account, Jumia in Nigeria is one of the online stores to buy this type of smart watch, but Jumia has been really disappointed me before, so I prefer to make use of Konga, I can even easily be able to get the phone number of sellers directly on Konga which I can call to make the delivery as fast as possible, Konga store has been the best for me.

About the smart watch, it do has a Bluetooth it uses to get notifications from mobile phones, notification like text messages, email messages, WhatsApp messages and messages from Telegram and the likes. It will be perfect to receive notification from Bitcointalk through Telegram bot.

Please, try to check the last link you posted, I think it needs correction. Or, is the fault from my end?
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
~Snipped

Kudos to you bro for translating for the community. You only translate am but na still serious work go into am. Well done.

I hope say everybody dey fine? Market don recover small and relief rally dey in place. I hope say we all still dey and didn't sell our BTC at loss. Bull market never end and that dump na just another correction but very powerful one at that. No big news about crypto for Nigeria so far except the fact say USDT/NGN dey hit all time high on a steady steady. Lol  Wink we still dey wait to know how the progress of the donations for our deceased brother.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Charles, Engineer Igeeh and Smart virus una try wella. Dis matta come show sey we nor dey for dem shoot bird, im mama com fly. Owa coordination na die be dat. We talk am, and we achieve am. E show how we imitate rice wey dey on top fia as na by coperation dem dey take full pot. Kudos, all man!
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
<>
I no sure say I sabi you for here but the fact say, you cum con pay attention to the matter way been dey on affect us for here mean say, you na better and confirm naija and e go sure say, you go dey shuck body for our matter and corner wella.
As many as all of una way join body to help us archive this mile stone way we don do so. You fit imagine the smile way go dwy Becky666 Widowed family face and how the money go help the family. All of una don try wella and as such, we don sell ourselves here kwa say, we no be people way just come make money waka but, people way despite watin we dey do, carry a sense of duty and responsibility for our brother and sister for here because, we be one and na so e suppose be. I clap hand for una, weldone.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Full member needed in Roobet signature campaign. You can read the rules and requirements. If you are qualified, then it will be good to apply.

Roobet.com Signature Campaign | The Honest Online Casino | Full Members+

Good Luck.

<...>
Thanks for the compliment. Will be good seeing you around.
member
Activity: 267
Merit: 11
Ooh my God!! Becky666 what a tragedy! May your soul rest in peace Amen oooo. He is one of the people that welcome me here the day I introduced myself here and he even gave me two merit. What a tragedy!! May God console your immediate family. My people una weldone for the show of love, those who dey behind this donation may God raise people for you when you have no power to do for yourself in the Holy name of Jesus! Amen. Rest in peace Brother. May we never record this kind of incident here again till our old age when we have retired from this Forum.

I remove Cap for:
BrainBoss
Charles-Tim
igehhh
Smartvirus
Upgrade00
Posi
Mpamaegbu
Lordhermes
gabbie2010
Gozie51
Josefjix
nelson4lov

And many other that I may not be  able to mention here Na only God go bless unaooo!
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Payment update

We don convert the donated amount into Naira.

Smartvirus received 187,630 naira

igehhh received 169,290.naira

Charles-Tim received 79,900 naira in total.

436,820 naira in total.


Well done Charles-Tim for the periodic updates since we been assign you as one of the few selected persons to receive funds on behalf of our growing community. You too much bro. I go dey look forward to an update wey go yarn us about how the waka for the money to reach Becky666 people go go. Kudos to everyone wey contribute and those wey support in one way or another. God go bless us all.
~Snipped

You too much my chief. No problem about the delay, things like that dey happen. Even me I no dey dey available for 24hrs. Thank you too for keeping the whole donation organized and straightforward.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Payment update

We don convert the donated amount into Naira.

Smartvirus received 187,630 naira

igehhh received 169,290.naira

Charles-Tim received 79,900 naira in total.

436,820 naira in total.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
My people I greet una o, before I talk anything for here, make I first apologise for delayed response via say, e get matter way i dey run like this and the program follow say, I get limited access to phone  and even to charge phone cef na wahala. Those way close to me go know the matter. Again, I go like commend all of una, me inclusive this time, way try drop something for our brother Becky666 left behind. Una don do very well and na only God go reward you for this helping hand way una lend so. At least Becky666, anywhere way en dey, e go dey smile in death knowing that, en people no disgrace am.

For the account way I dey handle via our brother matter, I received:

Rollbit donation = 0.0105BTC (TRX ID: 4aea7db2b28a5149f1d09c122ca2f2d968aa63c1c841986f223e9661f59599fc)
Transferred to an exchange at the and got a balance = 0.0104BTC (TRX ID: d8736bed484ee8ec834b1835837615ff95e7aba9337f2702e1a7003a38b04c1a)
Fee on transaction was = 11100sat
Swapped 0.0104BTC = 381USDT
Sold for NGN rate at #491
I hold in my local bank account #187,630.18


I thank una for this honour and trust way una give me, I dey very grateful. Na una United decision i dey wait so. Once again, my apologies and sincere gratitude.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Altcoin Discussion

The presales is over all token sold under 50mins I miss the opportunity to signup I no get the information on time, another opportunity now na to join this 3 weeks bounty I see dis project as legit cash out den dey operate on binance smart chain...i go like make una join the campaign or do the farm with at least $50 leave am for 2 years.

Bounty Link: RushMoon 🚀 | Automatic Liquidity Acquisition Yield Farm & AMM BSC

Duration : 3 weeks

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Full member needed in Rollbit signature campaign. You can read the rules and requirements. If you are qualified, then it will be good to apply.

Rollbit.com | Signature Campaign | Full Members+ ~ Earn up to $80/Week!

Good Luck.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Update about those that paid

Total USDT donated: 342
Igehhh, please convert the coins wey dey with you to naira, use good exchange rate o. After you don do ham, post us the naira amount here for the next update.
Una well done sorry for the last response last night I no sleep on time I been dey do one or two things so my brothers I don convert am as we discussed.

I traded the coin (342 USDT) at N495 na de best I see be dat as of the time I traded my Usdt on this record I'm hodling the naira in my account as I dey type so.

342 USDT = 169,290
Igehhh is officially hodling N169, 290.0 kobo
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Update about those that paid

This no be the final update about payment as we still go convert to naira but na the final update about those that paid. But, if you think say you still wan pay before the final update about payment, you can still pay in naira before we make the final conclusion of the bank account we wan transfer the money too. But, know say payment in Bitcoin and Tether no dey valid again as we go convert both to naira today, but you fit still haste pay into Charles-Tim bank account before Smartvirus, Igehhh and Charles-Tim are given go ahead to pay into Becky family's account number, make sure say you post about your payment for here, or you can message me for me to post about it for transparency.

Smartvirus
BTC: bc1q8mvnr3actrxn97v3pxn28tly9yu0yw5mpvxhts

igehhh
USDT (TRC20): TP4kLhXxQwy1MppaSSQPyi2vyeeK1YC83p (TRC20)

Charles-Tim bank account details
GTBank (please, make sure it is Guarantee Trust Bank)
0049732936
PM me (Charles-Tim) if you think the account name is necessary.

Bitcoin
1. Rollbit team: 0.01058000 BTC

Total BTC donated: 0.01058000

USDT (TRC20)
1. posi: 18.57 + 12 (30.57)  USDT
2. Mpamaegbu: $12
3. Anonymous: 300 USDT

Total USDT donated: 342

Naira
1. Josefjix: 9,900 naira
2. Lordhermes: 6,000 naira
3. nelson4lov: 10,000 naira
4. Charles-Tim: 10,000 naira
5. Igehh: 6,000 naira
6. Gozie51: 5,000 naira
7. CryptopreneurBrainboss: 12,000 naira
8. gabbie2010: 6,000 naira
9. Upgrade00: 10,000 naira
10. Smartvirus: 5,000 naira

Total naira donated= 79,900 naira

Total BTC donated: 0.01058000
Total USDT donated: 342
Total naira donated= 79,900 naira


Smartvirus and Igehhh, please convert the coins wey dey with you to naira, use good exchange rate o. After you don do ham, post us the naira amount here for the next update.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
The reason wey dey make alts dem dey crash pass be sey people nor too trust dem. Nothing more. We sabi sey Bitcoin must eva rise back by fia by force once im craze touch naked wire.

Wetin happen to altcoins be say since Bitcoin been touch that $62k all time high, altcoins don really outperform am and the dominance don drop very well from that 70%+ e be when the bull run start. So as the crash happen, Bitcoin don reclaim some of the market share now.  Bitcoin go still rise back because I strongly believe say we never reach the end of the bull run for now - $70K to $100k still dey in the picture. Anybody wey wan buy bitcoin now fit use DCA to buy so that the overall average price no go dey high. Make we see if by next week, market go recover.
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
My contri people I salute una for the massive financial support wey una give becky666 bereaved family God go bless una well well, when I come peep through this thread and I saw the deadline by Oga Charles I come check My bank account the thing come dry na im I quickly go organise cash chap chap go POS make dem transfer into my account, when I  see the contributions wey una make my head swell say we still get better and caring people for this countri una weldone o I salute una for dis kind gesture make una dey represent here well.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

  • either the money in naira will be transferred to Charles-Tim, while Charles-Tim go transfer the money to Becky666 family.
  • or Smartvirus, Igehhh and Charles-Tim go individually transfer the fund to Becky666 family.
For the sake of transparency I go for the second option make we give the capacity to the holders of the money make dem disburse am come give us report here in that way de oyibo dem wey dey follow us go confirm say true true dis men for here mean wetin den been talk.

I know say wetin I want talk now fit upset una but I still dey feel say this amount we don gather so for fit save Becky666 life because I know say 59% of death in Nigeria na money dey cause am but we no go share the blame cus say Becky no tell us the condition of the illness and secondly him no seek for financial assistance.

Abeg my family our contribution nobe only for funerals oo God4bid, una wey dey go through some illness or something wey go need hand u fit still let us know we go try our best... If u get girl u want fck u no get money too we fit support too any way na way oooo... Una weldone.
Jump to: