Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 117. (Read 1023159 times)

member
Activity: 499
Merit: 16

You go fit run this bot for your telegram, na straight from our forum and you get get every notifications concerning your posts. Na him be this @BTTSuperNotifier_bot. Just copy that link weh I send and run am for telegram like that.
Thanks bro for this little information wey u just mention oo, cos I don dey find ways to always get notifications if person quote or reply my post. But the bot bin dey ask for UID, how person go take get the UID?
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Username: Yawa2020
Gender: Male
State of resident (optional): Niger
Skills: Fashion designer (both ladies and gents wears)

My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌

Welcome here my brother. The matter weh you nack here get as e be o but na true weh you talk anyway. You think say na only for Abuja them deh use connection, e deh everywhere. But make I no lie you, another reason weh make you no deh get merit go fit be as na mostly for bounties weh your posts deh. Some oga them deh talk say them no deh like merit posts weh no deh constructive, and bounty posts no deh constructive na.

Abeg anywhere to dey see notifications if person quote your reply? 🤔 This thread don begin dey give person joy 😂 Na big miss wey person no know abt this thread before ooo💔😅 thanks to oga patapata @brainboss 💪🙌

You go fit run this bot for your telegram, na straight from our forum and you get get every notifications concerning your posts. Na him be this @BTTSuperNotifier_bot. Just copy that link weh I send and run am for telegram like that.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌

U dey welcom bro, here tinx are being done wt moderation and modesty, na learn you go focus ur mind 2 as 4nw, wennu donngrow reach d kind level wey be say u dey convince yourself say u don sabi, den e go dey flow natural, nd abeg make u no abuse anything here or on any oda board or take dem 4 granted bcos it will tell, read d rules of d forum and make u dry post tins wey make sense, u go av a nice experience bin here 4 dis corner.
Welcome.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Abeg anywhere to dey see notifications if person quote your reply? 🤔 This thread don begin dey give person joy 😂 Na big miss wey person no know abt this thread before ooo💔😅 thanks to oga patapata @brainboss 💪🙌

Yes o. You fit read this post by fillippone on how to be notified on a smartband of merits and mentions. D sumari be say u go need buy a smartwatch, den you go subscribe to a notification bot. Then according to the article, you go configure d smartband so dat e fit receive beta notifications from d phone. Plenti senior men for yankee don confirm am sha . I nor sabi if any we brodas don do am.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
I want use this opportunity to thank all the oga them wey dey make Naija name they happen for this forum. Ona too much. My belle sweet wela as I dey join this Naija forum full time. And as I don join now, no going back. Na forward ever backward neva. I salute ona oh.
 

My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌
My paddyman sorry say small boy or new comer won put mouth for your matta. But as I check through your post history I discover say you dey more interested for bounties pass other things for the forum. I feel say you no get so much interest to contribute some ogbonge tins and tinsis for the forum. I don do few post and I get merit but that wan no mean say I sabi pass you but you go do small research so that your post go bi like soup wey get meat, fish and gbomo wey go attract people. Also make you look for thread wey you get interest, for me I go like economy and politics and society. Na there my strength go dey for now until I don learn well well about the forum.  Paddy I believe say yo fit get plenty merit and the skills dey your body. I know say Naija no easy so man must hussle but if you build your account you fit collect more pay. Sorry oh if I in anyway make you vex oh.  

Sure boss, you no too far from truth. Na why I say I go appreciate any paddy wey go dey put me through for this forum till I become pro.
Abeg where dem dey discus naija politics matter? 😂 I know say that thread go dey give person joy 😂
No wahala since you dom accept the truth. As you dom enter here so, anything wey you no understand na here you feet ask the question senior men dem go sharperly ansa you then guide you on how you go take dey waka for forum.
Na here we dey yarn every every about naija political mata, feel free yarn the okpata as e take dey happen but try make your info be legit ooo.
member
Activity: 756
Merit: 30
Abeg anywhere to dey see notifications if person quote your reply? 🤔 This thread don begin dey give person joy 😂 Na big miss wey person no know abt this thread before ooo💔😅 thanks to oga patapata @brainboss 💪🙌
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Wuna welldone my fellow naija people😀. I don dey dis forum since March just dey move about different posts and thread. I no know say naija get board for here wey we fit dey relate dey speak our pidgin d way we lyk. Now I feel lyk I don enta house. I dy hail d boss @cryptopreneurBrainboss for creating dis thread for dis forum.
God go bless you and other people wey follow dy contribute and guide our naija people for this forum.
My username na: Asiska02
My gender na: Male
Skills wey I get: Blogging, content writer.
You Dey very welcome to the thread and hopefully we go Dey use the word board rather than thread, you no be brand new person from your profile so you already know something about this forum and I got talk say you sabi rules and guidelines but I go still recommend you read the first guiding post for this thread by @Cryptopreneurbrainboss e go really help you kick start your journey here wella, once again welcome.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Is this a business for the couple? 
I doubt, Senator Ike Ekweremadu has been in the senate for a long time since 2003 and you know how very well paid Nigerian politicians pay themselves. This could not have been a business, it is probably a one time thing, wey dem nor expect say go cause wahala for them.

Was the boy in question kidnapped, taken against his will or was he paid and agreed to do the operation?
The news say dem deceive am say na better dem dey carry go for abroad.

I know people do stupid things for money, was he paid to sell his kidney?
True that some people are willing to sell their kidneys, however, the problem for the matter na say the boy na underage and a homeless boy, and normally someone who is underaged, you nor suppose reason am as person wey fit make decision for himself.

There is a long list for kidney donors and maybe EKWEREMADU as a father was impatient and wanted a shortcut.
As a father and a wealthy one at that he should have been able to make a right decision, he could well afford dialysis machine for his child till a proper donor is found, but chose to go his own way. It is terrible to put one life over another because of privilege.

The Uk government frowns heavily at organ trafficking and illegal organ harvesting, and recently if you dey follow up news well well, you go see say the cases of organ trafficking dun dey dey too high for UK. If them find our senator and e wife guilty, him fit serve serious jail time that way. I don't have any sympathy for them, if they are found guilty, they should face the law...many people dey loss for 9ja, we nor know wetin dey do them.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
Wuna welldone my fellow naija people😀. I don dey dis forum since March just dey move about different posts and thread. I no know say naija get board for here wey we fit dey relate dey speak our pidgin d way we lyk. Now I feel lyk I don enta house. I dy hail d boss @cryptopreneurBrainboss for creating dis thread for dis forum.
God go bless you and other people wey follow dy contribute and guide our naija people for this forum.
My username na: Asiska02
My gender na: Male
Skills wey I get: Blogging, content writer.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌
I they feel weting u dy feel bro, but this forum as e dy so, e get somethings wey go fit fesh you merits, but if you start with Bounty, many people go they ignore your post, because them go dy reason say you make your post ust to get merit and continue your bounty signature campaigns, maybe na why, but once them see say you keep it up to dy drop better posts, them go surly merit you.
hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death
I want use this opportunity to thank all the oga them wey dey make Naija name they happen for this forum. Ona too much. My belle sweet wela as I dey join this Naija forum full time. And as I don join now, no going back. Na forward ever backward neva. I salute ona oh.
 

My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌
My paddyman sorry say small boy or new comer won put mouth for your matta. But as I check through your post history I discover say you dey more interested for bounties pass other things for the forum. I feel say you no get so much interest to contribute some ogbonge tins and tinsis for the forum. I don do few post and I get merit but that wan no mean say I sabi pass you but you go do small research so that your post go bi like soup wey get meat, fish and gbomo wey go attract people. Also make you look for thread wey you get interest, for me I go like economy and politics and society. Na there my strength go dey for now until I don learn well well about the forum.  Paddy I believe say yo fit get plenty merit and the skills dey your body. I know say Naija no easy so man must hussle but if you build your account you fit collect more pay. Sorry oh if I in anyway make you vex oh.  
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Username: Yawa2020
Gender: Male
State of resident (optional): Niger
Skills: Fashion designer (both ladies and gents wears)

My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌
My brother @Yawa2020, I welcome you and I dey hapi say you locate here wey your people dey.
As for wetin you talk about getting merit for forum, that one no follow because even person wey no no you go sama you holy water if you yarn wetin make sense to wetin em post or you make post wey dey kajard and wey people go learn from, something wey maybe dem never no before or something wey dem dom hear but dem no no how to go about am. I dom go through your profile see when you join forum but I never see where you yarn anything. I go encourage you to dey contribute positively for here, solve problems or bring good suggestions to how some things go dey better for forum you go watch how you go take dey rewarded with merit.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
I bin lik dis Ike Ekweremadu guy b4 o but, dis en matter eh, e no fine 4 eye nd as e no fine 4 eye, na so e no swt 4 ear too. D only Evident to d matter as e be now be say, true true, dem plan harvest kidney frm teenager nd dem arrest dem 4 UK. Although, dem dey claim say na under agreement, dem bin message UK say, na watin dem wan do b dat b4 dem fly d boy com nd d pikin dem wan harvest en kidney don rch 18yrs.

Na dere mata burst shah. Oyibo no dey lik us nd u knw say, dem get machine dem way dem fit use determine age via radio isotope dating. Na dere dem go carry hook am 4 neck via say, me, I beliv say dem don use d poverty state of d pikin nd en family, carry ride on dem. Ike Ekweremadu no try 4 dis 1 shah.
Ike really fuked up big time, imagine this kind situation, me I see am say na selfish interest make them carry small pikin come furge Visa for am and increase him age, I understand say na Their pikin kidney transplant they wan do but the way them carry d matter e no fair at all. As the matter be now, them Don keep am for there say if them find out say na true be say him gbab that pikin nr, him go face 10 years for jail because as we they now them no gree for him bail.
member
Activity: 756
Merit: 30
Username: Yawa2020
Gender: Male
State of resident (optional): Niger
Skills: Fashion designer (both ladies and gents wears)

My experience so far for this forum be say you no fit get any merit if you no Sabi people ooo cuz from my observations ehh na people wey Sabi each other dey give each other merit and leave us wey be newbies for backyard 😂
I Don publish like three post sha but e no smell any merit 💔 anyway, I go appreciate anybody wey go dey put me through for this forum sortey I go become pro🙌
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
I bin lik dis Ike Ekweremadu guy b4 o but, dis en matter eh, e no fine 4 eye nd as e no fine 4 eye, na so e no swt 4 ear too. D only Evident to d matter as e be now be say, true true, dem plan harvest kidney frm teenager nd dem arrest dem 4 UK. Although, dem dey claim say na under agreement, dem bin message UK say, na watin dem wan do b dat b4 dem fly d boy com nd d pikin dem wan harvest en kidney don rch 18yrs.

Na dere mata burst shah. Oyibo no dey lik us nd u knw say, dem get machine dem way dem fit use determine age via radio isotope dating. Na dere dem go carry hook am 4 neck via say, me, I beliv say dem don use d poverty state of d pikin nd en family, carry ride on dem. Ike Ekweremadu no try 4 dis 1 shah.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
This IKE EKWEREMADU and wife matter, how una see am...I no know whether anybody don mention the matter for here. Wetin really sup for the matter. I know say the matter dey court but I know say Ekweremadu na one of the longest served senators. Him don see money and him money long. So the person wey dem carry go UK na for ritual purpose or health transplant. If na for transplant based on agree, I think UK government suppose dey aware.
Abi all these na pure wickedness? Inhumanity to humans
I haven’t heard any solid information about the EKWEREMADU case. There are lots of unanswered questions. Is this a business for the couple? How long have they been doing this? Was the boy in question kidnapped, taken against his will or was he paid and agreed to do the operation? I know people do stupid things for money, was he paid to sell his kidney? There is a long list for kidney donors and maybe EKWEREMADU as a father was impatient and wanted a shortcut. That could be his defense, however the case is still in the early stages and much has not been told to the public. I will reserve my judgement until the court decides.
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
This IKE EKWEREMADU and wife matter, how una see am...I no know whether anybody don mention the matter for here. Wetin really sup for the matter. I know say the matter dey court but I know say Ekweremadu na one of the longest served senators. Him don see money and him money long. So the person wey dem carry go UK na for ritual purpose or health transplant. If na for transplant based on agree, I think UK government suppose dey aware.
Abi all these na pure wickedness? Inhumanity to humans
Ekwetemadu don buy market for UK, the thing wey be say if na naija it happens he go scot free, a country wey law no dey catch politicians or rich men but his case na double wahala, Firstly he fortified the boy 15 from to 21 years offence No. 1, secondly he wan harvest the poor boy kidney for his daughter kidney transplant, imagine the money wey he go spend on top of dis matter, dey no gree put up a well equipped hospital for naija, instead stole our money meant for consituency projects carry an go UK go buy properties, na small small God go dey deal with them. see the photo of the poor boy.
https://www.nairaland.com/7194001/organ-harvesting-photos-15-year-old
 Karma is real.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
This IKE EKWEREMADU and wife matter, how una see am...I no know whether anybody don mention the matter for here. Wetin really sup for the matter. I know say the matter dey court but I know say Ekweremadu na one of the longest served senators. Him don see money and him money long. So the person wey dem carry go UK na for ritual purpose or health transplant. If na for transplant based on agree, I think UK government suppose dey aware.
Abi all these na pure wickedness? Inhumanity to humans
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
The problem be say those politicians purposely or intentionally suffer Nigerians and subject them to abject poverty because they no say people go come out to vote for them by enticing them with big money, look at wetin happen for Ekiti State wey APC paid voters 10K and PDP 5K, they were even displaying it in public, Imagine a private school teacher wey dey earn 10K monthly see dis kind opportunity to vote and collect 10K will they turn it down NO?  they go vote am because of poverty and not minding that they don enter one chance and another round of suffer-suffer for 4 years, honestly a lot has to be done to sensitize our people against vote buying.

You r 2 much. I love dis talk. Nai make I dey caused Nigeria electorates. Dem no get sense. Nd dose pipo na di old pipo plenti pass. Me I no want talk politics again bcoz me I dey angry... Even ma fellow wey supposed understand dis things, e no dey understand interested dem go argue out of point. Nigeria Politics na moni nd di old pipo need Moni.

Me I still dey talk am say, Obi go win if he go do like MKO Abiola. If not me I doubt am ooo. Me I no need a prophet 2 come nd tell me. Politics. 

Nigerian youth understand what happened in #endsars nd vote rightly. Thanks
Shebi una wan kill Peter Obi make e do like MKO Abiola abi?? You nor know how e happen for Abiola time, na six feet below e go. He followers way ginger am to declare himself winner run leave for road. Now na only for history we dey remember e name. Make we trust the electoral process this time, we go vote our man and the people favorite go win. Them no go fit deny us this one
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Generally, dem too de carry this tribal arguments too much and e no suppose be so. Na everyone get their own bias, it could towards a or towards b. labeling it as tribalism is too push a certain agenda weh we all sabi the outcome. na the so so labeling truncate the endsars protest, na him make dem label ipob too con de give terrorists freedom. na make we de rebuff those tribalistic claim every time e cross our path remain cos this election season, na everyone wan chop
I respect your talk brother, na so this our Nija be oo, we have to try change ourselves if not this Tribal difference they always be big issue. Now reason how the election don dear, instead way we go all go for better candidate way go move this country forward for better future, our elders go they tell us say this one na our person so make we vote am if them Know say no be him better to get the position. we have to end Tribalism in other to succeed.
Jump to: