Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 119. (Read 1023159 times)

hero member
Activity: 1064
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
You can also use your Voters Identification Number VIN to check.

I been register my PVC 2015 during that BUBU election, I just checked to verify my VIN and my name and polling unit show bodly.
I don they plan to get new one but workload plenty for my head with procrastination but I happy as this one still legit, I go follow crowd vote better candidate next year and I pray make them no rig am for the wrong person.
These one way NNPP no gree join force with Oga peter, I hope they don't get duck down by these Rastafarians weh we get for with upper hands, I no they like politics but we must vote the right candidate to make things right this time.

#Say no to tribalism, #Say no to Religious fight, #Let us unite as one.




#Copied

Abeg, try they properly put quotes for your post, I no happy as them they Report Bright for plagiarism, a lot of effort has been made but it is likely getting Perma ban.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
@marykeller where ever you got this post from it has a lot of brains inside it, sometime I wonder why someone won’t be interested in the politics of his nation or even worse try to support the very people who are ruining things in the next election based on bride, sentiments, tribalism or even religious believes because when the cancer of the nation really cashes up, every time na every Nigerian citizens they fill am, no one is exempted from it, the country Dey big mess and if we continue like this it my best unrecoverable, let us vote wisely.
The truth of the matter be say, make we all have a plan B. Make we no wait for dis our yeye politicians to help us rescue Nigeria. The country jakajaka(beyond repair), everything scatter, poor man d suffer suffer.
Wetin all of them(politicians) care about na dia ego. If you no get something solid here like a good business or job, make you try have JAPA plans.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Well @Marykeller, i will tells you that those people seating there knows thing to fix normal but they are there for self gain and to make all money spent over the elections, imagine someone pay $19k to delegates, $20k and $17k so are you expecting if he wins he shouldn't get back those funds spent?
The answer is very simple, Yes! They will still act the same way that was Peter Obi said he don't have such money to spent and also not sure to win under the umbrella of PDP making him to decamp to LP. He knew the people's pain and they passing through also refused to danced to their tunes. please let us try our best to make sure we effect change and put a young man, not a man who is next to his grave. 
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I dey hope say make youths get their PVC and come out enmass to vote out those yeye politicians in 2023, votes no dey count on social media na to go out and cast votes , na 2023 election will be a big opportunity to permanently retire those moneybags politicians wey thief all our money

I hear as some youths take rough rough Tinubu convoy for Lagos yesterday as against how people take welcome PO for airport. Our politicians them know say if election na by free and fair or online voting as advanced countries them deh do am, all those thieves no go ever smell that seat. And that is why them no want to allow us advance to online voting.

imagine a graduate wey dey earn N30,000 for NPOWER, where a politician dey use 100,000 million collect form, that money is enough to employ many graduates on a N50,000 monthly scales for years.

My brother na true say N30,000 deh small but make we talk true that NPower thing na pure scam. I know of people weh deh enrolled there and get work elsewhere. Them just use that one deh collect from government and I know say e go deh worse for north.
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
As the election they approach na so tension Dey rise, many of us by now don make up our mind for who them go vote for, but I pray that our decision was made by putting the future of the country at heart, for real Nigeria need that breath of fresh air and these goes beyond religion or tribe, but right now the main koko be say me we all go get our PVC (permanent voters Card) because the opportunity for a better Nigeria lies on our vote.

I pray for this unity among youths comes 2023 election because the rate at which the pressure Is going around shows that we are united and not just united but to vote out the looters nd the bad people on stage to purify our future for our unborn children and for a better for everyone to be admired.
Let the unity of our youths among us continue till the ending days of our P. Election. I watch some videos of Mr.PO on FB at Airport, menh I saw the love around him with his fellow nigerians taking pictures and selfies omo that man need not to spend money to run his campaign as youths ready down there for him. Both old and new born babies
👉👉👉 Video link here
I dey hope say make youths get their PVC and come out enmass to vote out those yeye politicians in 2023, votes no dey count on social media na to go out and cast votes , na 2023 election will be a big opportunity to permanently retire those moneybags politicians wey thief all our money, if we cannot do that next then I fear things will continue to go worse, honestly people dey suffer for dis country imagine a graduate wey dey earn N30,000 for NPOWER, where a politician dey use 100,000 million collect form, that money is enough to employ many graduates on a N50,000 monthly scales for years.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Una sabi how politicians like to deh over hype themselves na.
But anyhow e take be, Kwankwaso no go fit win presidential election, but e go fit help person win and e go fit make person loss with his supporters.

Na the same thing weh I deh talk. These politicians they act like them pass wetin them be. With all the talk say na Atiku influence them take form PDM weh come enter PDP, Atiku still never fit win election. Abi na Buhari own we want to talk about? Buhari na strongman for north yet he could not win until grandpa Tinubu helped his career. As you talk finish even Kwankwaso himself no fit win presidential election. Na PO be the movement now, Kwankwaso better behave o.
hero member
Activity: 952
Merit: 742

First make i appreciate your efforts to provide this useful information.
I don try to enter the link but e no gree response be like say them short am down or fit from my Network, as I enter my details come pass the security check up na so the thing no gree give me any information again.
Abeg people wey try check their own how far, any authentication from the link make i know whether e from my ends.
We need to stop all nonsense, enough is enough.
The option wey they allow person check with name and date of birth no too they load, but the other one way you go use your VIN they work because I just confirm am now and it works but e sha slow before e go load.  Try and put all your VIN number to this link with your last name, e go show your details.
https://voters.inecnigeria.org/#statusViaVin
Try am now with this link make we see your feedback.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
E don dey official now sey na Okowa and nor be Wike be Atiku running mate. I hear sey Ahmed Lawan don jump like lizard enta PDP. E don start. Na so.
E shock me o via d Atiku running mate mata. Dis politics xpecially 4 we naija be a e get. Dem go jst mak ur mind dey nd 5 d last minute wen u no con dey reason anytin nd no beliv say, anytin go fit sup again, dem go jst switch. E don clear 4 Wike eye now na, say no b by plenty talk nd dat tin way dem call brodahood, e dey work wella. Dis Okowa guy neva do too much, dem jst wan use am suppress pple mind 4 d East, to divert attention frm Obi nd I sure say, Nigerians dey alert shah.

Many things no suppose dey surprise una for politics shaa...if say you get me for Facebook, you for see how I dey analyze these things and e dey work 100%.
I knew that Atiku will not use Wike as running mate. The only thing wey suppose force Atiku use wike, na I say APC give Amaechi ticket. But as APC no send Amaechi, nothing come out for wike.

If you be Atiku, dem say make you use Wike do vice, you go gree?
No matta say everybody dey hail Wike, we still no say him no be de kind president Nigeria need.
Governor wey go dey address people and be saying "Ntoor", "Waka", "Thunder fire you"... na just because this part of the world we from, no body dey take anything serious.

Okowa na cool headed guy. No talk say no body sabi him. No be because say him no dey go channels TV go shout like person dem drug. Okowa don be PDP governors chairman, him still be the chairman of 2019 pdp primary election and many committees for pdp. Na kind man wey dey reason before him talk. Na those kind people suppose be vp.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
@marykeller where ever you got this post from it has a lot of brains inside it, sometime I wonder why someone won’t be interested in the politics of his nation or even worse try to support the very people who are ruining things in the next election based on bride, sentiments, tribalism or even religious believes because when the cancer of the nation really cashes up, every time na every Nigerian citizens they fill am, no one is exempted from it, the country Dey big mess and if we continue like this it my best unrecoverable, let us vote wisely.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
As the election they approach na so tension Dey rise, many of us by now don make up our mind for who them go vote for, but I pray that our decision was made by putting the future of the country at heart, for real Nigeria need that breath of fresh air and these goes beyond religion or tribe, but right now the main koko be say me we all go get our PVC (permanent voters Card) because the opportunity for a better Nigeria lies on our vote.

I pray for this unity among youths comes 2023 election because the rate at which the pressure Is going around shows that we are united and not just united but to vote out the looters nd the bad people on stage to purify our future for our unborn children and for a better for everyone to be admired.
Let the unity of our youths among us continue till the ending days of our P. Election. I watch some videos of Mr.PO on FB at Airport, menh I saw the love around him with his fellow nigerians taking pictures and selfies omo that man need not to spend money to run his campaign as youths ready down there for him. Both old and new born babies
👉👉👉 Video link here
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM


E don dey official now sey na Okowa and nor be Wike be Atiku running mate. I hear sey Ahmed Lawan don jump like lizard enta PDP. E don start. Na so.
Ahmed Lawal still dey APC but the useless party don replace the name of the man wey win APC Lawan seat for Yobe state with the same Ahmed Lawal wey go contest presidential primaries and lost, the list had already been submitted to INEC, Bashir Machina the man wey won the seat talk say him no go comot for the seat for Ahmed Lawan, now na to go to court to reclaim his mandate be his next step.
Ahmed Lawal gambled and miscalculated, he don dey senate since 2007 and he no won commot there after 15 years that will be his fourth term now going for the fifth term look how greedy our politicians be.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
I hear sey Ahmed Lawan don jump like lizard enta PDP. E don start. Na so.
Nor be small thing my brother, Why do our politicians keep jumping around? the politics for nigeria na game of interest and loyalty. The northerners na number one people for loyalty and oneness, just to ensure say power remain for the north, dem go play all the politics gather all their power together. Ahmed dun go there sake of say make the votes from the north nor dey shared. The northerners are very united, even more than others for other side of we country, nai make dem dey get majority well well. I just dey observe to see who Tinubu go pick, but for me i dey suspect say na Ahmed Makarfi wey be former governor of kaduna and former chairman for PDP, e gats be northerner if Tinubu go wan still get vote from that side.

You dey right my brother. Anyhow wey we take mirror am, the north get one kind unity wey go make them do something for themselves at the last hour wey you no go believe. Even for voting self you go see how even the herders and show makers go get PVC take vote. This there monarch system really help them well to respect and respond to their leaders call. If lawal don run enter PDP, na just for him to support Atiku and you see him do am quick so dat him voters go know early enough say na PDP dem go vote for

As for Peter Obi, I dey hear rumour say kwankwanso fit join am, if e go happen like that ehn... the election next year go dey very serious.

News dey carry am say na Dr Doyin Okupe, the former Special Assistant on Media and Publicity to ex-President Olusegun Obasanjo be him running mate. We still dey look them all..
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
As the election they approach na so tension Dey rise, many of us by now don make up our mind for who them go vote for, but I pray that our decision was made by putting the future of the country at heart, for real Nigeria need that breath of fresh air and these goes beyond religion or tribe, but right now the main koko be say me we all go get our PVC (permanent voters Card) because the opportunity for a better Nigeria lies on our vote.
member
Activity: 499
Merit: 16
Make Obi try collect vote from northern wella but the guy don dey pull enough weight for social media, him don dey trend well and I hope that go enta for voting pattern make miracle happen and make Nigerians jubilate like when Nigeria win Atlanta Olympics for 1996.
Brother man, naija election pass to dey trend for twitter oo. Na only we youth dey rate peter Obi for the general election our mama and papa dem no go hesitate give their vote to either of Atiku or BAT. For Peter Obi to emerge as the winner a lot of campaign and sensitisation gaz dey for we old people. And make we no too dey follow wetin dey twitter cos majority of the youth wey dey canvass for Obi no get PVC even if dem get na just for getting sake.

Make we now compare the political aparthy in the south to the north we go need a lot of effort to win this election for Obi I swear cos dem northeners no give a f**k about how incapable their candidate is as long as him be northerner too dem go vote anybody en mass.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Mean while, me go stil lik mak Peter Obi r win dis tin. Na my wish say, mak our vote reali count nd mak Nigerians no dey partisan to dis election. Mak we 4 vote via persn we feel say ft bring small Chang 2 d kontry way don dey rot finish. We need am.

My brother na our wish say the correct persin enta as president because that 1 dey important but the thing be say naija politics as you talk am, get as e be. The number of people wey go vote still matter. The whole of South East vote no go fit past only north central and dis northern people still dey close eyes vote for their people no matter how bad wey the northern candidate dey. Make Obi try collect vote from northern wella but the guy don dey pull enough weight for social media, him don dey trend well and I hope that go enta for voting pattern make miracle happen and make Nigerians jubilate like when Nigeria win Atlanta Olympics for 1996.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Topic: How To verify an Existing voter Registration Details

As e they Hot, this coming election youths they show their interest to participate in the coming election as many of us wey no get voters card don they try get one so that we go all come out in large number to cast or votes as we they hope to change this Government completely.

INEC don provide link which we can use to verify our voters registration details, so I bring am come here make we try verify our details to they sure in order  to avoid problem during election time.

Follow this link to check and verify your details

To Verify your voter details follow the following steps.

1. State
2. Surname and
3. Date of Birth

Then check your status.

You can also use your Voters Identification Number VIN to check.

If your details no they valid or not available on the INEC database then you go complain give INEC in order to avoid any issue on Election day.

NOTE: This is only applicable for people wey don already have voters card and wanted to they sure or confirm if their card still they valid. The newly registered voters have to wait until they get their PVC.

First make i appreciate your efforts to provide this useful information.
I don try to enter the link but e no gree response be like say them short am down or fit from my Network, as I enter my details come pass the security check up na so the thing no gree give me any information again.
Abeg people wey try check their own how far, any authentication from the link make i know whether e from my ends.
We need to stop all nonsense, enough is enough.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
E don dey official now sey na Okowa and nor be Wike be Atiku running mate. I hear sey Ahmed Lawan don jump like lizard enta PDP. E don start. Na so.
E shock me o via d Atiku running mate mata. Dis politics xpecially 4 we naija be a e get. Dem go jst mak ur mind dey nd 5 d last minute wen u no con dey reason anytin nd no beliv say, anytin go fit sup again, dem go jst switch. E don clear 4 Wike eye now na, say no b by plenty talk nd dat tin way dem call brodahood, e dey work wella. Dis Okowa guy neva do too much, dem jst wan use am suppress pple mind 4 d East, to divert attention frm Obi nd I sure say, Nigerians dey alert shah.

Ahmed Lawan dey fine en belle na, na so d kontry be. Na where u go fit see chop u go like go nd where u fit dey influence ordas. Mak e dey jump shah.

Mean while, me go stil lik mak Peter Obi r win dis tin. Na my wish say, mak our vote reali count nd mak Nigerians no dey partisan to dis election. Mak we 4 vote via persn we feel say ft bring small Chang 2 d kontry way don dey rot finish. We need am.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
That man get influence too. From wetin I deh hear, him alone fit give any party weh him support around 5 million votes from the north. But we no know how true that thing be. Una sabi how politicians like to deh over hype themselves na.

The thing you hear about Kwankwaso no be hype o, that man na grassroot politician. You dey hear about Kwankwsiyya movement? That movement na him be the largest political movement for North and it therefore means that it is the largest in Nigeria. You know this our politicians for this our place, them no get any movement. Na when election reach you go see them begin sell akara for road.
But anyhow e take be, Kwankwaso no go fit win presidential election, but e go fit help person win and e go fit make person loss with his supporters.
member
Activity: 742
Merit: 30
Topic: How To verify an Existing voter Registration Details



Follow this link to check and verify your details

To Verify your voter details follow the following steps.

1. State
2. Surname and
3. Date of Birth

Then check your status.

You can also use your Voters Identification Number VIN to check.

You don really try brother for this link way you provide for us here, the second method they work fast, as I been use state, and date of Birth, the network slow so I no get feedback on time, but as I input my last five numbers of my VIN number, e show my details including my pooling unit. For now, me I they ready for the election.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I hear sey Ahmed Lawan don jump like lizard enta PDP. E don start. Na so.
Nor be small thing my brother, Why do our politicians keep jumping around? the politics for nigeria na game of interest and loyalty. The northerners na number one people for loyalty and oneness, just to ensure say power remain for the north, dem go play all the politics gather all their power together. Ahmed dun go there sake of say make the votes from the north nor dey shared. The northerners are very united, even more than others for other side of we country, nai make dem dey get majority well well. I just dey observe to see who Tinubu go pick, but for me i dey suspect say na Ahmed Makarfi wey be former governor of kaduna and former chairman for PDP, e gats be northerner if Tinubu go wan still get vote from that side. As for Peter Obi, I dey hear rumour say kwankwanso fit join am, if e go happen like that ehn... the election next year go dey very serious.
Jump to: