Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 42. (Read 9540 times)

legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 06, 2020, 09:15:32 AM
#34
Hia! Vex for wetin kwanu, Charles-Tim. I reason your matta well and I go like to implement am anytime wey I go write new thread on local, I go just put Naija on top am kwamkpe! Make I throw you cool water for body sef for dat observation wey you make. One luv my people. I hope una don begin buy rice small small for mudu dey keep for this December sha.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
December 05, 2020, 04:31:13 PM
#33
I dey greet you na all, I dey like your proverbs which dey bring me joy all the time. Well done to Mpamaegbu and others wey dey make this thread dey active, and I na greet you na all again.

I just dey reason say make the OP change the title of this topic as 'Africa' no fit ham, people wey dey here na Nigerians (Naija), make we no hide the name of Naija, make the OP change the topic to 'Nigerian Proverbs in Pidgin'.

Please, no be offended o, just my suggestion.
member
Activity: 672
Merit: 29
December 03, 2020, 05:22:04 PM
#32
Make I throw own pidgin proverbs

Okro no d grow pass em owner
Meaning: A child can't be wiser or older than his or her parents

Soup wey sweet na your money kill am
Meaning: you do justice to a beautiful thing with your money

Inye gabu gabu
Meaning: what will be will be

Onyema ihe echi gabu
Meaning: nobody knows tomorrow

legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 30, 2020, 09:17:23 AM
#31
Sey cat sabi swim nor make am catfish.
Meaning: The nomenclature of a thing doesn't necessarily confer on it real characteristics. There are things one can do by chance but it doesn't prove one is endowed with it and can sustain it.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 17, 2020, 11:31:20 AM
#30
Hand wey tey for pocket know sey nothing dey that pocket.
Meaning: When something lingers without progressive action taken, there is financial inhibition somewhere.

Fish wey scatter for soup still dey inside the soup.
Meaning: Whatever one does for oneself is still to one's advantage.
member
Activity: 91
Merit: 35
October 28, 2020, 09:42:46 AM
#29
Sometin wey elder go see while sitting, a child no sabi see am from a tree
meaning : Learn and respect elders, experience is the best teacher

Penis wey dem hold wey no hard, no go get hole to fuck
Laziness won't give you good opportunity

legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
October 16, 2020, 03:38:04 AM
#28
Jollof rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
Meaning: No condition is permanent in life. Time and chance happen to all life's issues.

Pastor wey dey pray for mad person nor dey close eyes.
Meaning: Being precautions is necessary when faced with danger regardless of one's status.
Very true mate, most especially this Last one wey talk about pastor wey dey pray for mad person, laugh won kill me oooh, cus the proverb dey very funny, come still make better sense join, just sey my well don run totally dry, if not, I suppose pour you even though na 1 drop 💧 of water to take say thank you for making my day, but not to worry, I go do am immediately water enter my well.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 15, 2020, 11:39:06 AM
#27
Jollof rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
Meaning: No condition is permanent in life. Time and chance happen to all life's issues.

Pastor wey dey pray for mad person nor dey close eyes.
Meaning: Being precautions is necessary when faced with danger regardless of one's status.
member
Activity: 223
Merit: 11
October 11, 2020, 01:31:01 PM
#26
Pikin wey use agbada take start guy go talk wetin he go wear when he old.

Translation: Slow and steady wins the race.
member
Activity: 223
Merit: 11
October 11, 2020, 01:25:31 PM
#25
Moi moi and Akara get the same parent, na wetin dem. pass through make dem different

Translation: How you start doesn’t matter, what matters is how you finish.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 08, 2020, 12:15:21 AM
#24
Head wey nor wan think go carry load.
Meaning: Anyone who refuses to go through the process of acquiring education on how to execute a thing will exalt much strength in doing that same thing.

Na run wey nor serious, na im woman dey hold breast.
Meaning: Anything which isn't life threatening is often treated with levity.
legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 30, 2020, 01:08:16 AM
#23
Fivestar4everMVP, all these your proverbs ehn dem enter head wella. E show sey you be son of the soil. Wellu come to owa fold, wey bread 🤗. I suppose merit dat post whenever I get one as I don run dry now. But e go happen. We Naija peeps we plenty for here oh and some don even identify demselves for owa kparokpo joint sef. You go like check the rest of the gang for African Bitcointalk Community Hangout


Thank you my man, and thank you for that Informate, I go show for that area and indroduce myself fast fast, no time ⌚ to check time, na where my fellow Africans dey me dey like to dey, I don tire to read oyibo people gospel, their music no dey make sense for my eye again, na Africa be the way to go ooo.
Make I give you 1 na, na the Last one wey I get left

Stay blessed my oga
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 29, 2020, 09:53:40 PM
#22
Fivestar4everMVP, all these your proverbs ehn dem enter head wella. E show sey you be son of the soil. Wellu come to owa fold, wey bread 🤗. I suppose merit dat post whenever I get one as I don run dry now. But e go happen. We Naija peeps we plenty for here oh and some don even identify demselves for owa kparokpo joint sef. You go like check the rest of the gang for African Bitcointalk Community Hangout

legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 23, 2020, 01:06:33 AM
#21
Sea Wey Smooth No Dey Make Skillful Sailors
meaning: things that are too easy to accomplish doesn't make a man great.

Ashes Wey Person Throw Dey Always Fly Back To Him
meaning: what ever you do, be it good or bad, will always come back to you ...law of karma

When God Dey Cook, We No Dey See Smoke
meaning: when God is planning to do something, we don't see or know it until he does it

And some funny ones i know

Pikin Fit Play With Him Mama Breast, But No Fit Play With Him Papa Testicles
meaning: there's a limit to everyone's patience

No Matter How Far A Man Send Him Piss(urine) Go, The Last Drop Go Always End Up In Between His Legs
meaning: just saying that no matter how far a man tries to run away from he's bad deeds, they will always come back to him

No Matter How Your temper Hot Reach, E No Fit Cook yam
meaning: no matter hot your temper is, there are still some things you cant do

happy to discover my fellow African brothers here
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 22, 2020, 08:17:15 AM
#20
Pikin wey wan chop party rice, e nor dey fear dance.
Meaning: To succeed in life you really don't have to care about negative comments from people.

Onye amu ri nma amaghi ihe onye ibi na-ahu.
Meaning: Those who have good fortune thrown at them don't have any idea of what those without it are faced with.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 08, 2020, 11:42:45 AM
#19
Persin wey dey owe landlord rent no dey fry stew wey curry dey.
Meaning: Indebtedness should limit one's comfort, especially around those one owes.

Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.
Meaning: It's commonsense not to over step one's bounds when given a free hand.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 01, 2020, 12:29:31 AM
#18
Do you know who I am? Do you know who I am? Na so hold up dey take start.
Meaning: The inability to compromise on little things often complicates it.

No matter how lizard do press up reach, e nor fit get muscle reach crocodile.
Meaning: You can't really change the nature of things. It's better to accept them the way they are.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 10, 2020, 12:25:39 PM
#17
E nor dey hard before e begin hard
Meaning: It doesn't take long before it begins to get rough and difficult.

The same thing wey make egg strong for pot na im make yam also soft for pot.
Meaning: Different strokes for different folks.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
August 06, 2020, 02:18:17 AM
#16
I no be your mate na e make slippers get size.
Meaning; We should recognise those who are superior to us and treat them with respect at all time.
jr. member
Activity: 30
Merit: 2
July 31, 2020, 02:24:35 AM
#15
Rat wey die on top bag of rice no be hunger kill am na over excitement.


Meaning
Patience is virtue.
Pages:
Jump to: