Pages:
Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 4. (Read 554634 times)

jr. member
Activity: 66
Merit: 7
November 07, 2023, 10:39:16 PM
Username: Jamestown70
Gender: male
State:Bayelsa
Skill: I am open to learn one

Thank you brotherly for the warm welcome I wish to utilize this platform to gain more insight on cryptocurrency and also find and meet interesting person's for here.

Shalom
legendary
Activity: 2114
Merit: 15144
Fully fledged Merit Cycler - Golden Feather 22-23
November 07, 2023, 08:07:52 PM
PIGIN VERSION OF fillippone THREAD
Everything you wanted to know about BTC futures but were afraid to ask!

https://bitcointalksearch.org/topic/m.52572357





Hello, maybe it's better to extrapolate this (and a similar translated post to a new thread on your board?)
Maybe also recovering the images?
I guess the post would be more easily reachable to new forum members.

Maybe this is work for the moderator?
Thanks!
member
Activity: 75
Merit: 16
November 07, 2023, 12:04:49 AM
Username: Btcdeybodi
Gender: Male
State: Rivers
Skill: Crypto Entrepreneur

I greet all of Una wey dey this forum, una no try at all o how Una go dey this kind beta forum una no come give me update say see wetin dey sup make me too follow the trend base on wetin me too go fit learn and contribute for here, anyhow wey e b all of us na one so anything wey we know say we go dey involved in other to bring our country name to the world make we dey do am o my people oyibo man say there's no limit to greatness so you guys should keep doing exploits I'm impressed with wetin I don't see so far for here. Una thank you for giving me this opportunity to introduce my humble self. One love
full member
Activity: 224
Merit: 151
November 04, 2023, 08:05:12 AM
Naija people I dey hail ooo, make una no vex say I dey post now for here. I dey see this thread today. I dey new for the forum

Username: Justbillywitt
Gender: Male
Skills: Investment coach. Feasibility and Viability analyst.
full member
Activity: 182
Merit: 109
November 03, 2023, 05:47:19 AM
Good day my fellow country people, I greet everybody in the house.

Please am new here, make ona carry me along, If I fuckup along the way make ona correct me as newbie wey I be abeg🙏🙏 am willing to learn.

Username: barikui1
State:  Rivers state
Skill: graphic designer, hair stylist
member
Activity: 196
Merit: 70
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
October 30, 2023, 05:37:44 AM
username: Cryptoprincess101
Gender: Female
State: Lagos
Skill: Fashion Stylist/designer

Wow, it is very impressive to see that my people are here in a community where it's goals is to proffer solution and give basic information about bitcoin which has every tendency to become the next generation currency. I am optimistic that women are now developing interest in joining world community forum like this and I believe the women will not be left out in giving their opinion and views on what can give solution to world problems. With all sincerity, I say I'm happy to be in the midst of men please you guys should pet me o I'm a princess, Lol.
newbie
Activity: 1
Merit: 0
October 28, 2023, 04:10:13 PM
User name : sultanny
Gender: male
State : Abuja
Skill : computer science

My fellow naija people I say great oo I was just introduced to the forum so when I was just going around the from I just see the local board which I say this thread and I decided to introduce my self an hope to have more help and understanding from my fellow naija people
full member
Activity: 140
Merit: 63
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
October 27, 2023, 09:51:00 PM
User name: pi-network314159
Gender:Male
State: Rivers State
Skill: fulklift operator

My naija people I dey great ona. As I come this place I just say make ona know say na ona person be this.
As I know no much about how this platform dey work so I dey beg ona say make ona guide me through for this place make I no go make mistake. Ona thank you.
newbie
Activity: 4
Merit: 0
October 25, 2023, 01:23:34 PM
Username: Dextro1
Gender: male
Country/state of origin: Nigeria/Edo State
Skill: Graphic Designer

My people I greet oo
I dey new for this forum nai make I say make i introduce myself to una.
I go like to learn alot from una and this forum oo
Una too much
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
October 18, 2023, 03:37:35 PM
Username: Dan Arewa
Gender (optional): Male
State of resident (optional): Kano
Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend): Quality shoe producer
You are welcome to our Naija bro, I an happy to see more newbies coming into the forum to learn, and you have also come to identify with your people for the first time. This is great, I will advice you to ask any question that you want to know here before going out there in the general board to ask, so that our ogas at the top will be able to give you the answers. Don't post too much for now, but instead you should do more of reading and learning, so that you can understand the discussions on board. You need to improve yourself in order to grow here.
jr. member
Activity: 100
Merit: 4
October 12, 2023, 10:34:14 AM
Username: Dan Arewa
Gender (optional): Male
State of resident (optional): Kano
Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend): Quality shoe producer
Welcome Dan. We dey happy to receive you here and we hope say you go dey as contributory to the success of this naija board and forum in general as everyone senior member or legend don contribute in total.
No effort is a waste and the effort of knowledge and goodwill always get the best of results. Welcome again o.
newbie
Activity: 4
Merit: 1
October 12, 2023, 07:29:22 AM
Username: Dan Arewa
Gender (optional): Male
State of resident (optional): Kano
Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend): Quality shoe producer
full member
Activity: 238
Merit: 151
October 10, 2023, 09:30:19 PM

Richbased welcome but me I no free with this your prayer for cryptopreneurBrainboss reason being that,  instead make we say him reward dey heaven,  e better make the reward come for this world ooo,  because for heaven no body go need blessing so make all the blessing come tocryptopreneurBrainboss for this world make him enjoy the wealth in maximum, in fact make him enjoy the blessing for the world until he exust all the blessings and rewards allocated to home for this world before he enter heaven.

Nothin like your reward dey for heaven, make we pray for rewards for this earth because na for this world we dey plant any seed were we think go give us rewards.

Lol, yes o you are right my country man but make you know say no reward wey pass the one wey from baba God o, even if you gather the whole wealth for Earth we go still leave am go one day so wetin matter or what you be remembered for is how many life you have touched positively within your existence on earth. So no reward supperceeds that of God so I still stand on existing protocol to say that Crytopreneur brainboss your reward dey for heaven o Lol
full member
Activity: 504
Merit: 198
If bitcoin be for me...
October 10, 2023, 05:10:01 PM

Find the board wey you go fit in so that you  go follow dey discuss anything wey them dey talk doe there. Life na small, small those people wey reach Legendary rank, na like this themselves too start, before them  build themselves and their account here with plenty knowledge wey them learn through the forum.
Chaiii @ruttoshi this ur tok swit me wella for belle lik wuman wey don conceive. For the forum e no get as e wan be for unto say you de put in effort and kip by de forum general rules you grow na only time e go take, but still ur pace of growth for the forum e dey ur hand de way u take am serious and ready to learn and apply wetin u dey learn in thread discussions.
 
As newbies I go lik remind una say de luv we get for one anoda inside de forum e massive, nobodi wori no bodi, just respect urself and the space of odas. No try to be the reason for de downfall of any bodi and no envy any bodi growth and success cos de cake go reach everybodi. Yesterday I was a brand new member, now today I don turn FM na so tomorrow I go turn legendary nah just so de forum be. Na turn by turn as par say you ready to put in effort. Mk I gbaa break here... Our new members Una welcome oh.
sr. member
Activity: 294
Merit: 267
Baba God Noni
October 10, 2023, 02:42:04 PM
I join mouth use this opportunity welcome all the new members of this local board. Life for here dey very easy, if you stick around the forum to learn. Learning na something wey suppose to dey give you joy as you dey do am so that you go find wetin you dey learn interesting, and you fit understand am easily.

Make una take una time make research of wetin una no know and you fit still use the search engine for this forum find anything wey you won know as many topic wey people dey talk now, people for the forum do discuss am before.

Find the board wey you go fit in so that you  go follow dey discuss anything wey them dey talk doe there. Life na small, small those people wey reach Legendary rank, na like this themselves too start, before them  build themselves and their account here with plenty knowledge wey them learn through the forum.
full member
Activity: 1176
Merit: 118
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
October 08, 2023, 02:55:56 PM
Quote from: Abbatty
Username: Abbatty
Gender: male
State of resident: Cross River
Skills: Tailor

I greet everybody for here. I just see this section recently and as i see our people here e just sweet me for bele at least e go easy for me now as i wan learn about bitcoin and cryptocurrency because things de hard me to grab for other sections. I don see plenty useful posts wey go help me for here already abeg make una welcome me with open hands because i never sabi how things de be for here.

Thank you all
You're highly welcome to Naija local board man, but you have to do yourself a favour to read the rules and regulations that governed the bitcointalk.org and the Naija local board rules which are very important to every members of this forum to learn because, there are some rules you will break here the punishment will not allow you to talk about the good side of BTC.
member
Activity: 102
Merit: 21
October 08, 2023, 04:23:48 AM
Username: Abbatty
Gender: male
State of resident: Cross River
Skills: Tailor

I greet everybody for here. I just see this section recently and as i see our people here e just sweet me for bele at least e go easy for me now as i wan learn about bitcoin and cryptocurrency because things de hard me to grab for other sections. I don see plenty useful posts wey go help me for here already abeg make una welcome me with open hands because i never sabi how things de be for here.

Thank you all

sr. member
Activity: 434
Merit: 500
October 06, 2023, 11:31:37 AM
Hello my pipo, e don teh small wenn I dey dis forum but I no sabi sai where my pipo gather dey like dis because I no too dey active like that due to some reason but now as I don find my local board I go dey try dey active well well now becus I believe tins go dey easy for me to dey relate well well.

Username: Humblevirus
Gender: male
State of resident: kwara state
Skills: Enterprenuer


Omo be like you really de occupied because how you go get account for this forum from last year and you no de active. It’s not bad sha man gaz hustle one way or the other just to make ends meet. I am glad you found this our corner so because e de difficult for some people to locate this our caban. I no even know wede i go welcome u as a newcomer or as person wey don tey here. Anyways Welcome to the forum and the naija board I believe you are already familiar with the rules of the forum as you don be junior Member so. The forum no hard once you obey the rules and regulations you no go get any problem and this place wey you de so na your brothers and sisters gather here so if you get any difficulty with anything No hesitate to ask here make we share ideas.
full member
Activity: 232
Merit: 194
October 05, 2023, 06:18:18 PM
Hello my pipo, e don teh small wenn I dey dis forum but I no sabi sai where my pipo gather dey like dis because I no too dey active like that due to some reason but now as I don find my local board I go dey try dey active well well now becus I believe tins go dey easy for me to dey relate well well.

Username: Humblevirus
Gender: male
State of resident: kwara state
Skills: Enterprenuer
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
October 04, 2023, 07:59:28 PM
Username: usasauki2004
Gender: Male
Skills: Entrepreneur

I am very delighted to be part of this wonderful forum. It is of utmost importance to abide by the rules and regulations which I believe with you people here then am secured. Looking forward to learn more about bitcoin and good things about the forum with you people serving as my guide and mentor. I Dy greet wuna all.
Welcome to our local board,  make sure you read the forum rules and always have them in your reminder each time you want to participate in anything here in the forum because forum rules is your compass to navigate around here without any problem,  and take your time to read more as a newbie before you start to build an image here.
Pages:
Jump to: