Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 39. (Read 9498 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 08, 2021, 02:50:41 PM
#92
Smartvirus, na the koko you yarn so. And unto the proverb, na so e bi. Those wey dey consult ojukokoro go sabi sey na true you yarn. E get any babalawo wey nor dey ever add kolanuts and alligator pepper to their demand 🤔. E get? Nah! E nor get, except na the wan wey carry im own enta church level unto different stylee. Every babalawo na anya nzu.

Na where dem for dey advise pikin we get papa, na for there orphan dey learn
Meaning: A word is enough for a wise.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
May 06, 2021, 12:09:10 PM
#91
Who dey with me for hear na, I no fit cry this cry alone o. Who and me follow dey make una throwaway something for here make I see. I don tire to dey see myself and if we make water flow well for here, e go help too. Just that, I no dey too get that thing these days but, we need dey make things happen for here, e go sure. Anyhow shah, make we dey try dey checkmate ourcef, na the matter be that.

Proverb
In Pigin: My people say, Alegator pepper seed no dey ever finish for juju man pocket
In English: A saying goes, there is always the seed of an Alegator pepper in the pockets of a chief priest
Meaning: As a professional, you ought to be ready at all times on your field, you shouldn't be found lacking or unprepared at any point.

Make una take this one motivate. Na our corner be this, make we get am.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
April 29, 2021, 02:21:21 PM
#90
<>
My guy way sabi cool not only our tongue but our body too, e be like your tank dry these days o, as e be so eh, me I don say make I poor you water too. Make your brain for cool so that, you fit dey throw us the naija wisdom talk make the pikin them way dey the forum for dey from there learn how e dey be.

I go like thank una kwa way dey make this corner dey survive, my vision for this place eh, una dey actualize am and e dey sweet my belle. This place never go down below where I expect am to be and na una effort dey cause am so, I acknowledge all of una way dey put hand and shock mouth for the matter. The struggle dey on, make we niaja dey jam dem for eye anytime them show here. My hand dey up for una.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 26, 2021, 12:34:13 PM
#89
At least I don grab some proverbs put my head in case if person yarn for proverbs I go grab the meaning asap than looking like ode.
Yes oh, especially wen persin dey go im in-law place to marry. Nothing wey fit disgrace a guyman pass dat proverb thing oh for in-law place. Those old people sabi how to fall young guys hand to show sey dem too sabi something pass people wey go school. But if your head full, dem throw one you throw dem two, dem go chill. I dey tell you!

As the saying goes "person wey the explain proverbs give, the money wey dey take marry he or her mama lost road"
Snip>
Na true you yarn there unto the arrangement thing.


Proverbs
In Pigin: Them say, you no go fit carry your beads go sell for India
In English: Its said that, you can't export your local beads for sales in India
Meaning: You can't hope to sell a thing back to the originators or producers
Another proverb wey resemble dis one for my area na — Dem nor dey carry tombo (palmie/palmwine) go Obowo.

Obowo na famous town for Mbaise, Imo State, wey people sabi sey dem get betta palmwine. So, it's pointless taking palmwine to that place.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
April 22, 2021, 07:19:42 AM
#88
E get some Nigerian wise quote way I hear from people fir my area lately. I feel say make I drop am here kwa as na watin here be and na to keep here updated and busy join. Make una hear am as them take talk am.

Proverbs
In Pigin: Them say, you no go fit carry your beads go sell for India
In English: Its said that, you can't export your local beads for sales in India
Meaning: You can't hope to sell a thing back to the originators or producers

In Pigin: The monkey way dey lead for group of monkey them no dey always be the biggest
In English: The monkey that leads in a park of monkeys isn't often the big once.
Meaning: The measure of a person's worth and capacity isn't by its size, its a matter of your content.

Na so I take hear am and na so i dan drop am. Make our wise quote make us grow wise.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
April 21, 2021, 02:20:45 PM
#87
As the saying goes "person wey the explain proverbs give, the money wey dey take marry he or her mama lost road"
Na one you kwa just drop so o, e just lack arrangement and interpretation shah. No be say, we no grab watin the African wise abi make I say Nigerian wise quote dey talk o but, na as we dey do am here I dey try refer to. Say, if you bin just take style, arrange like proverbs for the Pigin, translation for normal English then, you drop meaning so that, the Oyibo way dey carry eye dey spy us for here go dey grab the knowledge way our papa them keep for us. E for sure shah. Anyhow, e go well say, you kwa don fine your way reach here. You no miss road, na we get am for here and once once, you fit dey come drop something here too. Make we dey show them capacity, e full our belle.
member
Activity: 672
Merit: 29
April 20, 2021, 04:52:57 PM
#86
All these my peeps una dey try wella. I supposed to sama all of una coolele water but my freezer dry as e dey na. I go still pour una d eater anything wey e show. Una sabi wetin I mean na. D way wey una dey take drop these yarns ehn come make me even begin think sey na popsy dem me and dem dey yarn 😜. Who train una, train una wella. Una weldone!
We African get proverbs wella nah. I hail my Africa brothers una too much for all this proverbs. At least I don grab some proverbs put my head in case if person yarn for proverbs I go grab the meaning asap than looking like ode. As the saying goes "person wey the explain proverbs give, the money wey dey take marry he or her mama lost road"
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 14, 2021, 01:01:17 AM
#85
All these my peeps una dey try wella. I supposed to sama all of una coolele water but my freezer dry as e dey na. I go still pour una d eater anything wey e show. Una sabi wetin I mean na. D way wey una dey take drop these yarns ehn come make me even begin think sey na popsy dem me and dem dey yarn 😜. Who train una, train una wella. Una weldone!
hero member
Activity: 896
Merit: 645
April 09, 2021, 04:24:06 AM
#84
I greet una my people. I dey see una working and from here eh, I fit just breeze in, carry any proverb throwaway parson and I sure say, e go dey strange to the person. Una try and as e be, I wan join mouth.

Proverb
1. Them say, old man way dey for dark room go seat down for chair con dey direct pikin say, go hear, look hear and check here and that thing way you dey fine you go see am.
Meaning: Being used to a thing is wisdom and it give you an extra knowledge of that thing than others.

2. Pikin way dey seat down for where elders gather, one day that pikin go be leader.
Meaning: You are often bound to be the caliber of people you share consolation with.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
April 08, 2021, 07:30:50 AM
#83
My people, we dey together. E dey give me joy when I dey see say una dey put effort to make sure say, we no comot for our position for this other languages board and that position na for first and second at all times. Una dey try. I get some new naija wisdom talk for una shah. Make una hear as we dey talk am.

Naija wisdom talk (Proverbs):

4 Pigin: No dey for bitter kola tree then, you go dey stretch to pluck pea from pea tree
In English: Don't be on a bitter kola tree and then you stretch to pluck pea from a pea tree
Meaning: Don't jump from a pressing and inconclusive issue to another issue.

4 Pigin: My people say, make you use big man eyes look big man pocket
In English: A saying goes that, you should use a wealthy man's eyes in looking at a wealthy man's pockets
Meaning: When you want to request something from a rich or wealthy person, do so according to his capacity. Don't go asking for peanuts less he or she considers it as an insult.

I dey with una for the struggle. Make una faji.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
April 02, 2021, 04:25:10 PM
#82
Proverb: Person way dem give goat chop say e nor bellefull nai cor fowl go bellefull am?
Meaning: A greedy person can never be satisfied
member
Activity: 672
Merit: 29
April 02, 2021, 07:14:30 AM
#81
Pikin wey dey chop akara dey chop him money.
Meaning: If one lives a careless life or spends Money extravagantly,he will still be the one that will suffer it.

No mata how nyash make yanga reach, leg must still first am enter house grin.
Meaning: You cannot outshine someone with more importance than you in an organization
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 30, 2021, 11:51:54 AM
#80
I wonder where all this proverbs dey come from o. E dey surprise me say, our people get this kind talk for mouth.
You rememba dat Papilo advert for Peak ba — It's in You! Na so the thing dey owa body for Naija. Forget, owa people correct die na only bad polithieftians be owa problem.

Pigin: When tilapia borrow money way e no fit pay, na catfish dey pay for the debt.
Chai! I dey tell you oh! Nor be small thing.


Proverb
For pigin: Them say na delay make fowl no fit fly when other birds dey fly.
This one enter brain wella! Every time wey I watch fowl dey do dat denge before e jump na so I go dey wonder wetin dey even fear them.

Pokapoka124, me sight you too bro.

I hail all of una wey dey make dis my corner una own too. One luv, my peeps!
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
March 28, 2021, 04:01:44 PM
#79
Proverb: E go better e go better na so 9ja take dey like this so
Meaning: Beware of empty promises
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
March 26, 2021, 02:16:11 PM
#78
My people I hail una o. Una way dey try dey warm here up to make sure say, e no fall-out of line. Una do well. Me I wan throw way una my own proverb too. My people say,

Proverb
For pigin: Them say na delay make fowl no fit fly when other birds dey fly.
In English: It is said that, it is due to long wait or delay that made the chicken not to be able to fly as other birds do.

Insinuation: it is assumed from observation that, the chicken takes a lot of time in measuring to confirm if it could archive a height in a flight or not on like other birds that just takes to the air.

Meaning: When you delay too much in doing a thing, it becomes harmful as it could mean opportunity lost. In essence, your left with scraps in an investment. It also explains why you should buy BTC when its best which is now than anticipate.

I look forward for more.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
March 22, 2021, 05:26:02 PM
#77
Okay, I don come. Why this texas people cef go get mind push this post go down, e be like say them no dey fear naija o, naija way get doings. Anyway, make I nack una this onces;

Pigin: When tilapia borrow money way e no fit pay, na catfish dey pay for the debt.
English: If tilapia lends money and can't pay back, the catfish jumps in to settle the debt.
Meaning: If a child finds himself or herself in a huge debt situation, its ways the parents or guidance that suffers to pay up.
Lesson: #You've got to watch your child not to bring the family trouble.

Make una manage that one for now. More go pour in later.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
March 20, 2021, 04:00:39 PM
#76
People way sabi the thing, I hail una o. I wonder where all this proverbs dey come from o. E dey surprise me say, our people get this kind talk for mouth. Una proverbs go welllllll. Make I throw way una my own.

1. Old  man way say e no sabi dig hole, watin e dey avoid pass the stress te hole go give am.
Meaning: sometimes, its not about how to say a thing that makes the awful situations  persist but, the consequences of that truth.

2. The same pot them use  cook for chameleon na em them dey use cook for lizard.
Meaning: Your always a party to those or the things your found identifying with and as such, your dished out same reward or punishment.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 19, 2021, 10:25:52 AM
#75
Pokapoka124, you make sense die!

Make I put these ones join body —

Mumu nor dey sabi sey im married sister na visitor whenever she come.
Meaning: Familiarity breeds contempt, simply put.

E nor get as eba go fall for ground wey sand nor go gum am.
Meaning: Once someone is exposed to hardship, the manifestations will be glaring to the eye.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
March 15, 2021, 06:31:31 PM
#74
Proverb: Na day way dark nai make road turn bush
Meaning: Life can be rocky sometimes and when you hit rock bottom people may look down on you and see you different

Proverb: Pikin way dey sidown for barbershop every day one day barber go dash am free haircut
Meaning: Don't give up sooner or later you will catch a break
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
March 14, 2021, 06:46:56 AM
#73
Unto the pikin matta, most parents nor dey like accept blame wen their pikin begin misbehave.
Na here way the matter dey. The up bringing of small pikin matta well well via say, na watin e learn from that time, e dey carry on for life. Gene or no gene, pikin way them teach well, you go see am say, e go carry on the better life way them teach am. This teaching no remain for house o because, e get the once way e dey learn from outside too but, na the environment and teaching from house go help the pikin to either resist the ones way dey come from outside or accept am.
To say pikin fail, no be the pikin fail o, na the parents or guidan because, when the pikin born, en been be clean slate. E no know anything for the life way e come until e begin learn from firstly,  the parent before e take leg enter outside.

Abeg, make una no mind the phenotype matter, na small small book I read before dey try resurface.
Pages:
Jump to: