Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 34. (Read 998764 times)

sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Hey guys I'm a newbie
Username: Pillsike
Gender: male
State or residence: Abia state
 
   To be honest I have little or no knowledge about crypto currency, though  I participated in a few airdrops like meta war and pi, no of them worked out sha that's why I'm actually here.so my people, help me out. How do I get merits, how often do I need to post, how long does my post have to be, how can I be sure to get engagements. I still have a lot of questions but let's just start with these.
    Abeg I really need help here I feel like I don't know what I'm doing .

Welcome on board mate and one thing you go know be say nothing good comes easy and you gats to work.
No too stress yourself but rather dey see the forum as a get together  and a forum wey all your crypto issues fit dey possibly solved.
I know say everybody dey actually find merit but the truth be say, people go easily merit you when you talk something wey touch their heart.
Even me I still dey new for here but I no go lie say God no dey try for me and you just  need to comot your mind for merit and try as much as possible to make post wey even if you na you wan merit am, you fit get mind give better merit
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes.

Me no follow para o, naira abeg take note. If e gree you, make you avoid the hones of those weh deh para for you to avoid wotowoto. Make them no use vex begin tear you apart. Come to my house and stay. Na two friendly hands me and my household want take welcome you. You be senior man, o naira! Na my love letter be that to naira.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?

 As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country.
According to our leaders their intention no be to redesign per say , but say their intention na to bring out money wey people done hide, so that it will be in circulation, as me I see the color of money I was like what is this if that is truly their motive not bad at all because money wey people don hide no be small oh my brother so make we try look this thing for another dimension, and CBN have lifted all deposit charges so abeg if una get old money make we try carry them go bank.
hero member
Activity: 784
Merit: 633
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?

 As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?

 As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
We know the purpose of redesigning the naira notes but em d too ridiculous say the CBN no fit come up with better redesigning, if no be just filter redesigning naira notes. If you look at the dollar notes wey you uploaded, there's a bit creativity for dollar note compared the old one and the new one. But for our case no creativity or craft d am inside. Na just filter blue color d apply on am

Em no b bad thing if we get this kind creativity for our naira note


See wetin peso fit come up with, within 1hr 30minutes. So CBN no get peso wey go just redesign our naira to make it more beautiful as this one dey so.

This redesigning of naira notes the exact way it is no bam atal. No sound as if the filter CBN apply give make sense. This na wetin majority of Nigerians the castigate about. No just talk sae we suppose like am without talking about am
Wetin dey vex me pass be say them dey lie say na 8billion naira na e dem use do rebrand for where that one dey happen, make them give us statistics how them spend am. See the yeye thing wey dem do just to thief our money through a legal way.

I know say this rebranding go help strengthen the currency but at the same time e no fit remove corruption or poverty. Eight billion we dem use if them use am for project for we country to benefit from na bad thing. OK make person tell me how this rebranding go take benefit the common man like me and you for this country. The problem with Nigeria leaders be say anything we them dey do na for a purpose to favor themselves or to choke their rival.

I believe say this rebrand na to choke their enemies for this forth coming election and to also get means to print and steal our money o. Nigeria needs leaders wey go fit tackle serious problems wey dey affect the country no be to go dey rebrand money.
 
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
We know the purpose of redesigning the naira notes but em d too ridiculous say the CBN no fit come up with better redesigning, if no be just filter redesigning naira notes. If you look at the dollar notes wey you uploaded, there's a bit creativity for dollar note compared the old one and the new one. But for our case no creativity or craft d am inside. Na just filter blue color d apply on am

Em no b bad thing if we get this kind creativity for our naira note


See wetin peso fit come up with, within 1hr 30minutes. So CBN no get peso wey go just redesign our naira to make it more beautiful as this one dey so.

This redesigning of naira notes the exact way it is no bam atal. No sound as if the filter CBN apply give make sense. This na wetin majority of Nigerians the castigate about. No just talk sae we suppose like am without talking about am
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
  To be honest I have little or no knowledge about crypto currency, though  I participated in a few airdrops like meta war and pi, no of them worked out sha that's why I'm actually here.so my people, help me out. How do I get merits, how often do I need to post, how long does my post have to be, how can I be sure to get engagements. I still have a lot of questions but let's just start with these.
    Abeg I really need help here I feel like I don't know what I'm doing .
Welcome mate, quite a lot of us started with zero knowledge of cryptocurrencies, no man was born with any knowledge at all, but if person they consistent and persistent say im wan learn something, then the knowledge of that thing would definitely come to him. Forget about airdrops my brother, just concentrate on Bitcoin, use this forum take garner knowledge, just ask questions wey go help you develop your knowledge and users in the forum as well as this local community go help you out with the answers.

Having said that, no too reason merit as you just start, once knowledge choke for your side, merit go follow am. You should post as often as you want to, that one they up to you, but as you be new user so, reading is most important than posting. Your posts can be of any length at all, it is up to you, and if you want make your new threads get engagements, then the post must make sense, if not people go vex they put you on ignore. Welcome brother, just relax, everything go clear for your eye with time.
full member
Activity: 882
Merit: 207
NEW TOPIC: History as Buhari Supervises Crude Oil Drilling in the North
Quote
For the first time in history, President Muhammadu Buhari is expected to officially kick off the drilling of crude oil in the north on Tuesday, about two years after the mineral resource was discovered in the region. This is a major boost to the efforts by the federal government to ensure that the region produces crude oil in commercial quantities.Specifically, the president will conduct the ground-breaking ceremony of the Kolmani Oil Prospecting Lease (OPL) 809 and 810 at the Kolmani field site located in Bauchi and Gombe states.

The president is expected to carry out the historic exercise with the support of the Minister of State for Petroleum, Mr. Timipre Sylva and the Group Chief Executive Officer of the Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPC), Mallam Mele Kyari, among others, THISDAY gathered.It was further learnt that the oilfields in Bauchi and Gombe states will be developed by Sterling Global Oil, New Nigeria Development Commission (NNDC) and the NNPC Limited. “The ceremony will be held on Tuesday, November 22, and will be attended by Mr. President himself together with most of his cabinet members including...
Read more: https://www.thisdaylive.com/index.php/2022/11/20/history-as-buhari-supervises-crude-oil-drilling-in-the-north/

I dey happy as dey dun find oil for the north and maybe now our northerner leader go fit agreed to the terms of giving every state their independence. I seriously they wish this discover to dey successful so the North for face their own national resources and commot eye for the south own. I believe say this new development go strength the country economy and fit reduced the fuel spike in price and scarcity wey we dey get. You no say the north get well industrial men wey go run better refinery for them and e go dey successful unlike wetin we dey experience for the south.

Sha wetin you dey think of this new discovery and how e go affect the counter both positively and negatively?.
I been dey very happy when I learnt about this discovery. President Buhari don use this one as an important achievement before him comot for office. At least the south can be allowed to enjoy its resources thereby creating abundance of petroleum products with hopes say the prices go dey reduced. New job openings too, only if they intend to use nationals and not foreigners. The oil refineries and other oil infrastructures will be developed/built to accommodate this discovery and am seeing less monopolization or hording of its products because it will be in abundance, hopefully.
legendary
Activity: 854
Merit: 1246




DaNNy001 and uchegod-21 your quotations are wrong, so you can re-edit it before another person also quote it wrongly. The redesigning of the Naira is not a problem in Nigeria, but the problem in Nigeria is the price of goods and services. If any government can reduce the prices of goods and services and also create Enabling environment for the Citizens and the foreign investors then everything will be ok in the country. That is why some people are saying that they should approve the use of coins either on paper or on the normal coin.

To save Nigerian economy is to accept the payment of 1 Kobo to #1, and to #50 massively than #100 to #1000
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
For me, I nor see anything wrong with the new redesign sha.
Same here, all the talk about say the money nor fine, the colour nor go well no matter, the main thing na say make person get the money, e go dey fine for spending. Even as una dey talk say e nor fine, e nor get wetin una go still do last last, you go still use am like that till e go fine for una eyes. Kif you say because you nor like the colour, say you nor go use am...Na Shege you go see, not just Sapa. The focus should remain getting this money in abundance.

Also you will find out that this new currency design is being printed in Nigeria and not outside the country.

Quote
the redesigned currencies are locally produced by the Nigerian Security Printing and Minting (NSPM) PLC.
source

sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
NEW TOPIC: History as Buhari Supervises Crude Oil Drilling in the North

I dey happy as dey dun find oil for the north and maybe now our northerner leader go fit agreed to the terms of giving every state their independence. I seriously they wish this discover to dey successful so the North for face their own national resources and commot eye for the south own. I believe say this new development go strength the country economy and fit reduced the fuel spike in price and scarcity wey we dey get. You no say the north get well industrial men wey go run better refinery for them and e go dey successful unlike wetin we dey experience for the south.

Sha wetin you dey think of this new discovery and how e go affect the counter both positively and negatively?.
Na good news be this sha. I d happy to hear to sae North don finally get their own crude oil. But the problem be sae, after all this, we go still carry the crude oil go another country go refine am. I wan ask weda Nigeria never reach to get their own refinery or what? We still d hope on the one wey Dangote d build up till now.

The amount wey dem d spend for subsidy of crude oil no be here. Na why Atiku d call for privatization of oil sector.  
The FG dey d other side d call for the remover of fuel subsidy.

We be one of rich oil-producing country for the world but we no get one single refinery. The country just d depend on crude oil that generate 10% revenue of the country to survive wey be sae we get agriculture and others that can boost the economy. Nigerian need to go back to the 1999 Constitution
I been think say dangote and otedola been they build refinery waiting come happen again this one we no hear anything about the thing again, me personally I don tire to they complain self na pray me I just they pray now, imaging a country like nigeria a blessed nation like ours but we they carry fuel comot form this country to another, our leaders no just get forsight and thief thief done blind their eyes, see waiting lack of foresight they cost us now as fuel scarce for every were , people wey come get they sell 250, he go better my brother.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I dey disappointed say our president Buhari get mind carry governor of Central bank Godwin Emefiele, minister of state finance and budget and national planning Clement Agba, even Efcc boss Abdurasheed bawa

This country na real cruise. No be Bawa weh court send to prison for contempt of court them release again? If na poor man now na so the case go deh solid but for big men na money issue them deh take settle am. The type of corruption weh deh hammer this country no go ever let am rise. We need revolution to change the narratives. And some people still want make Tifnubu enter abi, how this ones deh take see this life self?

Hehe. Like this them don go soak the money for bleach come out and nah this rubbish wey dem use #8bn do?

Omo this one funny me sha. But no be lie you talk there. The new notes be like wetin bleach touch. This Buhari and his men don kill this country finish. See the type of cash weh them say them take do the work.
newbie
Activity: 26
Merit: 1
Hey guys I'm a newbie
Username: Pillsike
Gender: male
State or residence: Abia state
 
   To be honest I have little or no knowledge about crypto currency, though  I participated in a few airdrops like meta war and pi, no of them worked out sha that's why I'm actually here.so my people, help me out. How do I get merits, how often do I need to post, how long does my post have to be, how can I be sure to get engagements. I still have a lot of questions but let's just start with these.
    Abeg I really need help here I feel like I don't know what I'm doing .
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
~snip~
For me, I nor see anything wrong with the new redesign sha. I just believe say Oga Meffy don achieve him aim. Plenty people don comot the old Naira notes wey dem store for house. If we comot sentiments and anger wey we get for the FG,we go sabi say the economic impact of the Naira redesign project go still achieve the goal. Me I personally believe am.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
President Buhari unveil New Naira notes
Our number one for the country Don approved and unveil the new naira notes today during the weekly executive meeting at state house. CBN governor say the new naira go begin dey circulate as soon as possible while the deposit of old ones will continue. You can read full details here Buhari unveiled new naira notes
Na the image be this
Na only colour dem change thou. I pray make e serve the purpose dem do am for cux our problem for naija pass extra ordinary.

As I see this money self he no sweet me I expected more from the design doh, people wey hide money now go they vex now say na waiting them they suffer them for be this not bad, I think there is an Act law to change a countries currency after some years I remember them changing 5,10,20,50 naira then to leather own so at least they still remember some Act law, waiting still they funny me na people wey pack money hide nawa, them go still hide the new onces, greed no they finish for this country.
member
Activity: 756
Merit: 30
I'm very disappointed in the comments wey I dey see for media concerning the new naira wey CBN bring out. Na so our ignorance don grow reach? Majority of Comment wey I dey see especially from this our local thread Don prove say we no know the reason for the creation of new naira and we are just after beauty. It is embarrassing to see us bad mouthing ourselves in the name of mocking the government and dem policies. The hatred for this administration and every of it policy is alarming. Na America we dey copy up and down and dem too change their $ with no much difference. So why the fud here?

This is the sample of the $ old and new. The purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

This naira new note just dey trend and Nigerians just dey disappointed. But me I no see any problem with the new note. When we hear new naira note, what we're we expecting? Something like dollars or pounds? Naira note dey durable and beautiful already, so the purpose of new notes no be to make am fine and put flowers. The purpose na to make people wey hoard naira release am and render sum useless. We don already see the effects as old old money dem don dey fall out. So, wetin dem need na just to differentiate between old and new, the color change is OK for that.


This one no go work, I know when dem been try implement this but e no work.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform


If really dem do dis won 👆, nai I go like well well. Di small small Moni dem wey we get for di kwantri e no fit use am buy anything again. So if dem implement dis won nd print more on dis won. I go Happy.

omo this one na spicy news oo because this our so called Naira note Don loose value well for this country. 5naira sef no be money again because even the least banana chewing gum you no fit use  am buy.
So at least with this update maybe e go force people to respect the naira small because most things we go dey buy am for kobo, 1 Naira etc.
So if Nigeria go fit implement am e go good well well
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
President Buhari unveil New Naira notes
Our number one for the country Don approved and unveil the new naira notes today during the weekly executive meeting at state house. CBN governor say the new naira go begin dey circulate as soon as possible while the deposit of old ones will continue. You can read full details here Buhari unveiled new naira notes
Na the image be this
Na only colour dem change thou. I pray make e serve the purpose dem do am for cux our problem for naija pass extra ordinary.

It is nice but weti make dem 2 change dis currency sef? Di changed sef I no see anything oda thing dan di color. Every oda thing still dey kamkpe.  Nd di color sef dem no used thick won, di color e dey very light.
The FG or CBN governor suppose tell the general public sae all the naira note from 2021 backwards dem no go accept am as legal tender again. Starting from soso time to this particular time. People no go d collect naira note wey get date of  2017,2018,2019,2020 and below.

This government no d surprise me again. I never see anything wey dey go fit do right apart from stealing our money.

See wetin d just do. Just to color our money and come use the word redesigning come deceive us
Pages:
Jump to: