Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 33. (Read 947853 times)

hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
The goal of redesigning was for security reasons; most of you are missing the point of the entire project;
My qualms with the redesign of the naira is not even about the security purpose but how does this redesign help the economy? How does this design alleviate poverty? How does this redesign put food on the table of the poor masses? Does this redesign create employment opportunities? These are the main issues. A crucial question that must be asked is if Godwin Emefiele had been selected as the party flag bearer would he have considered redesigning the naira?
hero member
Activity: 910
Merit: 686
My major vex be say all these men dey travel go overseas to see wetin dey happen, na there dem dey do their political meetings, yet dem no fit copy development come back, dem no fit copy as oyibo dey resign for office.

Na dis part off me pass, e dey funny sha. Make naija politician resign because say him fuck up no go fit sup oo. Those people wey dey reason say to steal and make EFCC catch you na big name for dem, e better pass make you resign for your work make the whole world see say you no dey competent. Looking for big names through illegal way has become normal as it will add to there record in history that’s what dem dey feel now o. There crimes are obvious now that dey can’t even deny the fact that they’re not doing it. Las las e go better brother. As we dey struggle dey go, e go better for our nation one day.
legendary
Activity: 2352
Merit: 4221
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The goal of redesigning was for security reasons; most of you are missing the point of the entire project;

No be lie you talk but nobi Nigeria we dey. If you make all the money wey politicians dun steal useless, that one no go just make dem still more next time they get the opportunity and this time around dey go comot the money for naira carry am go dollars and that way talking money out of the economy instead of putting money through investment in the country. Same thing goes for the money obtained through illegal means, this one no go just increase the security threat of the nation making kidnappers going back to their old ways to demand ransom and causing nuisance.

Assuming we dey assured of the security of the nation then their plans for come into great effect but as usual we dey only get better plans for theoretical form but we no dey fit execute am as e no dey ever work. Here no be America or the western world. Just because something work dat side no mean say e go work here, we no get the capacity to execute their kind plans and anybody wey understand this go sabi how to carry this country go forward. China understand say the western world doing no go favour dem so dey lock demselves out dey use their own style and today them dey just one step behind to dominate the world.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
If they really carry out this project, it will be very nice to participate but I dey sense deception. Probably dem dey bring bcos of di forthcoming election, dem wan use am lure di youth to vote for dem and abandon the project after election. Me I no see di reality of the project. And if it is from Nigerian Government (President or NITDA), dem for make newspapers publication. But make we see weti go happen first. For di registration, u fit register di two or one?
To be sincere with you guys, I don't think all this news are real because we all know there are several fake media all around Nigeria, and the global space in it entirety. And this one is probably one of them and we should not take them serious, in fact with the uncertainty of the cryptocurrency market, everyone is skeptical about anything that has to do with blockchain and digital currency, in as much as there is general adoption of Bitcoin and other coins by the youths not all are adopting it in the legal way, we have some cryptocurrency projects that are pour scam and those are giving the entire cryptocurrency industry a bad name, making people to become skeptical in adopting real blockchain projects and good coins like Bitcoin. I don't think, Nigeria as a country is close to adopting blockchain since the recent e-naira was not created to run in the blockchain and being the country official CBDC which was supposed to compete against other digital currencies like Bitcoin USTD or other stable and unstable digital currencies.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Abeg makes we put politics aside, the naira redesigning no be to change anything but to target two things which are, eliminating stolen and store away naira notes by corrupt politicians and other financial criminals and the second is to give our currency a new facelift in form of renovation. Forget how much is spent in doing this and let no politician called activists like Sowore confused they are the same set of people who contributed largely to bringing Nigeria to bad economic stste we are today don't let them confuse you I don't take any of them seriously anymore but the bottom line is that the naira rebranding is a very big welcome development let keep politics aside, if you leave in the northern part of Nigeria you will know the level of our naira note degradation and need for a facelift and even Nigeria is not the first country to do so even the US dollar is frequently redesigned and new notes are printed at regular interval.

My brotherly you don finish talk, make we no make mistakes to take any polician seriously. All of dem na thieves, I dey always talk am. But some of the thieves get conscience while some don sell their conscience to the devil.
My major vex be say all these men dey travel go overseas to see wetin dey happen, na there dem dey do their political meetings, yet dem no fit copy development come back, dem no fit copy as oyibo dey resign for office.
How many oyibo go dey for Jagaban age, instead make dem go rest, dem go dey display dementia dey shout PDAPC telling us to get our APV and APC to vote them. And yet thousands of Nigerian youths wey dem don enslave with power dey under the sun dey hail old man to lead them.
legendary
Activity: 854
Merit: 1246
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
If they really carry out this project, it will be very nice to participate but I dey sense deception. Probably dem dey bring bcos of di forthcoming election, dem wan use am lure di youth to vote for dem and abandon the project after election. Me I no see di reality of the project. And if it is from Nigerian Government (President or NITDA), dem for make newspapers publication. But make we see weti go happen first. For di registration, u fit register di two or one?
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata.
Please how much did the government say was spent on the project because I have searched the internet and I haven't seen a specific price that they claimed was used for this new currency redesigning. The news i only saw was that there is no official amount stated yet as what was used for the project , hence i dey surprised were you hear or see amount from wey you say wan mad you. Share link for us make we see where you get your information from.
According to Sowore and this link https://www.channelstv.com/2022/11/23/funds-for-naira-redesign-should-have-been-given-to-asuu-sowore/, that na the amount wey we govt troway to take "redesign" we naira. The man dey yarn say instead of we govt to take the money do beta tin like settle ASUU, see wetin dem carry am do. Since I no get valid source to found my belief, I no fit accuse anybody. But e dey do me like say them corner side some of these funds so dem fit use hold body for the election period.
Abeg makes we put politics aside, the naira redesigning no be to change anything but to target two things which are, eliminating stolen and store away naira notes by corrupt politicians and other financial criminals and the second is to give our currency a new facelift in form of renovation. Forget how much is spent in doing this and let no politician called activists like Sowore confused they are the same set of people who contributed largely to bringing Nigeria to bad economic stste we are today don't let them confuse you I don't take any of them seriously anymore but the bottom line is that the naira rebranding is a very big welcome development let keep politics aside, if you leave in the northern part of Nigeria you will know the level of our naira note degradation and need for a facelift and even Nigeria is not the first country to do so even the US dollar is frequently redesigned and new notes are printed at regular interval.
hero member
Activity: 770
Merit: 629
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?

 As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country.
According to our leaders their intention no be to redesign per say , but say their intention na to bring out money wey people done hide, so that it will be in circulation, as me I see the color of money I was like what is this if that is truly their motive not bad at all because money wey people don hide no be small oh my brother so make we try look this thing for another dimension, and CBN have lifted all deposit charges so abeg if una get old money make we try carry them go bank.
I code! But make u no trust dis people oo, dem fit get their hidden agenda. Truly, e good make central banks dey redesign periodically, but d timing of dis 1 bad gan, why now? I know d benefit country fit enjoy from redesigning, but dis people fit dey use am favour their special candidate. E fit be for Tinubu bcos e be APC or for Atiku bcos e be Fulani. See politics in Nigeria deep, so no trust dem or take dem 4 their words. Why did they redesign the naira in a hurry? Or u no see say dem no change any design? Dem just change colour and some effects. Dis is condemnable my brother, that's d truth.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata.
Please how much did the government say was spent on the project because I have searched the internet and I haven't seen a specific price that they claimed was used for this new currency redesigning. The news i only saw was that there is no official amount stated yet as what was used for the project , hence i dey surprised were you hear or see amount from wey you say wan mad you. Share link for us make we see where you get your information from.
According to Sowore and this link https://www.channelstv.com/2022/11/23/funds-for-naira-redesign-should-have-been-given-to-asuu-sowore/, that na the amount wey we govt troway to take "redesign" we naira. The man dey yarn say instead of we govt to take the money do beta tin like settle ASUU, see wetin dem carry am do. Since I no get valid source to found my belief, I no fit accuse anybody. But e dey do me like say them corner side some of these funds so dem fit use hold body for the election period.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
This one na good development as along say na legit. Why I talk so na becasue say, I don too fill online forms wey we Naija government bring. I nor go fit forget N-Power and their nonsense batch selection abi na call up and at the end of the day nothing to show for am. But if this people really dey serious I go follow praise them because na good thing wey e be.
This one na beta info, and it goes well for ear. But based on the kind country people wey we get Dem no go just hijack the process use am do man_know-man tin and end up giving the opportunity to people wey no really get interest n love for this kind tin but just based on the RBS involved only.

Anyway, we just hope it makes sense at the end of it all.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
This one na good development as along say na legit. Why I talk so na becasue say, I don too fill online forms wey we Naija government bring. I nor go fit forget N-Power and their nonsense batch selection abi na call up and at the end of the day nothing to show for am. But if this people really dey serious I go follow praise them because na good thing wey e be.
legendary
Activity: 1372
Merit: 1103
Bitcoin Casino Est. 2013
And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata.
Please how much did the government say was spent on the project because I have searched the internet and I haven't seen a specific price that they claimed was used for this new currency redesigning. The news i only saw was that there is no official amount stated yet as what was used for the project , hence i dey surprised were you hear or see amount from wey you say wan mad you. Share link for us make we see where you get your information from.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
According to our leaders their intention no be to redesign per say , but say their intention na to bring out money wey people done hide, so that it will be in circulation, as me I see the color of money I was like what is this if that is truly their motive not bad at all because money wey people don hide no be small oh my brother so make we try look this thing for another dimension, and CBN have lifted all deposit charges so abeg if una get old money make we try carry them go bank.
I tink say dem bin wan go cashless b4. Abi no b part of d reason way bck mobile banking nd CBDC eNaira (e#) way dem bring...

Hw will printing of new notes nd dat one carry join body?
Hw e carry concern moni way pple hide abi d one way dey in circulation?

Dat no b our wahala 4 dis nation. Dem knw watin b our wahala nd we kwa sabi watin dem sabi bt 4 common man to change somtin 4 dis we nation, e too hard. Where e bad reach be say, u ft tink say u dey die 4 somtin nd die 4 notin.

D wayo way full we naija, no be watin one man ft solve nd so we go join hand 2geda mak we take 2023 election nd mak votes start 2 count 4 dis we nation.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value
I greet you my brother, when I first hear the story about central bank of Nigeria wanting to release a new design on the 200, 500, 1000 naira note, I no see am as necessary till I learnt that part of their reasons na because too many of the currency Dey circulation and away from banks, and money launderers and them kind don Dey save the money away from banks.

And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata. My people make we wise up.

The goal of redesigning was for security reasons; most of you are missing the point of the entire project; this single act has rendered the pile of money stored for the political game next year useless; we now have the license to print our notes to save printing costs as well. Currency is not for fashion; the more colors you add, the more expensive it is to print; this is why most world currencies only have one color. If you are familiar with printing, you will know that work with more than one color is always very expensive to print. The new nots appears common, but it contains security details that you may not understand. the US dollar old currency and the new one is the same only few details were changed for security reasons.
legendary
Activity: 2352
Merit: 4221
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?

You see me para? Nothing concern me with how Naira dey color. Infact I dey accept all colors as normally I no dey discriminate (I no be racist) all colors matas even though na black dem wan do am. We still dey game, we go dey chase the bag until we get that bag wey go make the paper begin chase us back. Wetin dun happen dun happen na to move on as protest no dey work for this country. Normally if na outside and the citizens no like any new development dem go enter street go protest and something urgent will be done about it.

Our own na to shoot us dem sabi. How much self dem carry design this thing but sha wetin we go do, nobi today dem begin thief the national cake. All of dem na the same thing, no surprise them all go shift go labour party or make obi defeat go majority party if him try win and the corruption continues. Cartel man dey wey dey run this country, all this one wey we dey see for front na just film. Every election tym na so dem get one person wey dem go paint as the saviour but as usual nothing come out.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value
I greet you my brother, when I first hear the story about central bank of Nigeria wanting to release a new design on the 200, 500, 1000 naira note, I no see am as necessary till I learnt that part of their reasons na because too many of the currency Dey circulation and away from banks, and money launderers and them kind don Dey save the money away from banks.

And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata. My people make we wise up.
hero member
Activity: 770
Merit: 548
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
Dis na good news for us na now I believe say government don finally accept crypto for we country for them to come up with this initiative. E make sense well well at least na opportunity for people we won learn about blockchain to get the knowledge and skill.

I hope say all these no be disguise because of election because this Buhari government no straight o,I hope say this scholarship go be open floor no be the one wey this government men go pack all the slots give dem children or their relations so that make only dem enjoy Nigeria funds.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Blockchain Scholarship for Nigerians

The Buhari government don accept to offer scholarship to Nigerians wey dey interested to study blockchain technology for Nigeria.

NITDA the organize scholarship programs for 30,000 Nigerians. If you dey interested and you wan apply. Make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSdzZ-dOj8idu0DVKAqmNQEzCYz8Hbxddi_sci6vTcljQJWCBQ/viewform

If you wan apply for mentorship for various states, make you use this link
https://docs.google.com/forms/d/e/1FAIpQLSd2SuTr7Io1WlG1E_qSCK9HX-HRB4UfNhQchyAP4Iis3p2glA/viewform

This na positive step by Buhari led government to empower young people for blockchain skills. At least this go transform the country
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
We know the purpose of redesigning the naira notes but em d too ridiculous say the CBN no fit come up with better redesigning, if no be just filter redesigning naira notes. If you look at the dollar notes wey you uploaded, there's a bit creativity for dollar note compared the old one and the new one. But for our case no creativity or craft d am inside. Na just filter blue color d apply on am

Em no b bad thing if we get this kind creativity for our naira note


See wetin peso fit come up with, within 1hr 30minutes. So CBN no get peso wey go just redesign our naira to make it more beautiful as this one dey so.

This redesigning of naira notes the exact way it is no bam atal. No sound as if the filter CBN apply give make sense. This na wetin majority of Nigerians the castigate about. No just talk sae we suppose like am without talking about am

Wetin you mean by creativity? Na for ontop Naira note Nigerians wan show their creativity? We Nigerians too dey pick up fight where fight no dey, we too dey pick up talk where talk no dey. Na wetin make Government too dey use us and see us as mumu. Small thing we go happen, Nigerians go carry their whole mind and attention put like people wey no get job. If Ned Nwoko marry another wife, e go trend for 3 months, if Yul Edochi marry another wife, e go trend for 3 months, haba!

If naira fall to N900 to $1 we no longer care because the design of naira good? If government needed best designs, dem for do talent hunt and give everyone opportunity to design. Meanwhile, for preservation of the identity of our legal tender, new notes are not supposed to look totally different from old ones.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Hey guys I'm a newbie
Username: Pillsike
Gender: male
State or residence: Abia state
 
   To be honest I have little or no knowledge about crypto currency, though  I participated in a few airdrops like meta war and pi, no of them worked out sha that's why I'm actually here.so my people, help me out. How do I get merits, how often do I need to post, how long does my post have to be, how can I be sure to get engagements. I still have a lot of questions but let's just start with these.
    Abeg I really need help here I feel like I don't know what I'm doing .

Welcome on board mate and one thing you go know be say nothing good comes easy and you gats to work.
No too stress yourself but rather dey see the forum as a get together  and a forum wey all your crypto issues fit dey possibly solved.
I know say everybody dey actually find merit but the truth be say, people go easily merit you when you talk something wey touch their heart.
Even me I still dey new for here but I no go lie say God no dey try for me and you just  need to comot your mind for merit and try as much as possible to make post wey even if you na you wan merit am, you fit get mind give better merit
Pages:
Jump to: