Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 118. (Read 1023159 times)

legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
The problem be say those politicians purposely or intentionally suffer Nigerians and subject them to abject poverty because they no say people go come out to vote for them by enticing them with big money, look at wetin happen for Ekiti State wey APC paid voters 10K and PDP 5K, they were even displaying it in public, Imagine a private school teacher wey dey earn 10K monthly see dis kind opportunity to vote and collect 10K will they turn it down NO?  they go vote am because of poverty and not minding that they don enter one chance and another round of suffer-suffer for 4 years, honestly a lot has to be done to sensitize our people against vote buying.

You r 2 much. I love dis talk. Nai make I dey caused Nigeria electorates. Dem no get sense. Nd dose pipo na di old pipo plenti pass. Me I no want talk politics again bcoz me I dey angry... Even ma fellow wey supposed understand dis things, e no dey understand interested dem go argue out of point. Nigeria Politics na moni nd di old pipo need Moni.

Me I still dey talk am say, Obi go win if he go do like MKO Abiola. If not me I doubt am ooo. Me I no need a prophet 2 come nd tell me. Politics. 

Nigerian youth understand what happened in #endsars nd vote rightly. Thanks
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
Everybody finally get e right to support any candidate of e choice, whether e dey old or young.

Na true say everybody get right to vote who them like but my brother time don reach when anybody weh come meet me for urgent 2k after the election go first tell me who him vote before I go even listen to am. And if I know say him follow for people weh deh scream BAT BAT now, e go hard to give o. People get to receive sense by force. See as the thing deh hot now for everybody pocket. Dollar don do sprint enter N615 like play like play. How we want take survive another onslaught by another old and sick man if we no wake up now. Make them continue. The kind hunger weh deh ground now no even know big man again. Una see as people convert them jeeps to uber, that one na small thing if we no get am right again.
The problem be say those politicians purposely or intentionally suffer Nigerians and subject them to abject poverty because they no say people go come out to vote for them by enticing them with big money, look at wetin happen for Ekiti State wey APC paid voters 10K and PDP 5K, they were even displaying it in public, Imagine a private school teacher wey dey earn 10K monthly see dis kind opportunity to vote and collect 10K will they turn it down NO?  they go vote am because of poverty and not minding that they don enter one chance and another round of suffer-suffer for 4 years, honestly a lot has to be done to sensitize our people against vote buying.
member
Activity: 579
Merit: 13
Are you kind to your neighbor? Think it through
Generally, dem too de carry this tribal arguments too much and e no suppose be so. Na everyone get their own bias, it could towards a or towards b. labeling it as tribalism is too push a certain agenda weh we all sabi the outcome. na the so so labeling truncate the endsars protest, na him make dem label ipob too con de give terrorists freedom. na make we de rebuff those tribalistic claim every time e cross our path remain cos this election season, na everyone wan chop
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Unfortunately, our oppressors have conditioned most Nigerians into being okay with their suffering and not seeing any need to try to become better. Because many have tried and failed, many people have lost all hopes as regards the redemption of this country and do not see any possibility of it being better, hence they just want to survive and if possibly join the band wagon of criminals to secure their own portion of the national cake.
I completely agree with you. I have said this a couple of times in discussions with my friends, these 'men' have systematically put it in 'our' heads that Nigeria can never be better, they have successfully instilled the defeatist mentality in Nigerians, that is why it is not uncommon to hear a typical Nigerian say 'Let us face reality', and as they face reality, another oppressor assumes power and the chain of suffering incessantly continues. Mind you for someone who has accepted his or her 'reality' to be hunger, poverty, terrible power supply, unemployment, bad roads, et cetera, that individual would not mind selling their votes for a meagre one thousand naira, that individual would not mind shunning elections, cause to them, it can't get any better, or worse.

To be honest, i am quite optimistic about 2023, i do sincerely hope that Nigerians break free from this defeatist mentality and do what is right, enough is enough of cheering on our oppressors, and in the end suffering continuously, the man to change Nigeria for good is here, but i wish every Nigerian can see it and do what is right.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
E dey like say you dey in position of authority for workplace like HR post, and na you dey hire you go come dey look surname or tribe before you give person work. No be better thing, na all this overdo nai make the country deh where he deh

My broda did e.g wey u give no be like say e follow join regarding to the Mata of this election atmosphere 4 naija now. The one you dey talk na tribalistic agenda na but the election mata wey dey ground na about national interest and development, dem no be the same thing. It is clear as everybody dey see am say the country dey fall in every aspect so way forward be the thing.
E be like when somebody dey see road and him dey say make you leave am say him want enta bush.
My sister na the same thing we dey talk. Wetin concern help I dey ask you for with who I vote for. Na wickedness be that and some people won dey take am as the norm. Everybody dey entitled to him opinion and everybody get freedom to vote who him won vote. What if the person lie for you say e vote your candidate you go come give am millions. If na so we for no dey answer our friends and colleagues way no come out for endsars protest cos no be everybody come outside.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
E dey like say you dey in position of authority for workplace like HR post, and na you dey hire you go come dey look surname or tribe before you give person work. No be better thing, na all this overdo nai make the country deh where he deh

My broda did e.g wey u give no be like say e follow join regarding to the Mata of this election atmosphere 4 naija now. The one you dey talk na tribalistic agenda na but the election mata wey dey ground na about national interest and development, dem no be the same thing. It is clear as everybody dey see am say the country dey fall in every aspect so way forward be the thing.
E be like when somebody dey see road and him dey say make you leave am say him want enta bush.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Fuel dom climb 200 from 165 we dem see am, diesel dom leave 300 naira enter 850

Na only that one we deh even talk? Add kerosene price join too. And no be better one them deh even sell for filling stations self. You go see kerosene, you go deh ask yourself if na diesel. Most filling stations no even deh sell kerosene again self.

Wetin reach like that. Nothing concern you with who person vote. How many you fit keep malice. Abeg make he be say you dey joke cause he no go make sense if you really do that kind thing to someone.

My brother, no be malice o. I know say nothing concern me with who anybody want to vote in but e go concern me to make people receive sense if them do the wrong things. You no go expect to get help from someone weh you disobey like that. If person show you road and you say you no want follow that road, you no get any right to call the person to come trace you out. Take for instance, you try convince someone weh no get work to enter here and begin find small small thing but them refuse bluntly and then them begin ask you for cash a few months later. How you go feel?
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Everybody finally get e right to support any candidate of e choice, whether e dey old or young.

Na true say everybody get right to vote who them like but my brother time don reach when anybody weh come meet me for urgent 2k after the election go first tell me who him vote before I go even listen to am..
Wetin reach like that. Nothing concern you with who person vote. How many you fit keep malice. Abeg make he be say you dey joke cause he no go make sense if you really do that kind thing to someone. E dey like say you dey in position of authority for workplace like HR post, and na you dey hire you go come dey look surname or tribe before you give person work. No be better thing, na all this overdo nai make the country deh where he deh
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Everybody finally get e right to support any candidate of e choice, whether e dey old or young.

Na true say everybody get right to vote who them like but my brother time don reach when anybody weh come meet me for urgent 2k after the election go first tell me who him vote before I go even listen to am. And if I know say him follow for people weh deh scream BAT BAT now, e go hard to give o. People get to receive sense by force. See as the thing deh hot now for everybody pocket. Dollar don do sprint enter N615 like play like play. How we want take survive another onslaught by another old and sick man if we no wake up now. Make them continue. The kind hunger weh deh ground now no even know big man again. Una see as people convert them jeeps to uber, that one na small thing if we no get am right again.
Me I like as you take do the yarning and I believe say na beta message wey you dom pass for hia. For anybody wey dey talk say we get right to vote any candidate of our choice you no lie but I wam also remind us say we get the right to determine how we want make our economy be in the next 8years. If we want make $1 be 10,000 naira or if we want make the hunger continue as e dey for now na still for our hand e dey. Make una no also forget say na we and our family go suffer if we allow person wey dom get bad record or person wey dom take money buy em way enter seat to become our president sure sure em go wam recover em money one billion times and naija go sink final. Fuel dom climb 200 from 165 we dem see am, diesel dom leave 300 naira enter 850, if dis tins no show you sign say we need to come together in agreement vote for candidate wey young and sabi how to better our economy, abeg make we wake up now.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Everybody finally get e right to support any candidate of e choice, whether e dey old or young.

Na true say everybody get right to vote who them like but my brother time don reach when anybody weh come meet me for urgent 2k after the election go first tell me who him vote before I go even listen to am. And if I know say him follow for people weh deh scream BAT BAT now, e go hard to give o. People get to receive sense by force. See as the thing deh hot now for everybody pocket. Dollar don do sprint enter N615 like play like play. How we want take survive another onslaught by another old and sick man if we no wake up now. Make them continue. The kind hunger weh deh ground now no even know big man again. Una see as people convert them jeeps to uber, that one na small thing if we no get am right again.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Sometimes i wonder if we have become completely inure to suffering, or if we have fallen in love with our 'oppressors'...
Unfortunately, our oppressors have conditioned most Nigerians into being okay with their suffering and not seeing any need to try to become better. Because many have tried and failed, many people have lost all hopes as regards the redemption of this country and do not see any possibility of it being better, hence they just want to survive and if possibly join the band wagon of criminals to secure their own portion of the national cake.

The matter tire me well well. I no know wetin to call am, whether na out of selfishness or ignorance make people still deh support Tinubu to rule us as them deh see how frail and senile weh the man deh look.
Everybody finally get e right to support any candidate of e choice, whether e dey old or young. The thing wey we dey hope na say make everybody fit get PVC, make people go vote that day, and make their vote count without rigging.

I met someone who said his own motivation for getting his PVC is that he is tired of seeing old names in our electoral party system, plus in his opinion PDP & APC dun try reach, at least make another person and party enter there. I hope say we fit sustain the energy till the election go reach, because anybody we vote nai go dey for 8years.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
The matter tire me well well. I no know wetin ti call am, whether na out of selfishness or ignorance make people still deh support Tinubu to rule us as them deh see how frail and senile weh the man deh look. Nothing weh we no go do for money for this country self. Whether them want make Tinubu die on top that seat. God go forbid all of them.

Humans no be rational beings o. Na our emotions we dey use support the different candidates. I don see for twita wey one guy in particular talk say na Tinubu give am scholarship to take read law for uni. So e must to support am. Others dey support am base on say him been don helep their family before before. Dem forget say difference no dey between am an our oga at the top. For 2023 most of us just dey hope say Mr Peter go win but for the corner of our mind, we sabi say APC nor go gree. Dem no mind disburse 100M for all the wards for we Naija to take buy votes.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The suffering of today na from the mistake of 2011. Make we shine eye this time to know wetin we deh do. Na face we deh look vote now, no be party.

If we don listen to Tinubu when him be Lagos state governor (before fashola ) and Tinubu of today, we go see say if him enta na gota wey the country go pack because him just dey fall for ground anyhow for gathering like the one I see for online.

The matter tire me well well. I no know wetin ti call am, whether na out of selfishness or ignorance make people still deh support Tinubu to rule us as them deh see how frail and senile weh the man deh look. Nothing weh we no go do for money for this country self. Whether them want make Tinubu die on top that seat. God go forbid all of them.

About that our brother, him still deh active as I see new posts weh him make today. I hope say him go don correct him mistake by now.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
The suffering of today na from the mistake of 2011. Make we shine eye this time to know wetin we deh do. Na face we deh look vote now, no be party.

No be only you dey talk or feel like this. I hop say our youth no go still dey vote for men wey dey fall up and down to come lead this country again. If we don listen to Tinubu when him be Lagos state governor (before fashola ) and Tinubu of today, we go see say if him enta na gota wey the country go pack because him just dey fall for ground anyhow for gathering like the one I see for online. These men don old and inactive but them no want rest. Them give reduced age as public servant and the thing dey show now. Make we leave party now vote for the most qualified, Peter obi.

Abeg this our brother wey go fall into this plagiarism stuff, no be small thing oo. The thing reach 3 or so. Dis pple no be una guy, dem dey evrywher like olopa. Make we dey shine eyes & at least do small small thing wey mouth fit enta. Bread no dey naija as we sabi oridy. Olowa go show us say him dey kamkpe 4 our end.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
I hope you no follow for people weh dash us this calamity weh be Bubu. The way this thing come be now, e be like make we rewind the clock to 2011 self before the coming of Bubu make all eyes clear. The suffering of today na from the mistake of 2011. Make we shine eye this time to know wetin we deh do. Na face we deh look vote now, no be party.
I can assure you that even if you take back the hands of time to 2011, do not be surprised that Buhari would still emerge victorious, after Buhari's first tenure of 4 years, of which another election was held in 2015, didn't he still emerge victorious for the second time, even after the disastrous first 4 years in office. I simply can't understand Nigerians. Isn't it the same Tinubu who was instrumental in Buhari's emergence as the president that quite a lot of people are supporting and rooting for to be president, he was in Lagos the other day and you need to see the number of people waiting to welcome and greet him. Sometimes i wonder if we have become completely inure to suffering, or if we have fallen in love with our 'oppressors', or we are just plain hungry and do not mind eating the crumbs that falls off our oppressors' tables, tbh, i can't wait for the 2023 election to come and go, the result is going to be a very crucial one for our nation.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Abeg o who be this Bright weh them ban? You fit to put the user name complete make we know.
Ooh. Sorry guys, the name na Mr.right85
Them comot am for him current campaign and they are calling for his ban for plagiarising contents from livescore. I weak cos nothing you fit talk to die the matter, only the moderators fit show mercy which I doubt.

O boy, I read the matter now as you direct us with link. No be small matter so o. I don know the user weh you deh talk and him deh make posts with points but I no fit explain how him come allow plagiarism catch am. And na within the same week weh him use all those stories them gbab am. Na wa o, for this kind hard time na him this one come deh happen to am. Our senior men here deh always warn about this plagiarism thing. Abeg make we deh careful.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg o who be this Bright weh them ban? You fit to put the user name complete make we know.

Abeg who them ban?
I talk am say make them easy to post and walker for this place e no easy as them see am like. This place ehh them sabi humble person like mad, so make we try get solid intel before we relate am here if not e no balance atall.

Ooh. Sorry guys, the name na Mr.right85
Them comot am for him current campaign and they are calling for his ban for plagiarising contents from livescore. I weak cos nothing you fit talk to die the matter, only the moderators fit show mercy which I doubt.
See the report for >>>Here<<<

Anything way you know Sabi, no freestyle am, e they land person for moderators prison.

I see, the gbega too much oo, this one no be say na only one but they pinch am like 2 to 3 places wey him dey do runs. So like this now na perma ban or na still restrictions them give am?

This people don humble me b4 na wetin make i no do pass myself again and this tin now to go reflect us partially bicus if them trace am e go show na 9ja pesin be that. I don talk am many times say make we for try stop to the Burst post or copi nd pste, abeg try whether we fit go beg on behalf of am to secure our man.
hero member
Activity: 1064
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Abeg o who be this Bright weh them ban? You fit to put the user name complete make we know.

Abeg who them ban?
I talk am say make them easy to post and walker for this place e no easy as them see am like. This place ehh them sabi humble person like mad, so make we try get solid intel before we relate am here if not e no balance atall.

Ooh. Sorry guys, the name na Mr.right85
Them comot am for him current campaign and they are calling for his ban for plagiarising contents from livescore. I weak cos nothing you fit talk to die the matter, only the moderators fit show mercy which I doubt.
See the report for >>>Here<<<

Anything way you know Sabi, no freestyle am, e they land person for moderators prison.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You can also use your Voters Identification Number VIN to check.

I been register my PVC 2015 during that BUBU election, I just checked to verify my VIN and my name and polling unit show bodly.
I don they plan to get new one but workload plenty for my head with procrastination but I happy as this one still legit, I go follow crowd vote better candidate next year and I pray make them no rig am for the wrong person.
These one way NNPP no gree join force with Oga peter, I hope they don't get duck down by these Rastafarians weh we get for with upper hands, I no they like politics but we must vote the right candidate to make things right this time.

#Say no to tribalism, #Say no to Religious fight, #Let us unite as one.

#Copied

Abeg, try they properly put quotes for your post, I no happy as them they Report Bright for plagiarism, a lot of effort has been made but it is likely getting Perma ban.

See bro forget am!
E go work fin onto say wetin happen las 2 years show say youth still get levels, them try dia best yet youths no gree o them still balance for ground based on the endsars and endbadgovernance movement tell me say Peter Obi go still win. Boys eyes 👀 don red for the country oo so no need to dull like this.

Jump to: