Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 114. (Read 1022827 times)

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
2023 election dey carry different pressure and tempo come. I believe say more intensity go rise. The youths don prepare for the election. No matter how e be, the magomago people still dey Apc and pdp, I mean Atiku and Asiwaju. These men sabi rig and buy votes, even as youths dey ginger, we still need some politicians to decamp to Laboir Party, people who go follow compete with the politicians for rigging level, then we go do the remaining waka for leg.

Make we no relax, make una dey sensitize una old parents about the symbol of Labour Party wey be 3 people head because they are used to umbrella and broom.
This is exactly what I've been telling the so called OBIdient supporters on social media that election are not won online. You still need to sanitize the grassroots nobe by getting PVC, and when Election Day reach none of them go come out vote.. 80% of voters are without mobile phones and I'm sure most of them don't even know Peter Obi. LP supporters you guys need to do more. Una just dey create unnecessary online pools  Grin

Charles-Tim what's your take on Celsius lowering their liquidation price from 17k to 14k? The last time they set up their LP to $17k Bitcoin went from 21k to 18k. Are we expecting the worse soon?

legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
<...>
Welcome here baba, i twaile for you as you don find us for where we they discuss Nigerian informate so oh, as you know here na our local thread wey we they manage for now, as we they push for our main local board, we still believe say very soon the admin wey they for forum go approve our request, so we go park comot here, go sit down wella for our local board with different childboards so discussions go they go on seamlessly. I greet you once more, feel free to ask anything for here, men they ground to give you better replies sharparly sharparly.
hero member
Activity: 812
Merit: 927
Oboi eh see levels! My mind bin tell me say 9ja people must dey here! Na now I see this board oo. So all this big names like @Cryptoprenuerbrainboss, @Charles-Tim na 9ja people. I tuale for una. He mean say my way for here Don clear be that na. God go bless everybody wey put hand wan make this board go forward. The way una Unite for here Baba God go unite our country in peace and Harmony, Come help us rescue am from all this yamama and durty durty politicians

My info's be

Forum name : ZAGURU12
Gender : Adam's gender   Grin
Skills: Graphics design, content writer and comics creator
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
As e be say our election don the fast approach like this, we need prepare, I no go Dey wrong to say this na the most social media and physically active election Nigeria go get. People are slowly waking up, but the road still Dey far and we go need double up on our energy. The right man no matter the tribe and religion na Wetin we need for the country, so out your pvc to good use e fit be the next president go adopt crypto-currency fully for Nigeria.

2023 election dey carry different pressure and tempo come. I believe say more intensity go rise. The youths don prepare for the election. No matter how e be, the magomago people still dey Apc and pdp, I mean Atiku and Asiwaju. These men sabi rig and buy votes, even as youths dey ginger, we still need some politicians to decamp to Laboir Party, people who go follow compete with the politicians for rigging level, then we go do the remaining waka for leg.

Make we no relax, make una dey sensitize una old parents about the symbol of Labour Party wey be 3 people head because they are used to umbrella and broom.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
The right man no matter the tribe and religion na Wetin we need for the country, so out your pvc to good use e fit be the next president go adopt crypto-currency fully for Nigeria.

The talk na im you just talk so. But we all don sabi say party don fail this country and some certain people wey belong to those parties na arror heads for the collapse wey d country dey face now.

Mark my words, before 2030, law makers go try to pass bill wey go make political offices become inheritance, so that if them thief finish, their children go continue.

Chai this one really off me. Politicians and law makers are really unbelievable so if you talk like this I no go too surprise . For myself if Nigeria no scatter before that time, then dem go fix am.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
As e be say our election don the fast approach like this, we need prepare, I no go Dey wrong to say this na the most social media and physically active election Nigeria go get. People are slowly waking up, but the road still Dey far and we go need double up on our energy. The right man no matter the tribe and religion na Wetin we need for the country, so out your pvc to good use e fit be the next president go adopt crypto-currency fully for Nigeria.
You dey right, you tok wetin dey my mind, the atmosphere this year dey different from wetin we dey used to. People don dey see say power fit shift toward where the masses point. Politicians don dey fear cos their old tactics nor go favour them this time, like you talk we still get long way to go e still get some people way nor fit see past their condition nai make them dey gree do politicians dirty work for them.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
As e be say our election don the fast approach like this, we need prepare, I no go Dey wrong to say this na the most social media and physically active election Nigeria go get. People are slowly waking up, but the road still Dey far and we go need double up on our energy. The right man no matter the tribe and religion na Wetin we need for the country, so out your pvc to good use e fit be the next president go adopt crypto-currency fully for Nigeria.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
casinosblockchain.io
i hail oo my country pipo, abeg make una no vex i have been little busy all this days so i never really seat at place to focus on our unit here. i have read lot of updates but no place to start replying so i just say let me throw salute to our country in same blood line.

I hail you back brotherly. E no compulsory say you reply all the posts and infact e no compulsory say you go reply any post.  Anyone you fit reply, quote it and reply and allow others slide. Like me, plenty matter overtake me for real so I no too regular here but I still dey contribute.

For enaira matta eh, our government stingy. Them no wan push the enaira, and sorry to say dem no too get sense. Everything na force force dem wan take achieve it. For sim registration, na for dem use. But their mate for El Salvador been give anybody wey download wallet $30. Why them no fit use this method.

Thank you my man, e no easy at all my eyes full like this but base on how e be i go try.
Abeg this eNaira of a thing how we Gov don do am all this while i bin get some update say boys no gbado am oo base on say them spoil boys chops for www that one make wetin e no get good record like this.
but anyhow e be make we try small put effort this coming election to put smile for our faces to stop this complain all time.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Other countries don dey get CBDC, so e go beta make we follow put body at once, who knows wetin e go turn tomorrow.
I like the way you dey think guy, i like your perspective. The thing wey dey vex most persons including me na the large amount of money them talk say dem spend take launch the project (you know how corruption dey be) and also the fact say the thing cun get wrong timing as per say na just after our government start to put eye for crypto matter nai dem go voltage CBDC come board.
Thank you senior man for the kind talk.
For our government and their looting, I surprise say e still dey shock una. Nothing those men do dey surprise me again. How many you wan count? You don forget how much individuals donate for Covid-19 and the international bodies. Hafa, Las Las the governors hoard food for warehouse why many people dey die for hunger. If you think say government mean well for you, you dey joke with yourself. Wetin dem dey do na to make you poor and submissive to them for ever. Mark my words, before 2030, law makers go try to pass bill wey go make political offices become inheritance, so that if them thief finish, their children go continue.

As for election, be careful with the opinions of your religious leaders, vote for the candidate of your choice and don't let them influence you, some of them are selecting the candidates good for them and you will be wrong not to consider your own opinions.

Plenty men of God don cast, people wey God call no plenty. Majority of these men wey you see dey worship wetin dem no know. If them sleep, their ancestors go wisper for their ear, when dem wake up dey say God tell them. No worry, by 2025 and above, you go dey hear say men drag pastors commot for pulpit and beat them.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Other countries don dey get CBDC, so e go beta make we follow put body at once, who knows wetin e go turn tomorrow.
I like the way you dey think guy, i like your perspective. The thing wey dey vex most persons including me na the large amount of money them talk say dem spend take launch the project (you know how corruption dey be) and also the fact say the thing cun get wrong timing as per say na just after our government start to put eye for crypto matter nai dem go voltage CBDC come board.

As for election, be careful with the opinions of your religious leaders, vote for the candidate of your choice and don't let them influence you, some of them are selecting the candidates good for them and you will be wrong not to consider your own opinions.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Me shaa no still see problem with enaira o, na welcome development e be. Other countries don dey get CBDC, so e go beta make we follow put body at once, who knows wetin e go turn tomorrow. Na this feeling of inferiority say we no reach na wetin make oyibo dey ahead of us for everywhere. Make Nigeria join the bandwagon, if e good we take, if e no good we clean mouth comot joor.
Mind you that CBDC's aren't a sort of investment, so i really do not understand what you mean by "who knows wetin e go turn tomorrow", like it is going to change form or something, it is still going to be a digital fiat currency 'tomorrow' or any other time for that matter, and that is it, it will still function like the naira, centralized, controlled, created by the CBN, just that it is digital, so what do you want us to expect from it 'tomorrow'. There is no such inferiority complex bro, we are just being factual here, we are developing, that is if we haven't slipped down the ladder to underdeveloped, and we are behind first world countries, it is what it is, and you have to accept that. Maybe if we had used our resources the proper way, and concentrated on more productive things than CBDC's, we prolly won't be this far behind.
Nigeria don dey in bash since we begin see the country, no be e-naira put Nigeria for mess and no be e-naira go commot Nigeria for mess. I agree say e-naira no be any kind of investment wey go yield money for future, but we no go fit predict how the future go be. Somewhere two years ago, me and you been dey fear to collect money for hand because of Covid-19. Some people sef dey wear gloves to collect money. What if something similar to that happen for future and other countries go dey use their digital money, then Nigeria go sit-down dey watch?
For so much sey e-naira no go better Nigeria economy, me sef no dey against the idea. Anything wey be digital, make we join body like that follow, na there the road dey. E no matter whether plenty people use am or not, but anytime the need arise we go use am go our way.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Still, I don hear pastor way ready use en moni campaign 4 Obi. E eV dey orda members to go get dere PVC nd mak dem carri am com chrch or dem go worship frm outside. U wonda d kind God en dey serve!
Live all does idiots way dere god no dey luk upon d suffering of Nigerians, does one's way wan tak widow penny carri chop yam while dem suffer, stay 4 hunger dey expect change. D change na Obi, make we vote am in!

Get ur PVC!

My broda the country don too show people too much suffery and everybody jus dey try try mak we see say e beta. Sure thing be say we still go get pastors wey go wan climb on dis opportunity to mak pepper. As we dey look to get our PVC, make we still dey shine our eyes on top am. PVC na free but I don dey hear say som inec men don dey ask people for small small pepper to register dem. Naija na really a place wey need repairs in every area.
hero member
Activity: 910
Merit: 686

Last last na obedient we don dey see for every corner na po. No be wen result go show we go dey hear another thing, na that one go come cause the main gbege for the area. Truly too all the aspirants know say the guy get something for head but because them see the office as business, dem go do everything to reach them but dis time around, God don take power away from devil.
Na so e dey always be brother, at d end of d day person wey deserve d sit no go win because say dem people wey go vote put money for front and no be so e suppose be. Peter Obi na person wey good for president but as e dey be now d matter no be small thing. Make e no just turn out like Shehu Sani of Kaduna wey get hype for social media and for off media nothing to show for it. I just hope people wey dy show am support for social media go comot vote for am dat day.

Quote
Shey we still hear wetin okonjo iweala pikin talk about Nigeria ba? My mouth shut up for now.

Wetin d pikin yarn again, make we hear an na
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I here say many prophecies don come say our 001 no go fit enta there for us, so like this now Youth they try their best to get all it takes our 001 to be there so like this just find your time make your PVC ready before e too late. If for say no be the way Youth they ginger like this now today them for don go stop PVC registration but na weight of people still make them open registrations.
#Because na only beggers dey know person wey stingy#

All dis 1 way dem dey prophecy rubbish na 4 dere members way dey giv dem ear. In fact cef, dis pple dey try key into watin dey sup 4 d Nigeria. Dem dey gamble am via say, dem knw say we kontry, na moni dem dey use decide persn way go dey dat 001 seat nd as Obi no dey remit, dem no beliv say e fit enta dere. Na dis analysis dem cari dey get dere revelation nd if we con allow am 2 happy lik dis, e go con sure 4 dem say, dem b beta prophet, gain mor members nd offering. Na so e just b 4 dem, business men way calll dem cef pastors.

If Obi now, enta dere chrch go worship or do tanks givin, prophecy go change. Or dem no go jst near d mata bt surely, dem go recognise am. Na so e jst be.

Still, I don hear pastor way ready use en moni campaign 4 Obi. E eV dey orda members to go get dere PVC nd mak dem carri am com chrch or dem go worship frm outside. U wonda d kind God en dey serve!
Live all does idiots way dere god no dey luk upon d suffering of Nigerians, does one's way wan tak widow penny carri chop yam while dem suffer, stay 4 hunger dey expect change. D change na Obi, make we vote am in!

Get ur PVC!
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

#Because na only beggers dey know person wey stingy#

This one off me. So the one wey women dey talk no follow ?

Last last na obedient we don dey see for every corner na po. No be wen result go show we go dey hear another thing, na that one go come cause the main gbege for the area. Truly too all the aspirants know say the guy get something for head but because them see the office as business, dem go do everything to reach them but dis time around, God don take power away from devil.

Shey we still hear wetin okonjo iweala pikin talk about Nigeria ba? My mouth shut up for now.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I here say many prophecies don come say our 001 no go fit enta there for us, so like this now Youth they try their best to get all it takes our 001 to be there so like this just find your time make your PVC ready before e too late. If for say no be the way Youth they ginger like this now today them for don go stop PVC registration but na weight of people still make them open registrations.
Forget about those prophecies jare.. Prophecy wey na them talk to themselves or the one wey God talk to them? See eeh, as eh stands now, most of these pastors na scam, them dey find who go come there church come donate huge money so that they fit go buy "Range Rover" dey cruise run town, but if they come find out say you no be that type wey dey remit anyhow, they go start to talk rubbish..  most of these people you dey see carry Bible Waka up and down, na hunger cause am. Test them any day and you go see say they go fall hand big time. So the best thing na for us to come out in mass to support our 001 @ Peter Obi.

#Because na only beggers dey know person wey stingy#

No be joke me self come reason am the way them they lament on our 001 say him that him this. Like the move wey our 001 don move I never see any presidential aspirants don that kind movement ever since I grow up. If you see am you go know say the man come for something wey go betterment we country and I want make them free am to run as 001 for we country. Just imagine how him make movement go Egypt to know their secret there why them get 24/7 light wey be say we Giant of Africa no fit boast of 4kMegawatt of electricity for since from 1960.. omo matter plenty like this.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Me shaa no still see problem with enaira o, na welcome development e be. Other countries don dey get CBDC, so e go beta make we follow put body at once, who knows wetin e go turn tomorrow. Na this feeling of inferiority say we no reach na wetin make oyibo dey ahead of us for everywhere. Make Nigeria join the bandwagon, if e good we take, if e no good we clean mouth comot joor.
Mind you that CBDC's aren't a sort of investment, so i really do not understand what you mean by "who knows wetin e go turn tomorrow", like it is going to change form or something, it is still going to be a digital fiat currency 'tomorrow' or any other time for that matter, and that is it, it will still function like the naira, centralized, controlled, created by the CBN, just that it is digital, so what do you want us to expect from it 'tomorrow'. There is no such inferiority complex bro, we are just being factual here, we are developing, that is if we haven't slipped down the ladder to underdeveloped, and we are behind first world countries, it is what it is, and you have to accept that. Maybe if we had used our resources the proper way, and concentrated on more productive things than CBDC's, we prolly won't be this far behind.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Actually speaking I agree with this very statement of yours, because frankly speaking, I am sure CBN can't boast of having 10% Nigerians using the so called eNaira our Federal government wasted so much money launching last year, when we have got more pressing issues affecting the country e.g banditary, terrorism poverty and e.t.c.. Because for me, I just pray that the next person who will emmerge as the next president of Nigeria should be someone who has the country at heart and knows the right thing to do at all times
Exactly, to be honest i do not see any benefit of CBDC's to an underdeveloped or developing country, it is just like creating a 'second' fiat currency, and that is not productive at all. First world countries have less problems than us, at least economically and politically, so in their case i can understand why they would want to be part of the CBDC bandwagon. Well, i have known Nigeria to be a country that places importance on less crucial issues, leaving more pressing matters that ought to be attended to, and that is the scenario yet again. Our matter resemble man wey him house they burn, him begin to dey chase rat up and down; no be 'juju' be that.

Me shaa no still see problem with enaira o, na welcome development e be. Other countries don dey get CBDC, so e go beta make we follow put body at once, who knows wetin e go turn tomorrow. Na this feeling of inferiority say we no reach na wetin make oyibo dey ahead of us for everywhere. Make Nigeria join the bandwagon, if e good we take, if e no good we clean mouth comot joor.

But my major problem be say make dem no make am compulsory which I know dem no go fit. Make dem make am optional but dem fit put incentives for person wey use enaira, from there the adoption go expand dey go.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
E don tey wey I show face for hear to see my people, una weldone, na here be our own side for dis forum, I they great everybody.
I come see say we Don they get new people wey they join us for the forum, I they use dis medium welcome everyone, I hope my ogas wey dey hear don  show una ways and how to avoid anything wey they against the forum rules and regulations, I they welcome una.
I don fully come back, I go dey active now for my  community.
hero member
Activity: 1022
Merit: 723

Jump to: