Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 35. (Read 9496 times)

newbie
Activity: 25
Merit: 1
September 07, 2021, 11:14:38 AM
Omo this proverb dey to tori my brain, make me self drop my own for una
Proverb
If wall no open, wizard no go enter.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 07, 2021, 01:37:23 AM
Omo @Mpamaegbu, na so I for carry miss you for this we corner o but, God dey shah and this one show say, you na real man of the people with the way people come out con voltage for you. I just get joy say, you d0n show back to join body with me make we dey carry this our corner dey go, na you be the ginger for here and me no for fit do am alone.
Yes oh! Na Baba God get owa back oh. Una see as something wey dey small wan rob me of greater joy. E touch me wen I come remember how dis corner for be if I nor dey around. E make me feel wetin men wey get fine young wives dey feel when dem realize sey dem wan die 😅

Proverb:
In pighin: our people dey talk say, person way shit for road dey easily forget but, person way mash the shit, e no dey or e dey hard am to forget.
Dis ya proverb enta brain wella. I fit even relate am with my recent case sef. D guy wey report me nor even sabi wetin I pass through as na me wey mash d shit wey im shit sabi how e bi for body.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
September 06, 2021, 01:37:12 PM
Omo @Mpamaegbu, na so I for carry miss you for this we corner o but, God dey shah and this one show say, you na real man of the people with the way people come out con voltage for you. I just get joy say, you d0n show back to join body with me make we dey carry this our corner dey go, na you be the ginger for here and me no for fit do am alone. Oya o, one proverb turn up for we matter...

Proverb:
In pighin: our people dey talk say, person way shit for road dey easily forget but, person way mash the shit, e no dey or e dey hard am to forget.

I go live this one like this, make we carry our head reason am ourselves.
You dey very welcome brother, you don teach us the importance of living right and making friends. Welcome back Mpamaegbu!
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 03, 2021, 12:22:45 AM
Smartvirus, I come begin reason how e go even be to try use pestle shoot something like arrow until you come explain am. D thing enta brain wella, and na true talk. How you go give persin wey wan help you overload like dat and expect am to achieve result. Anoda proverb wey resemble dat your own be:

Pikin wey dem carry for back nor dey sabi sey road far

You sabi how e dey be wen dem back pikin (piggy back, if na oyibo language) and e go just dey play for d back wey im dey na.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
September 02, 2021, 07:41:44 AM
Some more wisdom for the culture.

Proverb: Hawk go chop butterfly wey say e wan dey fly like bird.
Meaning: Try to be yourself at all times
Omo, this one sure just now. E familiar small but, the context way e carry come na em make the thing dey sweet for ear! I get emails them here no worry. Make I throw one for una

Proverb:
For we Pighin: My people say, pikin way no wan survive na em go tell e papa say, make e carry pestle (mortar and pestle) use as bow to take shot arrow.
For Oyibo English: A saying in my place goes, it is the child that doesn't want to survive that would tell the father to use a pestle (Mortar and pestle) for a bow and shot an arrow.
Meaning: it is one who is not willing or ready to archive a thing that would make the process or proceses difficult for the helper. Try to keep it to a minimum, help out and you might be good to go.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 30, 2021, 08:12:03 PM
Some more wisdom for the culture.
~
Proverb 1 ✅
Proverb 2 ✅
Proverb 3 ✅

Na real wisdom you share there my broda. Even though I don hear dem before but d way wey you take put am for pidgin come make d thing don wella. I go pour you colele wata wen food done. This owa corner dey really help us to sharpen d native part of owa brain, nor be so 🤔. At least wen we gather for where old people dem dey for village or even town we too go fit surprise dem with owa contributions too with proverbs. Una dey try here.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
August 29, 2021, 08:42:50 PM
Some more wisdom for the culture.

Proverb: Hawk go chop butterfly wey say e wan dey fly like bird.
Meaning: Try to be yourself at all times

Proverb: You nor dey carry basket go river say na water you wan fetch.
Meaning: You have to be properly prepared for any task at hand

Proverb: Dem nor dey carry two leg dey check if water dey deep.
Meaning: Exercise caution when trying out something new


legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 28, 2021, 02:56:24 AM
First post on this board, very excited, first first i cut cap cun troway salute give everybody for the house wey dey make things and things dey sup for here...make una permit me, make i use two secs drop small wisdom make the jollof for reach me.
Na real jollof oh... 😅. Well, no shaking. Once the proverb tight I go baff d person wey send am with colele water if cold water dey my side. Dat wan nor be issue at all. But dat your proverb na mad oh! E crack me up small and I take style imagine how the pain go be too. Nice one. Again, wellu come to owa old people corner where we dey take wisdom and ogbenge sense totori owaselves.

~snipped
I like your second proverb. And e also remind me of prayer warriors wey dey pray for people and dey tell dem to get faith. But wen the thing rough for prayer warriors dem side most of dem nor dey exercise dat faith oh. Bros, abeg I go like make you follow owa format to dey put the proverb for bold s lolo we go easily catch am. Tanku
hero member
Activity: 966
Merit: 545
August 27, 2021, 11:48:34 AM
First post on this board, very excited, first first i cut cap cun troway salute give everybody for the house wey dey make things and things dey sup for here...make una permit me, make i use two secs drop small wisdom make the jollof for reach me.

Pigin Proverb: As you dey do, try dey do jeje make you nor go put hand for tortoise yansh.

Meaning: Be careful in everything you do, so you don't put or find yourself in a very tight corner.

Welcome na here strong men dey cap intellectual. This na one of my favorite threads for forum o I know say you go enjoy am too. Shout out to Mpamaegbu  for creating this place for kontri people.
Proverb: Workman way nor sabi work go always blame him tools
Meaning: Only incompetent people blame others for their failures
Proverb: who dey drown for water nor sabi wetin be patience o
Meaning: A desperate person will do anything to survive
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
August 27, 2021, 10:50:11 AM
First post on this board, very excited, first first i cut cap cun troway salute give everybody for the house wey dey make things and things dey sup for here...make una permit me, make i use two secs drop small wisdom make the jollof for reach me.

Pigin Proverb: As you dey do, try dey do jeje make you nor go put hand for tortoise yansh.

Meaning: Be careful in everything you do, so you don't put or find yourself in a very tight corner.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
August 26, 2021, 04:53:27 AM
Pigin Proverb: Anyhow e be ogoro must jump
Oh, so na jumb e bi? I bin dey think sey na "Ogoro must drop" oh 🙊. BTW, wetin be "Ogoro" sef?

Ogoro means Frog. Jumping nai be frog mode of locomotion.
 Proverb: Na the same walking stick way dey help you waka nai go still break your leg if you nor hold am well
Meaning: Treat everyone and everything with care because even the most harmless thing can become deadly if misused
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 25, 2021, 01:09:28 PM
Pigin Proverb: Anyhow e be ogoro must jump
Oh, so na jumb e bi? I bin dey think sey na "Ogoro must drop" oh 🙊. BTW, wetin be "Ogoro" sef?


Pikin wey im Papa sey make im break door dey use two legs break the door.
Meaning: Those who have the support of patriots go extra mile in whatever they do.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
August 23, 2021, 04:52:02 AM
Pigin Proverb: Anyhow e be ogoro must jump
Meaning: What will happen will happen you can't change it
Proverb: When the king asks for meat he does not wish to hear the story of the cow
Meaning: There is no refusal to those in the corridors of power. The powerful always get their way
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 22, 2021, 02:05:20 PM
Mpamaegbu your skin full u don wet my body with coolele water nor be small I salute you ruggedly as them dey talk for pitakwa.
My broda, na wetin we get na im we dey throwey take baff all man wey make sense. Na so e supposed be na. But those wey dey act like crab and aradite to dey gum dem own for body without vomiting am na dem sabi. May be dem go carry am go to contest for 2023 elections for Also Rock. My advice be sey make all man just shine eyes and dey digidigbam like dat so una nor go enta walahi. And those of us wey dey high here go dey help as we fit reach. Na one love.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
August 19, 2021, 09:29:35 PM
Proverb;
Pigin: All die na die
Meaning: Don't be afraid of failing
True! Dat na short but ogbenge proverb. I like d message wey e carry as it's relevant in today's world. People wan go heaven but dem dey fear to die.
Mpamaegbu your skin full u don wet my body with coolele water nor be small I salute you ruggedly as them dey talk for pitakwa.
Pigin: If you cook food for community them go chop am finish but if community cook food for you...you nor go fit finish am
Meaning: A united people is stronger than a single force
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
August 19, 2021, 01:12:46 PM
E be like the thing dey my body this days o. Make I dey throw way for una make we all dey learn dey go

Proverb:
For the Pighin: them say our forefathers them dey talk say, no matter how toro-toro big or fine reach, them no dey still use am do sacrifice for the gods.
Pighin to English translation: my people use to say, our forefathers did say, no matter how big and cute the turkey might be, it would never be suitable for sacrifices to the gods.
Meaning: There are things and ways that are best suited for some things. How appealing a thing looks doesn't matter at that point rather than doing it how it ought to be done.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
August 17, 2021, 04:39:32 PM
Proverb;
Pigin: All die na die
Meaning: Don't be afraid of failing
True! Dat na short but ogbenge proverb. I like d message wey e carry as it's relevant in today's world. People wan go heaven but dem dey fear to die.
My people, my people, oh! Rugged youuuuu, e sweet meeeee! Na the naija spirit be this, e no get how e wan be!
E get proverb way I hear and e loud scatter. Una no go miss am, no worry. Hear am;

Proverb;
E go like this for the pighin: them say the best way to chyke deaf and dumb way e go understand say you wan run bedroom matters with her, na to find way show am your prick.
For the Englishman:  The best way to ask out a deaf and dumb and make her know you have plans of sleeping with her is to find a good time and show her your d*ck.
Meaning: At times, it's just easier to understand by going straight to the point!
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 17, 2021, 01:25:27 PM
Proverb;
Pigin: All die na die
Meaning: Don't be afraid of failing
True! Dat na short but ogbenge proverb. I like d message wey e carry as it's relevant in today's world. People wan go heaven but dem dey fear to die.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
August 17, 2021, 05:46:56 AM
Proverb;
Pigin: All die na die
Meaning: Don't be afraid of failing
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 17, 2021, 02:35:27 AM
Persin wey go sleep wen im anus dey itch am go wake up with smell smell fingers.
Confucius bin chook mouth for dis matta too.
Meaning: A problem left unresolved escalates with time.



Pages:
Jump to: