Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 261. (Read 554634 times)

hero member
Activity: 966
Merit: 545
January 04, 2021, 07:00:24 PM
Even our war jet nodey get gas as e fly reach sambisa boom him don crash... How una see dis mata

All this tori na allegedly, nothing concrete don come out yet so make we dey see first. Although e nor go surprise me before
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 04, 2021, 10:21:49 AM
Tori 4 Town
Snipe>
My dear, all those stuff na mere rumour oh. I nor see anything wey point to facts there. If you even look well you go see sey na anonymous handle dem take post am. Nothing to verify there. Abeg, make we nor help propagandists spread their hatred. If to say na from reputable handle dem take post that screenshot wey you share, then I for know wetin I go talk.
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
January 04, 2021, 09:28:38 AM
Tori 4 Town
Ma pipo i hail una how una dey? E get tori wey dey town I say make we follow chok mouth as edey hot de pipo dem wey sabi computer wey dey hack pipo kidney join body don expose som names o wey dey support dey sponsor bokoharam 4 wey country say na dem dey cause katakat 4 wey naija. As dem list de names so our Army General Brautai wey dey in charge of we army dem say na him be bokoharam No2 man oo say all de guns, de bomb wey dey com 4 d naija military say him dey divert dem give book haram oo make dem shotu shotu and nyash our small small girls dem. My pipo de way bokoharam dey lay armbush 4 our soldiers nodey normal oo den dey get first hand informate. Even our war jet nodey get gas as e fly reach sambisa boom him don crash... How una see dis mata? Asari na person I suspect since nobe today our burna boy say him nofit see toto put prick 4 nyash na so today tori carry... Una weldon.

member
Activity: 91
Merit: 35
January 04, 2021, 08:37:34 AM
Happy new year to all of una and many happy returns. I hope we all enjoy the festive small and we no finish to spend our money on top enjoyment. Abeg make una save money ooo as we all know say January be the slowest month in the year. Let us not panic sell awa bitcoin on top hunger matter just in case you don spend your money finish. Make we continue to hustle for a better 2021.

I hail una and congratulations to our boss  CryptopreneurBrainboss for winning the award, more grease to ur elbows and many more to come.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
January 04, 2021, 05:02:34 AM
I greet una my fellow Naija people, hope you no mind say I no post for local thread for awhile, na one thing or the other wey cause ham. Happy new year to us all. I happy die say we no dey carry last, I supposed to have also done this officially say our legendary brother, CryptopreneurBrainboss, won an award and a price last year. This mean say we Naija dey try for this forum, only wey remain na to have our own local board which we don dey expect na.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
January 03, 2021, 04:10:40 PM
As we dey welcome and jolly with you, make I take style warn you kwa because, e get some unofficial rules way dey skip person very easily like this one way you just do.
Nothing dey wrong with the content o but, the way your post follow each other for yash, according to the forum, e no go well and them go regard am as spamming. Instead of to make different posts way go follow each other for yash, just edit am to be one post.
If you wan quote another post, just shift your cursor go where the post gat enter, fine the post you want under the reply box then, tap Insert Quote for top left of your device then, arrange am as you want.

I know say, you still dey fine your way around the forum and how them dey do things here. I know say e no easy and with time you go learn but learn this one now, make you no go do am for places like meta and e go hock you for neck. Na small small and you dey try. We dey with ourselves for here. One love naija.
Na small small him go adapt, Nairaland follow help most of us how to use this forum, you sef suppose cut out our quotes make e for be say na only am you dey tap for bumbum make him code.. but at all at all na him bad pass pikin wey hear elderly man advice him suffer no dey ever lost.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 03, 2021, 04:04:24 PM
As we dey welcome and jolly with you, make I take style warn you kwa because, e get some unofficial rules way dey skip person very easily like this one way you just do.
Welcome onboard my naija brother, you don already near member rank na just make your activity increase remain. No reason am na with time bro... Nice skillset bro.
Thank you for the warm welcome. I know say everywhere go popori every soon
welcome, my broda 4rm anoda mother, hope sey u don read all de official and unofficial rules? abeg make we read dem becus dey will guild us 2 greatness.
Thank you, I don read am. I go do my best not to lose guard and I believe with the voltage of this community. I nor geh shaking
Nothing dey wrong with the content o but, the way your post follow each other for yash, according to the forum, e no go well and them go regard am as spamming. Instead of to make different posts way go follow each other for yash, just edit am to be one post.
If you wan quote another post, just shift your cursor go where the post gat enter, fine the post you want under the reply box then, tap Insert Quote for top left of your device then, arrange am as you want.

I know say, you still dey fine your way around the forum and how them dey do things here. I know say e no easy and with time you go learn but learn this one now, make you no go do am for places like meta and e go hock you for neck. Na small small and you dey try. We dey with ourselves for here. One love naija.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
January 03, 2021, 01:54:45 PM
Welcome onboard my naija brother, you don already near member rank na just make your activity increase remain. No reason am na with time bro... Nice skillset bro.
Thank you for the warm welcome. I know say everywhere go popori every soon
full member
Activity: 756
Merit: 231
January 03, 2021, 11:35:43 AM

Username: PokaPoka124
City:             Warri
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, graphics designer
welcome, my broda 4rm anoda mother, hope sey u don read all de official and unofficial rules? abeg make we read dem becus dey will guild us 2 greatness. Warri dey hia well well nd we b naigbor becus am 4rm Edo.

@Becky666, your hand never strong for the BBCODE stuffs? just make the designs for every rank for we in campaigning for the local board wey we wan get.. sometimes we no dey see campaign join we go just wear am na another thing be that wey fit make our intentions known.. Happy new year.
Dat one na gud idea nd we go execut ur suggestion, tanks. Well, nelson4lov cucuma go join hand and dis BBCODE no go b issue tanks my able broda.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
January 03, 2021, 09:41:41 AM
Username: PokaPoka124
City:             Warri
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, graphics designer
Welcome onboard my naija brother, you don already near member rank na just make your activity increase remain. No reason am na with time bro... Nice skillset bro.

@Becky666, your hand never strong for the BBCODE stuffs? just make the designs for every rank for we in campaigning for the local board wey we wan get.. sometimes we no dey see campaign join we go just wear am na another thing be that wey fit make our intentions known.. Happy new year.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
January 03, 2021, 07:06:43 AM
It's better late than never and as e be so, I dey welcome una to 2021. Happy new year my people. No dull moment this year o, people way still dey festive dey go, work don start o, make we hustle the hustle make our pikin no drive tire for road or drive ballress for street o.
God's grace na watin I wish una this fresh year.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
January 02, 2021, 06:45:32 PM
Username: PokaPoka124
City:             Warri
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, graphics designer
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 02, 2021, 05:00:28 AM
I throwey my HNY greetings here to all man! I hope una enjoy the holiday wella and una chickens cook well. Abeg, e go good make wey try to dey throw in comments here regularly for this 2021 so that e go help build owa presence for this forum as we dey push for owa own local board something. If dem see sey we dey serious with contributions dat one go mean sey any argument to deny us nor go fit stand. I read somewhere here wey one tribe dey ask for dis same thing and part of the argument against dem be sey those people nor get better contributions. Abeg, make we all join hands together to make owasefs great. Na cooperation dey make rice full pot. This na my new year message be dat.

One luv...
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
January 01, 2021, 10:10:54 AM
ma pipo how una dey happy new year i dey hapi to see una my pipo i small album 4 forum todai Comperative Features On Top Phone Antivius For Crypto Wallets Protection i loya lik dis so  Grin half bread is beta dan kurikuri una sabi d tin
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
December 31, 2020, 04:08:35 PM
This guy ehn...You and all these your type of proverbs sef... Lol.
As in eh, be like that guy grow up for ghetto(no vex) whr bad bad tins dey happen, him pidgin and proverbs them na die, if you no reason am twice u no go understand pim.
I hope say even with this covid matter, all of una gani wella and e no really worry pass movement and food matter.
Smartvirus, me and my bany like this like this dey road dey go club for fagiment, but wetin don spoil our mood be say we no go dey till fowl give us signal, as na becos our oga (Gov. Nwike) don talk say make we no crossover till after 12:00 base on the coro matter, if him boys catch you, na cell you go find yaself, me want rock out 2020 comot for my blood as e dey hot, but no shaking.
legendary
Activity: 1316
Merit: 1610
The BSFL Sherrif 📛
December 31, 2020, 12:28:07 PM
 my pipo i hapi wella to see una as we dey end 2020 so na so so katakata we see 4 we country and we stil gidigba 4 ground. As we dey enta second lockdown so. ani work u dey do hold am tight as campaign no dey so Dem no dey tell blind man say salt dey soup mak una use una head nobodi lik us. our pipo say na woman wey never see problem dey hold breast run our eyes don see tins 4 here.

My pitakwa pipo our Gov Wike don talk o say if na club mak u do am dis nite if na to cari olosho mak u cari o as de opportunity nogo dey lik dat 4 new year. Our pipo say Woman wey dey find pikin nodey wear pant sleep as we dey enta new year so set ur goals if u get update share wit ur friends. @nelson4lov @Becky666 @mpamaegbu I  hear wetin una talk... Una weldon.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
December 31, 2020, 11:08:16 AM
Happy new year my beloved people. 2021 go come with honey and more winnings this year really tough and rough but we stand against all odds make the new year no follow him immediate younger brother show men shege na our earnest prayers be that. But the most important thing now na continuity of life and good health be the most important one.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
December 31, 2020, 10:31:19 AM
Anytime way I enter this thread eh, my mood dey just light up. I dey always feel like say I dey house as na here way my pple really dey. Pple way understand how e dey be. I greet una for this last day of the month and year 2020. Like play like play, we don't almost dey pursue this year commot be this. I hope say even with this covid matter, all of una gani wella and e no really worry pass movement and food matter. Anyhow e be, next year dey come with another challenge so, make we ready way am, e no fit way us. Una way don survive reach this long, na success we all be. As we dey end the year so, make we do am peacefully and mind where we go be for the night for those way go like commot. Begin the year with God, na em go show you way. 2021 na our year o, we go dey push and push till our pple for here stand on solid ground for the deck.

Happy new year in advance to all of una, I love una wella

From your brother
Smartvirus
full member
Activity: 756
Merit: 231
December 30, 2020, 01:28:48 PM
Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Baba life be like wheelbarrow eno balance mama sacrifice for me well well pure water she never drink all d cars I wan buy no way baba I no get joy as I dey so but baba God dey our mata any how ebe

But no allow the tin put you down. I remember when I small I tell myself if my mama no chop my money nobody go chop am but as I grow older I come dey small pikin talk inside am. The reason we dey alive na to help people, the moment we don help finish we go go visit our marker.
Dat la de simple truth, wen i b small i used 2 talk am sey mama papa na em be my right pensi until i loss him 2 death, but anoda pensi raised me till i grow 2 become a man, we shouldn't choose our favorite between humans but always offer our help to anyone available, by so doing the rewards will always come from the marker.
Quote
Hope say una Xmas dey go well. Merry Xmas and happy new year to all man for here for advancementation. Una tight no be beans. Make una no forget oh our 2021 goal na to get local board anything wey you fit contribute like idea to make an a success bring am come.
We go make am a reality wen de time coms.....
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 30, 2020, 11:38:33 AM
make i burst ur brain 87% of our naija brodas wey dey dis forum no dey gree show face 4 here i don see like 10 legendary members wey be naija but dey never near here before..
This guy ehn...You and all these your type of proverbs sef... Lol. Well, for dat thing wey you talk about owa people wey dey hide from this thread. I sabi sey na fear dem make dem behave like dat. Dem nor want make people begin look dem with one kain eye as Naija pikin dem as many people too dey look us as bad people. Sometimes e good to stand for wetin you believe and bone Uche face.
Jump to: