Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 37. (Read 9496 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 18, 2021, 08:02:38 PM
My people dey talk say:
Pighin: Pikin way get one cloth, e no o dey follow children way get many clothes or rich man pikin dey play for sand.
English: a child that has a single clothen doesn't play with children that has a lot of cloths or rich mens kids in the sand.
Meaning: know what you have and how to treasure it as such.
Dat na ogbenge talk.

About the Oba burial, make I ask una first – Person wey suffer get money fit spend am dat way wey dem do for Oba? Even profitable Forex traders wey like blink blink and cruise nor go fit throw cash like dat na. Anoda thing be sey those guys just exposed demselves to Buhari and EFCC now.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 17, 2021, 07:23:22 PM
Omo, e don burst o. For the pass 2days now, Oba for Igbo land don take over headlines for we country. The kind money way these men them dey throw way eh, you cef go wonder if na the same naija way we dey since na em all this money deu come out from. That na to show say, if e rough wella or no .After how e rough, people way dey faji the situation still many. Una weldon o. I say make I throw leg pass here small but then, make I drop small naija wisdom talk.

Proverb:
In Pighin: them say person way too claim say en be wise man, na for foolish man backyard e dey take die.
In English: someone who always claims to be wise, they often dies in a foolish man's backyard.
Meaning: someone that always refuses to take advice or oftens acts as though he or she is too wise is often the foolish one
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
July 16, 2021, 05:36:46 PM
People way dey give me joy, people way oil dey their head, I greet una finish. How e dey be for una side na? I sure say, everything nice even with the plenty wahala way full our world today. Hope say una dey hear watin dey sup for Oba... Cubana don shut down everywhere and I know say, some people cef eh, e dey hungry them to show themselves small even if there pocket no set well. On that note na em I wan throw way this one for una.

My people dey talk say:
Pighin: Pikin way get one cloth, e no o dey follow children way get many clothes or rich man pikin dey play for sand.
English: a child that has a single clothen doesn't play with children that has a lot of cloths or rich mens kids in the sand.
Meaning: know what you have and how to treasure it as such.

Make una use this one hold side for now, everything go set las-las.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
July 10, 2021, 04:10:51 AM
Proverb: Them nor dey use two leg check if river deep
Meaning: Don’t leap into a situation without first thinking about the consequences.
This one na sure pass! Even mad men sef dem dey practice dat technic. If you nor do am like dat, na compulsory swimming by force you go do oh. 👍. Chai! Dis colele wata wey I nor dey get to take sama una here dey pain me wella.
I see you Mpamaegbu...na baba God dey your back nor be eczema. Proverb: My people say small pikin way dey hide for night go lick sugar na for morning e dey shit worm
Meaning: Nothing is hidden in the dark. Every action has its consequences
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 06, 2021, 06:45:32 PM
I dey greet ooo, people way get me. I canda for here and I dey see say, una dey alright kwa with the way una carry better hand, hold the place so. Una dey do well. I say make I sama una small grass root naija wisdom talk small. Just that, this one eh, e for sweet wella if I use my tongue talk am o. Anyhow na, make we hear as them dey take talk am for my side.

Proverb
For Pighin: My people say, en go die, en go die, no dey die!
In English: You will die, you will die, would not die!
Meaning: procrastination is always what promotes the duration of a problem or the solution and it remains unsolved.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 06, 2021, 02:07:49 AM
Proverb: Them nor dey use two leg check if river deep
Meaning: Don’t leap into a situation without first thinking about the consequences.
This one na sure pass! Even mad men sef dem dey practice dat technic. If you nor do am like dat, na compulsory swimming by force you go do oh. 👍. Chai! Dis colele wata wey I nor dey get to take sama una here dey pain me wella.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
July 05, 2021, 10:36:18 AM
Proverb: Them nor dey use two leg check if river deep
Meaning: Don’t leap into a situation without first thinking about the consequences.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
July 05, 2021, 08:32:42 AM
@CryptocurencyKing, well I nor go get problem with the visitor if im respect himself and nor touch my TV remote because my people sey, "Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control."
Na true o. Visitor way touch TV remote con dey control the house anyhow on watin people go view or not don pass Visitor o. Anyhow shah, the matter still be say, when na borrow person dey use something and e dey try use am well even though e mishandle am small, you gat manage with am if you fit o becuase, e go still live am for you commot. Na when e be say, you don see say, this Visitor with the way e dey go, e fit spoil market or give you market, na that time na em, you no gat allow or gree am o. Make you no dey do courtesy and person put hand for your eye. That one don turn mumu be that.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 03, 2021, 05:39:36 PM
Smartvirus, you too like betta thing 😆😆.

@CryptocurencyKing, well I nor go get problem with the visitor if im respect himself and nor touch my TV remote because my people sey, "Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control."
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 30, 2021, 05:02:14 PM
See this pple  them, so una just dey here dey enjoy una cef for we corner. Me I dey here too o, make I con follow una dey get joy too. I get one to throwaway for una kwa.

The proverb be say: My people say, when you get visitor for house, anyhow e be, you go manage am because, no be him get the house.

When you've got a visitor that doesn't seem to act as you expected of him or her, you've got to bear with them as the house isn't theirs.

Meaning: Temporal occupancy doesn't mean ownership, you must leave at some point so to last longer, treat a thing with care while you have it. Let's live life as though it isn't ours.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
June 30, 2021, 04:26:35 PM
Proverb: The way them dey drink tea nor be same way rhem dey drink pepper soup oh
Meaning: There are different methods for different problems
Correct guy there. E get where e touch no worry, I feel am scatter. Na so e just be o, pepper soup and tea get different weight o and na so you go take treat the matter too.

"Man wey marry woman wey get deformed legs, na im sabi how to sleep with am."
This one chokee just now, Jeez! I just dey try imagine the scenario but, e no too dey enter you know, that kind thing, hahahahaha. No Roy guys, I dey enjoy myself with una I swear. People way no dey come here dey miss something o. Forum way be say, to laff hard cef, I con see where something dey give me joy na em I no go lap the joint once once, na fk na. I say make I fall in the corner small con feel men them and lke this eh, una show me say una dey ground.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 29, 2021, 04:31:42 PM
Pighin: Becuase say your indomie quick done, e no mean say person way dey cook beans no go chop.
Those wey go school well and wey break betta chalk go sey dat your proverb na "excellento!" Talk am the way wey e go carry dat exclamation mark to understand how I twist mouth talk am here 😆


Proverb: The way them dey drink tea nor be same way rhem dey drink pepper soup oh
Meaning: There are different methods for different problems
Anoda proverb wey resemble dat one for my place na:

"Man wey marry woman wey get deformed legs, na im sabi how to sleep with am."
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
June 29, 2021, 03:40:50 PM
Proverb: The way them dey drink tea nor be same way rhem dey drink pepper soup oh
Meaning: There are different methods for different problems
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
June 29, 2021, 02:50:47 PM
Chaiii, naija boys don wise finish shah, the wise quote way I hear today shock me. E funny me but e sure die. I say make i drop  make we follow enjoy am together. This one na 21st century something, make una hear as them take talk am.

Proverb:
Pighin: Becuase say your indomie quick done, e no mean say person way dey cook beans no go chop. Las las, we go dey alright.
English: Because your noodles is ready in few minutes, it doesn't mean someone who's beans pot is on fire won't eat. We would all be okay at the end.
Meaning: Because you archived your fortune quickly, it doesn't mean someone with a long term plan won't archive his or her aims. We would all get there in due time.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 24, 2021, 07:02:00 PM
About that aboki matter eh, I for try am o but, I no want watin person go tell me say, na em get Nigeria, even my village join too and you know say, those guys get dagger way dey sharp anyhow. No be watin man go like test them.
😆😆, Na common small danger you dey fear. You nor fit use hand break am sharperly? Anyway, enjoy my broda. I don even bin think dis matta small sef, shey we even get any aboki for dis forum sef abi dem strength nor carry to fall into dis place ni? 🤷
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 24, 2021, 06:46:34 PM
Dem sey man wey tie towel nor dey pursue native fowl. Na small small dem dey take chase am.
Hahahahahahahahaha this one funny me I swear. Imagine the scenario way the towel fall... na so the something way been day dangle inside unseen go just show face for outside, just like that.
Guy man go dive the towel like this eh, e go shock anybody way dey outside, lol.

Anyhow e be, you @Mpamaegbu na still strong hands for the we corner and the forum and na your hand we dey follow say, make we corner dey bizo.

About that aboki matter eh, I for try am o but, I no want watin person go tell me say, na em get Nigeria, even my village join too and you know say, those guys get dagger way dey sharp anyhow. No be watin man go like test them.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 21, 2021, 01:07:04 PM
Pokapoka124 and CryptocurencyKing, una too sabi. Make una just tell that aboki wey dey sell soft and gala near una compound to give una two galas each and a bottle of chilled drink to wash am down. After we go settle who go foot the bill.

Dem sey man wey tie towel nor dey pursue native fowl. Na small small dem dey take chase am.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 20, 2021, 04:36:08 PM
Better proverb, na im be dat oh. You na correct.

How come you nor dey run any parole unto campaign level na? E nor dey give me joy wen I see sey my peeps nor wear anything as logo because I sabi how e hard for we coWtry to dey pay bills.
I nor dey campaign as e be now most of the available campaign na from full members them dey reason.
Ah swear, campaign this days hard no be small. E con turn out say, na people way don dey since dey get joy now via say, no new one dey burst out way be say, men fir dey switch like before. You na man way dey work @Pokapoka. You dey try, I no go lie you but, as the matter be like this eh, you no gat slow down o. Make campaign no turn watin go weak you. Make you deu try dey do watin you dey do, the time way campaign go lap, na your activity this period go poor drink for your head way be say, manager no go see as e be for your user and e no go reason your matter. You na full member now na, e don soft for you somehow but still, the journey long o, so na to dey use your head dey collect 1 or 2 dey go. One luv omo naija.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
June 14, 2021, 02:57:12 PM
Proverb: Na the kind uniform way masquerade wear nai go determine e dancing step.
Meaning: The way you're treated depends on the perception people have of you
Better proverb, na im be dat oh. You na correct.

How come you nor dey run any parole unto campaign level na? E nor dey give me joy wen I see sey my peeps nor wear anything as logo because I sabi how e hard for we coWtry to dey pay bills. Abeg, try find one enta, even if na bounty e go betta than staying out. Just find betta bounty wey dem dey report through google form so dat your post history go tidy up as you still take corner eye dey wait for wetin you dey wait for.

I nor dey campaign as e be now most of the available campaign na from full members them dey reason. So man need to struggle to grow normally everything for 9ja na struggle before. But thanks for the advice I need to sit up and increase my activity for forum. This thread dy gimme joy even I dey down mentally I go just come spy one proverb here way go gimme joy. Shout out to everybody way dey make this place dey gbedu
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 14, 2021, 02:28:40 AM
Proverb: Na the kind uniform way masquerade wear nai go determine e dancing step.
Meaning: The way you're treated depends on the perception people have of you
Better proverb, na im be dat oh. You na correct.

How come you nor dey run any parole unto campaign level na? E nor dey give me joy wen I see sey my peeps nor wear anything as logo because I sabi how e hard for we coWtry to dey pay bills. Abeg, try find one enta, even if na bounty e go betta than staying out. Just find betta bounty wey dem dey report through google form so dat your post history go tidy up as you still take corner eye dey wait for wetin you dey wait for.

CryptocurencyKing, my guy wey sabi. I hail there. Una follow dey encourage owa collective struggles. Make una nor worry, very soon e go tight wella for all man.
Pages:
Jump to: