Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 38. (Read 9496 times)

hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 13, 2021, 07:06:34 PM
> Kpuff
E sweet my belle sey you rememba all day colele something something of dat time. Na as e finish na im make good morning turn how you dey na 😏. I wish sey d wata dey flow for my end, you trust wetin I for dey do na. We na one people and na so e suppose be. Nor relent my broda. Qwantinue, according to your presido.
That coolele water been sure o, you try that time wella. I know say you for dey qwantinue the thing but, e hard now, I understand. The be say, our people fir dey follow and I no go commot myself inside this one. We suppose dey follow dey throwaway this coolele water make we for take baff and do other things for here. Na so e suppose be and e for help wella via to draw people come here and to make sure say, every where stew.
Na the matter be that though, una try too I no go lie una. At least, the thread still dey survive and e never fall out of line anytime. Una dey make sure say, e get where e suppose dey everything and e no dey pass that side so, I carry hand up for una on that one. E sure scatter.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
June 13, 2021, 01:36:53 AM
Proverb: Na the kind uniform way masquerade wear nai go determine e dancing step.
Meaning: The way you're treated depends on the perception people have of you
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 12, 2021, 02:18:17 AM
> Kpuff
E sweet my belle sey you rememba all day colele something something of dat time. Na as e finish na im make good morning turn how you dey na 😏. I wish sey d wata dey flow for my end, you trust wetin I for dey do na. We na one people and na so e suppose be. Nor relent my broda. Qwantinue, according to your presido.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
June 09, 2021, 05:14:48 PM
Na true shah on the matter for this way and that colele water something. I remember when you been open this corner, na so everybody way drop something way sweet for mouth via  African way don be Nigerian words of wisdom been dey get colele water and na so the place con dey boom. E con be say, people dey research, even ask forefathers them to inspire them small make them for dey drop something. Now like this way e con be say, the water no too dey drop, na so we drop kwa. Make e no be like that o, make our own something  our own Nigerian wisdom talk be the thing way dey sweet we, way dey make us wan put body and again, make we dey fine ourself carry come here. Una dey try.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 07, 2021, 03:58:05 AM
Ah no dey carry last my brother. As a sharp guy wey I be I don rush carry chair siddon for one corner. Thanks for the link.
You do well my broda. Also, make you try dey drag other people enta dat owa forum too. Encourage those wey you nor but wey neva join us to enta dat way.

My people way sabi the thing, I greet una o. How e dey happen for una side na... this way no too soft o. E be like we tire small so...
Hia! Tire kwa. We nor tire oh. Rather we perspire to aspire to inspire... Make I follow speak grammar wey I nor sabi too. We full ground here bro. Nor shaking. I just need colele water to dey throwey una but d thing neva dey ready now. One luv!
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 06, 2021, 02:40:09 PM
My people way sabi the thing, I greet una o. How e dey happen for una side na... this way no too soft o. E be like we tire small so, I say make I dey help make the place still be as e suppose be way be say, person way dey luk from corner go know say, we still dey move. I get small papa talk for una shah, that be say, our people dey say

Proverb: Food way you no ready to chop, them no dey wash hand follow am

If you ain't ready to eat a particular food, there is no point washing your hands over such food.

Meaning in actual: If you ain't ready to keep up with a thing, don't just start it.

Una weldon. Make we carry this one motivate.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
May 30, 2021, 06:58:50 AM
I hear say, our fore fathers dey get one talk way be say,

Proverb: person way do bad merison (medicine) to kill you, if e die by bad merison, e no be bad thing.

When someone consults with fetish doctor or dark magic to kill another individual, should that person die by dark magic, it isn't a bad magic.

Meaning: If you plan even for someone and the evil reconciles on you or the same evil you planned for an individual is redirected to you with the same gravity and its effected on you than others, it ain't a bad thing.

Na to tell you say, nobody holy pass. That good man way you see fit be bad man and as e be so, e fit get watin pass your own for en waist so, respect yourself and no plan bad thing for person.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
May 29, 2021, 07:23:58 AM

Proverb: Belle nor dey fear nai make am dey front

Meaning: You can level up if you rid yourself of fear
jr. member
Activity: 125
Merit: 1
May 27, 2021, 01:42:54 PM
Proverb: Poor man no dey siddon for front bench for village meeting.

Meaning: You're irrelevant when you have nothing to offer.
jr. member
Activity: 125
Merit: 1
May 25, 2021, 09:32:50 AM
Meaning: It takes a trouble bigger than you to get you out of hibernation.
Dat your English analysis hold the proverb well for shokoto. E show sey you sef follow break chalk. Tuale for you, my man!

Cryptomarxx, I take two hands welcome you for owa corner here. Shey you don storm the orda corner too? Na the address to locate the joint be dis https://bitcointalksearch.org/topic/m.57066104
Ah no dey carry last my brother. As a sharp guy wey I be I don rush carry chair siddon for one corner. Thanks for the link.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 24, 2021, 02:51:12 AM
Meaning: It takes a trouble bigger than you to get you out of hibernation.
Dat your English analysis hold the proverb well for shokoto. E show sey you sef follow break chalk. Tuale for you, my man!

Cryptomarxx, I take two hands welcome you for owa corner here. Shey you don storm the orda corner too? Na the address to locate the joint be dis https://bitcointalksearch.org/topic/m.57066104
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
May 22, 2021, 03:36:51 AM
E dey give me joy when I see my people dey try find there way to where come corner way be our own to make there own too because, na really us get am. As we create am, na so we carry posses am too and nothing sure pass like that. I dey sure say, with time, others way never find road go see road Waka come as our former presido wife dey talk.
Anyhow e be, make we dey throwaway something, Smartvirus call am African Wisdom Quote but, me I go call am Nigerian Wisdom Quote, we go dey drop am until e reach to use write book. I no go lie, 9ja we, we follow scatter.

Proverb: My people say, toad no dey come out for daytime except say something dey pursue am.

A toad can't be seen in the out except something is chasing it.

Meaning: It takes a trouble bigger than you to get you out of hibernation.
jr. member
Activity: 125
Merit: 1
May 21, 2021, 03:59:02 PM
Thank you my ogas at the topmost top Smartvirus and Mpamaegbu. I trowey salute to all of una wey dey this forum, wey dey work hard to make sure say de forum dey go well. I dey happy to dey among una midst and together we go join body to make this our local joint stand gidigbam.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
May 20, 2021, 05:52:42 PM
#99
Anytime way e happen say this our corner no dey that side way I dey like am to dey, e no dey soft for my body. I belive say una understand watin i dey talk. E pain me for eye say, I see watin I no fit understand for where my corner dey day. Na fk. So, as e dey be make I throwaway una dis 9ne make una use am soft.

Proverb: Shit get up say, na em be 'them no fit cause or praise'

Feces got up to say, 'he isn't caused or parise'

The problem goes to imply that an evil person is neither criticised directly nor is the person praised.
No go do strongman you con see the one evil man for your village then, you say na you wan fuck am up o. If you no strong, better dey your corner and hold your side.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 19, 2021, 07:36:02 AM
#98
Abeg, where the proverb dey and who be this cef, the user no dey family though, my big man, you fir show me that proverb make me cef fit get the wisdom and laff kwa.
Na the part wey funny me be that below...

Proverb: De bird wey dey for hand na de bird be that, nothing dey for bush.

I believe im go don go check owa local joint out by now as I give am link to the place. So, very soon you too go sabi who im be kwa.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
May 19, 2021, 06:28:09 AM
#97
Cryptomarxx, your proverb make me laugh. Nice one from a new dimension.
Abeg, where the proverb dey and who be this cef, the user no dey family though, my big man, you fir show me that proverb make me cef fit get the wisdom and laff kwa. Mehn, una do well say una fit remember this corner. E wayh me small this time around but, I no fit forget say, here na where I suppose day dey denge. Imagine when we never been get corner na, both here and the hangout. Na so so English for nose way no dey sweet me for belle we dey drop. Very exhausting, lol.

My people way no dey come here, how yna dey carry survive the steam na, e be like una skul no be chaise o, the fee na cut throat so, una no fit follow us do the jaguda we dey do here! Una for try with us small shah.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 18, 2021, 07:40:30 PM
#96
Omo na my first time for this place be this o. I just dey take time read all ona proverbs them, them goes well. I for like make we check out for ourselves wella, life no easy as we see am. The kind proverbs ona Dey drop here mean say plenty ethical men full here o.  Me sef go loud my own

In pidgin: Nobody go gree buy cow if him fit get the milk free.
In English: Nobody buys the cow if they can get the milk for free.
Meaning: it  refers to a man who will not marry or commit to a woman because she is already giving him what he wants from her.
Wellu come, wey breadi. As you nack enta here, na so you sharpally throwey one give us. E show sey d thing sure for yousef. Na your papa born you truetrue. Anyway, sey anoda joint wey other naija peeps too dey gather eat peppersoup and nkwobi https://bitcointalksearch.org/topic/nigeria-naija-5121680

Cryptomarxx, your proverb make me laugh. Nice one from a new dimension.
jr. member
Activity: 125
Merit: 1
May 18, 2021, 06:11:35 PM
#95
Proverb: De bird wey dey for hand na de bird be that, nothing dey for bush.

Meaning: A bird at hand is worth more than nine in the bush.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
May 12, 2021, 06:09:04 AM
#94
Omo na my first time for this place be this o. I just dey take time read all ona proverbs them, them goes well. I for like make we check out for ourselves wella, life no easy as we see am. The kind proverbs ona Dey drop here mean say plenty ethical men full here o.  Me sef go loud my own
Na only you waka come,,, you dey very welcome to share this our corner with us and as you don become your corner too. Watin just remain now be say, you go just dey lap here once once make you dey follow us tidy we corner make e for dey go well everytime and as you dey do am so eh, na so your name go dey smell for the area and when coolele water go dey, we go pour am for your body make you for feel am. You know as e dey be.

Your proverb come board too, e show say, e dey your body and we go dey expect more. Faji
member
Activity: 112
Merit: 11
May 10, 2021, 10:40:00 AM
#93

Jump to: