Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 116. (Read 1023030 times)

hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
All we new pipo wey just enta i welcome una. D first tin una gats know be say this forum nor be Nairaland o. Plenti Olopka dey here if u do any how, you see any how or beta still as we dey talk am for we local parlance if you do any how, you go collect wotowoto. Dem nor dey hear abeg o here o. So if u dey copi copi from d internet like say na your own and you nor talk where you copi am from, if dem olopka wey dey here catch you, na Okene (suspension/ permanent ban) sharp sharp.

Newbies make una check this thread to confirm wetin I don talk - Report plagiarism (copy/paste) here. Mods: please give temp or permban as needed
I enjoy dis informato wey u just drop now so make person wey get ear make him hear. Cos any man or woman wey com here the jump jump, the do do, the clap clap and shake shake waist anyhow go end up collecting wotoporosly cos the laws wey d guide dis forum aswr no be anybody mate.
So who no knw make him go read the link above.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
    Dis new thread dey self moderated to prevent spam and scam like activities. I promise say I no go misuse am, e go only come into use when na for the betterment of the community.

    Ma people I greet una oh, this thread wey I create like dis na for we to come together gossip, laugh and enjoy things wey dey happen for dis cryptocurrency industry wey relate to us or affect us directly. No shy here oh, just dey free discuss everything wey you get for mind for here, if you get any questions we dey for your mind, just ask.

    Make we just try our best to obey every forum rules and regulations and only legal activities go dey allowed to function on this thread.

    NOTE:
    [1]: No go dey trade with another person you just meet for here unless you trust them and all trade related transaction, carry am go Marketplace board and child boards for transparency.

    [2]: Official language Pidgin (Local dialect dey also welcomed).
    [3]: First timers abeg just introduced yourself so we fit relate weller
    • Username:
    • Gender
    • State of resident (optional)
    • Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend)
    .
    [4]: if you wan start new topic, abeg use dis format: [/list]
    Code:
    [b][color=red]NEW TOPIC[/color][/b]
    then you gist us wetin you get to talk.

    Example: NEW TOPIC: wetin be your experience for dis forum so far?.

    Constructive suggestion they welcome in order to improve discussion wey dey go on for the thread.
    Our Naija FG inside de House of Reps don talk say Dem want make gambling operators dem start to the collect their customers Dem National Identity Number (NIN) before them place their bet.

    How una see dis matter? Cos for me oh I just the feel say de reason be say na to try shutdown de high level of minors wey don the involve themselves anyhow inside gambling, especially for betshops dem.
    But  how possible say dis kind tin fit really take place and say betshops go actually do am, based on say Dem fit feel say Dem go lose patronage if Dem start to ask for NIN from customers cos even some adults sef no even get NIN.

    hero member
    Activity: 1036
    Merit: 861
    Livecasino.io
    All we new pipo wey just enta i welcome una. D first tin una gats know be say this forum nor be Nairaland o. Plenti Olopka dey here if u do any how, you see any how or beta still as we dey talk am for we local parlance if you do any how, you go collect wotowoto. Dem nor dey hear abeg o here o. So if u dey copi copi from d internet like say na your own and you nor talk where you copi am from, if dem olopka wey dey here catch you, na Okene (suspension/ permanent ban) sharp sharp.

    Newbies make una check this thread to confirm wetin I don talk - Report plagiarism (copy/paste) here. Mods: please give temp or permban as needed
    hero member
    Activity: 1036
    Merit: 625
    BTC, a coin of today and tomorrow.
    Men don fall in here mehn mehn. I don see plenty we join us, sotey Yawa follow enter here.

    😂😂😂 I for arrest you for this talk ooo but as per bro wey we be I go free style you 🙌
    That Ekweremadu matayas na one kind ooo as different version of the story just dey comot from every angle 💔 na just predicament befall the man but I no wan chuk mouth for that matter until the investigation is over. Anyway, as una dey welcome us, make una try dey share pop corn and cold malt. 🥤 Thank you 🙌
    Yawa, na you go bring the one you carry come first. When people dey drop posts, the forum dey avoid wetin dem call spam. Which mean say, if you drop post, you go wait make another person drop too before you go drop another one. Like above, only you drop two times, dem.say e no good.

    I believe say dem don give you some links make you take read, incase dem never give you, try read these ones I go drop for you.
    https://bitcointalksearch.org/topic/bitcointalk-posting-etiquette-5184741. POSTING ETIQUETTE
    Unofficial list of (official) Bitcointalk.org rules, guidelines, FAQ

    If you get time, you fit check some of these topics wey Ratimov put together here. You get dedicate small time read. I know say an average Nija boy get plenty things for head. No reason am
    Ratimov's Forum Guides, Tutorials & Lists
    member
    Activity: 756
    Merit: 30
    Men don fall in here mehn mehn. I don see plenty we join us, sotey Yawa follow enter here.

    😂😂😂 I for arrest you for this talk ooo but as per bro wey we be I go free style you 🙌
    That Ekweremadu matayas na one kind ooo as different version of the story just dey comot from every angle 💔 na just predicament befall the man but I no wan chuk mouth for that matter until the investigation is over. Anyway, as una dey welcome us, make una try dey share pop corn and cold malt. 🥤 Thank you 🙌
    member
    Activity: 756
    Merit: 30
    @BIT-BENDER thank you for your suggestion. But I go appreciate if you go put me through on how to quote properly. Me sef dey surprise how my quote dey get plenty pyramid. I dey follow the thread kamkpe 💪 to learn from people wey dey ready to teach us newbies.
    hero member
    Activity: 1036
    Merit: 625
    BTC, a coin of today and tomorrow.
    Good evening my people. How una dey? Since I drop that Ekweremadu post I bin go offline, I just login now and I no recognise our local board thread again. I gats go back to check whether I don open Bangladesh board Grin Grin  Grin

    Men don fall in here mehn mehn. I don see plenty we join us, sotey Yawa follow enter here. I welcome all of una for this thread. While plenty na new users, some don tey for the forum but never come here. I welcome everyone.

    Make we try dey work according to the overall forum rules make we no for fall victim of any kind. As the influx don dey rise here, better eyes go dey on us base on say our tape as Naija people done cast for online matter. Make we dey thread with caution. Anything you no understand Make you ask your brother man. Uma Wehdone.
    hero member
    Activity: 1498
    Merit: 702
    @yawa2020 we learn everyday, I go like make you understand something this your post above me is quoted wrong you put your own message for box, that aside the quote pyramid self na Dey too much and times with out number the forum the frown on am, I go rather advice you another better means here since it’s just a thread for our local community you fit use @ like how I started this my post, if the person is following up him go see am and from the content of your message know Wetin you Dey talk about.
    member
    Activity: 1540
    Merit: 68

    No be so my brother. The truth be say normal normal to get merit hard because to make post weh go trend and attract merits itself hard. Also, no be by sabi person o. as we sabi one another for here, you still need make sure seh your post de get grade and quality so that if merit full am well well, nobody go talk say na crowdfund or do aproko reach that level.

    Maintain the one love biko and continue to explore the forum. Growth deh gradual, merits follow am for the process too
    Thank you so much for your suggestion and encouragement

    The easiest way to win my broda, is to win together
    hero member
    Activity: 1148
    Merit: 555
    My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
    😂😂😂
    Well, thanks 😊 una Don show me love already. Naija to the world 💪

    Haba!! Bro, I go talk say this statement na big lie, because give the forum something good and the forum go bless you and we your naija brothers go also bless you. I just checked your previous post and na bounty reports full there, abeg where you been think say merit go come from? And even your last 4 posted threads are not even up to 400 words and even in Altcoin discussion not even "Beginners & help"... Bro, I think say you never do things right, because if you do things right, the right thing go locate you. But all the same, welcome to our naija sub section of the forum. And manage that my 1 merit I sent. Thanks

    Wetin I don see for your matter be say you put bounty for front nai make you never fit grow. See now you nor fit quote post properly, your post history na bounty reports full am. No single attempt to involve yourself for forum discussion, e no good. I no go blame you since na hustle you come here to hustle. But try learn something, nor be only bounty dey forum. People dey learn better here. Put eye outside altcoins discussion
    member
    Activity: 1540
    Merit: 68

    My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
    I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌

    No be so my brother. The truth be say normal normal to get merit hard because to make post weh go trend and attract merits itself hard. Also, no be by sabi person o. as we sabi one another for here, you still need make sure seh your post de get grade and quality so that if merit full am well well, nobody go talk say na crowdfund or do aproko reach that level.

    Maintain the one love biko and continue to explore the forum. Growth deh gradual, merits follow am for the process too
    member
    Activity: 756
    Merit: 30
    My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
    😂😂😂
    Well, thanks 😊 una Don show me love already. Naija to the world 💪

    Haba!! Bro, I go talk say this statement na big lie, because give the forum something good and the forum go bless you and we your naija brothers go also bless you. I just checked your previous post and na bounty reports full there, abeg where you been think say merit go come from? And even your last 4 posted threads are not even up to 400 words and even in Altcoin discussion not even "Beginners & help"... Bro, I think say you never do things right, because if you do things right, the right thing go locate you. But all the same, welcome to our naija sub section of the forum. And manage that my 1 merit I sent. Thanks

    hero member
    Activity: 1022
    Merit: 723
    My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂

    Haba!! Bro, I go talk say this statement na big lie, because give the forum something good and the forum go bless you and we your naija brothers go also bless you. I just checked your previous post and na bounty reports full there, abeg where you been think say merit go come from? And even your last 4 posted threads are not even up to 400 words and even in Altcoin discussion not even "Beginners & help"... Bro, I think say you never do things right, because if you do things right, the right thing go locate you. But all the same, welcome to our naija sub section of the forum. And manage that my 1 merit I sent. Thanks
    hero member
    Activity: 952
    Merit: 742
    Helo my pipu! I dey grit wuna ooo

    I b newbie wen no Sabi anytin about cryptocurrency but d way I Don found pipu I 4 here I believe my problem about cryptocurrency Don dey surrender small small. I believe wuna go guide all d newbie.

    Tank 2 u all.. One love keep us together

    Welcome to Bitcointalk forum and welcome to our Nija Corner, na here we gather dey. As you just they enter pls try and avoid anything wey relate to copy and paste, because dis forum no want am, make you try dy creative and active. Together we go grow and for this forum.
    They always try read rules wey they guide forum and our own Thread also wey our oga @CryptopreneurBrainboss provide for us in the first page. Enjoy
    member
    Activity: 756
    Merit: 30
    Username: Yawa2020
    Gender: Male
    State of resident (optional): Niger
    Skills: Fashion designer (both ladies and gents wears)

    My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
    I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌

    Welcome here my brother. The matter weh you nack here get as e be o but na true weh you talk anyway. You think say na only for Abuja them deh use connection, e deh everywhere. But make I no lie you, another reason weh make you no deh get merit go fit be as na mostly for bounties weh your posts deh. Some oga them deh talk say them no deh like merit posts weh no deh constructive, and bounty posts no deh constructive na.

    Abeg anywhere to dey see notifications if person quote your reply? 🤔 This thread don begin dey give person joy 😂 Na big miss wey person no know abt this thread before ooo💔😅 thanks to oga patapata @brainboss 💪🙌

    You go fit run this bot for your telegram, na straight from our forum and you get get every notifications concerning your posts. Na him be this @BTTSuperNotifier_bot. Just copy that link weh I send and run am for telegram like that.
    Wow! This is amazing 🙌 this bot is dope. Thanks once again
    member
    Activity: 756
    Merit: 30
    Helo my pipu! I dey grit wuna ooo

    I b newbie wen no Sabi anytin about cryptocurrency but d way I Don found pipu I 4 here I believe my problem about cryptocurrency Don dey surrender small small. I believe wuna go guide all d newbie.

    Tank 2 u all.. One love keep us together

    You be nupe by tribe I guess 😂
    member
    Activity: 756
    Merit: 30
    You go fit run this bot for your telegram, na straight from our forum and you get get every notifications concerning your posts. Na him be this @BTTSuperNotifier_bot. Just copy that link weh I send and run am for telegram like that.
    [/quote]
    Oya na everywhere good 🙌 make I try am see. Thank you
    member
    Activity: 499
    Merit: 16

    You go fit run this bot for your telegram, na straight from our forum and you get get every notifications concerning your posts. Na him be this @BTTSuperNotifier_bot. Just copy that link weh I send and run am for telegram like that.
    Thanks bro for this little information wey u just mention oo, cos I don dey find ways to always get notifications if person quote or reply my post. But the bot bin dey ask for UID, how person go take get the UID?
    Just go your profile, then copy your profile link. The url for your browser na him be your profile link. If you copy am com paste am anywhere, you go see some numbers for the url. Na d numbers dey come last for d url, 7 digit number. Na your UID be that. Na so them dy write am (https://bitcointalksearch.org/user/asiska02-3452791) na the last 7 digit be the UID.
    Much thanks brother man, i don later get am but thanks anyways. Na why e dey pain me say i no quick know about this thread be dis, everybody bin dey help one another as much as they can.
    hero member
    Activity: 910
    Merit: 686

    You go fit run this bot for your telegram, na straight from our forum and you get get every notifications concerning your posts. Na him be this @BTTSuperNotifier_bot. Just copy that link weh I send and run am for telegram like that.
    Thanks bro for this little information wey u just mention oo, cos I don dey find ways to always get notifications if person quote or reply my post. But the bot bin dey ask for UID, how person go take get the UID?
    Just go your profile, then copy your profile link. The url for your browser na him be your profile link. If you copy am com paste am anywhere, you go see some numbers for the url. Na d numbers dey come last for d url, 7 digit number. Na your UID be that. Na so them dy write am (https://bitcointalksearch.org/user/asiska02-3452791) na the last 7 digit be the UID.
    hero member
    Activity: 784
    Merit: 568
    Helo my pipu! I dey grit wuna ooo

    I b newbie wen no Sabi anytin about cryptocurrency but d way I Don found pipu 4 here I believe my problem about cryptocurrency Don dey surrender small small. I believe wuna go guide all d newbie.

    Jump to: