Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 234. (Read 1031636 times)

legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<••>
I dey see you well well for altcoin board, no be lie, your talk for here make sense, e be like you bag plenty money from student coin haha, as you create thread on them, na altcoin block dey no be Bitcoin, me never hodl bitcoin ever since I notice say na 1 or 0.5 btc go give you major block,

Haha, leave that student coin matter oga mi, student coin fall their bounty hunters hand big time, na just say me no dey attach emotion to business, if not, I for don vex sell all the stc wey I buy and join bounty hunters wey dey call them scam even when I know say the project no be scam, imagine student coin team say dey go pay bounty hunters 200 million stc for 12 weeks, that's 3 months of work, me happy say atleast no matter how e bad reach, I go make small money from the bounty, I leave better project wey I be dey promote go join student coin bounty, work for good 12 weeks, help in our little way, we help them raise 70 million dollars for their ICO, at the end of the day, dey turn say bounty hunters no do any work, for that, they no fit pay 200 million again, total converted stc wey they later distribute for hunters no reach 500,000 stc  out of 200 million, the matter pain me die but wetin man go do, I just have to let it go.

Quote

Na recently I start to dey enter altcoin board again after when scam bounties no deliver me around 2018-2109.
Wetin I notice be say, better project no dey do bounties again on bitcointalk, you go just see strange project go just enter Binance from nowhere.
I totally agree with you, most projects nowadays, most especially the projects wey their developers get money no dey do bounties again, even if some still dey do, you go notice say most of them no dey include signature campaign again.
My prayer be say make God help me(us) make i(we) make better money so i(we) fit stop bounty hunting before light switch off 😁😁
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
All this coin una dey discover cef, e no dey fear una. You go just see something con believe say, e go sure for you, na safe moon abi one of the moon them way Brainboss display say, them dey even dey proud say them don scam person finish and nothing person fit do them, chaii. This life no be play o. The crypto space too dangerous guy. Anyhow shah, na the life we choose to life and na 99% consciousness we dey use run am. Make una try, me and altcoin matter, e be as e get. Though, e dey wayh when men them hit hard o. Like that Solana, that update weak me! Una dey try

Lol. Na so e be. The truth be say, if we no dey ready to take risks then e go dey difficult to make good profits for this crypto market. If na person wey dey always fear to remove money take risks, then the possibility of making money via altcoins dey very low. Plenty gains dey for altcoins but the same way gains plenty, na same way risks plenty as well. So e dey like 50/50 chance but based on my personal experience, I go say e worth am. Investing altcoins dey super risky which is why experts dey always suggest using spare cash or money we no go too dey upset or pained abi we lose.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
So my simple and straightforward conclusion be say, altcoins dey more risky to invest in than bitcoin, but the profit dey always dey higher than bitcoin's profit if one invest in the right one.
Baba you no talk lie I dey always tell people say any coin or token you no get reach 1 or more make you leave am cus you no go ever get any better profit no matter how long you hodl am, e better say person get plenty worthless shitcoins and hope say e go better in the next 3-5 years than to hold 0.003 bitcoin for 10 years. Like some of my shitcoin I hodl like 2M token for some just imagine say one day e hit $1 no be $2m I don make so? Men dey run am we too go run am one day.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
<••>
I dey see you well well for altcoin board, no be lie, your talk for here make sense, e be like you bag plenty money from student coin haha, as you create thread on them, na altcoin block dey no be Bitcoin, me never hodl bitcoin ever since I notice say na 1 or 0.5 btc go give you major block,

Na recently I start to dey enter altcoin board again after when scam bounties no deliver me around 2018-2109.
Wetin I notice be say, better project no dey do bounties again on bitcointalk, you go just see strange project go just enter Binance from nowhere.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I tell you cus from what I know any project wey be like e go get potential no dey get any potential at all, na those ones wey person no too psut mind dey bring person money las las,
Me i wan know because, for now, altcoin no really he my thing, no be say I no get patience o or I dey fear but then, I no just sabi utilise am and I need small touch lighting for that way shah.
To be sincere with you brother, people talk say na where a wise man hand reach n, na Im he dey hang him bag, so wetin I dey try talk be say, me myself, I be altcoiner, ever since bitcoin enter 3k$ and above, I never touch am, though no be say na the price pursue me ooh, wetin pursue me from bitcoin na when the transaction cost con to dey high, I con decide to clear road for bitcoin, I jump enter Ethereum, from Ethereum, I begin earn and buy erc20 tokens and na so my altcoin journey start.
To cut the matter short, altcoin fit change your life for good, but this na if you enter the right one early enough, (notice say two things wey I join together, "the right one" & "early enough"), though investing in altcoins dey always come with a higher risk than investing in bitcoin alone, but the thing be say, if God help person jam the legitimate ones and you enter it early,  that person go make money far more than wetin he fit make with bitcoin.
So my simple and straightforward conclusion be say, altcoins dey more risky to invest in than bitcoin, but the profit dey always dey higher than bitcoin's profit if one invest in the right one.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I tell you cus from what I know any project wey be like e go get potential no dey get any potential at all, na those ones wey person no too psut mind dey bring person money las las,
Talk dey here o and e ring me for ear wella. The thing be say, na the team way dey behind project dey be the project and the matter way the project come up to tackle if, e dey unique for the crypto space but then, how person wan take dey know all this small small detail like the team way dey behind project, how you wan carry know how serious way them be because, na matter be that o. I get plan, I get plan no be plan o. Anything way never activate e dey be as e get but then, na when e never activate way person dey get chance to benefit pass. So, e be like the matter fall back to the risk way person take.

At least, before you take any risk, you go first calculate am and no be as body sweet you reach so, how una dey access una own abi na altcoin discussion matter una dey use correlate? Me i wan know because, for now, altcoin no really he my thing, no be say I no get patience o or I dey fear but then, I no just sabi utilise am and I need small touch lighting for that way shah.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Add Cartesi to ya list oh. I talk about am here last year when dat token dey less than 4cents. But e dey around 70cents now.

You are right on point. i dump that token when the price was around 5cents. thinking there was no market. today my eyes don open and i don see the direction where it is heading. the project is heading towards the right direction and might moon to over 2 dollars sooner or later.
Haaba! Wetin be $2? Na speed e go take zoom pass day level wen e set. Just dey watch. Nor forget sey e enta $1.7 ATH some weeks ago oh. Dat token go do pass $5. In fact na Theta token me dey take compare am with. And right now Theta dey around $7+ afta e don do $15+ sef. Just check dat CTSI roadmap and programmes, yousef go know sey dem nor com play. Dem mean serious business. Na only time e go take dem before dem reach where dem dey go.
member
Activity: 175
Merit: 10
ITSMYNE
Btw, how Una dey survive this bear so?
The bear rally neva start oh. If you dey see wetin dey happen na as bear market na im be sey you go shrink oh wen d real blood begin flow for dance floor. Make you ask those wey witness 2018/19 na.

I dey consider buy some top coins wey don correct well well like Algorand, Tezos and NEAR tokens.  
Add Cartesi to ya list oh. I talk about am here last year when dat token dey less than 4cents. But e dey around 70cents now.

You are right on point. i dump that token when the price was around 5cents. thinking there was no market. today my eyes don open and i don see the direction where it is heading. the project is heading towards the right direction and might moon to over 2 dollars sooner or later.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
<....>
Me no wan waste time dey check on projects again, any one wey do like say them go blow,I dey enter two seconds.
I tell you cus from what I know any project wey be like e go get potential no dey get any potential at all, na those ones wey person no too psut mind dey bring person money las las, every tin for life na risk. One thing I know be say coin wey get potential node too get plenty awareness or supports till they are listed.

All this coin una dey discover cef, e no dey fear una. You go just see something con believe say, e go sure for you,
Baba life no dey two ooo anything you believe in just do am comot mind nobody knows tomorrow, when Bitcoin come out na so. People been bad mouth am too, people wey take the risk are millionaires today.
jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody

Aboy, na him be dat. Dem dey develop their own decentralized swap exchange wey dey call am Shibaswap.

Omoh exchange ko come de plenty pass tokens!! Plenty lyk dis get very small trading volume, but de tinq be say dia returns de make sense for staking, but I no know whether na legit, or them just put am like that as furniture
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
All this coin una dey discover cef, e no dey fear una. You go just see something con believe say, e go sure for you, na safe moon abi one of the moon them way Brainboss display say, them dey even dey proud say them don scam person finish and nothing person fit do them, chaii. This life no be play o. The crypto space too dangerous guy. Anyhow shah, na the life we choose to life and na 99% consciousness we dey use run am. Make una try, me and altcoin matter, e be as e get. Though, e dey wayh when men them hit hard o. Like that Solana, that update weak me! Una dey try
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
this kind coin go take time to blow. Looking at the current price e fit take about 10 years to hit $1.
Na the same tin wey person talk for this thread , along the way, them dey complain say SHIBA no fit reach $1 cos of him large market supply. The thing be say as long as Binance don secure him place for their market, the possibility to give block dey okay, no be lie.

Na now I dey hear about shibaSwap like this sef, if na so then, e go blow, I no doubt am. SHIBA already get name for the space well well, them get correct community support and na the greatest tin a project suppose get. Me no wan waste time dey check on projects again, any one wey do like say them go blow,I dey enter two seconds.
Haha, better dey careful dey enter, I go advice make you better dey do your own research before you go the enter any coin wey show signs say e won blow, cus If you never know, no be only human being dey set trap ooh, even bear know how to set bull trap, if something look like say e go up and people without researching fomo in on top am, and later, the thing come dey go down, n eem we dey call bull trap oooh.
And talking of Shiba, no go dey day dream, even with Shibaswap, no go dey think say you go sell Shiba for 1$ anytime soon ooo, even in the next 5 years, I no think say Shiba go don reach 0.01$ not to talk of 1$. So conclusion be say make you no get me wrong, I no dey talk say 1$ for Shiba no dey possible, but e go take a very long time, atleast make dogecoin reach 1$ first.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
this kind coin go take time to blow. Looking at the current price e fit take about 10 years to hit $1.
Na the same tin wey person talk for this thread , along the way, them dey complain say SHIBA no fit reach $1 cos of him large market supply. The thing be say as long as Binance don secure him place for their market, the possibility to give block dey okay, no be lie.

Na now I dey hear about shibaSwap like this sef, if na so then, e go blow, I no doubt am. SHIBA already get name for the space well well, them get correct community support and na the greatest tin a project suppose get. Me no wan waste time dey check on projects again, any one wey do like say them go blow,I dey enter two seconds.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Btw, how Una dey survive this bear so?
The bear rally neva start oh. If you dey see wetin dey happen na as bear market na im be sey you go shrink oh wen d real blood begin flow for dance floor. Make you ask those wey witness 2018/19 na.


But bros we fit still dey surprise say this time around no go b the same as the past. Remember how halving dey work and now the big buyers dey hodl the thing tight like monkey dey carry hold branch of tree. That hodling dey make coins no drop as we fit dey think. One tin any cryptocurrency be say you no go fit no how to use binocular take view am.


Quote
used by some government cabals that feels their control of hard currencies like USD is under threat..

This statement by @LordMiguel still make sense becos youth dey really get benefit from many aspect of cryptocurrency both hodling, trading or staking and many of this guys fit no dey cool with am.

You go surprise say some of their village youths wey them no don dey liberate themselves and no body dey wash their cars again lol. Policies are made from and for some purpose.

Una Weldon my pepo
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
How una dey do na, anybody dey put eye for this shibaswap I dey hear off. I dey believe if for real dem launch as the rumors dey talk, dat coin go blow oh.
Which one come be ShibaSwap again na abi na the same Shiba Inu token wey I know? If na that coin any how den want do make dem do, the small amount wey I buy the coin don full ground I no go buy am pass $50, this kind coin go take time to blow. Looking at the current price e fit take about 10 years to hit $1.

I never even do any proper research on that coin I been just buy base on the promotion I see on binance few months ago. This kind coin na to buy comot mind
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
How una dey do na, anybody dey put eye for this shibaswap I dey hear off. I dey believe if for real dem launch as the rumors dey talk, dat coin go blow oh. Already e get fans die, u know as all dis Meme doge like coin dey be and since shitcoin dem just dey para para dis days, who knows person fit get major block if e invest insider.

Already the coin dey trade for our oga platform wey be binance and other smalli exchanges dem just dey worry worry the coin. How una dey see am abeg, anybody get any bad belle talk for where the coin dey make una let me know abeg so my money no go lost as I dey plan put money for the project.

This swap dem and launchpad just dey dominate dis days, person supposed cash out from atleast one na abi na my own go bad pass lol.

Which one come be ShibaSwap again na abi na the same Shiba Inu token wey I know?

Aboy, na him be dat. Dem dey develop their own decentralized swap exchange wey dey call am Shibaswap.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Btw, how Una dey survive this bear so?
The bear rally neva start oh. If you dey see wetin dey happen na as bear market na im be sey you go shrink oh wen d real blood begin flow for dance floor. Make you ask those wey witness 2018/19 na.

I dey consider buy some top coins wey don correct well well like Algorand, Tezos and NEAR tokens.  
Add Cartesi to ya list oh. I talk about am here last year when dat token dey less than 4cents. But e dey around 70cents now.
jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody
Altcoin Discussion

The presales is over all token sold under 50mins I miss the opportunity to signup I no get the information on time, another opportunity now na to join this 3 weeks bounty I see dis project as legit cash out den dey operate on binance smart chain...i go like make una join the campaign or do the farm with at least $50 leave am for 2 years.

Bounty Link: RushMoon 🚀 | Automatic Liquidity Acquisition Yield Farm & AMM BSC

Duration : 3 weeks



I just discovered that the audit was done by solidity finance. after what transpired between solidity and compound finance last year. i decided not to do anything that is related with solidity finance as the auditor. those guys are pure scammers and conduct loads of shabby deals with scammers.

I de fear all this AMM them, currently all my crypto de for pancakeswap pool, I no Sabi weda e de safe, I de Follow eye ApeSwap, burgerswap and bakeryswap, any suggestion you ko fit give me?
member
Activity: 175
Merit: 10
ITSMYNE
Altcoin Discussion

The presales is over all token sold under 50mins I miss the opportunity to signup I no get the information on time, another opportunity now na to join this 3 weeks bounty I see dis project as legit cash out den dey operate on binance smart chain...i go like make una join the campaign or do the farm with at least $50 leave am for 2 years.

Bounty Link: RushMoon 🚀 | Automatic Liquidity Acquisition Yield Farm & AMM BSC

Duration : 3 weeks



I just discovered that the audit was done by solidity finance. after what transpired between solidity and compound finance last year. i decided not to do anything that is related with solidity finance as the auditor. those guys are pure scammers and conduct loads of shabby deals with scammers.
member
Activity: 175
Merit: 10
ITSMYNE
The CBN governor, Godwin Emefiele says crypto trading in Nigeria are done illegitimately

Do not get this confused, I would have posted this along in the last topic made, but I think discussing it separately will be the best. Although, the news are the same but this is another CBN governor's speech during the same 279th MPR meeting held in Abuja just of recent where the CBN governor speaks good about cryptocurrencies.





Godwin Emefiele said, “We have carried out our investigation. We found out that a substantial percentage of our people are getting involved in cryptocurrency, which is not the best. Don’t get me wrong, some may be legitimate, but most are illegitimate. Under cryptocurrency and Bitcoin, Nigeria comes 2nd while on the global side of the economy, Nigeria comes 27th. We are still conducting our investigation, and we will make our data available.”

The questions are:
1. Is the CBN governor right about this?
2. What evidence(s) did the CBN governor has about this?
3. Is it the work of CBN governor to talk about this when no government body has not carried out a research to actually know most Nigerian crypto traders are making illegal transactions?
4. Or, has there been any research disclosed about this yet? I doubt that

When Western Union are used, including MoneyGram, nothing is done. If not because if the Western Union and money gram that make certain rules like yearly minimum withdrawal and reversing of funds sent, it has been a potential means frudsters can use, and yet many frudsters will still be using both. The CBN governor has nothing to say about it but only talking bad about cryptocurrencies. There are still many other ways fiat transactions are used illegally to defraud people, but yet the CBN governor did not ban fiat like Pounds, Euro and Dollar. In fact, fiat are mostly used in illegal activities. Also, I wonder why he has not banned the use of credit card which is impossible to ban.


i can say this without doubt that the CBN has no actual facts to prove this but a review from google trends and sample analysis for crypto platforms. they are NOT CARRYING out any investigation. the CBN governor is under duress to make a bold statement on the state of affairs surrounding crypto and bitcoin. Not to insult his personality but Godwin is just a  vessel of destruction used by some government cabals that feels their control of hard currencies like USD is under threat.
Jump to: