Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 258. (Read 554634 times)

sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
February 06, 2021, 05:21:47 AM
Hehehe, naija don vex me, them don shame me, for the past three years, naija been dey trend for the crypto space,  naija be the first fiat to list on Binance, put calls, before others follow, MXC exchange list naija fiat against other pair, and other reputable exchange, 1xbet, betway, remitano first supports naira deposit/withdrawal, all of these foreign tins come naija, now big Belle people stop our enjoyment. Wetin them lack na information, if you no dey inform you dey deform...

Abeg, my blood, transact your stuff now via p2p, them no go fit stop us, we move.,no just worry.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
February 05, 2021, 07:25:20 PM
This news is now circulating in Nigeria, one of my sisters sent it to me, and in less than 2 hours time Gozie51 also sent me the news.



Even, if Nigeria will ban crypto deposit or crypto generally, it should be circulating all over the news and we will see it coming, not ad libitum. Nothing of such in my side. Or, what do you people think is going on? This seems more fake.

I checked punch recently and found it to be true.
https://punchng.com/cbn-orders-banks-to-close-crypto-currency-accounts/
Omo bro, to be honest when I see the news I shock, like I no believe say this our government go like to make life much harder for this country, no jobs for the youths, people way go school if no be connection no work, person way study micro biology go dey work for bank as cleaner, the country just dey backward coupled with the way prices of food stuffs dey really high now, na before you fit manage 1k for two days, nowadays only half day the money Don finish, to me nothing this current government bring other than more suffer to add on top the one we been dey suffer already, I dey really disappointed with the Nigerian government, but this na the rainy days sun go shine one day, anyway I agree with @Nelson4lov we go adapt with time, so we move 🚶.........
Oh sorry SARS dey that side follow this side 🕺😂
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
February 05, 2021, 06:12:40 PM
Omo this evening news about CBN ban on crypto just weak me. Considering say govt been give us go ahead some months ago in 2020 come make the matter more confusing. This na very big loss for us coz e no go take long before some platforms start to restrict Nigerians. Even these projects wey do ICOs and token sales fit add Nigerians to their list of restricted countries just as them dey do US citizens. The whole thing just dey messed up.  For now, too many uncertainty dey surrounding usage of crypto by Nigerians. First na paypal, now na crypto.

Well, one thing I know for sure be say with crypto, way go always dey. Thousands of US citizens still dey trade and invest in cryptos without problems so why we no go fit do am too? We go adapt make una no fear come panic sell.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
February 05, 2021, 05:49:40 PM
When i hear this news eh, the matter shake me o, i no go lie una. E no just funny me at all because, na from here most of don get strength and dey see something to use hold our side wella. Which kind wahala country we dey live cef, i just tire with the many rubbish people way dey rule us, nothing is dynamic about them. When we feel say we dey go somewhere, them go just turn the other way.

So na like this them wan use pay all the money way them borrow from China? Watin really dey worry this people, abi there greed no get end? Abi na the G-boys be there wahala because in the real sense, those boys dey bring in rather than taking out as them way be politicians dey do and even at that, if you block one way, another one go still open. Some of them cef no need you buy coin send for them, na just to phish for your details, use am chop online. Abi oyibo no know say the online life, na sense we dey carry run am abi them kwa no dey scam we too! All this one no justify say the way pure but then, crypto no be the wahala. Country way get refinary and e no dey function yet, them dey pay the staff them for work way them no dey do. Oya erect structures and empower people no way, the small empower project wey them bring, e don dey go 6months now without any break through. Make them for bring projects way go tech the new generation technology make we get brand to export, them no go reason am. Na just good name say them dey fight scammers so them fit borrow more money be there wahala!

As for me, my operations remains the same. No body go push me sell my reserve and na only when i wan sell i go sell anything. My crypto affairs continues till them give me wahala. Na that time them go tell me if them give me job and i no work or show me who i scam abi i no get certificate to obtain job. After there president go say all Nigerian youths dey lazy when na them old men they block our way. Better schools we no get, how we wan con contest on an international base? Na only say there children go represent us them dey fine. As them don archive for life, them think say another person no go make am. God go punish all of them way join body reason that matter as all of them no get sense so. We go set pass and everything go dey go jeje. Tip tap i go just fine one oversea connection if e be like e wan hard for the country, transfer my coin, e use western union push my money back for me, everywhere soft. Rubbish!
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
February 05, 2021, 04:55:58 PM
I think the Nigerian government are sparsely populated with old overaged people, at every sector and this citizens are grumpy, the Nigerian government are not and hasn't been associated with swift action on a problem/matter, so the swiftness in this ban of crypto-currency is of a shock and fishy to me, the government speaking of corruption, is laughable, with knowing how corrupt they can be, the government should have called on all stake holders And maybe a referendum before any ban, or a advanced warning, this won't change my crypto-currency responsibilities, but I think Nigerian government can do better than this.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
February 05, 2021, 04:43:00 PM
Looking well we all know that India is way better than our government , CBN banning crypto currency is a negative huge move to our society , but I don't even see any that the court would bdo about this ,our court is even controlled by our government , we should just hold our heads up and wait for 2023 , and we shouldn't forget p2p ,we really need it at this moment if we want to survive . But I know the will over turn the ban when BTC holders in high offices Begin to talk or questions them, we Sabi the matter now
Na the thing be that, the government controls everything in Naija, e go dey hard for now true true. The way you don talk ham true, we go hold on to people wey fit challenge CBN. E just dey pain me say I no dey the position for immediate action by suing CBN to court, but make we hope say this will be the next line of action. We don see how our government are incompetent and incapable to solve the problem wey dey start. If they fit think this way, I think the beginning of Naijas to dey suffer just started. I see Naija SEC have good intentions but CBN do not have such for cryptocurrencies. Make we see waiting go happen and make we hope positively.
member
Activity: 123
Merit: 25
February 05, 2021, 04:18:39 PM
...
This is what happened in India in 2018 happening now in Nigeria, but the India supreme court reversed the order in which the banks are still against it but unfavorable by the India supreme court which makes cryptocurrencies legal in India. I hope this will be the case for Nigeria too in the long run, the court will likely turned down the order, but I am thinking this may also be difficult until we have good leaders that do not just turn down something without no reason than filing criminal charges against it. The bank do not know the set back they already set for Nigeria today as they ban crypto. But, let us hope this ban will be invalid at the long run.
Looking well we all know that India is way better than our government , CBN banning crypto currency is a negative huge move to our society , but I don't even see any that the court would bdo about this ,our court is even controlled by our government , we should just hold our heads up and wait for 2023 , and we shouldn't forget p2p ,we really need it at this moment if we want to survive . But I know the will over turn the ban when BTC holders in high offices Begin to talk or questions them, we Sabi the matter now
member
Activity: 62
Merit: 14
February 05, 2021, 03:55:54 PM
until we have good leaders that do not just turn down something without no reason than filing criminal charges against it.
I love this statement
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
February 05, 2021, 03:36:24 PM
...
This is what happened in India in 2018 happening now in Nigeria, but the India supreme court reversed the order in which the banks are still against it but unfavorable by the India supreme court which makes cryptocurrencies legal in India. I hope this will be the case for Nigeria too in the long run, the court will likely turned down the order, but I am thinking this may also be difficult until we have good leaders that do not just turn down something without no reason than filing criminal charges against it. The bank do not know the set back they already set for Nigeria today as they ban crypto. But, let us hope this ban will be invalid at the long run.
member
Activity: 62
Merit: 14
February 05, 2021, 03:17:17 PM
This news is now circulating in Nigeria, one of my sisters sent it to me, and in less than 2 hours time Gozie51 also sent me the news.



Even, if Nigeria will ban crypto deposit or crypto generally, it should be circulating all over the news and we will see it coming, not ad libitum. Nothing of such in my side. Or, what do you people think is going on? This seems more fake.

I checked punch recently and found it to be true.
https://punchng.com/cbn-orders-banks-to-close-crypto-currency-accounts/

We Don hear wetin u the talk but as things dey our country jst the talk am we no the hear ntin
We go continue with wetin we the do.
Small hope wey ppl the use hold body na wetin our govt 1 destroy
See as things dey so ehh crypto big pass our country, people wey dey bring out this rule no knw ntin abt cryptocurrency

And if may ask what's the main aim of crypto?
It's to enable peer-to-peer transactions ryt??
And since the are saying CBN no crypto
It's even enabling the main aim of cryptocurrencies

As I dey lyk this this news sef no the bother me
As far as say we fit still do peer-to-peer transactions am okk
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
February 05, 2021, 10:04:52 AM
This news is now circulating in Nigeria, one of my sisters sent it to me, and in less than 2 hours time Gozie51 also sent me the news.



Even, if Nigeria will ban crypto deposit or crypto generally, it should be circulating all over the news and we will see it coming, not ad libitum. Nothing of such in my side. Or, what do you people think is going on? This seems more fake.

I checked punch recently and found it to be true.
https://punchng.com/cbn-orders-banks-to-close-crypto-currency-accounts/
member
Activity: 62
Merit: 14
February 05, 2021, 08:14:09 AM
If u knw say u never collect 4 awuf kaikai 4 dis thread https://bitcointalk.org/index.php?topic=5289839.220 tap me idey run am 2secs...we go hapi laslas.nobe force o our pipo say man wey fuck dey hungry nodey comot G-string pant. @theoboy I hear ur cry no wahala we dey
Thanks man
Anyhow we go make am
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
February 05, 2021, 06:37:07 AM
If u knw say u never collect 4 awuf kaikai 4 dis thread https://bitcointalk.org/index.php?topic=5289839.220 tap me idey run am 2secs...we go hapi laslas.nobe force o our pipo say man wey fuck dey hungry nodey comot G-string pant. @theoboy I hear ur cry no wahala we dey
member
Activity: 62
Merit: 14
February 05, 2021, 05:14:56 AM
@ Theoboy dey hustle small small any money u hustle come here dash ur broda him go give u change too.
Na who suppose the tell who this one 🤣🤣
We wey jst the start but anyhow we go all make am🙇
Thanks for the advice abt meta
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
February 04, 2021, 07:59:41 PM
@ Theoboy and @Obi theo una welcome oo be like una be ejima. See mak una use una head waka well nobe every u go chok mouth 4 mata, comot bodi 4 Meta just dey B&H dey hustle small small any money u hustle come here dash ur broda him go give u change too. No cari ur money giv oyibo if not shishi nobody go dash u 4 here.

Theoboy we node yan English 4 here save dat strength 4 campaigns
member
Activity: 62
Merit: 14
February 04, 2021, 04:49:03 PM
Omo this place the sweet me die.......
Asin I happy as I see this place, the kind joy I d derive to see my brothers and sister(s) for here ehh e the sweet me well... , I no fit explain am sef
But any how
The saying wey them the talk say u no fit go anywhere u no go see naija person; like this nw ehh I don finally believe am
Abeg at least make we the try check up on this small part of the forum wey we get make the place the try dey lively small ABEG🙏
Naija ohh 🇳🇬🇳🇬 I hail
member
Activity: 123
Merit: 25
February 04, 2021, 04:48:37 PM
Omo, I dey happy as I don see my fellow Nigerian for here, I don search tire but Las Las I don find am finally I don see where to express my self wella , as we small like this make we take time the show level for here make them know say we follow dey for the forum ,
   Me I be Igbo boy ,inside imo state  the rest na history ,I fit Yan una as we dey roll for the forum again nice to meet you all...
member
Activity: 62
Merit: 14
February 04, 2021, 03:11:47 PM
Theoboy! your username cef eh, e go tell person way never see you here before say you be Naija boy.
Bro na the only better name wey enter my head ohh 🤣
But at least we don try get small corner for the forum with tym we will get or own local board😁
Na jst tym
Small small we go get there
Thank you
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
February 04, 2021, 02:02:04 PM
Theoboy! your username cef eh, e go tell person way never see you here before say you be Naija boy. You try say na only you waka come, e show say you be man way go sabi fine road wella. We join mouth carry welcome you come this our small corner for the forum. E no big o but, e dey accommodate all of us. E get how we dey carry run the intro for here shah, if you been check the first page, you for see am but, nothing spoil. E good say you don land, na to carry ourselves we dey do for here o and try make you dey rep us well for the forum, when you wan commot small steam and English don hard you speak, your people dey here to gfollow you yarn wella. Wel don sir.
member
Activity: 62
Merit: 14
February 04, 2021, 09:15:53 AM
Hello my fellow Nigerians,
I have been on this forum for over 2 months nw and I never knew this part of the forum existed😔😔, jst came across it while going through the forum
Nice to meet y'all
So na hw e s b? 🤣
Jump to: