Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 121. (Read 1023467 times)

sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Sowore talk say for him to dey travel to go learn mean say e never prepare to rule Nigeria.
While Deji talk say, him suppose dey Ekiti where election go happen to try deliver him candidate. But him run commot for the country.

Wetin be una position for this matter?

Omoyele Sowere na talkative. No be every matter person weh be leader deh put mouth. E get some weh you go leave for your boys or followers to talk. Na so Sowerw supposed to deh do. Problem with darkness be say e no deh like truth. As Peter Obi talk true wetin him want to go do for Egypt na crime for Sowere eye. So person weh deh lead go stop to deh learn abi? Una see Sowere way of reasoning now abi? My brother if you know wetin these so called activists deh do behind closed doors you no go even want to talk to any of them. Most of them no get any genuine intentions, na money them deh find. For Deji matter, I no sabi whether LP get candidate for the Ekiti election. If Labour no get candidate I no see any reason why Peter Obi should go there.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
TOPIC: PETER OBI DON ZOOM OFF TO EGYPT.

The presidential aspirant of Labour Party weh be the person wey dey trend for social media, especially among youths don zoom off go Egypt. Him say e wan go under study Egypt power sector and education. Many Nigerians say na good move, but two activists wey I no know whether na politicians I go call dem disagree with Peter Obi movement.

Sowore talk say for him to dey travel to go learn mean say e never prepare to rule Nigeria.
While Deji talk say, him suppose dey Ekiti where election go happen to try deliver him candidate. But him run commot for the country.

Wetin be una position for this matter?
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
but my question be say enh, why him no shake him hand as others them dey do ? Make ornah shuck mouth for this matters. I mean why Boris Johnson no shake PO ? Abi make I no worry about am ?
Well, i think the hand matter na nothing to worry about, like sato-prince talk, the pictures na for internet e dey, e fit be say na them no upload the one wey boris and peter obi dey shake hands.
But on a religious side sha(una know say me be a very religious person Grin), who God almighty don endorse, He don endorse am be that ooh, that person no need any human endorsement again, God don endorse peter obi, all we need to do now is to get our voters card ready for 2023, make we make sure say our vote count for peter obi.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
I really gbadu the awareness wey dey on top the matters now like this unto election, i dey read say INEC dey under pressure to postpone abi na extend the deadline for the PVC registration because the turn up of people wey wan register to vote dey very unexpected.
Yes oh, and as things be now, i believe say them go extend am, Inec Chaiman don come out talk say them go soon give us informating regarding extension of the deadline, the man also talk say so long as Nigerians go promise am say them go vote, say Inec go extend registration so that more people go register, and that everybody vote go count.

Make we hope say na like that wey baba talk am, na so the thing go happen, Naija don big pass to they rig elections, and i really get hope say next year election to a large extent go they free and fair, so make we no fear anything, and for those wey no wan vote because them think say their vote no go count, i believe say this time around go they different, so make we comot that mindset go collect PVC and vote next year cause our vote go count oh.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
why him no shake him hand as others them dey do ? Make ornah shuck mouth for this matters. I mean why Boris Johnson no shake PO ? Abi make I no worry about am ?
Lmao, maybe e fit be say them dun already shake hand before dem snap, or the picture were dem shake hand, dem nor publish that one...maybe e nor too fine, you know say normally nor be one picture Photographer dey take Grin, no need to think any other additional meaning to the thing so.

The truth remains that, we have to look beyond religion and tribe when casting votes in the forthcoming elections, especially the presidential seat. We gats judge from credibility and put people wey  go fit deliver for the next eight years, we dun too suffer for naija. The candidates wey the parties go choose as vice go matter a lot as well, because people eyes dey on am.

I really gbadu the awareness wey dey on top the matters now like this unto election, i dey read say INEC dey under pressure to postpone abi na extend the deadline for the PVC registration because the turn up of people wey wan register to vote dey very unexpected.

I sincerely hope say we fit sustain this energy till election reach, if possibly make one event happen wey go remind us the need the more to comot this old men from power, we need to be better, i hope we can get better.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The youths have been underestimated alot in Nigeria, who learn or get courage and confidence from the Endsars matters ?

Na the youths take them hand deh underestimate themselves. Small money like these weh the youths go see them go begin change mouth. See how#endsars case take be. Na the same youths them deh support Tinubu and Atiku now and many of them deh talk say Peter Obi no stand any chance for the election. But me and you sabi say na Obi be the best candidate. Youths want where them go give them money. And Obi no deh give shinshi. Na that one deh make them no support Peter Obi.

but my question be say enh, why him no shake him hand as others them dey do ? Make ornah shuck mouth for this matters. I mean why Boris Johnson no shake PO ? Abi make I no worry about am ?

Nigerians we too like superstitions and permutations o. I no see anything weh happen for the picture. No be everybody deh like shake hands.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
No be wetin to reason too much abeg I know say na just small thing carry PO go there, besides him na activist, him like to travel round to know the best for him next level, things wey him fit put normal for we country. I don listen to many of him speech na from there I know say that man no just dey travel for formality but na to study those pipo how them carry make am for life. While the rest pipo you see so just go there for conference meeting and after everything them go show their selves outside say them travel. Another thing you go know say PO na very humble man him no like show himself atall atall.
hero member
Activity: 966
Merit: 701

Not really, I just dey curious why the both of them no do as the other 9ja presido them and PM of UK Dem dey always do!
Na less! The Endsars matters shock them, this time we go get wetin we want! 💚🤍💚
I sure say na meeting them dey come out from na them tay take the photo Wetin important say Peter Obi no slack for the level way e dey. The other people you bring come out na all former Presidents, Buhari go there in his capacity as President, Goodluck na the same thing, OBJ na former President. Na only Peter Obi be the regular man there.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Emotional damage


Why you dey mock me nah ? I feel like crying  Cry Grin Grin Wink

[/quote]
No worry about am na nothing. You suppose know say na internet the pictures dey and no be all the pictures them go upload. No be their two dey one place dey smile together I no feel say bad belle dey between them. Peter Obi na successful business tycoon he don travel sidown with big men nor be because of Boris Johnson e go dey dance azonto. My question be say ehn if he no shake him hand e go affect our man credibility we need Boris endorsement to choose president?
[/quote]

Not really, I just dey curious why the both of them no do as the other 9ja presido them and PM of UK Dem dey always do!
Na less! The Endsars matters shock them, this time we go get wetin we want! 💚🤍💚
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Nigerian old leader's be like this leave, e no get small trace of Nutrients from him body, no matter how you water am,he no fit come back to green again, do wen we see stuff's like this wee just need to let the go totally, some people dey weh dey feel say Tinubu go win. E no go dey possible, rather something else go sup. Atiku also, the biggest slap go go too Wike face for underestimating an opponents and revealing too much of them plans. APC and PDP be like Phil Jones and Harry Maguire for Manchester United them need to go!
Emotional damage


but my question be say enh, why him no shake him hand as others them dey do ? Make ornah shuck mouth for this matters. I mean why Boris Johnson no shake PO ? Abi make I no worry about am ?

No worry about am na nothing. You suppose know say na internet the pictures dey and no be all the pictures them go upload. No be their two dey one place dey smile together I no feel say bad belle dey between them. Peter Obi na successful business tycoon he don travel sidown with big men nor be because of Boris Johnson e go dey dance azonto. My question be say ehn if he no shake him hand e go affect our man credibility we need Boris endorsement to choose president?
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigerian old leader's be like this leave, e no get small trace of Nutrients from him body, no matter how you water am,he no fit come back to green again, do wen we see stuff's like this wee just need to let the go totally, some people dey weh dey feel say Tinubu go win. E no go dey possible, rather something else go sup. Atiku also, the biggest slap go go too Wike face for underestimating an opponents and revealing too much of them plans. APC and PDP be like Phil Jones and Harry Maguire for Manchester United them need to go!



And also, Des pictures of the past presidents of Nigeria and the United Kingdom Prime Ministers for No ( 10 )ten downing street.
Obasenjo, Goodluck Ebele Jonathan and also our current PMB - Buhari all of them done go done come back successfully, since I see the picture I come dey get small hope, but my question be say enh, why him no shake him hand as others them dey do ? Make ornah shuck mouth for this matters. I mean why Boris Johnson no shake PO ? Abi make I no worry about am ?


hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The biggest problem that we face as a country be say many Nigerians they inure to suffering, to the extent say them no care again, if you dash them ordinary 1k naira, them they ready to sell their votes give who them know say na bad candidate, that is the situation wey we they face now, i hope say that kind thing no go they for 2023, you no suppose they suffer they smile, that kind thing no make sense.
Dat one dey and e nor follo at all. Imagin d kin post way persn put up d orda time as encouragement 4 pple to go dey run voters card reg, say item 7 com board, omo, na d way dem don make most person tink b dat nd many pple as na poor pple full d kontry pass don accent accent lik dat. To chop belleful 4 1day nd dey hungry 4 4yrs. Normal kontry man suppose knw say, en vote na en ryt nd to get voters card dey important bt, dat mentality don wash comot finish.

Anode tin 2 ask ourcef 4 we kontry b say, votes dey count at all? We fit get up te ourcef say na democracy we dey practice at all? Say na our vote put Bubu 4 d chair e don dey seatdon 4 over 8yrs nw? E hard to get hope 4 dis we kontry!

Na so e be oo.. vote dey count but na pipo inside there dey manipulate the vote to favor them or if them see say garri don pass water them go rig the election so that e go favor them. So any how e be we go try make our vote count for we country so that we go vote pesin wey we want to be there. Our PVC our powa, I remember that time we dey vote but after everything you go see say na pesin wey them want to be there go still sit down for the seat 😅
This one tire me oo!!
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
The biggest problem that we face as a country be say many Nigerians they inure to suffering, to the extent say them no care again, if you dash them ordinary 1k naira, them they ready to sell their votes give who them know say na bad candidate, that is the situation wey we they face now, i hope say that kind thing no go they for 2023, you no suppose they suffer they smile, that kind thing no make sense.

Walahi, wetin you yarn no be lie. Na one of the biggest fear wey I get so. As eveybodi dey shout "I am OBIdient" upandan nor be say when e reach election day now all those agents go bring a bag of rice and even 500 take collect their votes. My worry na for people wey dey inside those interior villages. Because na for there wey the real rigging dey happen. I don PO work for Bayelsa during their governorship election for 2019. I sabi wetin my eyes see dat day. Aside vote buying, dem fit use intimidation too take make people no vote their choice or no vote at all. 


Quote
Abeg my people, no allow anybody tell you say Nigeria no fit better, with good leadership we can be better. And if you have decided not to vote, carry for mind say you follow for the problem wey we get for this country.

John Maxwell talk say everything rise and fall on leadership. And that one na true talk. United Arab Emirates (UAE) wey no get anything reach were naija dey don go far because say dem get good leadership. I just believe say this time we go get am right.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The biggest problem that we face as a country be say many Nigerians they inure to suffering, to the extent say them no care again, if you dash them ordinary 1k naira, them they ready to sell their votes give who them know say na bad candidate, that is the situation wey we they face now, i hope say that kind thing no go they for 2023, you no suppose they suffer they smile, that kind thing no make sense.
Dat one dey and e nor follo at all. Imagin d kin post way persn put up d orda time as encouragement 4 pple to go dey run voters card reg, say item 7 com board, omo, na d way dem don make most person tink b dat nd many pple as na poor pple full d kontry pass don accent accent lik dat. To chop belleful 4 1day nd dey hungry 4 4yrs. Normal kontry man suppose knw say, en vote na en ryt nd to get voters card dey important bt, dat mentality don wash comot finish.

Anode tin 2 ask ourcef 4 we kontry b say, votes dey count at all? We fit get up te ourcef say na democracy we dey practice at all? Say na our vote put Bubu 4 d chair e don dey seatdon 4 over 8yrs nw? E hard to get hope 4 dis we kontry!
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
The biggest problem that we face as a country be say many Nigerians they inure to suffering, to the extent say them no care again, if you dash them ordinary 1k naira, them they ready to sell their votes give who them know say na bad candidate, that is the situation wey we they face now, i hope say that kind thing no go they for 2023, you no suppose they suffer they smile, that kind thing no make sense.

Another problem we get na im be say this aristocrats that are sitting on the wealth of this country so ehn, them don sell the idealogy to most of our population say Naija no fit better, that is why it is very normal for you to hear a Nigerian say "let us face reality", abeg which kind nonsense reality we wan face wey we never face for all this suffering wey they beat Nigerians, i hope say 2023, nothing like "make we face reality" go they, the only reality wey i wan they face now na to vote in the best candidate, make all this old men go rest, they have stolen enough funds from us already.

Abeg my people, no allow anybody tell you say Nigeria no fit better, with good leadership we can be better. And if you have decided not to vote, carry for mind say you follow for the problem wey we get for this country.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If you dey do anything, just espect the worst and always as you dey hope for the best. Frankly, Tinubu and Atiku no wan gree, but anything weh ornah dey do, make ornah no forget say, somebody hand dey responsible for the death and killings of lekki tole gate. Asides that one, if we no reset the nation, e go try before e go better, I hope the best to change the country gets into the position.
But I e no work wetin go be the plan B ? Make we dey set up plans ahead! I dey talk like say the full youth's for the 9ja dey see am.
Make we try vote ohh, so we no go be prey to these predators.

I don talk am be4 say imagine if all labour union vote, youths like that vote for peter obi, wetin remain wey no be sworing in . Peter Obi sense dey ground and the guy get better record regarding to finance wen him be Anambra chairmo. Make them no rig the election na that one be the major thing becos these two guys wey him dey contest with na killer riggers. Make we dey tell youths to go get PVC and vote for labour party. PDP and APC na same blood dey inside the two.

I swear my broda!
me sef don even reason am since say if Peter Obi win the Presidential election pipo wey dey seat fit go rig the election or them fit bring one story come say error dey somewhere before you know them go cancel am looking say the man pull pressure, and e come be like say all the youth come balance for Peter Obi side include our super stars them. I don even see song with some of them composed for Peter Obi like this PVC collection dey on a 100% demand. E get one Post i see for FB say catholic priest say No PVC no Church, omo that one come turtori my body wela wela. My pipo eyes don open like this and e really red for everybody.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The youths have been underestimated alot in Nigeria, who learn or get courage and confidence from the Endsars matters ? Normally last last everybody go kpia one day, so why we no take that risks ? I no dey talk say any body go die ohhh, but we can do it once more, today nah public holiday, prepare yourself ahead go run am tomorrow, e no go bad!

We need to push the old fool's aside despite their wealth, they have taken alot and it's high time, okay from Tinunbu's speech after winning the primaries election, are you okay with that ? Ask yourself, if them recruit your son dey feed am Cassava and Abgado you go like am ?

PDP? They're just laughable and a loud Vice president who knows nothing about Power, Atiku should kindly go manage the resources he has!
hero member
Activity: 952
Merit: 742
If you dey do anything, just espect the worst and always as you dey hope for the best. Frankly, Tinubu and Atiku no wan gree, but anything weh ornah dey do, make ornah no forget say, somebody hand dey responsible for the death and killings of lekki tole gate. Asides that one, if we no reset the nation, e go try before e go better, I hope the best to change the country gets into the position.
But I e no work wetin go be the plan B ? Make we dey set up plans ahead! I dey talk like say the full youth's for the 9ja dey see am.
Make we try vote ohh, so we no go be prey to these predators.
For now, all this talk talk wey others they talk no go bring solution to this matter, the only solution wey me don they see na how this our youths don ready for this country to change it for better. As you don talk am, both Tinubu and Atiku they go after their own bele ne, so make we try come out cast our votes, because this time that talk way una they talk say our votes no they count, I they sure say e go count this time because we youths don ready for them.
If any of us never Get PVC I they beg make we try get PVC because if we vote they will count it.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

Na the same man weh tell us say to tackle unemployment, say na to recruit 10million youths into the army and they will be eating agbado, rice, cassava.' Which kind mumu talk be that self.
My brother na 50 million youths the old man talk, the statement shock me shaa.

O, the thing shock you self. You see the figure weh the man put there. A whole 50 million youths for that matter. The same youths weh them deh kill up and down. The way Tinubu and his friends take handle that #endsars movement, no youths supposed even take about Tinubu at all. But e be like say we love people weh deh oppress us for this country.


Everybody weh deh support Tinubu, may Tinubu happen to all of una. Na only Peter Obi dey sane among the candidates.
This is not the right approach to the campaign.

My brother, na simple prayer point be that. No be curse na. Since people like suffering, make e happen only for them head. The Buhari own weh we deh no do them. Them see a man weh hand deh shake shake and they say na him go be their president, he could not even hold the flag when it was given to him, may the man rule their businesses and lives na. Na simple matter like that. How people go open their eyes and walk into pit? How? Love of money na him keep us like this for 9ja.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

To be honest both Atiku and Tinubu are educated, sane, with wealth of experience. But de matta be say no be dem Nigerians want this time around.

My broda e be like say you never sabi these two men. Them no want go there to work but to embezzle. Like for Atiku now, you sabi how many years wey him don dey run for election wey him don fail? And you sabi say Nigerian election na money so him don waste money waste enough money and na to pack am back him dey come for. To God these two people na wrong thing for Nigeria if them ever become president. You sabi say Atiku dey part of the hallibuton scander for America wey make them be no want see him leg for there? Tinubu no well as we all know and him too corrupt and him pack Lagos money. Although Nigerian politicians na ole but Peter Obi dey a little different from their ways. And which experience wey dem get wey Peter Obi no get as formal governor that has led his personal business well.
Jump to: