Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 260. (Read 554634 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 20, 2021, 10:00:00 AM
This idea of sim verification by NIN in this kind short amount of time na one of the most stupid things I don see for this country.
You forget sey the usual Naija things — Dem go ever postpone it na. Just wait and see. BTW, the January deadline be for people wey get the NIN already oh. I think the time frame nor dey short for that. Na something wey person fit stay on top im bed do sef in less than 3mins. So, anybody wey get the NIN already from registered National ID nor supposed get issues with that except the persin just wan delay. Na the codes be this in case anyone nor know already:

Code:
* To know your NIN number dial (*346#)
                  
1.To link it with MTN dial (*785#)                        

2. To link with Airtel dial (*121*1#).            

3. To link with 9mobile dial (*200*8#)                            

4 . To link with GL0, Send " UPDATE NIN , NIN NUMBER, first name ,last name " to (109) .
Eg "UPDATE NIN, 12345678901, Jamiu Alabi Oke "  to 109.

If you leave us, we always like 11th hour rush. Shift the time from now to October, people nor go still serious until we enter September. Na owa pattern be that.


bevnation, I greet thee oh. How Wike and the  rest of the thieftians?
member
Activity: 70
Merit: 19
January 19, 2021, 08:40:00 PM
Username: bevnation
Gender: Female
Country and state of resident: Nigeria/Port Harcourt

My people I greet oh,na my first time be this oh

Me I no knw hw they won make everybody go do this NiN for this kind short period of time,I for say make them still give us time so that everybody go try take time do their own and because of covid19 them no suppose allow too much crowd for one place but now this thing dey make them gather too much crowd.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
January 19, 2021, 02:09:21 PM
Username: Mr.right85
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria/Port Harcourt

I dey pay loyalty o, my pple. life 4 d forum no eazi i no go lie una, i don try bt d mata jst be as e get. I jst get joy now say place like dis day 4 me to come rst small. I jst wnt mak una know me as una pple too o, anyhow e be, i dey una hand.

4 d mata on we country, e no be watin persn no go giv attension o nd na we d youths way dey suffer all d pressure. How we go do na, like say we fit do anytin cef, na dat side bad pass. Frm one wahala to another. To b common man for this country bad o.

Welcome to our corner of Bitcointalk. E fit dey small now but we go get our own board soon as our numbers don dey grow. I dey dey glad anytime I see my fellow PH people here. E dey remind me say i no dey alone on this journey. Welcome once again. Just keep your head down and contribute well. With time, you go dey used to the forum. Also, any opportunity wey you see say you fit benefit from, no fail to take am.


My people, I hope everybody don ready for the incoming NIN blockings from NIMC. This idea of sim verification by NIN in this kind short amount of time na one of the most stupid things I don see for this country.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 19, 2021, 08:59:35 AM
Mr.right85, welcome wey bread  Grin. Na the place to be for this forum be here for Naija peeps. So, just feel at home to yarn owa local flavour, nothing do you. But that your last paragraph get as e be oh. E come be like sey na one of lost hope. I nor believe sey we supposed lose hope at all for we country. We gat to keep standing up for ourselves. Otherwise, those polithieftians go easily achieve wetin dem dey plan. Shey you sey how that #endsars matter take go? E show the resilient spirit of owa Naija peeps. Keep on keeping faith. E go better
hero member
Activity: 896
Merit: 645
January 14, 2021, 12:54:39 PM
Username: Mr.right85
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria/Port Harcourt

I dey pay loyalty o, my pple. life 4 d forum no eazi i no go lie una, i don try bt d mata jst be as e get. I jst get joy now say place like dis day 4 me to come rst small. I jst wnt mak una know me as una pple too o, anyhow e be, i dey una hand.

4 d mata on we country, e no be watin persn no go giv attension o nd na we d youths way dey suffer all d pressure. How we go do na, like say we fit do anytin cef, na dat side bad pass. Frm one wahala to another. To b common man for this country bad o.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 14, 2021, 07:21:35 AM
The kain crowd way dey position for these NIN centers nor be here o..And we claim say we dey try prevent the spread of covid.
Na here ns em water dey swallow me. How our government dey act like say them no dey watch news or see crowd way gather when e happen say na something way go put money for government purse.
Govt still dey put deadline for people to register for NIN.
On this other matter eh, i no go blame government, our people too get stronghead. You and me know say no be today National ID reg start but then, almost everybdody no gree do am. We sey always dey push am go front until e be as e be now. Where i go blmae government for thus siude be say, the time e dey take them to give you plastic ID too long and na watin dey tire people be that. Imagine say if you run am for Abuja, e no go take you up to 2 weeks to get plastic ID but once e be another start, especially states for south-south, the matter go reach you start one degree program for school and graduate cef and plastic ID never ready. The country just tire person with the way things dey go.
I believe say fg wan just use this registration as a means to spike the covid cases for our country so them fit resume lockdown and collect funds from international body.
E fit be true o, nothing way the government of this country no fit do. The government as e be now eh,no be government for the people o, na government for myself and my family. The rest no concern them. Na why person no just gat carry this country get hope but, we go dey try shah.

No work sweet pass online work oh. And those of us wey dey campaigns here una sabi how kishi dey enter per week level and how the thing take dey swell pocket and put food for table. Most of those people wey dey out there no even dey make half of wetin we dey make here gisting. Yet, people wan die on top finding government work. Na the same energy wey dem dey waste for nairaland dey burn data yet Seun nor dey drop anything for anyone. And if you tell dem about Bitcoin or cryptocurrency some of dem go sey na ponzi. Well, who nor know nor go know.
Na true you yan o, to get job for we naija na die hard struggle if you no get compass o. The few way you go see cef eh, the kind condition way follow and there pay rate eh, e be like say you dey beg for the money. Work way you go dey work cef con dey owe them befire them even wan pay your salary,,, na there the matter go wayh you, i experience am so tay i tire!
Na how my waka for here take start o, now cef eh, i no sure say i go fit work for any body cef. Na online doings sure pass, where you no dey call anybody boss, no body dey put eye on top you or push you around, where you no dey answer or submit report to anybody. You just dey do your thing in your own time and you dey make your money. Who no go like that kind thing, na why to know small book and the right people to show you around good.
Men them way bring us come here and people way sabi, i salute una finish and our Papa naija for the forum CryptopreneurBrainboss , i pay respect brother as you use dey carry everybody for body dey go. Na so we gat dey, if you no sabi carry people for body learn am but, use your head.
member
Activity: 278
Merit: 15
January 13, 2021, 04:17:13 PM
Nigeria has come out on top among cryptocurrency users.

Nigeria has overtaken India twice in terms of the number of active cryptocurrency users. There are 2 million people in the country who use an alternative currency every day.

hero member
Activity: 1120
Merit: 555
January 12, 2021, 03:18:22 PM
Brainboss, abeg na time to include this NIN thing as current topic for title.
Our government nor try for this NIN registration matter at all. The kain crowd way dey position for these NIN centers nor be here o..And we claim say we dey try prevent the spread of covid. Govt still dey put deadline for people to register for NIN. I believe say fg wan just use this registration as a means to spike the covid cases for our country so them fit resume lockdown and collect funds from international body. Even our banks nor dey try, how you go keep crowd for outside bank say you dey observe covid 19 protocol e nor make sense at all.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 12, 2021, 08:38:46 AM
Na true you yarn. The coWtry sef reach to tire persin. The leadership and the gbagbos wey dey inside too much. Nowadays sef, tori about murder and armed robbery nor dey too shake me because dem dey too many to read. I just glance the tori and then look for another news wey go fit make me smile to read. Bubu sef nor know wetin to do again. The cowtry cast nor be small.


Brainboss, abeg na time to include this NIN thing as current topic for title.


Person way suppose dey school either for four years or five years course via universality, for watin e no dey sure of employment cef when e graduate, e don dey add 2 more years on top, even the secondary school people cef, na wahala.
Make I yarn you the koko, owa parents dem give us bad orientation to believe sey we need to work for someone or government once we graduate. But that na big fat lie. No work sweet pass online work oh. And those of us wey dey campaigns here una sabi how kishi dey enter per week level and how the thing take dey swell pocket and put food for table. Most of those people wey dey out there no even dey make half of wetin we dey make here gisting. Yet, people wan die on top finding government work. Na the same energy wey dem dey waste for nairaland dey burn data yet Seun nor dey drop anything for anyone. And if you tell dem about Bitcoin or cryptocurrency some of dem go sey na ponzi. Well, who nor know nor go know.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
January 12, 2021, 06:25:15 AM
Now the NIN people way government don force on us via reg and sim card linking palaba don go there own strike... Abeg, watin dey happen for our 9ja, abi make we pack go start life somewhere, me I still believe in the opinion say, grass green where you pour am water but, the water don dey finish o.
How e wan be na???
Pant don wear us finish for we 9ja o the worst part be say na G-string. NIN number wey I no get if dem wan block mak dem block even NiN staffs don go strike Grin. My broda man my sista woman. If u get way make you travel o life here no balance bfore bra go wear you.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 12, 2021, 06:11:33 AM
Abeg eh, we country, I no know how e dey be again. Everything thing, every sector just dey see strike as last resort. If no be labour, na ASUU, na doctors, if no be doctors, na NEPA, if no be NEPA na tanker drivers. Sometimes cef,na all go follow join body dey run am. Person way suppose dey school either for four years or five years course via universality, for watin e no dey sure of employment cef when e graduate, e don dey add 2 more years on top, even the secondary school people cef, na wahala.

Now the NIN people way government don force on us via reg and sim card linking palaba don go there own strike... Abeg, watin dey happen for our 9ja, abi make we pack go start life somewhere, me I still believe in the opinion say, grass green where you pour am water but, the water don dey finish o.
How e wan be na???
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
January 10, 2021, 10:03:44 AM
I be law abiding person and I go dey follow una ideas and steps as how things be for here cos I still dey grab and will continue learning day by day.
My sister we welcome you for here as we accept any gender for this place like this, as you don enter so, make you put eye for every boards dey learn one thing or the oda for u to be better poster and learner, I like the fact say you be law abider, d only law wey dey important for here na to avoid plagiarism, them no dey take am play at all, if you comit am you don comot here final be dat.
I look forward to having a very good relationship with you all. Thanks
Sure, we dey with you, just dey active for this ghetto make your face show, any wahala wey dey bother you, you no get shaking to carry am come here make we put tru. Our oga Brainboss go too go help u too if we no fit deliver. Enjoy the ghetto.

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
January 08, 2021, 06:28:04 AM
Abeg if u neva join de BitcoinTalk Party na de link be dat e was created early last year mak we turn am to our tin e don dey dey borin make we show dem say we dey break social network.i know say most of una sabi dat link so. We fit create our board der oo

Baba e get
General board
Bitcoin discussion
Hangout
Game board
PM
Video call
Edey borin via say na just 200+ members dey were u get chance to gain popularity as na baba dem 4 de forum dey dere. U fit chyke Tman & Lovemay too... U seek permission b4 u pm no just dey pm pm o na automatic block o e get rules
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 07, 2021, 01:15:41 PM
Abeg if u neva join de BitcoinTalk Party na de link be dat e was created early last year mak we turn am to our tin e don dey dey borin make we show dem say we dey break social network.i know say most of una sabi dat link so. We fit create our board der oo
I no go lie, I just dey see this link for the first time and as e be so, I for like know watin be the reason why the reason or small talk about why them set up the Bitcointalk party something. Person no dey just join group just like that na. As e be like e boring so for people way dey the group, e fit be say, na via say them join without even getting the least idea way back the group and las-las as them join, them no con like am. So, e for good say, update come board on the group so, we no go get another boring member.
member
Activity: 79
Merit: 10
January 07, 2021, 07:35:12 AM
Username:   Bholutefe
Gender:        Female
State of Residence and Country: Lagos/Nigeria
Skills:   Fx Trader
 

Hello my people, I thank una for giving new born babies like myself the privilege to be among my country people, I dey very new here,  I been just join this forum recently and e be one kin very interesting and informative forum for me, I dey learn ever since i don join and I still dey learn, e make sense well well and I dey very happy to see myself among my country people, other nationalities too dey wey I dey grab base on one or two ideas and senses from their posts and topics. I be law abiding person and I go dey follow una ideas and steps as how things be for here cos I still dey grab and will continue learning day by day.  I look forward to having a very good relationship with you all. Thanks
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
January 07, 2021, 04:51:00 AM
Abeg if u neva join de BitcoinTalk Party na de link be dat e was created early last year mak we turn am to our tin e don dey dey borin make we show dem say we dey break social network.i know say most of una sabi dat link so. We fit create our board der oo
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 06, 2021, 07:22:58 PM
For the kind word way wedeu now eh, nothing fit be crime until them verify am even at that, na until the court talk say, na so e be even when we ourselves know the truth. Adena e them finish now,na for us to match down go their houses to go root them out or kill them? NO! That one no solve any matter. What if e con turn out to be say, na fake news or some names way follow dey incurate and the few dey innocent?
As wedeu chuk mouth for matter way come board for we country, we gat still kwa, use our head follow up make we no make mistake we no fit erase or undo. Verification helps.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
January 06, 2021, 06:58:01 PM

As we dey welcome and jolly with you, make I take style warn you kwa because, e get some unofficial rules way dey skip person very easily like this one way you just do.
Noted. Thanks brother

Quote from: igehhh link=topic=5121680.msg56036191#msg56036191 date=1609959
 [b
person wey find u woman no go buy u condom o [/b]
Hmmm nor be lie. If we carry this matter for head e nor go profit us. The best tin for me o na for us to do part to make sure say our small corner better. If we fit achieve that one we nor go dey reason their tomatoes and oil way dem dey bring for elections
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
January 06, 2021, 03:06:00 PM
Tori 4 Town
Snipe>
Nothing to verify there. Abeg, make we nor help propagandists spread their hatred. If to say na from reputable handle dem take post that screenshot wey you share, then I for know wetin I go talk.
baba nain make i post am make we follow choke mouth but make we reason am na all dis names wey dem call so u no suspect anibody 4 here? on ur own assumptions cause nobe god dey expose terorist o na humans lik us too dey do am. as an enginnering or science students if numbers dey unknown u go make assumptions to get the missing number. na tru demsay dem say we dey cari sabi true. me i still dey suspect Asari oo cus of him history how him covert from Christian to muslim run comot go Niger go nationalize. dis man hate buhari lik mad o and dis man too dey in support of Biafra agitation dis kin person fit cus katakat 4 we country o... person wey find u woman no go buy u condom o mak we use our head analys dis issue wella... nobody open gov ynash pass anomynous dem o we knw der history.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
January 06, 2021, 02:47:39 PM
Tori 4 Town
Ma pipo i hail una how una dey? E get tori wey dey town I say make we follow chok mouth as edey hot de pipo dem wey sabi computer wey dey hack pipo kidney join body don expose som names o wey dey support dey sponsor bokoharam 4 wey country say na dem dey cause katakat 4 wey naija. As dem list de names so our Army General Brautai wey dey in charge of we army dem say na him be bokoharam No2 man oo say all de guns, de bomb wey dey com 4 d naija military say him dey divert dem give book haram oo make dem shotu shotu and nyash our small small girls dem. My pipo de way bokoharam dey lay armbush 4 our soldiers nodey normal oo den dey get first hand informate. Even our war jet nodey get gas as e fly reach sambisa boom him don crash... How una see dis mata? Asari na person I suspect since nobe today our burna boy say him nofit see toto put prick 4 nyash na so today tori carry... Una weldon.

Snipe>
,
Baba this thing no really mean anything like that sha, anybody fit hide behind this anonymity to spread political propaganda, the best na to avoid all these half baked journalism make e for no break us further.
Jump to: