Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 125. (Read 1023785 times)

hero member
Activity: 2520
Merit: 624
@Zlantan. Guy you for try find somewhere open thread on top this success story for forum. I check your post and this story no open any thread. The story dey inspiring. Although na we naija the thing teach something more as this government dey us on top bitcoin ishe.

I deh tell you o. Zlantan for enter main forum open thread on top this case as na good one weh supposed even make all our oyibo peeps them follow shook mouth for the matter. E go bring you blessings too, you understand wetin I mean. Na correct happy ending be the gist. These our leaders them own don too much for 9ja. Wetin we do them self, weh them no go let us rest for corner or drink water and keep cup. But I for like know the damages weh EFCC pay the guy. There should be punishment for them.

Na so I think am oo because na good vibes. Me for want take am do story but I look am say e go be like say I dey shoot omo iya for leg , na im make me ask @Zlantan to blow the whistle louder for forum. I read where him say him dey cook something about am. My broda such info na as e dey hot oo since na court judgement, you for comot mouth now blow the thing loud, if e cool the vibes go dey die down.

As for this government na God go judge them. Buhari don play us like ball finish now him wan pass us to Tinubu or him cousin Atiku. I believe say those APC cabal go still work against Tiunbu for the general elections. Sometimes I dey wonder if our leaders get conscience.
If Tinubu Abi na TiBulu (what ever be him name), if that name by mistake win 2023 election, omo, na serously gbege this country enter ooo, the cry wey we dey cry for this buhari tenure go be small one ooooh, make no body better vote for that man, that man no get any thing to offer Nigeria, they don turn the presidential office of our country to turn by turn affair, TiBulu feel say na him turn to rule, that na why he won answer president TiBulu by all means, make no body vote for that man ooooh.


By the way, how una dey 😁😁
Runaway soldier don come back ooooh. 😄

O boy... The result of the selection no give me joy at all. If Tinubu rig himself enter mennn na bigger challenge oo because Tinubu no be Democrat oo, Tinubu dey corrupt like Atiku. Where we dey even go for this country. If Peter Obi no win hmmm I see more problem oo.
Tinubu  just carry money dey give governors make them dey step down and most of the governors and formal speaker (Demeji Bankole) na him boys. Tinubu wey dey comot people and dey put people wey him want for house of rep and senate. Na so him comot Sen. Mamora replace him with his wife Sen.Oluremi Tinubu. Chai wetin Tinubu want really do for there person wey for go rest. See how young men dey step down for old man. Demeji Bankole dey even bow down dey laugh with him teeth wey be like artificial. Chai this country don scatter the more.... Is a pity if Peter Obi no win. Well... I believe if the vote count, youth no go vote Tinubu at least not after the toll gate killing and men go campaign against him.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
As for this government na God go judge them. Buhari don play us like ball finish now him wan pass us to Tinubu or him cousin Atiku. I believe say those APC cabal go still work against Tiunbu for the general elections. Sometimes I dey wonder if our leaders get conscience.
If Tinubu Abi na TiBulu (what ever be him name), if that name by mistake win 2023 election, omo, na serously gbege this country enter ooo, the cry wey we dey cry for this buhari tenure go be small one ooooh, make no body better vote for that man, that man no get any thing to offer Nigeria, they don turn the presidential office of our country to turn by turn affair, TiBulu feel say na him turn to rule, that na why he won answer president TiBulu by all means, make no body vote for that man ooooh.


By the way, how una dey 😁😁
Runaway soldier don come back ooooh. 😄
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
@Zlantan. Guy you for try find somewhere open thread on top this success story for forum. I check your post and this story no open any thread. The story dey inspiring. Although na we naija the thing teach something more as this government dey us on top bitcoin ishe.

I deh tell you o. Zlantan for enter main forum open thread on top this case as na good one weh supposed even make all our oyibo peeps them follow shook mouth for the matter. E go bring you blessings too, you understand wetin I mean. Na correct happy ending be the gist. These our leaders them own don too much for 9ja. Wetin we do them self, weh them no go let us rest for corner or drink water and keep cup. But I for like know the damages weh EFCC pay the guy. There should be punishment for them.
legendary
Activity: 896
Merit: 1020
@Zlantan. Guy you for try find somewhere open thread on top this success story for forum. I check your post and this story no open any thread. The story dey inspiring. Although na we naija the thing teach something more as this government dey us on top bitcoin ishe.
I been want say where the link dey to go read am before I come see where you touch light am put. Nice info bro, I give u something dere.
Baba you too much. Thank you for the cool drink wey you bring from fridge come give me. As for the thread I go work on am and the work go soon come out. Once more I appreciate you baba.
Make we no mind this our government people, na personal pucket all of the thieves dey find. Asuu still dey dere oo but na to buy form and step down and collect money from sabi. Na business Dem dey do with 100 million purchase of form. You buy form with 100 million and step down with more millions, which kind business pass that one within 2/3 months. See ROI on investment sharp sharp. Chai naija, country where the rich dey hammer more and the poor dey suffer more. God help your people.

As for this government na God go judge them. Buhari don play us like ball finish now him wan pass us to Tinubu or him cousin Atiku. I believe say those APC cabal go still work against Tiunbu for the general elections. Sometimes I dey wonder if our leaders get conscience.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Wetin happen for Eagles Square last night deh shameful. See as our papa them begin worship Tinubu. E dey clear say Tinubu deh sick and not capable. Na we the citizens deh do ourselves.
It is clear that our problems are far from being solved, after listening to all the aspirants speak yesterday, to thinl that majority of the delegates elected Tinubu to represent APC in the 2023 elections is appalling, not that the margin with which he won was a tight one, it was a landslide victory. It is indeed shameful and Nigeria never ceases to disgrace herself both locally and internationally. Having said that, it is now up to the electorate, for me Peter Obi remains the most credible candidate for next year's election, but my vote is just one out of millions, so i indeed hope millions other would share my ideas too, and elect this man into power for a better Nigeria to come.
fact the court say make them give am everything wey dem collect from am.
Na correct guy you be, it is good as you bring this matter come make we carry eyes see am here, na wetin we they see for Naija be that, police and EFCC go they act without evidence, once them see say life soft for you, them go they vex, they go like collect money from you find one crime put for your head; Zlantann body sweet me well well as this guy take win this case. No matter wetin EFCC wan think, that one concern them, my prayer be say life go soft for every Nigerian user wey they for this forum, na just matter of time we go all relax for one spot like this ehn, they yarn our success story on top better moet and champagne.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
@Zlantan. Guy you for try find somewhere open thread on top this success story for forum. I check your post and this story no open any thread. The story dey inspiring. Although na we naija the thing teach something more as this government dey us on top bitcoin ishe.
I been want say where the link dey to go read am before I come see where you touch light am put. Nice info bro, I give u something dere.

Make we no mind this our government people, na personal pucket all of the thieves dey find. Asuu still dey dere oo but na to buy form and step down and collect money from sabi. Na business Dem dey do with 100 million purchase of form. You buy form with 100 million and step down with more millions, which kind business pass that one within 2/3 months. See ROI on investment sharp sharp. Chai naija, country where the rich dey hammer more and the poor dey suffer more. God help your people.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Honestly, I get goosebumps as I sit down dey read the matters weh my brother @Zlantan cap. E sweet me, honestly this nah so every woman suppose dey. Thanks for sharing, I tap into the story one day too, I go get person pikin weh go fight for me without looking at the oods. Thanks n I like as you take cap d matters for d unit. U be Man! Be like ANH your first time seff to write for Des our board ohhh.
You're welcome!
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.

Make ona no vex say I want move out of politics. I know say Naija dey boil currently with political wahala and killi killi everywhere. But at least we need to smile small. I just get info say that naija BTC trader Linus Williams aka BLord wey been win EFCC for court just buy one clean motor for him lawyer wife to celebrate and appreciate her. The guy say the woman stand for him back and defend am wela althrough the case with EFCC. Infact BLord say na the woman help am win the case. Make we no forget say EFCC been catch the guy say the guy get him money from wuru wuru. Them seize the guy man cars and properties because them no sabi anything about crypto. Na so the guy carry them go court and him come win EFCC. In fact the court say make them give am everything wey dem collect from am.


My brother @Zlantann say naija dey boil and Apc primary election dey ground no stop us to hear this kind good news, I dey happy say finally the guy win the case and I dey happier because em open up to the court and all Nigerians say na cryptocurrency be the source of em money,  I pray say make the guy no give up make em make sure say em collect back all em properties wey Efcc been force am collect. At least more Nigerians go see say them go enjoy life and also make good money if them invest in Cryptocurrency.
legendary
Activity: 896
Merit: 1020

link

Abeg make ona no vex say I want move out of politics and other important things we dey happen for Naija. I know say Naija dey boil currently with political wahala and killi killi everywhere. But at least we need to smile small. I just get info say that naija BTC trader Linus Williams aka BLord wey been win EFCC for court just buy one clean motor for him lawyer wife to celebrate and appreciate her. The guy say the woman stand for him back and defend am wela althrough the case with EFCC. Infact BLord say na the woman help am win the case. Make we no forget say EFCC been catch the guy say the guy get him money from wuru wuru. Them seize the guy man cars and properties because them no sabi anything about crypto. Na so the guy carry them go court and him come win EFCC. In fact the court say make them give am everything wey dem collect from am.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
What really baffles me is that non of the aspirant is talking about fixing the the power sector of this country

Mai broda 4get about dis power of a tin 4 now bcos wat is at hand is more dan dat , we ar talking abt d unrest panic ongoing dat de people are playing game wt human lives, i heard a circular wey bin dey go viral say make evry bodi hold dey 4 him house on june 12 bcos of their plan to launch anoda attack, wen i chek d calendar it fell on Sunday and man gas go 2 church, we need prayers but we must all try evry means 2 dey avoid unnecessary travelings and late night movement, y all dis in d name of a political power at human cost of lives, diaris judgement day o.
member
Activity: 104
Merit: 10
Steady grinding
What really baffles me is that non of the aspirant is talking about fixing the the power sector of this country.... If we want to go religious even before creation the first thing was light, Nigeria is in so much darkness that it's only light that can fix it, we will continue going in circles patching the wounds of economy, agriculture,health, security, education etc but the root and foundation in which all this can thrive is if we can have constant power supply if any president fixes this other sectors will begin to automatically align smoothly.... I just de pray make God give the next president wisdom to sort dis out or else notin go work na only temporary solution we go de do....
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The biggest problem is that the president himself is not competent at anything, other than his skin care routine and account balance ofcourse

Na serious concern for him skin care routine o. I take style reason you for that one and e burst my head. We deh serious problem for this country. The way this thing deh go, na any of the Rs go fit solve our numerous problems o. Either Referendum or Revolution. Wetin happen for Eagles Square last night deh shameful. See as our papa them begin worship Tinubu. E dey clear say Tinubu deh sick and not capable. Na we the citizens deh do ourselves.
jr. member
Activity: 38
Merit: 16
I nor know weda this government won pursue us comot for this country. The way efcc dey worry small boys for street dey fear me to be young and good looking na big crime. Them enter one house close to where I deh stay na so them carry everybody for the compound say them dey assist yahoo boys dey hide for the compound. No investigation, na so them pack property go
Naija na country of "Act first, then think later" so nor too de surprised to see dah kind thing oo cause na so e de be for everywhere
Just try dress well make ur hair de anyhow na so so pull up and harassment you go de see so. Sayy u be yahoo boy abi na ritualist de reign now
member
Activity: 1540
Merit: 68
And all these PVC matter u de talk so na scam jhare
Las las na north and their Fulani cows dem votes na em go count oo
But muu still sha get our PVC de follow pray make God sha give us good government.

When people no vote, na when e dey easier for person to rig the election. No matter as situation bad reach, make all man talk in mind at the polls by casting their vote for candidate of their choice, after this, you fit come complain say this one happen or another one. But if you no do this bear minimum, you no suppose dey put mouth for inside political matter.

God no fit come solve all our issues.

100 % true, and recent experience happned in osogbo when the margin was mere 10000 votes, in 6 hours(midnight), someone losing with over 10,000 votes miraculously won the election with over 40000 votes. all that happened was simple, little margin , declare inconclusive, prevent voters the new vote day. Rig the numbers, declare your winner.

In contrast to this, the last election in oyo, the incumbent party was already loosing with over 300,000 votes at noon, except cases like IMO where presidency rigged, you cannot rig your way through such elections



Today na today. We go see how the movement go be for Eagle Square and those weh go vex tear shirt and cry join am on top. So, APC later agree to zone the ticket to the south after them strong head say na north e go deh. I wonder wetin OUK go talk again with his support for Lawan because him be talk say na the reason why him dey support rubber stamp Lawan. Another thing weh I want be say I go happy make them play Tinubu out tonight. If that man win the ticket tonight na him be say money and corruption do dabaru this country go finish.

I think they tested waters by sending Adamu to declare a consensus, then backed down when that did not fail. The biggest problem is that the president himself is not competent at anything, other than his skin care routine and account balance ofcourse
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
To look or smell good now don become serious problem for 9ja o. But EFCC go see those weh deh steal billions, carry eye look another place like say them no know. The youths deh get harassed every day from the hands of police and solders and institutions like the EFCC. This country deh big problem like this o but we never find out. That #endsars demonstration go small from wetin i dey sense weh fit happen before election time.

See where the problem from, this country to bad to the extend if you dey do well, dem believe say your hand dirty. Either na corruption or yahoo and especially if you be young fellow then obviously e get be yahoo. People no believe say legit ways to hustle dey online and you no go blame them because all those wey dey show demselves for area and dem dey do well na street dem dey. For my area self, I dey fear 2-4, me I be person wey dey like bot movement and people wey no understand been dey think say na my cars. I dey get plenty eye for my mata I gas dey trek some distance to my house to avoid people seeing they different car wey dey drop me and secondly I dey hardly comot like normal worker so dem go dun believe say na street I dey.

You get to understand say authority anywhere in the world dey always go after the easy target. You think say any choppings they come out for all those politics nata, na yahoo boys EFCC dey use cash out their own that's why them go continue dey disturb them. Anyway any update for the APC primaries?.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I nor know weda this government won pursue us comot for this country. The way efcc dey worry small boys for street dey fear me to be young and good looking na big crime.

To look or smell good now don become serious problem for 9ja o. But EFCC go see those weh deh steal billions, carry eye look another place like say them no know. The youths deh get harassed every day from the hands of police and solders and institutions like the EFCC. This country deh big problem like this o but we never find out. That #endsars demonstration go small from wetin i dey sense weh fit happen before election time.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
I nor know weda this government won pursue us comot for this country. The way efcc dey worry small boys for street dey fear me to be young and good looking na big crime. Them enter one house close to where I deh stay na so them carry everybody for the compound say them dey assist yahoo boys dey hide for the compound. No investigation, na so them pack property go
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

Today na today. We go see how the movement go be for Eagle Square and those weh go vex tear shirt and cry join am on top. So, APC later agree to zone the ticket to the south after them strong head say na north e go deh. I wonder wetin OUK go talk again with his support for Lawan because him be talk say na the reason why him dey support rubber stamp Lawan. Another thing weh I want be say I go happy make them play Tinubu out tonight. If that man win the ticket tonight na him be say money and corruption do dabaru this country go finish.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
And all these PVC matter u de talk so na scam jhare
Las las na north and their Fulani cows dem votes na em go count oo
But muu still sha get our PVC de follow pray make God sha give us good government.

When people no vote, na when e dey easier for person to rig the election. No matter as situation bad reach, make all man talk in mind at the polls by casting their vote for candidate of their choice, after this, you fit come complain say this one happen or another one. But if you no do this bear minimum, you no suppose dey put mouth for inside political matter.

God no fit come solve all our issues.

Like!! You u understand ? God no fit come solve our issues! Omohhhhh What's it Gon be like them wen PO no win ?
Like I no dey say him no go win ohhh, but we gats get plan B and a back up plan just Incase it doesn't work! Nigeria honestly needs change in government and scrapping of any old timers in any political seat, I think it okay for Dem, what's up with the JESUS JESUS tweet and post now ? Omohhhhh be like nah only 9ja wan go rapture ohhh. Make person give me update.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
And all these PVC matter u de talk so na scam jhare
Las las na north and their Fulani cows dem votes na em go count oo
But muu still sha get our PVC de follow pray make God sha give us good government.

When people no vote, na when e dey easier for person to rig the election. No matter as situation bad reach, make all man talk in mind at the polls by casting their vote for candidate of their choice, after this, you fit come complain say this one happen or another one. But if you no do this bear minimum, you no suppose dey put mouth for inside political matter.

God no fit come solve all our issues.
true talk boss we have folded how hands enough and we done believe say our vote no they count but we need to standup make we get our pvc ready because we done tire, lets prove to this guys say we get right to select our own opponent no be to they complain but to get our pvc and vote change must  occur naija forever bro.
Jump to: