Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 259. (Read 554634 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 04, 2021, 05:26:06 AM

Lol,,, this guy you be real G no be lie. Upon the whole thing way dey that first picture, na watin roll like egbo u first see! Cheesy.
I dey tell you! That igehhh guy na real comedian. The dude dey crack me up with his yarns. May be him another Akpororo or Lasisi Elenu or even Aproko sef. About your craft, you try. Always do your best and nor send with time you will get better. Na persistence dey bring improvement. These guys wey sabi draw don dey eat better food on top this forum since last year reach now. This na why I nor dey follow condemn any course wey person dey study for school. You see how artists dey hammer big here na. And we get plenty lawyers wey nor even get work out there for Naija. I wish sey I fit draw, na opportunity to make something be dis.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
February 03, 2021, 03:19:35 AM
Baba I hail you too oo dis your art work nobe here dat first picture be lik say na egbo you roll  Angry but our own na our own. even as ur man head be like person wey chop witch so.
Anitin art work I dey comot hand bcus dis oyibo dem dey draw like witch o. Monkey no fine but him mama like am so, I suport ur ministry wit 1 botle of kaikai as I no too get so...mak we dey show odas luv too..

Na ur art fine pass u go win no fear.
Lol,,, this guy you be real G no be lie. Upon the whole thing way dey that first picture, na watin roll like egbo u first see! Cheesy. No be egbo o, na cardboard paper way empty inside o... Of a truth eh, this oyibo people take the art matter too serious o and them get all the tools them need. Na them digital art dey Marvel me pass. The way some guys dey win everytime eh, e con dey be me like say them play politics but, if you sabi art or watin fine, then you con look am well, observe the once way win. You too go gree say them deserve am. The judges dey try to be fair shah and na base on how e be for their own eye.

If my man chop witch, make e carry am bewitch them to like am o because, even as e shape like that, the stress way e give me no be here. I no fit come outside throughout the day time yesterday till I finish am. Na so the hustle just be shah but this art eh, me no go live am for them o, I go try upgrade make myself show for them for the naija. We still dey road...!

 I see your doings for the work shah @Igehhh e go well, e sweet my belle just now.  Cool
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
February 03, 2021, 01:00:40 AM
My people I dey hail una o. How e dey be and how we dey do na?
Anyhow e be, I drop one artwork for Duelbit contest o.
Baba I hail you too oo dis your art work nobe here dat first picture be lik say na egbo you roll  Angry but our own na our own even as ur man head be like person wey chop witch so. Anitin art work I dey comot hand bcus dis oyibo dem dey draw like witch o. Monkey no fine but him mama like am so, I suport ur ministry wit 1 botle of kaikai as I no too get so...mak we dey show odas luv too..

Na ur art fine pass u go win no fear.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
February 02, 2021, 06:29:30 PM
My people I dey hail una o. How e dey be and how we dey do na?

Anyhow e be, I drop one artwork for Duelbit contest o. Before una go laffe, I go like make una know say my hand no too strong, na small small freestyle we dey use hustle the forum make man for dey collect small thing and represent our people make e be say our face show. As e be so eh, me go like make una loud my art for me o, that is, if e go well shah. See the link here:
https://bitcointalksearch.org/topic/m.56253795
The competition no be here o, people no dey only show talent but, them dey show experience a d resources for the matter. Me I go really wan collect something for this one shah. E dey my body to take like this.

Na still una guy,
Smartvirus

Even as we still dey battle Coronavirus! Stay safe.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 01, 2021, 08:18:41 PM
As for NIN, I do my own sometime for 2016 so I no even bother to stress myself about am.
Na the same period wey me too do my own with only that white slip to show for receipt. But I dey surprised sey I connect when I try the NIN thing oh for my room. Shey you don try to connect your own? Try am, e go work. Na the code dey below in case you forget am 👇

Code:
* To know your NIN number dial (*346#)
                  
1.To link it with MTN dial (*785#)                        

2. To link with Airtel dial (*121*1#).            

3. To link with 9mobile dial (*200*8#)                            
4 . To link with GL0, Send " UPDATE NIN , NIN NUMBER, first name ,last name " to (109) .
Eg "UPDATE NIN, 12345678901, Jamiu Alabi Oke "  to 109.

I knw say na campaign dey make us nodey busy for here mak man fit chop.
Me I nor think sey na campaign dey cause am oh because if you well this place na im be the easiest to drop yarns and move on. You nor need to correct any grammar. Na just drop am as e dey be you for mind.

Anibody wey kpai brake 4 our mata we go pour water for him stove mak witch chop him ear drum.. We go get our local board by fire by force we go cause katakata 4 here. PH bois nodey cari last I no get joy o Huh
This guy! 😁😁 Your provoke nor be here oh. But I think sey na Warri nor dey carry last  Grin

In all, e go better make we dey fire up here so that we too go get something better for here. Those guys wey don get local board nor better pass us.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
January 31, 2021, 07:00:00 PM
Anibody wey kpai brake 4 our mata we go pour water for him stove mak witch chop him ear drum.. We go get our local board by fire by force we go cause katakata 4 here. PH bois nodey cari last I no get joy o Huh
Abobi, kpor well, kpor well, this mata no be today e start, I been dey cap with oga for here BB some days back, him clear me well for this mata, no be say them no wan give us, na to say them wan see our ginger as we don turn up plenty. Him also talk am say make we just dey drop topics wey concern African development via crypto, such things them fit convince them say we don dey into the crypto industry, after every every, oga go list all Africa related crypto topics for meta say e don reach for our turn to chop yam, na there we go turn up ginger intelligently, make theymos come hear our cry...
As for NIN, I do my own sometime for 2016 so I no even bother to stress myself about am. The government don even fail to block people. Them dey fail at everything.
Me self no fear again oh for this country wey we dey, nothing them go talk wey go make me shake body, me get NIN slip since 2014 till now the card never ready, how that kind dey happen, now them wan make I connect my sim to wetin I no sure say e still there data base, me no do anything, make them come block my sim.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
January 31, 2021, 04:24:49 PM
Hahaha. One thing I know be say, this people go wan see our community size and how active e dey first before them give us our own board. Na to continue keep the hustle alive and arrange for a plan wey them no go fit turn down.

I knw say na campaign dey make us nodey busy for here mak man fit chop. Wahala be like bone straight.
Baba abeg we cap mak I put u thru now.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
January 31, 2021, 04:15:04 PM
Sorry 4 dat, it is gud to take proper care of our health becus without dat we cannot carryout our daily activities. E no easy broda, may God heal as many wey dey sick hia or outside hia(Amen). E go gud mak we dey remember dis house becus na our own nd very soon tins go change for gud hia. Lmaooo and others wey just joined us are all welcome, ensure sey u read de rules abeg becus no second chance on dis forum oo.

True that. One of my favorite quotes be say health na wealth. Na who dey alright go fit get work done. Btw, thanks for your concern. I appreciate brotherly. I hope say you dey fine too and I also hope say the year dey go well so far for you.

My pipo how una dey eget as tins be o dis our surboard mata mak we try showcase our proposal 4 Meta mak we hear as ego be I knw oyibo no wan carry ear hear our mata nobe crime say we smart pass dem I knw say d 3Millions user 4 here 9ja get abt 1.5M users put calls nobe shoot bird mama fly we go show dem shegghe 4 here.... God pass dem der fada.

Anibody wey kpai brake 4 our mata we go pour water for him stove mak witch chop him ear drum.. We go get our local board by fire by force we go cause katakata 4 here. PH bois nodey cari last I no get joy o Huh

Hahaha. One thing I know be say, this people go wan see our community size and how active e dey first before them give us our own board. Na to continue keep the hustle alive and arrange for a plan wey them no go fit turn down.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
January 31, 2021, 04:03:58 PM
My pipo how una dey eget as tins be o dis our surboard mata mak we try showcase our proposal 4 Meta mak we hear as ego be I knw oyibo no wan carry ear hear our mata nobe crime say we smart pass dem I knw say d 3Millions user 4 here 9ja get abt 1.5M users put calls nobe shoot bird mama fly we go show dem shegghe 4 here.... God pass dem der fada.

Anibody wey kpai brake 4 our mata we go pour water for him stove mak witch chop him ear drum.. We go get our local board by fire by force we go cause katakata 4 here. PH bois nodey cari last I no get joy o Huh
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
January 31, 2021, 01:56:04 PM
E con be like say the January carry sickness come o but e go shock you say, even with the sickness cef, my naija brothers and sisters dey meet up our campaign quota! Na to tell you Africa man eye for the hustle no be today. Our country don teach us to open eye and we no just open am, we shine am join. Anyhow shah,

Make we try dey gather strength dey come here just to see or know how e be once-once before we go off line. Stress no dey am pass other boards o. Other boards way dey make me reason how I wan speak the english way I feel say I sabi, wahala! Here na soft soft, as I drop am, my people understand me, we move!!!
Anyhow e be, make we dey try, we go build.
full member
Activity: 756
Merit: 231
January 31, 2021, 09:51:41 AM
Greetings to my people. I don dey inactive for on top this our local board waka for a while. I don fall sick like thrice since December but that one no be excuse as I been still dey make posts, just not for here. so I wan take time apologize to my people because na all of us dey in this fight together.

Sorry 4 dat, it is gud to take proper care of our health becus without dat we cannot carryout our daily activities. E no easy broda, may God heal as many wey dey sick hia or outside hia(Amen). E go gud mak we dey remember dis house becus na our own nd very soon tins go change for gud hia. Lmaooo and others wey just joined us are all welcome, ensure sey u read de rules abeg becus no second chance on dis forum oo.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
January 29, 2021, 04:29:00 PM
Greetings to my people. I don dey inactive for on top this our local board waka for a while. I don fall sick like thrice since December but that one no be excuse as I been still dey make posts, just not for here. so I wan take time apologize to my people because na all of us dey in this fight together.

~Snipped

Skills: sysadmin, web developer, graphics designer, and crypto trader

I just want to thank CryptoBrainBoss for this thread.
I'm always happy to see my fellow Nigerians come together.

btw, I no get NIN sef! Grin
i am too lazy to get mine
maybe this week shaa!

Omo I dey  happy to see another developer in our community. Maybe at one point, we go team up create something for the community. As for NIN, I do my own sometime for 2016 so I no even bother to stress myself about am. The government don even fail to block people. Them dey fail at everything.
full member
Activity: 756
Merit: 231
January 28, 2021, 10:58:32 AM
But those wey dem own dey add am suppose to dey come here wella, especially those wey me and dem dey the same umbrella. One love guys.
Dat na gud talk broda, dose wey no dey come here do contriboot no dey do anytin gud toward dis our plan of securing local board, even thou dem campain no dey giv dem de opportunity; at-least seying one talk for a week go gud. Tanks 4every1 wey dey hia dey show luv 4 dis movement, una dey do well fabulously hia Grin. I be stay away 4 some times nd hopefully to be more jejely doing my little contribution dis time as usual, una weldon sirs/mas.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 27, 2021, 04:13:15 AM
Na true you talk CryptocurencyKing, nor be because of sey you mention my name oh. But correct sense dey on top your yarn, especially as we dey hustle to get owa own board. We suppose to dey put enough heat for this thread to increase yarns. Una understand the parole na. Well, I know sey many of owa guys nor too dey show here may be because their campaigns nor dey add posts for locals. But those wey dem own dey add am suppose to dey come here wella, especially those wey me and dem dey the same umbrella. One love guys.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
January 26, 2021, 06:19:37 PM
E con be like say our people for here tire small o abi,we dey on lock down. This our small place no con dey bizo the way e dey be before. Watin dey happen na because, I know say no be the data life dey worry us and say,NIN never start to dey block sim card. We need to dey keep here a life o, I dey thank some men them like Mpamaegbu way no dey allow here to dull like that. Una dey try! I dey beg our people say, make we dey come here to shuk mouth for matter way dey here or tell us how e dey be for our side inside we country. An the only way we fit carry dey get better update round the country because, news for media, them don edit am plenty o.
My people I greet una and una Weldon.
full member
Activity: 694
Merit: 108
santacoin.io
January 25, 2021, 05:57:01 PM
Lmaooo, welcome oh wey bread. You too sef walka lost ni as prodigal son but thank goodness sey you finally come home 😁. How the parole dey be for that una north with all the killing killing and boko activities? Una wey dey there dey try walahi. Me I nor fit live there for anything oh. But I hope your side for Gombe dey safe sha. Bro, kontinue to keep safe abeg. I like the skills wey you get. Na the game be dat. Keep it up.

Thanks for the warm welcome, Mpamaegbu.
Gombe is fine ooo. No killings, no kidnapping, no Boko Haram.
Gombe is totally safe. Only baba Buhari is flogging my people nonstop day and night 😂
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 25, 2021, 11:49:13 AM
Lmaooo, welcome oh wey bread. You too sef walka lost ni as prodigal son but thank goodness sey you finally come home 😁. How the parole dey be for that una north with all the killing killing and boko activities? Una wey dey there dey try walahi. Me I nor fit live there for anything oh. But I hope your side for Gombe dey safe sha. Bro, kontinue to keep safe abeg. I like the skills wey you get. Na the game be dat. Keep it up.
full member
Activity: 694
Merit: 108
santacoin.io
January 25, 2021, 09:23:03 AM
Hello 9ja,

Bitcointalk: Lmaooo
Gender: Male
Location: Gombe/Nigeria
Skills: sysadmin, web developer, graphics designer, and crypto trader

I just want to thank CryptoBrainBoss for this thread.
I'm always happy to see my fellow Nigerians come together.

btw, I no get NIN sef! Grin
i am too lazy to get mine
maybe this week shaa!

legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 20, 2021, 02:04:38 PM
Hello my people here, abeg, make una no vex say I shift small comot from the topic of discussion.
The matter be say, e get one big(no be small) crypto project wey I dey arrange to launch before the middle of this year, so the level now be say I still dey try arrange serious tech guys wey fit work with me untop the project, so why I dey make this post for here be say, i need a very good web developer wey Sabi wetin the sup, I myself na web developer but I won hire person wey Sabi pass me make he or she  assist in creating website wey go make better sense.
So if any of my brothers or sisters here fit fit in, make he or she Halla me for dm here, I go respond back asap, and please know say be be free work oo, I go pay.
Thank you.
No wahala say you shift small comot for the matter way breketeh for ground o, the news way you carry come talk for here na better own and e dey sweet for belle. As e fit empower some of us here make people pocket no dry. You for cucuma just clear people on how the project be make other people know if them fit shock body but again, make e be watin no go cause wahala later.

Mehn, one number call me today o for afternoon. E sound like customer care shah but, na normal phone number, 11 digit. E dey tell me matter say my the NIN I send no complete after two weeks ago way I try link my Sim. E give me options to press as the call dey on shah and I fear do am via say, scam now they take different form. Make e no be watin them wan phish person NIN to set pass for themselves. How e be for una?
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 20, 2021, 11:20:38 AM

Jump to: