Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 36. (Read 9496 times)

legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
August 09, 2021, 06:14:06 PM
Persin wey swallow complete full coconut must to get ogbenge trust for where im anus dey to poopoo am.
.
Meaning: E mean sey before you go find trouble come make you kuku make sure sey you go fit tackle am wen e touch you.
All this strong talk eh, I dey wonder watin these men them way talk am been dey think before them reason this kind thing. Who wan swallow coconut kwanu,,, that person go really get mind o because, na very big whala be that shah. The type way go tia your yansh cef unless e elastic enough. No sire say I fit trust my yansh reach that level, lol.

Na true the talk be shah, infact eh, no fine trouble at all because, that man way you dey under rate, e fit turn put to be oga o or e fit get person way sure for en side. Like e dey be for madman until you jam am. For the life eh, e sure say you just dey your lane, make you no cast.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 09, 2021, 01:34:35 AM
Persin wey swallow complete full coconut must to get ogbenge trust for where im anus dey to poopoo am.
.
Meaning: E mean sey before you go find trouble come make you kuku make sure sey you go fit tackle am wen e touch you.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
August 05, 2021, 01:30:30 PM
Meaning: Some one that has passed you in whatever level of life endeavor has past you. Your best chance is to learn from him or her in order to be like him or her.
Person wey pass person still pass am, no matta what. E just be like as people begin compare Cubana Chief Priest with the main Cubana dude himself wey be Obi Cubana. The matta nor relate well at all na. The Chief Priest imsef sabi sey na boy wey im still be to Obi Cubana no matta d small change wey enta im hand.
Like play like play, this Obi Cubana name don turn something way go tai before people go forget am o. See name way been dey exist but, people no bin dey really think of am plenty and now, e don dey turn watin my guy dey use make analogy, lol...
Anyhow shah, the proverb way you drop so resemble my won shah but, if you check am well eh, if we wan commot respect be that o because, correct boy go always wan pay respect to e master. If we wan look am via hustle side, boy fit actually get the pepper pass en master o. If you check watin I talk now, you go see say I use 'pass', that na to mean say, e fit or e dey happen. In fact, many times cef. Like if we look Wizkid and Banky now for the industry, e go hard for anybody to believe say, Wizkid no pass Banky W na!
full member
Activity: 1456
Merit: 148
August 04, 2021, 04:18:39 PM
Pesin way never see wahala na him the use English pray oooo!!!
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 04, 2021, 10:27:46 AM
Meaning: Some one that has passed you in whatever level of life endeavor has past you. Your best chance is to learn from him or her in order to be like him or her.
Another proverb wey resemble that one be – no matta how pikin get cloths reach, im nor fit get rags pass im papa.

Person wey pass person still pass am, no matta what. E just be like as people begin compare Cubana Chief Priest with the main Cubana dude himself wey be Obi Cubana. The matta nor relate well at all na. The Chief Priest imsef sabi sey na boy wey im still be to Obi Cubana no matta d small change wey enta im hand.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
August 04, 2021, 10:07:22 AM
E get small proverb way be say eh, I still dey reason am because, e no really agree well with me since I hear am. The niqjq wise quote carry talk say;

Proverb;
Pighin: Your ear no go ever fit grow pass your head
English: Your ears can never grow more than your head
Meaning: Some one that has passed you in whatever level of life endeavor has past you. Your best chance is to learn from him or her in order to be like him or her.

Omo, e get as this talk be. I agree with the talk say, ear no fit grow pass person head but, the side way talk say, person way pass you don pass you finish, me no gree o. I know say, life fit be like that but, na via say you allow am to be like that. Na when you do something with situation e dey change o. How una see this talk?
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
August 02, 2021, 03:28:15 PM
I get small proverb to drop for una but then before I drop am, I wan first congratulobia for all of una way dey make things dey be for here and the forum. Una dey try to make sure say, we naija for here eh, them no fit live us for corner 9n any serious matter and for things way be say, e go improve the forum. Una sabi the thing no be lie. Oya na, make we here am as our papa them dey talk am.

Proverb
Pighin: my people dey talk say, person way hold stick for hand, e good make e hold ofor too (Na igbo Proverb e be normally)
English: a saying goes that, someone who handles a stick, uts also good thenperson handles an ofor (Ofor here means: a symbol of peace or honour)
Meaning: It's not always good to go with the mindset of war or destruction, be peaceful most times you can, its more better.

Na so e just be. Make we live well with one another, na we get ourselves.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
August 01, 2021, 04:44:25 PM
My people! I get one small gist for una oh. Oya, make una dress come nearer...

Bring ya right ear make I whisper the thing... Nor shout oh!

Em.. em.. I finally stepped up yesterday oh to Hero!

Betta jollof for all man na oh... Make una go read my ogbenge post wey I take thank all of una for reputation.

😏
My naija brother, man way sabi, man way get level, man way dey do well, the man with the coolele water, I salute you ruggedly. You too much. Bible say, man way get plenty, make them give am even more. I no know the portion but na so e be. Na more you don get so, imagine The Pharmacist dey tell you to apply for en hand,,, e shock me brotherly. That mean say, your face show scatter and them dey see the work way you dey do for here. Na so e suppose be and na so e gets be.

Omo, faji your new rank, e sure for you no be chaise and the cloth cef without measurement go fit you scatter when you wear am @sig. Omo, lead  us dey go, we dey your back.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 01, 2021, 01:09:53 PM
Make I shop this Man money Make I shop this Man money Na so Shawo take de start ooo!!
I welcome you to this corner, brotherly. Nice proverb but next time make you try explain wetin e mean as na the format for here. E even be like sey we don use dat proverb here sef. But all the same, nice one 👍.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 31, 2021, 07:07:14 PM
My people! I get one small gist for una oh. Oya, make una dress come nearer...

Bring ya right ear make I whisper the thing... Nor shout oh!

Em.. em.. I finally stepped up yesterday oh to Hero!

Betta jollof for all man na oh... Make una go read my ogbenge post wey I take thank all of una for reputation.

😏
Omo, congrats my won person. No be play o, we do  dey agther strength finish for we corner. Una rep no be here. I go show back to arrange this thing well but, make e first dey like this. Congrats man.
Omo, you try too o. No be play o because, to dey determine then, you con dey make impact after you don dey see money from signature them and other opportunities way dey the forum eh, e dey make building account and making quality post them hard true true. The fact say, you still get strength to get of yourself con push forward dey drop one or twos on a steady way con make you get watin you need to top up so eh, you na really strong man. E dey your body no worry. Faji, we dey with you.
full member
Activity: 1456
Merit: 148
July 31, 2021, 06:19:20 PM
Make I shop this Man money Make I shop this Man money Na so Ashawo take de start ooo!!
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 31, 2021, 06:05:21 PM
No be much wahala to grow big teeth but na to grow big lips to cover am be the gbenge.

Meaning: One should have a mastery of how to wriggle oneself out of troubles if one can't abstain from them.

Make we even use this Abba Kyari (the police officer turned tailor 🙊)and Hushpuppi gbenge take do example for this proverb sef.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 29, 2021, 10:05:38 AM
My people! I get one small gist for una oh. Oya, make una dress come nearer...

Bring ya right ear make I whisper the thing... Nor shout oh!

Em.. em.. I finally stepped up yesterday oh to Hero!

Betta jollof for all man na oh... Make una go read my ogbenge post wey I take thank all of una for reputation.

😏
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 26, 2021, 06:53:12 PM
Proverb: My people say na who know person dey do person
Meaning: if there is no enemy within the enemy outside cannot harm you
Obob as I write this one body sweet me
Another proverb wey resemble that your own be – Na rat wey dey house tell the one wey dey bush sey fish dey house.

Una wey done my people. This we corner don dey jollof wella unto men wey sabi yan betta cultural flavour take dey support ogbenge talk. E show sey una really put eye for ground as Parle and Marle dem dey talk to una. Una correct. E don tey wey una sabi book. Nor be today hole don dey yansh.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
July 23, 2021, 10:49:33 PM
Proverb: My people say na who know person dey do person
Meaning: if there is no enemy within the enemy outside cannot harm you
Obob as I write this one body sweet me

Proverb: Na person way nor know person na dey call am friend
Meaning: I go leave this one for open interpretation
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
July 23, 2021, 07:20:42 AM
Naija and trends, na our way shah, make life for dey sweet we dey go, no dull moment. Anyhow shah, to ginger matters up for the proverb matter, I get one small one to drop for una.

Proverb: E no get how room wan dark reach way Penis no go know road to where the opening for woman virgina dey.

No matter how dark a room might be, tge penis will always know where the virginal opening is.

Meaning: what is yours or what you know will always stick with you as though, there is a mapping to it embedded in your brain.

No reason am to much, na so the life just be, watin go be go be and watin be your own, na your own.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 20, 2021, 04:25:01 PM
My people dey talk say:
Pighin: Pikin way get one cloth, e no o dey follow children way get many clothes or rich man pikin dey play for sand.
English: a child that has a single clothen doesn't play with children that has a lot of cloths or rich mens kids in the sand.
Meaning: know what you have and how to treasure it as such.
Dat na ogbenge talk.

About the Oba burial, make I ask una first – Person wey suffer get money fit spend am dat way wey dem do for Oba? Even profitable Forex traders wey like blink blink and cruise nor go fit throw cash like dat na. Anoda thing be sey those guys just exposed demselves to Buhari and EFCC now.
No be lie. Money way person really suffer for, e dey hard am to commot am fir hand or spend am anyhow because, even if say them cef know say them go get am back, them still know say, na through that same suffer them gi use get am. Again, e go sure say make we note too say, these men them na social media people o. Like, them dey create thisuch activity to get response on there page, make them fro dey from there get returns normally. Na so e just be, the hustle no dey sleep for them side everly but still on still, the money too much. Too much money dey the naija.

Ma guy, EFCC na settlement now o. Every body now eh, na to take share for the national cake when they can. Na so the naija offices don corrupt reach and the men them, I show say, anyhow e be, before matter ho cast, them go settle every every.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
July 19, 2021, 04:44:11 AM
~snipped~
My broda, owa people dey sey – No matta how craze wey crazeman dey craze im dey sabi how to cross road. Abi when be d last time wey you see motor kill craze man? Na only you nor know sey Buhari get special hatred for South East and South South? So, guys there supposed learn how to dey code demselves. Make we just dey watch how im go change am for dem soon.
Nor be lie e don tay I see motor jam mad man o but my people talk say na when motor jam craze man na that time you go know say craze get family people. Anambra boys get excess money some na base on kanayo kanayo format.. Just see the kain men way show for the burial na..nobody know them but them get millions. The only popular Yorubas there na dbanj and davido and na usher work dem come do
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 19, 2021, 01:54:56 AM
~snipped~
My broda, owa people dey sey – No matta how craze wey crazeman dey craze im dey sabi how to cross road. Abi when be d last time wey you see motor kill craze man? Na only you nor know sey Buhari get special hatred for South East and South South? So, guys there supposed learn how to dey code demselves. Make we just dey watch how im go change am for dem soon.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
July 18, 2021, 10:10:01 PM
About the Oba burial, make I ask una first – Person wey suffer get money fit spend am dat way wey dem do for Oba? Even profitable Forex traders wey like blink blink and cruise nor go fit throw cash like dat na. Anoda thing be sey those guys just exposed demselves to Buhari and EFCC now.
Expose wetin? Be like you never go Anambra before. Efcc wetin?Those guys get careless money. Nor be yahoo money be that o na wardrobe money nai make e dey Ghana must go bag
Pages:
Jump to: