Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 41. (Read 9540 times)

legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 30, 2021, 01:10:10 AM
#54
If lizard run climb tree come escape from cat, the cat go pretend like sey im nor dey eat lizard.
Meaning: When someone sees luxurious items beyond his financial capability or reach, they often pretend as if they don't care to have them.

Na where dem for dey advise pikin we get papa, na for there orphan dey learn.
Meaning: A word is enough for the wise.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 21, 2021, 03:37:30 AM
#53
Well, the truth be sey me nor fit stop any persin from posting wetin dem think sey be proverb. But na the original ones wey nor dey common anyhow dey get my attention and na dem I dey like merit. So, you fit throw your original own enter ring like this too.

The persin wey invent toilet nor mean well for dog
Meaning: For civilization to take place certain primitive advantages have to give way.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 20, 2021, 01:43:44 PM
#52
I no know how some of us dey take get our African proverbs but, I for like make e be say, the proverb the no go be the regular ones way we fit browse from online. E too soft like that! I go like make the proverbs we dey drop for here go be direct from your papa hut.
Men and women them way get childhood for village or hurt dey here?
If una dey, make una dey drop am for us make e no die out.
E go get one kind uniqueness about am and e no be everyday stuff, like tall way we dey hear for music or watch for tv though them still go well but, from the base ghonghoh.

How una see the talk?
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 14, 2021, 06:02:37 AM
#51
Every mallam get im own kettle
Meaning: Everyone has their own peculiar problem

E nor get as you go kill fowl wey im blood nor go touch ground.
Meaning: There's no way one can hide one's deeds (whether good or atrocities) forever.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 13, 2021, 09:43:29 AM
#50
(The Yoruba man says) Ojú timi!
My eyes have seen my anus!
I have witnessed the unbelievable!
This one confuse me small oh. Dem teach us for Yoruba class for school sey "Oju timi" na "I am ashamed" na. How e come take dey different here na.
Normally, language no suppose different o, even if e wan different cef, e for be very slightly but then, as you carry learn kwa, na so I use learn and this one no be my mother tongue so, I no go fit argue am plenty. The thing be say,
Na proverb I learn from my teacher back when I dey junior secondary. E become common tongue amongst us via say, when we dey read 'the god's are not to blame' by Ola Rotimi way the plot carry say, King Adewale sleep with the mother Queen Ojuola after en marry her via say, them separate long ago and no sabi themselves again.

So, when we dey read this novel, the proverb 'Oju timi' na em my teacher dey like echo for watin the abomination way the plot carry and na the meaning en give us be that so, I no know why e different but anyhow e be, maybe I no get the right Yoruba word but, na the proverb for pigin be that and na the meaning I translate so. Man no go ever fit see en own yash na why, the proverb dey about mystery, when the unthinkable happen.

I salute una my people.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 12, 2021, 01:28:32 PM
#49
(The Yoruba man says) Ojú timi!
My eyes have seen my anus!
I have witnessed the unbelievable!
This one confuse me small oh. Dem teach us for Yoruba class for school sey "Oju timi" na "I am ashamed" na. How e come take dey different here na.

Call me Fada, I enjoy your dubs but one thing we I discover there be sey you go try learn how to dey edit your posts to carry all of the things wey you wan yarn for one single post, especially if dem follow themselves bumper to bumper. Otherwise, the mopols for here go begin see you sey you dey spam oh and na bad thing for this compound. Spamming and copy copy (plagiarism) na serious gbenge here. Abeg make you dey avoid dem.
member
Activity: 131
Merit: 29
January 11, 2021, 07:51:11 PM
#48
"nobody for know say charcoal dey exist if no be fire"
Meaning: GREATNESS isn't born, it's made

   "Dem no dey stand give woman belle"
Meaning: Work was to be done, for a desired result. Smart work truly pays.
  
   "Person wey dey shit, no dey smile"
Meaning: who has problems never leaves the problem and starts playing around, you gotta face your battles squarely for better solutions
member
Activity: 131
Merit: 29
January 11, 2021, 03:52:54 PM
#47
"no use your raggae spoil my blues"
Meaning: don't allow over excitement let you  bring down someone's else's joy and happiness.

"Bad belle is allowed"
Meaning: in life hate is unavoidable. People must dislike, jealous and envy you for no just cause. It's eminent.
member
Activity: 131
Merit: 29
January 11, 2021, 03:45:54 PM
#46
Rivers (Ogoni) "osi osua"
Meaning: nobody tends to understand, apart from you.


  "Kari body with sense"
Meaning: why priding or been arrogant, be cautious, most especially be GUILDED.

   "Life na selfie"
Meaning: Life is personal, your destiny is in your hands, if help doesn't come, try helping yourself.
 
member
Activity: 131
Merit: 29
January 11, 2021, 03:31:48 PM
#45
Hahahaha love this thread

Pikin way him mama carry for back say him kick stone. Wetin him mama go come talk
Meaning: Don't be ungrateful to the people that helped you grow

Who sleep for ground nor dey fall from bed
Meaning: You can't give what you do not have

Na when you enter native doctor house you go know say juju get body odour
Meaning: You can't judge a book by it's cover

Who naked nor dey shook hand for pocket
Meaning: You can't give what you don't have

Na milk make soaking garri turn corn flakes
Meaning: Branding is very important

Na who wear tear tear cloth nai mad man dey call him brother
Meaning: You have to be in someone's shoes to feel his pain








Omo niggur you too much, this yarns burst my head 2seconds. Oil dey your head brother. Rugged you.. Especially the "who naked no dey put hand for pocket".
member
Activity: 131
Merit: 29
January 11, 2021, 03:23:22 PM
#44
Interesting, well let's go this way;👇

      1. Na only olosho no dey complain of see finish.
Meaning: it's only a prostitute that never gets shy, in life never give room for over familiarity.
     2. Na only time e go take, for stamara to call him papa name;
Meaning: Life's successes breakthrough only takes time and nothing more, but it must surely come.
    3. Pikin wey dey for him mama back no know say road far;
Meaning: People don't always know the sacrifices you take for them to actualise something, simply because they're not in your shoes, they never know your pain, effort and burden.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 10, 2021, 04:22:04 AM
#43
(The Yoruba man says) Ojú timi!
My eyes have seen my anus!
I have witnessed the unbelievable!

(Rivers) Tor é danu, naa tura capegere
Ear way go hear something, e no dey big like cap
Pay held to warnings to avoid trouble.

Soup way elder chop, e no dey move round for en belle
Be able to keep a secret

Una well done o, my people. I dey enjoy the wisdom una dey drop here.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 03, 2021, 02:05:50 PM
#42
Make I drop this one this night for my people
Snipe>
Pokapoka124, all these your proverbs ehn, dem show sey you na correct grassroots persin you be. The proverbs dem enter wella! Delta people, una too get funny proverbs just like una yarns sef dey make persin laugh. Na so I dey always laugh each time I watch Pararan for YouTube and his presentations of Mock News. My guy, I supposed throw you one something (you understand wetin I mean here na) to take appreciate your post but that something never dey my side now. But nor worry, I go do am once e show. Enjoy the new year!
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
January 02, 2021, 06:09:03 PM
#41
Make I drop this one this night for my people

Proverb:Na money dey make go-slow dey dey inside pot of soup
Meaning: if you want luxury you must work hard to get it

Proverb: Them nor dey beg small pikin make e nor grow big teeth as long as him get big lip to cover am
Meaning: You're accountable for your decisons

Proverb: Bingo nor dey bark for where bulldog dey na whistle e dey blow
Meaning: Mediocrity will always cower to excellence

Proverb: Nor be who first report dey win case
Meaning: The law is blind to sentiments

Proverb: Na who know person dey do person
Meaning: Always watch the people around you

Proverb: Who borrow money nor dey spray for outside
Meaning: Never spend above your income

Proverb: Urhobo man talk say Okro nor dey big pass him owner no matter how e tall reach, the farmer go still bend am harvest.
Meaning: Never be too proud that you forget your roots

Proverb: life dey sweet when you hol nor be when you dey owe
Meaning: Poverty takes away the joy of life

Proverb: Na who mess for bus nai dey squeeze face pass
Meaning: Never judge by appearance

Proverb: Na condition nai make crayfish bend
Meaning: Your situation can affect your disposition in life

Proverb: Na who get money like Job nai devil go need ask God permission before e touch am
Meaning: Money is a defence
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 22, 2020, 11:33:32 AM
#40
Na when you enter native doctor house you go know say juju get body odour
Kai! That one enter brain wella! Na true my broda. And e bi like sey you don fall in there well well 🤡but I hope you don stop by now sha?

"Who sleep for ground nor dey fall from bed", that one also totori me well. And this one too - "Na milk make soaking garri turn corn flakes"
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
December 17, 2020, 03:29:51 AM
#39
Hahahaha love this thread

Pikin way him mama carry for back say him kick stone. Wetin him mama go come talk
Meaning: Don't be ungrateful to the people that helped you grow

Who sleep for ground nor dey fall from bed
Meaning: You can't give what you do not have

Na when you enter native doctor house you go know say juju get body odour
Meaning: You can't judge a book by it's cover

Who naked nor dey shook hand for pocket
Meaning: You can't give what you don't have

Na milk make soaking garri turn corn flakes
Meaning: Branding is very important

Na who wear tear tear cloth nai mad man dey call him brother
Meaning: You have to be in someone's shoes to feel his pain
newbie
Activity: 15
Merit: 1
December 12, 2020, 07:17:20 PM
#38
Sense no be by Date of birth.
  meaning: Maturity is not by Age!


Cow wey no get tail, na God dey help am pursue fowl
meaning: He who have no one but God is with the majority!
That your first proverb enter wella. My people for village get another one wey still resemble that your own — my pikin tall nor be sey my pikin don grow. You go see small pikin wey get better height but nothing dey the brain to make am get better sense.

But your second proverb get k-leg some how because you miss something for the end. E supposed be, "Cow wey no get tail, na God dey help am pursue fly.

Lols na mistake or e go be say na autocorrect, I don correct am Sha. Thank you jor
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 11, 2020, 11:55:57 PM
#37
Sense no be by Date of birth.
  meaning: Maturity is not by Age!


Cow wey no get tail, na God dey help am pursue fowl
meaning: He who have no one but God is with the majority!
That your first proverb enter wella. My people for village get another one wey still resemble that your own — my pikin tall nor be sey my pikin don grow. You go see small pikin wey get better height but nothing dey the brain to make am get better sense.

But your second proverb get k-leg some how because you miss something for the end. E supposed be, "Cow wey no get tail, na God dey help am pursue fly.
newbie
Activity: 15
Merit: 1
December 11, 2020, 04:21:29 PM
#36
pikin wey say im mama no go sleep self no go sleep
Meaning:
A child who refuses to let Mom sleep will not sleep as well.
newbie
Activity: 15
Merit: 1
December 11, 2020, 04:15:21 PM
#35
Sense no be by Date of birth.
  meaning: Maturity is not by Age!


Cow wey no get tail, na God dey help am pursue fly
meaning: He who have no one but God is with the majority!
Pages:
Jump to: