Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 175. (Read 1027165 times)

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
To be honest, recently I don see many meme coins out right now, it's starting to be filled with developers wey want quick money
What were the early developer's dey filled with then? All na quick money be the ambition.
I dey tell u the get rich quick tin don dey since, check out ICO days, many millions of dollars waka for scam ico then IEO and today na Defi and meme coins turn. Legit one dey oooo but to see amm na wahala. I Remember for 2019 when one of my guy carry plenty money put for one project like that I been dey tell ammm make him do due diligence oooo but 4 we're the guy wan make big money na so my guy take lose all of his money too. The tin be say if you jump on anything sake of say you want make plenty money na the first step for losing plenty money be that.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
To be honest, recently I don see many memecoins out right now, it's starting to be filled with developers wey want quick money
What were the early developers dey filled with then? All na quick money be the ambition. When they see how bitcoin be, they started creating altcoins.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
For the matter no be only memecoins dey give 10x, other coins dey give as well but na memecoin own dem dey over hype because the average investors wey no sabi research na there dem dey based. And memecoin na hype dey give am e utility. While I bring this topic come na for we to reason the discussion, I see Shiba Inu developing an exchange wey dem dun launch and other things wey dey for pipeline.

This thing come make me look Wakanda Inu side I come dey here different rumors of development. Well person no suppose blindly invest for wetin dem no know but make we understand say memecoin dey quickly become a part of the ecosystem. Many projects now dey come like meme even though them go later build some utility.

You understand how e dey be for the industry, when one trend come out others go use that same trend just so they feel among. Make we dey seen sha if the memes go still be hot cake by 2024/25 well another bull cycle supposed start.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
NEW TOPIC: Your stand on Wakanda Inu. Ok normally ehh I no dey speak about memecoin since we all know say normally na joke but recently e come belike say memecoin dey slowly take their place for the market. Like as we get Bitcoin, smart contract, Defi, NFT, metaverse etc all get their time wey dem dey raise na so we come get memecoin too. We dun see how doge coin dun blow and shiba as well wetin you think go happened to Wakanda Inu.

As of looking at the project I noticed na the first African/Nigerian peojecyti even go far like for trading volume and all that and all exchange for Nigeria dun list am although e never enta tio exchange for the world. Wetin you think about am I dey hear some developing dey rumor around about e own metaverse, NFT marketplace etc.

This no be investment advice, I just wan make we see wetin dey community think, you think this coin go fit survive this bear market give some profit abi you think say e go died like most of the other memecoin them.
Because the majority of the population for this place na bitcoin fanatics them no dey give alt space to breathe even when the project go bring better bread we dey shut am down. Them tag alt section as shit post zone but for back some go dey buy low key. For wetin CryptopreneurBrainboss talk, I don get discussion with wakanda inu investors I get friends wey buy am still dey hold am. To say the truth I nor buy cos I been dey fear...na shiba inu I buy and I make better money for inside. These meme coins way people dey call useless na them dey do x10 gains. Yes I agree say the coins nor get use case but them dey do well regardless of the technology value.
The tin is say make you just know when to pull out of meme coin because plenty of them fit give 10x profits but if you no take the time that profits with meltdown like ice block for inside got water. U know the matter na.
Best tin na to cash in 4 the right time but make you use your head make taste for plenty money no carry you away, e don happen to me before we're I dey hope say mem coin were I dey hold go reach $1 price so I no sell when the coun reaches $0.47 hoping say e go keep rising, but baba echok me when the coin drop like pile of cakes.
Na to use your head be crypto matazzzzzz.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

To be honest, recently I don see many memecoins out right now, it's starting to be filled with developers wey want quick money, I also see one wey atleast don Tay e m na Alien Inu, this one get serious developer but I never too sure of am, my fear with memecoins be say almost all wan get the attention of Elon musk or just trying to mimick dogecoin by formulating a strategy from it, I believe memecoins can be a good investment if the project they serious and I no think say wakanda Inu dey serious.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC: Your stand on Wakanda Inu. Ok normally ehh I no dey speak about memecoin since we all know say normally na joke but recently e come belike say memecoin dey slowly take their place for the market. Like as we get Bitcoin, smart contract, Defi, NFT, metaverse etc all get their time wey dem dey raise na so we come get memecoin too. We dun see how doge coin dun blow and shiba as well wetin you think go happened to Wakanda Inu.

As of looking at the project I noticed na the first African/Nigerian peojecyti even go far like for trading volume and all that and all exchange for Nigeria dun list am although e never enta tio exchange for the world. Wetin you think about am I dey hear some developing dey rumor around about e own metaverse, NFT marketplace etc.

This no be investment advice, I just wan make we see wetin dey community think, you think this coin go fit survive this bear market give some profit abi you think say e go died like most of the other memecoin them.
I don come across this memecoin several times for coinmarketcap, though initially, the name catch my interest and I been say I go research am, but I later forget, and since then, I no bother to look e side again.
Personally, I no dey into memecoins, since all this while wey many dey testify of how memecoins change their lives, I never for ones pick any interest to invest in memecoins.
And as I dey type, I don take style style Waka enter coinmarketcap, I just do small research and my opinion for this matter be say.... I no think this coin go even survive this bear market, to me, wakanda coin no look like wetin go really make headlines like dogecoin and Shiba inu, but anyways, I go add am to my watchlist make I first monitor the movement small first before I go fully decide.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC: Your stand on Wakanda Inu. Ok normally ehh I no dey speak about memecoin since we all know say normally na joke but recently e come belike say memecoin dey slowly take their place for the market.
I no think so, meme coin like doge dey among good altcoins since it was created, Shiba Inu not long when it was created. Wakanda Inu come take him name similar to Shiba, the coin no dey do well. I no know much about the coin, but make we dey careful not to fall into the trap of shitcoin. See Tatcoin.

Because the majority of the population for this place na bitcoin fanatics them no dey give alt space to breathe even when the project go bring better bread we dey shut am down.
Shitcoins plenty na one of the reasons, altcoins dey centralized unlike bitcoin, the most decentralized among them all. This na bitcoin forum na another reason. E no dey bad to buy altcoin, take the profit if your buy gambled correctly, then sell ham for bitcoin. Altcoin dey riskier na another reason.

Them tag alt section as shit post zone but for back some go dey buy low key.
Nobody tag altcoin boards as shit post zone, Some bitcoin enthusiasts no dey no interested. If I remember what I read correctly, when CryptopreneurBrainboss applied for merit source, altcoin board dey among him ambition, then why Admin gave ham merit source at the time. I think na just the norm of this forum but altcoin board still no dey segregated, but merit for there dey small. Waiting you wan comment about gambling board too.

These meme coins way people dey call useless na them dey do x10 gains.
March 2019, Bitcoin price dey $3800. For 2021, Bitcoin price reach $69000.

I understood you, even doge rose 300x, Zilliga, Shiba Inu, Solana, Terra Luna and some other coins rise wella, but make we no forget some coins like EOS wey no rise. EOS even dey better, some coins became dead and some projects na scam.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
NEW TOPIC: Your stand on Wakanda Inu. Ok normally ehh I no dey speak about memecoin since we all know say normally na joke but recently e come belike say memecoin dey slowly take their place for the market. Like as we get Bitcoin, smart contract, Defi, NFT, metaverse etc all get their time wey dem dey raise na so we come get memecoin too. We dun see how doge coin dun blow and shiba as well wetin you think go happened to Wakanda Inu.

As of looking at the project I noticed na the first African/Nigerian peojecyti even go far like for trading volume and all that and all exchange for Nigeria dun list am although e never enta tio exchange for the world. Wetin you think about am I dey hear some developing dey rumor around about e own metaverse, NFT marketplace etc.

This no be investment advice, I just wan make we see wetin dey community think, you think this coin go fit survive this bear market give some profit abi you think say e go died like most of the other memecoin them.
Because the majority of the population for this place na bitcoin fanatics them no dey give alt space to breathe even when the project go bring better bread we dey shut am down. Them tag alt section as shit post zone but for back some go dey buy low key. For wetin CryptopreneurBrainboss talk, I don get discussion with wakanda inu investors I get friends wey buy am still dey hold am. To say the truth I nor buy cos I been dey fear...na shiba inu I buy and I make better money for inside. These meme coins way people dey call useless na them dey do x10 gains. Yes I agree say the coins nor get use case but them dey do well regardless of the technology value.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NEW TOPIC: Your stand on Wakanda Inu. Ok normally ehh I no dey speak about memecoin since we all know say normally na joke but recently e come belike say memecoin dey slowly take their place for the market. Like as we get Bitcoin, smart contract, Defi, NFT, metaverse etc all get their time wey dem dey raise na so we come get memecoin too. We dun see how doge coin dun blow and shiba as well wetin you think go happened to Wakanda Inu.

As of looking at the project I noticed na the first African/Nigerian peojecyti even go far like for trading volume and all that and all exchange for Nigeria dun list am although e never enta tio exchange for the world. Wetin you think about am I dey hear some developing dey rumor around about e own metaverse, NFT marketplace etc.

This no be investment advice, I just wan make we see wetin dey community think, you think this coin go fit survive this bear market give some profit abi you think say e go died like most of the other memecoin them.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na high rate dey kill many people. When legit traders give good rate them go say e too low them wan sell for 600 per dollar. Sometimes he dey make me laugh na greed na carry them go jam fraudsters. How you expect to make so much gain when others dey sell a fixed price. Use your instincts
If you dey compare the parallel exchange rate to vendors' rates, difference dey there, like $10 to $30 difference if e no dey more, but e no bad to sacrifice the difference for privacy reasons. I get you right, some people na scammers and put high price, victims like to dey fall easily for favourable prices.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
If na off exchange Marchant, make sure you know who u dey trade with, check well out of your friends you must get someone wey dey into this exchange business or sabi legit person. Patronize them make u no go dey cry later, again forget high rate na wetin dey make person fall victim pass for this street.

Wetin this rush for high rate go cause no go be small thing o. Make I even ask, all this our people weh deh talk of their friends weh fall into scammers hand during trading no fit help those their friends buy bitcoin and save them from scammers? Or their friends no know say them deh into cryptocurrency? I no understand. Abi na the same high rate thing deh cause am?
Na high rate dey kill many people. When legit traders give good rate them go say e too low them wan sell for 600 per dollar. Sometimes he dey make me laugh na greed na carry them go jam fraudsters. How you expect to make so much gain when others dey sell a fixed price. Use your instincts
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
If na off exchange Marchant, make sure you know who u dey trade with, check well out of your friends you must get someone wey dey into this exchange business or sabi legit person. Patronize them make u no go dey cry later, again forget high rate na wetin dey make person fall victim pass for this street.

Wetin this rush for high rate go cause no go be small thing o. Make I even ask, all this our people weh deh talk of their friends weh fall into scammers hand during trading no fit help those their friends buy bitcoin and save them from scammers? Or their friends no know say them deh into cryptocurrency? I no understand. Abi na the same high rate thing deh cause am?
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Avoid all those high rate them make e no be regret later.

If na off exchange Marchant, make sure you know who u dey trade with, check well out of your friends you must get someone wey dey into this exchange business or sabi legit person. Patronize them make u no go dey cry later, again forget high rate na wetin dey make person fall victim pass for this street.
Na 2ru yan be dis, I don fall victim to high rate tire them yapa for telegram na why I no dey bargain with trusted p2p once the rate dey cool 4 me I go just cash out forget the rest, most time na greed dey cause all dis loses becus seller wan get the highest rate.
Wen my own happen bank tell me say make I go report the fraud for EFCC abeg tell me no be to discard be that?
Na true talk be that, high rate na pure bait wey scammers keep. The high rate dey givee concern why person wan deliberately buy something higher. Again, e be like say e get wetin dem dey do to get the first front pages for binance. But e suppose be say na the most trusted vendors go appear first for p2p, but e be like the arrangement no follow trust. If say e follow e go make sense.

If you wan trade make you look out for buyer or seller with high volume of trade, this one na good hint.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Avoid all those high rate them make e no be regret later.

If na off exchange Marchant, make sure you know who u dey trade with, check well out of your friends you must get someone wey dey into this exchange business or sabi legit person. Patronize them make u no go dey cry later, again forget high rate na wetin dey make person fall victim pass for this street.
Na 2ru yan be dis, I don fall victim to high rate tire them yapa for telegram na why I no dey bargain with trusted p2p once the rate dey cool 4 me I go just cash out forget the rest, most time na greed dey cause all dis loses becus seller wan get the highest rate.
Wen my own happen bank tell me say make I go report the fraud for EFCC abeg tell me no be to discard be that?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Now my guy no fit tell bank say na bitcoin him sell give the guy because bank go just use am cash out and lock him account. My guy if confuse and dont know the next step to take.
If na on centralized exchange, tell the guy to report ham to the exchange customer care, very possible the guy never yet withdrawn the money, but no dey likely.

If na off exchange Marchant, make sure you know who u dey trade with, check well out of your friends you must get someone wey dey into this exchange business or sabi legit person. Patronize them make u no go dey cry later, again forget high rate na wetin dey make person fall victim pass for this street.
Assume Mr A no know me before, see Mr A ad for social media, WhatsApp Mr A say I wan buy bitcoin. Mr A sent me bitcoin and I sent him naira. But later, bank come deduct the money wey I sent Mr A due to the reason Cookdata post above. That go dey very complicated if na direct p2p. But I get you sa, you dey right.

For me, any buy or sell I wan do for direct p2p, I go prefer to use Nigerians wey dey do the business for this forum and dey reputed or the people wey I know him papa and Mama and yet I will be careful.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Scammers dy get new format everyday both in fiat and crypto and na the new trend weh guys dy use cheat person be this, please stay focus and shine your eye out there.

No be new format, e dey since. Dat person most dey work with a particular banker for the thing to happen so fast. We just need dey careful for this street as na wetin crypto be. This na another world all together, if you dey trade only use verified Marchant, e dey very easy to find them. If na Binance e get option to only see trade from verified Marchant. Avoid all those high rate them make e no be regret later.

If na off exchange Marchant, make sure you know who u dey trade with, check well out of your friends you must get someone wey dey into this exchange business or sabi legit person. Patronize them make u no go dey cry later, again forget high rate na wetin dey make person fall victim pass for this street.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Topic: New Alert tricks in p2p
So this my guy call me say they bank don lock him account afyer the money weh person transfer for am as him sell bitcoin give am was debited.
My guy bank debited him of ₦70,450 to guy weh him sell bitcoin give and the matter shock am enter as e be say they don settle their trade him and the guy, why be say bank go credit and come debit am again, the case rare abi.

My guy enter bank say make him go complain and e shock my guy say him bank don lock him account say him do fraud say person transfer money give am and him no settle wetin buy and since the guy went to his bank to complain, their bank forwarded the case to them and they have to flag my account after due process.

Now my guy no fit tell bank say na bitcoin him sell give the guy because bank go just use am cash out and lock him account. My guy if confuse and dont know the next step to take.

Scammers dy get new format everyday both in fiat and crypto and na the new trend weh guys dy use cheat person be this, please stay focus and shine your eye out there.
Crypto is scary sometimes especially with local vendors that are suppose to make things easier.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Wetin we dey hear and see for this our country don tire me. All man wan guy em fellow man. God forbids if am to scam someone pikin to be rich and successful. I keeping asking myself how this scammers go defraud people of their wealth and feel comfortable. No be juju be that.
I pray make person no scam our money japa cos na heartbreaking situation
hero member
Activity: 1008
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I hear say Binance don ban about 2 hundred Nigerian accounts to prevent fraud and money laundering, this one weak me why our people to dey desperate like this, make we wise up asap e get why.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I really no post am too spoil anybody's name since no be me be victim, but rather I post am so make we dey very careful because all this crypto-currency vendor wey you no dey sure of fit be scam i go recommend you deal with people way don already run business with you before, and the deal go on very smoothly na those one's you fit trust.

No problem if na like that you want am. Thank you. Na true say most times we deh fall victim because we deh look for high exchange rate and then forget say trap fit deh am. Scammers know say na wetin most people like and them go use am catch us. Me I know deh too find unnecessary high rate o. I only want to stick to the person weh I don deh use for long. That one deh give rest of mind. It is not good to deh change buyers like that because of small difference.
Jump to: