Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 174. (Read 1027165 times)

legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I wonder when she start school actually be because, e no look possible or doable. How can  person in just few years go archive watib on a normal, e ho take you at least 22years to archive normally. If we take eye look am or reason am on a normal level, e go way am gor real. E get why them get age for specific thing for the life way we dey now. Big difference exists between book sense and wisdom. When e come to book, you fit learn am and sabi am anywhere but when e come to being wise matta, that one na on another level. Na watin experience dey teach and person way don dey seatdon for oldmen floor and all count inside the experience. Omo, she go dey limited for that side.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Abeg my people make una no vex say I want bring mata outside dey tin we bin dey talk before, I see something we're make me come dey reason some kind things. This mata na about 16 year old 9ja girl were don barge Ph.D. abroad ooooh.

Get full gist 4 here: https://www.legit.ng/1258980-celebrating-british-nigerian-genius-esther-okade-bags-phd-14-plans-a-bank-by-15.html
As many people dey congratulate here others come dey talk say the gal achievement good but say e fit make here jump some kind childhood sense were she sopus get because of her age, and the matter come pick my interest oooo. How una see ammm I know say na good tin but if u look amm with corner eye you go see say oil dey for waiten them talk say the rush fit 2ruly make her miss some kind child training were she suppose to get.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I no see any effect of the Bitcoin ban 4 9ja

The effect deh o. Maybe you deh talk like this because e no directly affect you. You know how many bank accounts weh CBN freeze, abi you think say na fake news from those weh complained? Another thing be say the fear of it make many people no gree rush enter crypto. If no be because of that ban many more people for don enter crypto by now.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
I no see any effect of the Bitcoin ban 4 9ja
The effect dey o. Make I yarn you, as your eyes open so for crypto things and other online things, no be so everybody eyes open. You go imagine say some young boys for my side go bring phone give me say make I open facebook account for them. Person wey no fit open facebook account, na crypto wey dem ban him go fit do?
Crypto himself if you no put ban deh worry to learn,  talkless of when dem put ban. The ban just slow the speed dem for use accept crypto for Naija.

The only thing be say some small liver people just dey cast the btc thing more becos say govt com put eyes on top am. Dem also dey cast am say you see the price don fall and som wey invest dey cry but na dem no. If you know you know. The tin wey I believ be say if you no like something you no go talk gud abt am. Ban or no ban, pple still dey advertise am 4 radio & govt neva go afta dem.


@ Ripe_berry , we hala you. But u no gas say tins with mouth open like that (I believ you fit get where I dey go). Wall dey hear word. Na wayo wayo u go dey go. Make I open dor 4 u make e for no loss.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The tin be say me no see any thing ooooh because even with the so called cbn nonsense e no get any tin to stop for cryptocurrency 4 9ja and even the cbn governor na confused man as him say 9ja get digital naira were no dey run on blockchain so the man confuse die. I know say even him get Bitcoin for wallet but him just dey try do the Central.

For dis mata e get positive and negative. Many of us no go understand the negative because e no reach our side but u see does people wey dey top and dey pick interest for some kind job, e affect them like many Nigerian lose ambassador's of project dem been dey support because now dem no fit dey do events again like dat. Exchange begin rethink Nigerian market. Some yapa like Patricia and I believe others wey supposed enta Nigeria rethink am.

When you come look am with your other eye d thing raise more awareness oh as people self wey no know wetin crypto be begin dey reason am. Everybody now come dey do crypto. Immediately Market crash or raise you go see update for WhatsApp status.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
I no see any effect of the Bitcoin ban 4 9ja
The effect dey o. Make I yarn you, as your eyes open so for crypto things and other online things, no be so everybody eyes open. You go imagine say some young boys for my side go bring phone give me say make I open facebook account for them. Person wey no fit open facebook account, na crypto wey dem ban him go fit do?
Crypto himself if you no put ban deh worry to learn,  talkless of when dem put ban. The ban just slow the speed dem for use accept crypto for Naija.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Quote

The most popular and unpopular CBN policies of 2021 

A circular document dated 5th February 2021 and distributed to regulated financial firms, the apex bank of Africa’s largest economy warned and reminded local financial institutions against having any transactions in crypto or facilitating payments for crypto exchanges.

One year dun pass since our government through CBN run this matter, i wan ask something, how una feel say this matter dun affect crypto for Nigeria for the past one year? Has our community been affected by this policy. Any possibility dey say our government go fit lock up this matter this year onto say election go soon reach and dem go want make body sweet us?
The tin be say me no see any thing ooooh because even with the so called cbn nonsense e no get any tin to stop for cryptocurrency 4 9ja and even the cbn governor na confused man as him say 9ja get digital naira were no dey run on blockchain so the man confuse die. I know say even him get Bitcoin for wallet but him just dey try do the central bank tin and the national financial institutions dey him hand.
I no see any effect of the Bitcoin ban 4 9ja
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
One year dun pass since our government through CBN run this matter, i wan ask something, how una feel say this matter dun affect crypto for Nigeria for the past one year? Has our community been affected by this policy. Any possibility dey say our government go fit lock up this matter this year onto say election go soon reach and dem go want make body sweet us?
The ban get pros and cons

That time, I remember my brother that tell me say e go make sense to convert all my bitcoin to naira, he dey also fear due to Chinese FUD that dey around that time, na me come dey tell him say all na FUD say nothing go happen, tell ham say no be the first time China dey ban bitcoin, but bitcoin price still increased.

Because of what CBN president do, many Nigerians come dey panic. I believe this go let some Nigerians to back off and not invest in bitcoin and other crypto asset.

But the ban favoured us, no tax paid and other government issue related to tax, it is p2p and quite going excellently. Also crypto adoption for Naija still increased but I just dey think probably the adoption could have been more if CBN no ban crypto.

This no be indication of not to pay tax, we should be good citizens

But as it is like this, are they really monitoring people account, because people still they do cryptocurrency transactions and them accounts they active, abbi na me no know the exact ban wey they?
If you no get skeleton for your cupboard, you no need to fear, crypto transaction dey go on smooth, but we need to dey careful of any form of scam because if we are scammed, government no go intervene most likely.
member
Activity: 742
Merit: 30
One year dun pass since our government through CBN run this matter, i wan ask something, how una feel say this matter dun affect crypto for Nigeria for the past one year? Has our community been affected by this policy. Any possibility dey say our government go fit lock up this matter this year onto say election go soon reach and dem go want make body sweet us?

Na true talk o. So like play like play e doh reach one year weh CBN and that Godwin Emefiele ban Nigerians from trading cryptocurrency. Na anniversary weh e supposed be sef. I no go lie, that ban matter really discourage many people from doing cryptos as nobody want to do anything weh go make CBN ban them accounts.
This our country matter self they somehow, like seriously that ban wey CBN been put provide fear for many people body, even people wey been get plans to invest in crypto they fear make CBN no reason their accounts. But as it is like this, are they really monitoring people account, because people still they do cryptocurrency transactions and them accounts they active, abbi na me no know the exact ban wey they? 🤔
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
One year dun pass since our government through CBN run this matter, i wan ask something, how una feel say this matter dun affect crypto for Nigeria for the past one year? Has our community been affected by this policy. Any possibility dey say our government go fit lock up this matter this year onto say election go soon reach and dem go want make body sweet us?

Na true talk o. So like play like play e doh reach one year weh CBN and that Godwin Emefiele ban Nigerians from trading cryptocurrency. Na anniversary weh e supposed be sef. I no go lie, that ban matter really discourage many people from doing cryptos as nobody want to do anything weh go make CBN ban them accounts.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Quote

The most popular and unpopular CBN policies of 2021 

A circular document dated 5th February 2021 and distributed to regulated financial firms, the apex bank of Africa’s largest economy warned and reminded local financial institutions against having any transactions in crypto or facilitating payments for crypto exchanges.

One year dun pass since our government through CBN run this matter, i wan ask something, how una feel say this matter dun affect crypto for Nigeria for the past one year? Has our community been affected by this policy. Any possibility dey say our government go fit lock up this matter this year onto say election go soon reach and dem go want make body sweet us?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@ Ripe_berry

Hope you don read the forum rules? Rule 32: Posting multiple posts in a row (excluding bumps and reserved posts by the thread starter) is not allowed.

Welcome to our local thread, hope to dey see you dey active and making quality posts. Read the rules and understand ham to avoid ban.
member
Activity: 61
Merit: 10
User name: Ripe_berry
Gender: Female
Residence: Port Harcourt
Skill: Research Analyst

I be newbie ooooo, Me I observe say una dey do well and dey connected. E go good make we kip am up. As e   be say them say, if ppl  come together urinate e go foàm wella. I  commot cap give una. My brothers abeg me I want grow, make una carry me alongooo. Do merit giveaway reach my domot, I go dey ogbonge grateful.
Una too much
More grace
Ahead aheàd we go dey go



Me na Nigerian woman and I go want to know ma fellow women for the forum make we fit encourage ourselves na my husband wan discourage 4from crypto but thank God now him dey understand small, God go bless that my staff was put in this forum. I do learn many things 4rim my follow Nigeria people.

Welcome to naija board mama, na where our people de yan and share matter be this.
As e be so ehhnn, na bro full here from the way them de talk but we get one mama SatoPrincess for here, she self like crypto and meet up. I de sure say una go vibe well.
Once again, welcoming me to naija unofficial board.

Welcome mama, tuwale 4 u. I don happy as I see another gender like me for here. e come boost my moral small. But I still  neew sha. Me I like crypo n wan pesin wey go dey ginja me dey increase my medula for d koko. I dey ready to learn.
Wélcome ma  thanks to Baba I sight u
member
Activity: 742
Merit: 30
The thing there be say many people wey join memecoin, them been join am because them missed out on dogecoin or shibainu, na them be the type of crypto-currency hodlers wey no Sabi research, I no give memecoins any credits I believe say many of them they get utilities wey them no fit manage like P2E, Play to earn gaming platform and even Nft collection, bottom line them no look real again.
I believe u 100%, because some people self they follow hype wey people they give must if those meme coins, in order not to miss out the opportunity as they way they feel they miss during Dogecoin and Shibainu time. After they don jump buy coin, if the project no come go well they will be complain instead of doing a better research before investing.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Me na Nigerian woman and I go want to know ma fellow women for the forum make we fit encourage ourselves na my husband wan discourage 4from crypto but thank God now him dey understand small, God go bless that my staff was put in this forum. I do learn many things 4rim my follow Nigeria people.

Welcome to naija board mama, na where our people de yan and share matter be this.
As e be so ehhnn, na bro full here from the way them de talk but we get one mama SatoPrincess for here, she self like crypto and meet up. I de sure say una go vibe well.
Once again, welcoming me to naija unofficial board.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The thing there be say many people wey join memecoin, them been join am because them missed out on dogecoin or shibainu, na them be the type of crypto-currency hodlers wey no Sabi research
You mean say no 10x or 100x memcoin go ever dey again, you mean say people wey invest (gamble) for doge and Shiba Inu no go research for another available memecoin wey they see good and invest just little amount again?

many people come to dey rush Memecoin the thing is to say most of dem now dey cry  because money don goes because of overhyping.
E go dey painful if the coin or token be it meme or no memcoin no come reach all-time-high again or the price those people invested in the coin no dey attainable again.

No be only memcoin but many other altcoins. Other altcoin dey do as bad as memcoin also as the market no good until recently.
hero member
Activity: 1008
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The thing there be say many people wey join memecoin, them been join am because them missed out on dogecoin or shibainu, na them be the type of crypto-currency hodlers wey no Sabi research, I no give memecoins any credits I believe say many of them they get utilities wey them no fit manage like P2E, Play to earn gaming platform and even Nft collection, bottom line them no look real again.
Na true talk be that after dogecoin grows to $0.40 above and Shiba inu also follow with help from Tesla owner tweets, many people come to dey rush Memecoin the thing is to say most of dem now dey cry 😿 because money don goes because of overhyping.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
The thing there be say many people wey join memecoin, them been join am because them missed out on dogecoin or shibainu, na them be the type of crypto-currency hodlers wey no Sabi research, I no give memecoins any credits I believe say many of them they get utilities wey them no fit manage like P2E, Play to earn gaming platform and even Nft collection, bottom line them no look real again.
hero member
Activity: 1008
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Me na Nigerian woman and I go want to know ma fellow women for the forum make we fit encourage ourselves na my husband wan discourage 4from crypto but thank God now him dey understand small, God go bless that my staff was put in this forum. I do learn many things 4rim my follow Nigeria people.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
NEW TOPIC: Your stand on Wakanda Inu. Ok normally ehh I no dey speak about memecoin since we all know say normally na joke but recently e come belike say memecoin dey slowly take their place for the market. Like as we get Bitcoin, smart contract, Defi, NFT, metaverse etc all get their time wey dem dey raise na so we come get memecoin too. We dun see how doge coin dun blow and shiba as well wetin you think go happened to Wakanda Inu.
My guy, we get exceptional memecoins wey get usecases and na those ones wey I dey like look into. I nor even know sey Dogecoin na better coin until I take am pay for something a few years ago and the speed of execution be like wetin we dey experience with BSC today. Dat was at the time Bitcoin get dat delayed transaction ish because of congestion for mempool oh.  About Shiba, na coin wey many exchanges dey drag to list and there must be something wey dem see dey rush to list am wey laymen like us neva know. Na speed I take buy Shiba d first time wey I buy am and as e enter dat ATH last year I sold off for massive gains. In fact, I even sold around dat 0.00006 level b4 e reach ATH. I bought in back when it dropped. Now, I just dey stake am for Binance to play safe, hoping it will cancel out two more zeroes. As for Wakanda, fear nor let me touch dat one as I see so many Naija peeps dey promote am from d beginning.
Jump to: